Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,161,028 members, 7,845,338 topics. Date: Thursday, 30 May 2024 at 03:53 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (29) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61411 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (26) (27) (28) (29) (30) (31) (32) ... (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by MyneWhite1(f): 5:59am On Mar 01, 2010
Thank you Adebayo and maedan.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 8:22am On Mar 01, 2010
myne-white dis ya pidgin-gramma no be yanga,
i like d way u take show back with enuf tr'anga,
shuo. . . i dey bow sotey i don dey la'nga,
ur rhymes sweet like correct soup of fresh fish & baa'nga,
just na, just na so u don blend finish enta d zanga. . . . . .

no be joke wen i say u get 2 mush swagga,
dis ya me-rix so ehn high man pass paraga,
b4 i been think sey u be small oyinbo maga,
see me so nah as i don become d ba'ga,
we gats meet wan day cuz i owe u wan harp lager,
abegi join me 4 collabo make we do small ragga. . . . . .

grin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:16am On Mar 01, 2010
Lol, @ Ruudie u wey be pidgin encyclopedia
You wan finish Myne White wey just join dis our media grin
I dey 100% sure she no go grab half of this ur reply
Dis one wey she be self-acclaimed vernacular-shy tongue
But truly truly she come dey pick up
And I sure say soon she fit carry d Broken English Cup
She be a confirmed quick student
She fit soon take over as Naija Luv Rhymes President wink.



shight, I told myself I'm done with the pidgin rhyming - but I guess one more won't hurt tongue
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by MyJoe: 4:26pm On Mar 01, 2010
maedan:

shight, I told myself I'm done with the pidgin rhyming - but I guess one more won't hurt tongue

No, you are not done with it. You are too good at it to quit. Reading you on this thread is like listening to Tchaikovsky. More. Puh-leeeze  wink cool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 5:59pm On Mar 01, 2010
MyJoe:

No, you are not done with it. You are too good at it to quit. Reading you on this thread is like listening to Tchaikovsky. More. Puh-leeeze  wink cool


Wow, MyJoe, thanks you grin cheesy. I don't even think I know who Tchaikovsky is, but I'm flattered!!
***blush blush****

Though after I was unceremoniously banned once I made up my mind to cut down on my intellectual and creative contributions to this forum. It hurts to be so unappreciated tongue cool. Now I just post to ease the boredom. But after a charming compliment like yours maybe I'll have a rethink wink.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by MyJoe: 6:10pm On Mar 01, 2010
Please do. These pidgin rhymes thrill me to no end.  wink Peter Ilyich Tchaikovsky (1840-1893) was a Russian classical composer, whose works are noted for melodic intensity, instrumental brilliance and dramatic evocation of moods. Just like your poems in this thread, I can't get enough of him.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 6:27pm On Mar 01, 2010
MyJoe:

Please do. These pidgin rhymes thrill me to no end.  wink Peter Ilyich Tchaikovsky (1840-1893) was a Russian classical composer, whose works are noted for melodic intensity, instrumental brilliance and dramatic evocation of moods. Just like your poems in this thread, I can't get enough of him.

Melodic intensity, instrumental brilliance and dramatic evocation of moods?? I think I like you grin wink. Ok Ok seriously though cheesy, I consider it a privilege to be able to "thrill" such well-read and culturally exposed individuals such as yourself (see, I'm good with flattery too grin) even with this our local pidgin delicacy. I will do my best not to disappoint ( takes a humble little bow) LOL.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by MyJoe: 12:16pm On Mar 02, 2010
^^^  grin grin grin. Yes, I am really flattered now. But I wasn't flattering you ocheesy Trusting you will continue to deliver.  cool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:14pm On Mar 02, 2010
dis no be matter 4 who sabi book,
or who pass who 4 cook,
e no get how u wan take shiddon look,
how u go sabi chess u no sabi rook,
2 show ya'self & take go turn took,
and if u wan tranga, shake na shook,
some people go sey na fluke,
sey na small matta 2 over-look,
even 4 bible e dey matthew, mark & even luke,
wether ya name na donald duke,
or mister thomas cook,
senator, president even common crook,
wen true luv show, my guy u don hook!

1 Like

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:22pm On Mar 02, 2010
chei see as pesin papa fall down dey cry,
ol' man hol' head full bucket with sigh,
mouth no fit open sef talkless 2 lie,
chop e no gree, small an im e pass bonga' 4 dry,
all wey full im head na to jus go die.
follow me look as bon'boy dey form shy,
ben' neck like akara wey don over-fry,
turn mugu misbehave like pesin wey don high,
wetin im see; small bobi', laps & thigh,
small thing remain e 4 dey up dey fly,
4 im mind e don reash heaven lef' we 4 sky
power no dey but still yet im wan dey try,
anything wen open, wan time im don buy,
enuf bank-boy formings with coat & tie,
so make baby dey believe sey im be guy,
queshun nyanfu but my brodaz i ask maka-why!?
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:43pm On Mar 02, 2010
RuuDie:

dis no be matter 4 who sabi book,
or who pass who 4 cook,
e no get how u wan take shiddon look,
how u go sabi chess u no sabi rook,
2 show ya'self & take go turn took,
and if u wan tranga, shake na shook,
some people go sey na fluke,
sey na small matta 2 over-look,
even 4 bible e dey matthew, mark & even luke,
wether ya name na donald duke,
or mister thomas cook,
senator, president even common crook,
wen true luv show, my guy u don hook!




OMG, this is like your best everrr!! I know I've said this before about other poems. But this is my current fave. Y'know, one of these days we should compile the best of the best and get it published for a wider followership. We might even start a pidgin love rhyme revolution. My pipu whaddaya say?? grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 10:28am On Mar 05, 2010
maedan:

Y'know, one of these days we should compile the best of the best and get it published for a wider followership. We might even start a pidgin love rhyme revolution. My pipu whaddaya say?? grin

as u talk d scope nice,
in fact e no do me surprise,
na tey'tey i don sabi sey u wise,
betta pikin wey im efri'day levelz dey rise,
& u no dey take eye see suffer or shii'se,
but dis kain thin' no go be like beans & rice,
plenty work, vex & sweat go dey we head as be d price.

but as e be nah, me no run,
if na 2 support!? me be numba 1,
life matta na turn by turn,
power no be 4 only pipu wey carr'ey gun,
man mus' wet 4 rain, dry with sun,
dis we poem write ehn na bo'ku fun,
plus join e correct to plant seed of corn,
2 take carr'ey betta message like fire burn,
elders, homies, babes dem even those wey still 2 born!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by efepro(m): 6:10pm On Mar 05, 2010
@maedan, this thread no go end like so
i like as una rhymes they flow,
abeg make we no break this bond
i like as we just dey tag along,
this place no be just our meeting zone
for me, e don be like our home ,

February na our 1st anniversary
That’s why I dey enjoy am like
my state bursary
make we join hands, run am in full force
like thirsty horse
running to get water from e source
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:30pm On Mar 05, 2010
efepro:

@maedan,

February na our 1st anniversary
That’s why I dey enjoy am like
my state bursary
make we join hands, run am in full force
like thirsty horse
running to get water from e source


well done efepro, you sef get the right mind
unlike those bad belle with them teeth wey dey grind
as e be say we don earn the recognition and worldwide applause
instead made them pray for d same, na to dey hiss and show their flaws
Talent na gift from above, make we hold am tight
cos some struggle to write, but them no get the God-given might cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid1(m): 7:45am On Mar 06, 2010
tpia.:








[B]HISSSS[/B]
Ode ni e. . .when you thru' with hissing, go hug a transformer.

Aje buruku!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by illusion2: 9:55am On Mar 06, 2010
semid+:

Ode ni e. . .when you thru' with hissing, go hug a transformer.

Becareful what you wish for. . . .she may actually go ahead & hug one. . . what would then happen ? undecided

God would then hold you responsible tongue
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid1(m): 10:34am On Mar 06, 2010
illusion2:

Becareful what you wish for. . .  .she may actually go ahead & hug one. . . what would then happen ?  undecided

God would then hold you responsible  tongue
Lol. . .The evil b!@tch should have been cremated a long time ago.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by illusion2: 12:46pm On Mar 06, 2010
semid+:

Lol. . .The evil naughty woman should have been cremated a long time ago.
Ol'boy you harsh o ! Anyway back to poetry. , rid the hate with your odes wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by efepro(m): 1:04pm On Mar 06, 2010
@semid+.i be wan say u get bad mouth
i come reason am say, i no know wetin u dey talk about,
E be like say u dey vex
4get d kwams make u avoid d stress.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid1(m): 1:08pm On Mar 06, 2010
efepro:

@semid+.i be wan say u get bad mouth
i come reason am say, i no know wetin u dey talk about,
E be like say u dey vex
4get d kwams make u avoid d stress.
Thanks jare. . .btw, I got your text message.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:40pm On Mar 06, 2010
semid+:

Lol. . .The evil b!@tch should have been cremated a long time ago.
shocked shocked

Of all the stuff I've read folks on NL wish upon her, that's the worst!!!! I had to dig back and figure out what this was all about.

But she made an error bringing it here. She should have just created a topic for it, like she usually does.

Though @ semid you get bad mouth oh. I wouldn't want to be on ur wrong side!!! Lmbo grin.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:53pm On Mar 08, 2010
2 years pass & we still dey try talk,
time jus dey go & e later come dawn,
as we try reash no how e go 4 2 work,
small small we begin turn,
around-around like hand ontop clock,
wetin jus remain na 2 pick race begin run,
fire down to dat boat wey stand yonder 4 dock,
try meet-up b4 moon come overthrow sun,
a'le'le so we no go miss road jam bad-luck
make e no be dat na only we no go remain 4 numba 1
wen other pipu don finalize, close door with bolt 7 lock. . . . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 7:12pm On Mar 08, 2010
plenty years don pass,
sotey i no fit count,
still i no know where i dey,
inside my mind efri'day i dey shed water,
becuz till tomorrow i no jus know,
wether truely i do like man pikin,
even though u no vex,
u no cry or yarn like e dey pain,
u say u understand,
say gap no dey look red eye,
space no dey fear face,
but no day wen i no ask myself,
shey na me s***t 4 shurch!?
na ony me use my hand kpai we love.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 9:49am On Mar 10, 2010
na only u fit make me no sleep,
na only u dey make me think deep,
na only u go make me cry like dem flog me whip,
na only u can fit 2 make me beg sotey a' begin creep,
na only u don fall me ya'kata like sumthin' wey dem sweep,
na only u be d she'kpe wey i wan dey sip,
na only u go send me msg my phone beep,
na only u i give allowance 2 pa'roll with my jeep,
na only u be d melecine wey i want 4 my drip,
na only u go bring rope & i carr'ey skip,
na only u don hang me up like cloth wey dem clip,
na only u be d babe wey dey make me trip,
na only u 4 dis life i wan hol' tight 4 keep. . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 1:12pm On Mar 10, 2010
i don tire 2 dey alone,
tie-heart keep like sey na stone. . .

i don tire 2 dey alone,
all d time na busy tone. . .

i don tire 2 dey alone,
even plus all d plenty numbas inside my fone. . .

i don tire 2 dey alone,
wen others with dem babe dey jollof 4 ozone. . .

i don tire 2 dey alone,
where dat babe wey i go call my own. . .

i don tire 2 dey alone,
Papa God abeg send me dat eve wen hol' my bone. . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:25pm On Mar 10, 2010
Aw, Ruudie, the two poems are so cute! True love is very sweet with the right person. Nevertheless, take am easy smiley.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 3:58pm On Mar 13, 2010
RuuDie:

na only u fit make me no sleep,
na only u dey make me think deep,
na only u go make me cry like dem flog me whip,
na only u can fit 2 make me beg sotey a' begin creep,
na only u don fall me ya'kata like sumthin' wey dem sweep,
na only u be d she'kpe wey i wan dey sip,
na only u go send me msg my phone beep,
na only u i give allowance 2 pa'roll with my jeep,
na only u be d melecine wey i want 4 my drip,
na only u go bring rope & i carr'ey skip,
na only u don hang me up like cloth wey dem clip,
na only u be d babe wey dey make me trip,
na only u 4 dis life i wan hol' tight 4 keep. . . .


u kno go kill pesin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 4:00pm On Mar 13, 2010
maedan:




OMG, this is like your best everrr!! I know I've said this before about other poems. But this is my current fave. Y'know, one of these days we should compile the best of the best and get it published for a wider followership. We might even start a pidgin love rhyme revolution. My pipu whaddaya say?? grin



i equally concur with u missress
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:55pm On Mar 16, 2010
i still dey wait,
& na here i go stand,
my leg no go pain,
lai lai my eyes no go red,
1 single sweat no go drop,
na u be my only loff,
all my heart na im u hol',
until ur eye open scope area,
see man wey tanda' here dey trip die,
bodi no go shake,
dis head go dey look up,
ahead ahead turbo,
no threaten, le'le 4 papa. . . .
i dey hia'
and i go wait till i late!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:56am On Mar 18, 2010
RuuDie:

i still dey wait,
& na here i go stand,
my leg no go pain,
lai lai my eyes no go red,
1 single sweat no go drop,
na u be my only loff,
all my heart na im u hol',
until your eye open scope area,
see man wey tanda' here dey trip die,
bodi no go shake,
dis head go dey look up,
ahead ahead turbo,
no threaten, le'le 4 papa. . . .
i dey hia'
and i go wait till i late!


wait till u late ke!!

true true you wan kpai?

which kain luv be dis wey wan make u die??

abeg life is for the living, make you live and let love grin

Cos plenty girls dey for outside, very easy to get like blackberry curve cheesy tongue grin.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:05pm On Mar 18, 2010
u no go ever undastand,
i sabi sey girls plenty like sand,
correct 1s dem boku 4 dis we land,
but until dis baby lef' my hand,
na 4 here i go dey stand.

mai'be u think sey i no get sense,
sey 1 omo jus put me 4 suspence,
or i just wan dey build wall of defence,
but i no need 2 look am with lens,
wetin don go na past tense,
4 me, dis baby over-try, so hence
no need 4 me 2 come dey turu'kpense.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 3:16pm On Mar 19, 2010
Ruudie, biko this no be rhyming contest
We all don gree se na you be the best
If to sey na competition be dis, na u go win
Me no go lie, I dey trip for your conc waffi pidgin
Even your rhymes dey flow effortlessly like river
Goose-bumps develop for my body & I begin dey shiver
Even sef my sista read am, na em she begin dey trip
Sotey b'flies for her stomach begin dey back-flip
Anyhow sha, she sey make I holla at you
Whether u and her fit relate, make you be her boo?

(1) (2) (3) ... (26) (27) (28) (29) (30) (31) (32) ... (40) (Reply)

Oyeku:story Of Lust,injustice, Destiny And Human Wickedness, 18+ / Nephilim / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 56
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.