Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,879 members, 7,810,368 topics. Date: Saturday, 27 April 2024 at 07:48 AM

Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest - Culture (11) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest (37388 Views)

Words From The Epie Language Of Yenagoa. / Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up / Pidgin Words, Meaning And Origin You Need To Know (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (8) (9) (10) (11) (12) (13) (14) (Reply) (Go Down)

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by adaksbullet: 9:46pm On Oct 01, 2018
Am just Dy looked all off una wey his Dy speek pijin, are u no no say pijin his orijin from ekiti grin


My ekiti ppl Dem, how far na grin
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Dead(m): 9:50pm On Oct 01, 2018
eduminati:

Tah shurrrrrup your mouth there. I be correct Warri boy. Okumagba area for that matter. Na area be pidgin for Nigeria. You get mind ooo. I graduate from Uniben and Benin no get level at all for pidgin. I come here with full attack and I mean am well.

Warri people go say "na pikin wey no know the value of toto dey pack sand put." Na Warri be number one so you better put the respeck for our name. If you be area Abeg like am. I use this medium to hail our ogbe Ijaw, ekurede urhobo, ekurede Itsekiri, Okumagba, agbassa, iyara, edjeba, ugborikoko people etc. You no dey match line at all.

Benin, ph, Bayelsa dey trek for where we dey.
The pidgin wen you dey brag put, dey kere, how e take enter warri? Abi dey born you with pidgin? You just dey carry yarn, who no go, no know.
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Dead(m): 9:57pm On Oct 01, 2018
BlindAngel:



I tire for the guy mata ooo, just dey yarn dust... bini that they speak only bini only, that guy funny sha
you are not only a blindangel, you are also deaf. Were you no for Benin, when you dey missyarn. For my area sef, we dey forget say we get language. Who no go, no know.

2 Likes

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Odunharry(m): 9:58pm On Oct 01, 2018
ibkayee:

The streets
LOL. I see you, your face show well like campaign poster for street. How that way na? Hope nobody dey give you gbege there?
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 10:08pm On Oct 01, 2018
kenchizzy:
RUGGED YOU
Correct Kappin
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 10:08pm On Oct 01, 2018
kenchizzy:
RUGGED YOU
Correct Kappin
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 10:12pm On Oct 01, 2018
adaksbullet:
Am just Dy looked all off una wey his Dy speek pijin, are u no no say pijin his orijin from ekiti grin


My ekiti ppl Dem, how far na grin

Na joke bi dis Abi?
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 10:19pm On Oct 01, 2018
Ishilove:
You speak in esoteric tongues... undecided
No bi so o! Where are you from sef
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by beetown(m): 10:21pm On Oct 01, 2018
IamZod:
Oma Beetown, make u balling here o.

Na unto pidgin levels, make we sef rep Ugh city.


unto Pidgin lol.

we die here na.
ughelli city for the win.
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 10:25pm On Oct 01, 2018
bomasek:
I understand wetin the manchi talk,nothing eso or teric der

You no go fit quote her wen u not go insult me? Una Nairalanders sef ehn.
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 10:26pm On Oct 01, 2018
Youngetskilz23:
angry Omor today get as be oh mehn. Me and my PADI we just ball in another town , we jam some old time nigas , na so we deck for one side we dey brew monkey tail, they shayo dey go plus arizona Omor no be small thing boys don high wella. We just dey laugh they gist dey go, as e be like this eh. Pressure dey our body . Men don dey cap careless. Based on say today na 9ja birthday we dey celebrate ooo. Like this like this we no no when the shayo go quench.. we just dey jolly they go. My people na so my day be today oo . Updates brekete for ground.. make una stay tuned. Reporting live from alode Eleme pH city

Confam Pitakwa boy.
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 10:31pm On Oct 01, 2018
Ishilove:
Ofurukpe nigga...what does this mean?
Pidgin : Ofurukpe Nigga English: Pussy ass Nigga
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by cadre88(m): 10:32pm On Oct 01, 2018
Why you comment untop the post. You wan make popo catch you?
Anduku:
Nonsense
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Nobodys(f): 10:43pm On Oct 01, 2018
chaiiiiiiiiiiii, see better thread. kikikiki...I miss warri die. when you see small children dey speak correct pidgin, fear go catch u.....

1 Like

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 10:53pm On Oct 01, 2018
cadre88:
Why you comment untop the post. You wan make popo catch you?

Help me tell am o
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Nobody: 11:01pm On Oct 01, 2018
Mizwisdom:
Pipu wey de speak pidgin as language no de for here, wey ma Ikom, Ogoja, Obudu, Bekwarra pipu? Make una no mind these local champions wey full for here de speak slangs wey no get head dem no no how far.
we full ground my banni, ikom all the way

1 Like

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 11:01pm On Oct 01, 2018
Decapo:


This isn’t pure pidgin bros...you’re an adventurer wida u aro

Na u Sabi! Pidgin is a language it absorbs things from around it. it just so happens that Cultism is like a way of life in the South where pidgin is Gallant. if u wan judge me say I be Aro then go judge everybody for Bayelsa including middle aged people and children weh no go fit talk if they no add Wida.

1 Like

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 11:04pm On Oct 01, 2018
WHIZKIDEFE:
Oboy, see as men don yan everywhere full, choi.

Ona langua dey make me wan laugh my liver-pull.. cheesy ..

I greet the house oh!

Op, dis race wey you start so, you fit finish am so? To give monkey tea for cup easy oh, na to collect the cup back from am yawa go dey.

Make I relax dey observe how the go dey go for here..

Make E for nor loss,
Happy Independence to Naija! E nor easy.

Omen Me sef don de jam head sef o. the tin do hook me I no bin knw seh e go make Front page
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Nobody: 11:39pm On Oct 01, 2018
beetown:

unto Pidgin lol.

we die here na.
ughelli city for the win.
I dey tell u Okohgrin
shey u tear every every today?
I trust say everywhere pepperli for ur location..


Omo na full voltage we go sama men for here. LOL
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by joyhoney(f): 11:42pm On Oct 01, 2018
joyhoney:



correct guy! bros u dey there die
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by AgricStore: 11:43pm On Oct 01, 2018
tonzo:
Pele(sapele)naim be d ogbonge home of pidgin langua
How Una Marra be for here sef
No be say dem say ,I rep waff city.happy miliki to our obodo naija today.
As we dey shayo today make we use we ankaras take do evri sofri sofri.ekelebe no get say to dey if dem do anyhow dem go do go collect anyhow.

Driver dropping dey,make I enta Hausa quarters go change 100dolomi to naija kpogiri
I hail all the Sabi people for this Kuban

A better translation

Sapele is the original home of the pidgin English.
What's up with you guys?
It's not merely heresay, I represent warri. Happy Celebration to our country Nigeria today.

As we drink, let's use our senses and do things in moderation. The police don't know that if they trouble us, we will trouble them right back.

Driver, i want to alight. I am going to the Hausa Quarters to change my $100 dollars to Nigerian currency.

My regards to everyone on this thread.

grin

1 Like

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Ahmed99: 11:44pm On Oct 01, 2018
make una relax...i rep ph city first first no reason d matter, we kno say na benin get d pidgin buh we self we no dey learn no be say dem shoot bird e mama fly, na legit matter i dey yarn and for dose Wey cari our matter for head like Gala abeg shleve am unless u go collect..notin commout
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by BraniacX(m): 11:59pm On Oct 01, 2018
Esseite:


Wait oo, dem de speak pigin for parliament too? grin grin... or your own parliament mean something else?
Unofficial parliament nah.....assin where brosses congregate

1 Like

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by BraniacX(m): 12:08am On Oct 02, 2018
Ishilove:

Ofurukpe nigga...what does this mean?
Ofurukpe means those insects that fly into flames and bulbs trying to put them out in urhobo/isoko, so, you can say it interpretes as some little insect of a guy trying to put out our flame/fun/joy depending on the context, most importantly they end up getting burnt without anyone's assistance so its a subtle shade

1 Like

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by BraniacX(m): 12:20am On Oct 02, 2018
Ishilove:

Oh okay. It reads like furo adiye
You don too stay Lagos aswear

1 Like

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by bomasek(m): 6:19am On Oct 02, 2018
Sinistami:


You no go fit quote her wen u not go insult me? Una Nairalanders sef ehn.
So u dey claim warri but u no sabi wetin manchi mean,ask pH person to tell u.
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by ucheuzor1(m): 6:28am On Oct 02, 2018
I represent warri wella. The truth be say person no fit type words the way warri boys dey pronounce am. Keyboard dey limit the flow.

For example bread, rice, break, craise. The way me dey pronounce am, guys around me dey find am funny. I gat repeat am wella before Dem decode.


Base on everything eh, I go like guys to tell me wetin be;

Koto, gbete, flegbe, Congo meat.
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 6:29am On Oct 02, 2018
bomasek:
So u dey claim warri but u no sabi wetin manchi mean,ask pH person to tell u.

Who tell you say I no knw wetin Manchi mean? Na guy e mean na! I no just like wen pesin de use am for me because e get the way you go take put am. and I no de form Warri Mi na Bayelsan Yenagoa born and Bred.
You knw say for America you fit tell person say are you mad meaning are you angry but Naija you no go fit try am o. shey yu de get na.

1 Like

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 6:44am On Oct 02, 2018
Which Mode put this Thread for FP sef. where im de make I for Flex am for Bukka. But serious Na my first thread be this wen don Nak FP o. Thankgod Sha.
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by bomasek(m): 6:44am On Oct 02, 2018
Sinistami:


Who tell you say I no knw wetin Manchi mean? Na guy e mean na! I no just like wen pesin de use am for me because e get the way you go take put am. and I no de form Warri Mi na Bayelsan Yenagoa born and Bred.
You knw say for America you fit tell person say are you mad meaning are you angry but Naija you no go fit try am o. shey yu de get na.
Guy so u mean calling person my guy puts u off,no reply me cause I just wake. No point going back n forth with u
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 6:47am On Oct 02, 2018
bomasek:
Guy so u mean calling person my guy puts u off,no reply me cause I just wake. No point going back n forth with u

Yu nor go Undastand. e de sound like Maga for My ear
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by SultanYoung: 6:58am On Oct 02, 2018
Sinistami:


I bin think say Pepperoni don move komot Ekeki naw
oya we go lap for opolo

(1) (2) (3) ... (8) (9) (10) (11) (12) (13) (14) (Reply)

Olu Of Warri, Wife Holiday In Ghana, Meet President Akufo-Addo (Photos) / Oba Of Benin Detains Nelson Oghogho, Palace Aide (Photos) / I Removed 800-year-old Palace Deity As I’m Above Idols –oluwo Of Iwo

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 37
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.