Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,195 members, 7,822,041 topics. Date: Thursday, 09 May 2024 at 03:34 AM

Man Wey Dey Reason - Literature (9) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Man Wey Dey Reason (549935 Views)

As E Dey Happen (pidgin Tory Wey Sweet Wella) / AS E DEY Happen(a Pidgin Story) / Ibo Boy Wey Like Yoruba (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (6) (7) (8) (9) (10) (11) (12) ... (112) (Reply) (Go Down)

Re: Man Wey Dey Reason by 001solar(m): 12:58pm On Mar 14, 2013
Loading.....
Re: Man Wey Dey Reason by 4kizo(m): 1:01pm On Mar 14, 2013
Oga flow nthg do u my man, abeg flow dy go jare
Re: Man Wey Dey Reason by johnwizey: 1:07pm On Mar 14, 2013
Ds brainbox remind me of my fwend,both of dem av d same character
Re: Man Wey Dey Reason by Josphine4good(f): 1:11pm On Mar 14, 2013
Flow u are the man, keep it up
Re: Man Wey Dey Reason by dayleke: 1:16pm On Mar 14, 2013
Nice one Flow,
U still got it,I dey ur back o.
Re: Man Wey Dey Reason by dayleke: 1:20pm On Mar 14, 2013
@HNB
Long time now,
Haven't seen u online in a while,hope u good..
I can see u getting ur Flow dose too.
Re: Man Wey Dey Reason by dayleke: 1:25pm On Mar 14, 2013
Flow when u go update na?

Flow in Man's voice,"don't worry,when I upload u go see am,"

U too much man...
Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 1:33pm On Mar 14, 2013
"guy, i don do one bad thing now now oh" Brainbox said to me as he came to meet me in the well where i was fetching more water. "wetin be d bad thing wey u do?" i inquired. "after i don do L101 for the Tin tomatoes, i wan come buy the kerosene because i no say i no go fit do L101 for the kerosene" Brainbox began.

"ehen, wetin com happen?" i inquired. "naso i com tell Nkiru say i wan buy half bottle of Kerosene oh, se com say funnel wey she go use pour am for my container no dey there, naso she com enter inside house say she wan go bring the funnel oh" Brainbox added. "ehen, continue" i said. "shebi u know say our kerosene container dey black, and person no go know weda something dey inside if person look am?" Brainbox said. "i know na" i responded. "as she go inside go bring the funnel, naso i com quick quick pour one bottle of kerosene inside our container" Brainbox added. "as i see say she go notice say i don thief one bottle of kerosene naso i com burst two pure water com pour am inside that bottle wey i empty" Brainbox explained.

"as she come, she com still sell my half bottle for me, everything com be one and half" Brainbox added. "Brainbox!! U be original thief oh, i pity the person wey go buy that bottle wey u full with water oh" i said. "the person stove go just blow like bomb" Brainbox said and we both laughed loudly.

4 Likes

Re: Man Wey Dey Reason by dayleke: 1:43pm On Mar 14, 2013
See like minds
Flow,u guys don "kolo" no be small

1 Like

Re: Man Wey Dey Reason by dayleke: 1:45pm On Mar 14, 2013
Flow how u come know say BB(Brainbox) go do L101for dia na?
Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 1:54pm On Mar 14, 2013
dayleke: Flow how u come know say BB(Brainbox) go do L101for dia na?


because i know the guy say him like that kin thing
Re: Man Wey Dey Reason by purpinkx(m): 2:07pm On Mar 14, 2013
Brainbox bad well well
Re: Man Wey Dey Reason by Nobody: 2:59pm On Mar 14, 2013
FLowbaba watin mke me dey like ur storey,na bcoz e dey dey original, u no send ''tushness'' @all. Me dey feel u, u dey ON POINT!!!

1 Like

Re: Man Wey Dey Reason by Nobody: 3:34pm On Mar 14, 2013
.
Re: Man Wey Dey Reason by donifez(m): 3:46pm On Mar 14, 2013
Brain box..d guy really get brain jare.
Re: Man Wey Dey Reason by Nobody: 4:06pm On Mar 14, 2013
Thumbs up flow,u are the purest
Re: Man Wey Dey Reason by 001solar(m): 4:23pm On Mar 14, 2013
Ur first trend na sex and woman, Dis one na waitin we go call am now !!! Flow i dey gbadun u jo make u dey flow dey go
Re: Man Wey Dey Reason by 4kizo(m): 4:57pm On Mar 14, 2013
Nthg yet? undecidedNthg yet?
Re: Man Wey Dey Reason by valboy20(m): 5:12pm On Mar 14, 2013
Flow...e be lyk say dx brainbox wan bad pass u o....anyway, cum gist us mur tori
Re: Man Wey Dey Reason by IZUKWU(m): 5:22pm On Mar 14, 2013
Flow try tidy kate naw
Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 5:32pm On Mar 14, 2013
It was time to eat. Too bad, i was paired with the ravenous Baba jay.

"have u finished preparing the paw paw?" Pkc asked me. "yes, but i want make we eat this rice finish before we go chop the P-square" i responded. "bring it like that, lets eat it together with the rice" Pkc ordered.

Pkc had a bad eating habit. His combination of food was deadly. When we were at Umunkoto, there was a day he came to our house with mangoes and he met us cooking beans. That day we ate the mangoes together with beans. He even bragged about eating Kuli Kuli together with bread. And now rice and paw paw? Oh my world!!

With a slice of Paw paw each in our hands, we ate the "not too delicious" rice Snoop cooked, the Paw paw made it very delicious. Bigie and Tupac came in and joined us.
I was determined to try to meet up with the great speed Baba jay was eating. The ratio was 2:1 spoon, not too bad.


After meal, "Flow make we go Ilya du Neked wire go drink Pammy use wash dis food down na" Brainbox suggested as I, Brainbox, Man, Snoop, Tupac and Bigie sat under the mango tree outside.


Ilya du Neked wire was the joint where kegite members like I and Brainbox met to "vibrate" and drink "Holy water". Vibrate was a Kegite terminology that meant Converse in English and Yan in pidgin English. Holy water was a kegite terminology that meant Palm wine in English and Pammy in pidgin English. I loved the Kegite club so much, not only because it was a worldwide club, but because they don't maim fellow human beings like the secret cults and fraternities, that was why i joined the club. Not only that, i joined the club because of the slangs they used in conversing(vibrating). I and Brainbox were regular customers at Ilya du Neked wire joint when we were at Umunkoto. The joint was located close to Poly Nekede.


"Snoop are u a kariabity? Who are wa?" I asked Snoop. "i am that kpokpoti entity that was librated from an animalee to an entity, that day D, time T, entities were made in fulani nassarawaly, when my chiefo of Ilya du Lake Nwebere baptized me and called me AB Snoop" Snoop introduced himself in Kegite slang. "why i no com know u na, i be entity from Ilya du Lake Nwebere sef, abi u no dey come meeting?" i queried. "i no dey too come oh" Snoop confessed. "Ab Snoop, shine me ur golden falangis" I said to Snoop and we shook hands in a Kegite style.


"i no understand this Chinese wey una dey speak here oh" Man complained. "na because u no be Kegite na, ur own department na rice and beans department na" I said.


An hour later, I, Snoop, Brainbox, Tupac and Bigie were off to Ilya du Neked wire "nasarawaly" not knowing the amount of "kariabilities" we would meet there.

3 Likes 1 Share

Re: Man Wey Dey Reason by Josphine4good(f): 5:45pm On Mar 14, 2013
Flow don't worry I will reward u for making my day, nice work

1 Like

Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 5:50pm On Mar 14, 2013
cheesy grin
001solar: Ur first trend na sex and woman, Dis one na waitin we go call am now !!! Flow i dey gbadun u jo make u dey flow dey go

call am nite of a thousand laugh, with FLOW
Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 5:52pm On Mar 14, 2013
Josphine4good: Flow don't worry I will reward u for making my day, nice work

Whats the reward? kiss

1 Like

Re: Man Wey Dey Reason by 4kizo(m): 6:13pm On Mar 14, 2013
Baba flow keske oshodicomprayon, dis is Ab 4kizo on my tentackle firing 2 unilag 2 walk nd stumble anota, kpokponki, ilya hama reminga my hauz, d godz,
Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 6:51pm On Mar 14, 2013
4kizo: Baba flow keske oshodicomprayon, dis is Ab 4kizo on my tentackle firing 2 unilag 2 walk nd stumble anota, kpokponki, ilya hama reminga my hauz, d godz,

Baba 4kizo u are so much jambraha, entity like amoir, walk minus stumble, may ur first son never resemble ur landlord. Daysis
Re: Man Wey Dey Reason by Josphine4good(f): 7:03pm On Mar 14, 2013
flow1759:

Whats the reward? kiss
it is a secret wink
Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 7:23pm On Mar 14, 2013
Josphine4good: it is a secret wink

i go tell my daddy, and i go tell my mummy, say u no wan give me kpomoh
Re: Man Wey Dey Reason by johnwizey: 7:57pm On Mar 14, 2013
Gud job flow.kip it up
Re: Man Wey Dey Reason by 4kizo(m): 8:10pm On Mar 14, 2013
flow1759:

Baba 4kizo u are so much jambraha, entity like amoir, walk minus stumble, may ur first son never resemble ur landlord. Daysis
2 al am karid in disco rumola shld fire dia numenclature 4 onward peacemass, any attemptd attempt on welamela atete 4rm any animalee nd his days shall b alaka dat of yaradua, may our days b alaka dat of methusela.
Re: Man Wey Dey Reason by arizona145(m): 8:13pm On Mar 14, 2013
"Snoop are u a kariabity? Who are wa?" I asked Snoop. "i am that kpokpoti entity that was librated from an animalee to an entity, that day D, time T, entities were made in fulani nassarawaly, when my chiefo of Ilya du Lake Nwebere baptized me and called me AB Snoop" Snoop introduced himself in Kegite slang. "why i no com know u na, i be entity from Ilya du Lake Nwebere sef, abi u no dey come meeting?" i queried. "i no dey too come oh" Snoop confessed. "Ab Snoop,
shine me ur golden falangis" I said toSnoop and we shook hands in a Kegite style.


I love this one die. I ‎​A̶̲̥̅♏ an entity from Ilya Tawingy (IMT) Enugu. I was trans abakpa, trans Emene, trans obiagu trans what I can not decode from animalia to mmadu on that day D 12th Sept 06 by AB chiefo Nnodim Miracle a.k.a Gazza. FLOW ABEG ASHINA ME UR GOLDEN FALLANGIES

1 Like 2 Shares

Re: Man Wey Dey Reason by 4kizo(m): 8:30pm On Mar 14, 2013
arizona145: "Snoop are u a kariabity? Who are wa?" I asked Snoop. "i am that kpokpoti entity that was librated from an animalee to an entity, that day D, time T, entities were made in fulani nassarawaly, when my chiefo of Ilya du Lake Nwebere baptized me and called me AB Snoop" Snoop introduced himself in Kegite slang. "why i no com know u na, i be entity from Ilya du Lake Nwebere sef, abi u no dey come meeting?" i queried. "i no dey too come oh" Snoop confessed. "Ab Snoop,
shine me ur golden falangis" I said toSnoop and we shook hands in a Kegite style.


I love this one die. I ‎​A̶̲̥̅♏ an entity from Ilya Tawingy (IMT) Enugu. I was trans abakpa, trans Emene, trans obiagu trans what I can not decode from animalia to mmadu on that day D 12th Sept 06 by AB chiefo Nnodim Miracle a.k.a Gazza. FLOW ABEG ASHINA ME UR GOLDEN FALLANGIES
kariability runneth2ru my chronosomes, any kwashiotic attempt on minawolus atete, i wil opendentia by fire. Ab 4kizo hama.

(1) (2) (3) ... (6) (7) (8) (9) (10) (11) (12) ... (112) (Reply)

BROKEN HEDGE By Toyin Taiwo / My Life On Campus (A True Life Story). / Red Ashes

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 36
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.