Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,155,812 members, 7,827,985 topics. Date: Tuesday, 14 May 2024 at 08:42 PM

Angela & Greg, A Touching Story In Pidgin English - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Angela & Greg, A Touching Story In Pidgin English (2310 Views)

That Moment When You Have To Woo A Lady In Pidgin Language. / Ekene And Judith, A True Life Sexual Story In Pidgin English / A Touching Story About Love ( Will Make You Cry ) (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Angela & Greg, A Touching Story In Pidgin English by Iceking1(m): 5:43pm On Feb 01, 2015
GREG When we come to the issue of love, believe me, na by the grace of God. Dem nor get expert for inside.

Anyone can fall. So, when some pipo say dem nor believe say love dey exist, nor blame dem. Dem don site pepper for their eye befor.

This na story of Greg wey be choir master for Anglican church (I nor go talk where the church dey) During their praise week for the church nai Angela wey her friend wey dey go the church invite for see am.

That evening, he suit up. Na so e BJ dey shine becos of the many hair cream wey e take rub am. Pipo dey sing and dance, Angela just dey wet in love for Greg. "Faith! Faith!! Who be that guy wey dey play keyboard?" Faith look her nai she look towards the choir stand.

E site Greg. "Oh! That dude? Greg! Nai be our choir master. Wetin doam?" Angela just dey lust for the guy. "No o! Nothing" Sometimes, e nor wrong for a girl to see guy wey she like make she go approach am.

No matter how flower fine reach, if e nor position eself well, no bird go cum pollinate am.

So, when you as a young babe see guy man wey make your leg dey shake, swallow your pride and walk up to him. Start a chat and from there, the guy go play the rest.

After the program that evening, Faith dey find Angela for inside the church when she finally meet her with Greg dey talk for front of church. Dem don exchange numbers.


Two months later, Greg and Angela don dey talk about marriage. Greg don go far with Angela. Dem two don familiarise demselves with their families. So, dem decide to start counselling for Angela dem church. The first day of the counselling, the pastor and deaconess wey wan take dem that day cum say make dem start with prayer.


The four of dem close eyes when the pastor say in Jesus name. All of dem say Amen. Dem pray finish nai dem start the counselling.


At the end of the couselling nai the deaconess call Greg go one corner tell am say, during the prayer, God reveal to her say Angela dey possessed. And she get spirit husband. Say if dem marry, the husband go torment am till he die. That night, Greg nor fit sleep.


Na so e twist and turn for bed all through befor e manage close eyes. Greg go river go catch fish. When e throw e hook inside the river, e cum dey wait. Small time nai the line begin to heavy.


As he pull the hook make e take the fish, nai be boa wey the fish turn to. Na so e shout wake up. Na dream. Greg begin shake as he close e eyes and start to pray.


My pipo, when you think something sleep, your mind get the ability to play for you for dream. Greg don already fall in love deeply.


And right now, e nor go fit turn back. But the way things be so, e just have to take care. He report the issue to he own pastor. Becos e own pastor want make e marry from the church.


That one cum advice Greg to stop the relationship. The next counselling class, Greg don already tell Angela say e nor want again.


But e nor get the boldness to tell her the reason cos the deaconess tell am say make e nor tell her say only she go tell her.


True true, on the next counselling, the deaconess cum tell Angela make she forget about Greg say God nor destine dem two to marry eachother.


Na charm the deaconess take tell Angela the word cos she just accept without a word. As she talk the word finish, na so Angela get up begin go.


Next thing na one slim fine babe nai waka enter the office. The deaconess cum call the girl sidon introduce her to Greg nai she tell Greg say this na the woman wey God destine for am. Greg just dey look.


The babe sidon. Next thing dem don dey relate. Like play, Greg marry the babe, Justina. Justina na the deaconess only girl pikin wey be double sist. See, dem say for this life, na wetin man get e dey use take dey find wetin e want. Na spiritual powers the deaconess use take influence Greg love for her daughter.


After the marriage, for more than two years, things cum dey go down for Greg. Dem drop am for work. Instrument renting wey e dey do cum dey experience setback.


If mixer nor spoil this week, Gen go get fault. E nor cum dey get show like befor. Things cum tight for dem.


One evening, befor Greg come back from evening service from church, Justina don pack her things comot from the house. She drop note say she nor go ever fit continue for this kain suffer make she nor go chop her tongue one day. Greg sidon for parlour dey cry. When he cry finish, nai e enter room say make e go prepare to go meet mama Justina to tell her say her daughter pack. Where e for dey find find pam slippers for bottom of e bed nai e eye jam something like wood. He bring am out. Na candle image of man and woman wey dem use red thread tie together. As e dey look the image, na so Angela picture dey enter e mind. He begin call Angela name. Na charm Justina mama use for am. Say, as long as that image dey under the bed wey Greg dey sleep, e nor go ever get e senses.


Na becos of the hardship wey befall Greg nai make Justina get fed up pack.


My prayer for us be say: If the sugar wey dey my mouth nai make ant dey gather my life to destroy me, baba God, take the sugar away make you replace am with honey. Amen.


My pipo, during the time wey God go take change the sugar to honey, things go rough o. So, endure.


Now Greg eye don clear, e don remember say e get Angela. E cum make enquiries on how to locate Angela cos after dem break up, heartbreak carry her go Warri. Right now, she dey date one EGTL worker.
Re: Angela & Greg, A Touching Story In Pidgin English by Iceking1(m): 5:45pm On Feb 01, 2015
Now, problem dey ground becos Greg say e wan marry Angela. E don come share this story here say make we advice am on what to do. Know the following. # Greg wed as in marry Justina for church o.


#Greg get evidence say na chemo mama Justina use for am wey make am drive Angela marry Justina.


Moreover, this two pipo na friends for this forum except Justina. So, we know say, Justina go see this matter.



For ladies, wetin unu get to tell Angela to do? Make she give Greg a second chance? Make she tell Greg say she don cross that bridge and no going back cos of her new guy? Or wetin unu get for mind? My pipo, when some kain things happen for person, we nor dey know how e be, till e reach us.



Make we talk to dem with love. Right now, Justina say she nor wan marry again. But the mama wey dey behid the chemo love say na lie she lie. Greg say e rather die than continue the marriage with Justina. I beg make unu put leg for this matter.


Remember say, that day for church, dem swear say na for better for worse o. Somebody say nothing God nor go fit do. Say God fit put fire for wet things. So, e fit let love grow for where love nor dey.


E cum add say make Greg go take e wife make dem go for deliverance and prayers. My pipo, nor be me talk that one. So, talk your own befor I go decide the issue. Greg, Angela, Justina (she nor dey this forum), make unu listen o. God nor dey come down cum talk to pipo.


Na men God dey send. Talk cheap. We know. Advice na free. That one na confam. But na to take am nai dear. Case begin... All my brainy forumites, oya let's do what we know how to do best.
Re: Angela & Greg, A Touching Story In Pidgin English by chiibekee(f): 5:58pm On Feb 01, 2015
Make Angela forgive Greg and go back to him because if God no destine the two of the, Angela for don marry that new warri guy before Greg charm go clear for I'm eye.
Re: Angela & Greg, A Touching Story In Pidgin English by ifex370(m): 10:13pm On Feb 01, 2015
.
Re: Angela & Greg, A Touching Story In Pidgin English by wizard007(m): 7:16pm On Feb 02, 2015
*E get as e be, to understand na common sense, shebi na baba GOD get the real power*

E dey obvious say Angela is meant for Greg, make the guy no slack, Angela just dey use that warri guy dey keep body and soul together her own mind sef no comot for Greg matter.

(1) (Reply)

Will You Eat This? (graphic Photo) / My Hillarious Experience In The UK / Guys! Which Language Is The Best For Wooing A Girl? English Or Your Mothertongue

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 34
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.