Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,420 members, 7,815,950 topics. Date: Thursday, 02 May 2024 at 09:54 PM

My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... - Crime (622) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Crime / My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... (3064631 Views)

"New Generational" Aye Cult Member Addresses His Colleagues In A Viral Video / Ikorodu Cult Group Kills A Rival Cult Member (Disturbing Video) / My Story As A Cult Member, Initiation Phase Included (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (619) (620) (621) (622) (623) (624) (625) ... (643) (Reply) (Go Down)

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Shakathezulu1: 9:32am On Dec 09, 2023
ekene101:
Even the police and vigilante don belong,na them dey pull most of these hits for their confra.

Benin wey be minority still dey kpai dem selves mumu people.

More than 14 people have gone down since my last update but I chose not to post it because nobody dey pay me,who get sense make him hear.

But sentiment aside,this aye people are the problem everywhere,they are always the first to knack which leads to these unnecessary kpaings. Make them dey use their sense sometimes, everything no be violence,if dem knack dem now, dem go say no be their member.

U wey won go join aye, dem Sabi deny casualty,if dem knack na legit,but if dem knack u or any of their member,d person na Jew according to them.

I no tell you say others good o,abeg run from even town hall meeting talkless of anything colour. Dem go post u here if u no get sense.
Aye don do this one strong thing. Buhahahahahahahahahaha
Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Hardcore11: 12:20pm On Dec 09, 2023
freshkpomo:



It does but hardly do you see it exceed a month, their traditional leaders and vigilante are quick to wade into it and make peace.. they understand the pain of loosing a fellow tribesman and it's impact on the survival of the whole tribe in a country currently facing extermination from Sahel forces!
true

1 Like

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Nobody: 9:57pm On Dec 09, 2023
ekene101:
Even the police and vigilante don belong,na them dey pull most of these hits for their confra.

Benin wey be minority still dey kpai dem selves mumu people.

More than 14 people have gone down since my last update but I chose not to post it because nobody dey pay me,who get sense make him hear.

But sentiment aside,this aye people are the problem everywhere,they are always the first to knack which leads to these unnecessary kpaings. Make them dey use their sense sometimes, everything no be violence,if dem knack dem now, dem go say no be their member.

U wey won go join aye, dem Sabi deny casualty,if dem knack na legit,but if dem knack u or any of their member,d person na Jew according to them.

I no tell you say others good o,abeg run from even town hall meeting talkless of anything colour. Dem go post u here if u no get sense.
Na ayes nd eiye be the problem of cult violence for naija both other group lyk vikings make dey initiate riffraff nd illiterate, see ehh for where i grow nothing lyk alora or 22 dem nor born dem well na only eiye aye nd bagger dey make noise most especially eiye, very loud individuals nd d funny tin be say no sch for d area none of dem be undergraduate or graduate but u go dey hear ibk up nd down even nest up nd down,nd i been think say nest na sch.Funny tin b say if u see d way eiye dey argue ot eh e come b lyk say na different eiye dem join 😂 i just dey tire for dem at times na only bucca 22 na some other unpopular frat na i nor too sabi unto say dem nor too get level for south south, but u see eiye vikings nd ayes nothing u wan tell me dem nor get anything to offer period.

3 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by ekene101: 9:21am On Dec 10, 2023
Shakathezulu1:

Aye don do this one strong thing. Buhahahahahahahahahaha
only strong thing dem do me be say dem make town unsafe for everyone, person no fit dey go certain places for fear of wrong identity.

Me wey dey Waka freely and aye men wey all of dem don run go gather for one of their member location for fear of beheading from almost 3cults dem dey problems currently with who dey see strong thing?

Strong man strong man,but una dey hide, dey use external dey pull hit make dem no identify una, yet dem still dey kpai them.

Eiye don still kpai this one for Benin.

3 Likes 1 Share

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Makamatic: 1:22pm On Dec 10, 2023
ekene101:
bros no be carry talk matter, I believe say Auchi people still dey here dey read update.

Ayes don bam almost all the whole bike men for Auchi finish,minus those igarra bike men o, because those ones na eiye or jurist dem the do.

I mean aboki real aboki. The one wey dem shoot for ehekhi girls road close to Suleiman street wey cause war some months ago,na better aboki.

Person no know who be who again for the auchi lifestyle like this. No go carry dey mend person wey u no know o.

Confirm ... U know the matter .. all those indigene wey get small money and them never buy car get special bikemen wey they carry them and them they pay . You go see bike man carry them go outing , they go they order for themselves , bike man go they order too , they show am things , him go park him bike , them go still give am 10k if him drop them for house . Free 10k plus enjoyment and highness . Las Las aboki done they know one or two , them done blend am , him done join cult . Them go they use him bike for movement . Aye and Baga done spoil auchi bike men

4 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by ekene101: 2:02pm On Dec 10, 2023
Makamatic:


Confirm ... U know the matter .. all those indigene wey get small money and them never buy car get special bikemen wey they carry them and them they pay . You go see bike man carry them go outing , they go they order for themselves , bike man go they order too , they show am things , him go park him bike , them go still give am 10k if him drop them for house . Free 10k plus enjoyment and highness . Las Las aboki done they know one or two , them done blend am , him done join cult . Them go they use him bike for movement . Aye and Baga done spoil auchi bike men
ThankGod say another person don confirm am.

Dem go map person or won go drop am,na bike men dey wait them wey go carry dem escape.

Bike man go dey sync u won know if u dey game make dem go cast u and carry dem to ur location for dropping.

Auchi don finish unto confra matter,na just say Auchi king no dey give them the opportunity just as oba silent. If not Auchi for too worst.

5 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Neddstark: 3:46pm On Dec 10, 2023
So e don reach level say una dey blend aboki wey no sabi speak common grammar. So for convention illiterate Aboki go dey follow me dey anchor, claw and knack egede because we dey the same frat.
Cultism don enter gutter i swear.
Una welldone o.

10 Likes 1 Share

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Hardcore11: 5:54pm On Dec 10, 2023
Neddstark:
So e don reach level say una dey blend aboki wey no sabi speak common grammar. So for convention illiterate Aboki go dey follow me dey anchor, claw and knack egede because we dey the same frat.
Cultism don enter gutter i swear.
Una welldone o.
see finished done full cultism since them carry am enter street. Imagine dirty aboki wen dey ride bike na Axe man. It is finished grin

3 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Shakathezulu1: 6:17pm On Dec 10, 2023
ekene101:
only strong thing dem do me be say dem make town unsafe for everyone, person no fit dey go certain places for fear of wrong identity.

Me wey dey Waka freely and aye men wey all of dem don run go gather for one of their member location for fear of beheading from almost 3cults dem dey problems currently with who dey see strong thing?

Strong man strong man,but una dey hide, dey use external dey pull hit make dem no identify una, yet dem still dey kpai them.

Eiye don still kpai this one for Benin.
As I said, Ayes don do you strong thing. Sorry oh.
Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by EducatedMind369: 6:40pm On Dec 10, 2023
Just found out one of my roommate was forcefully initiated yesterday night. This is scary. Now he's scared, everyone in the room is scared.

Nawa o.

8 Likes 2 Shares

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by JasperVII(m): 7:16pm On Dec 10, 2023
EducatedMind369:
Just found out one of my roommate was forcefully initiated yesterday night. This is scary. Now he's scared, everyone in the room is scared.

Nawa o.
Better find somewhere else and pack to. Fast.

2 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by EducatedMind369: 7:35pm On Dec 10, 2023
JasperVII:

Better find somewhere else and pack to. Fast.
We all live in the school's hostel. I don't have anywhere to go.

2 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Neddstark: 8:07pm On Dec 10, 2023
EducatedMind369:
Just found out one of my roommate was forcefully initiated yesterday night. This is scary. Now he's scared, everyone in the room is scared.

Nawa o.

Forcebamming. If na SW, na Eiye. If na SS or SE na Baggers.
If you can subtly advice him to leave the school. Even his parents will understand. I know several folks who left their institution because of cultism and are doing fine right now. Life is most precious.

8 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by freshkpomo(m): 8:26pm On Dec 10, 2023
Neddstark:


Forcebamming. If na SW, na Eiye. If na SS or SE na Baggers.
If you can subtly advice him to leave the school. Even his parents will understand. I know several folks who left their institution because of cultism and are doing fine right now. Life is most precious.


This your advise clear. Two dudes were kidnapped and initiated by Eiye in colben, one left school and is still alive till today, the other stayed and continue with his work as a pastor and dude nor last 3 months. In Uniben, 3 dude were force bammed, two Left school, one to uniport and the other to a private university but the third that stayed back feeling no one knew him died like a chicken in a couple of weeks

7 Likes 1 Share

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by EducatedMind369: 8:49pm On Dec 10, 2023
Neddstark:


Forcebamming. If na SW, na Eiye. If na SS or SE na Baggers.
If you can subtly advice him to leave the school. Even his parents will understand. I know several folks who left their institution because of cultism and are doing fine right now. Life is most precious.
happened In Ekosodin actually.
Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Dynasticemperor: 8:14am On Dec 11, 2023
freshkpomo:



This your advise clear. [b]Two dudes were kidnapped and initiated [/b]by Eiye in colben, one left school and is still alive till today, the other stayed and continue with his work as a pastor and dude nor last 3 months. In Uniben, 3 dude were force bammed, two Left school, one to uniport and the other to a private university but the third that stayed back feeling no one knew him died like a chicken in a couple of weeks

This your story sound sketchy, no go talk this thing for where people dey make them no go laff you, even if you go police station go report this matter self them no go reason you. Kidnapped and forcefully initiated for confra wey only them carry their leg go join grin grin
Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by freshkpomo(m): 8:42am On Dec 11, 2023
Dynasticemperor:

This your story sound sketchy, no go talk this thing for where people dey make them no go laff you, even if you go police station go report this matter self them no go reason you. Kidnapped and forcefully initiated for confra wey only them carry their leg go join grin grin


The name of the school is there, they went to his room and kidnapped him through the ceiling, in their way they met some guys going to night vigil them pack them join too. I won't go too far because I know this particular boy it happened to. His big bro was my friend and he was and Eiye man and was disappointed what they did to his kid bro, na him use him hand go pack him kid bro property from school as the boy never set foot in that school again.

2 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by freshkpomo(m): 8:45am On Dec 11, 2023
EducatedMind369:
happened In Ekosodin actually.


Your friend better drop out and go elsewhere to get a good life as him never too stain so if not him nor go last. When them go din dey visit am for hostel and lecture hall by then him ID don cast abd even if him relocate then him go still find am hard to hide. School full Everywhere and na who dey alive dey go school.

10 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by ekene101: 11:08am On Dec 11, 2023
Shakathezulu1:

As I said, Ayes don do you strong thing. Sorry oh.
me and them,who dem dey behead daily?

8 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Makamatic: 11:49am On Dec 11, 2023
Shakathezulu1:

As I said, Ayes don do you strong thing. Sorry oh.

Aye no do am anything , na truth him they talk .. see that their number 1 man wey them pick for ekpoma last year , shebi last last them done pull string release am but him no graduate . Now him they ekp but no they go school , him no fit follow him temple members do thing again because a whole kpoai na him them go come they wembly if e Bleep up . Now na zone e they follow do things . They follow small children up and down they K alignment . School done close for am so , na alignment and thug they help am and you know ekpoma matter , them no they gree kill indigene if e set , na outsider them they kill .

12 Likes 1 Share

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by ekene101: 4:09pm On Dec 11, 2023
Makamatic:


Aye no do am anything , na truth him they talk .. see that their number 1 man wey them pick for ekpoma last year , shebi last last them done pull string release am but him no graduate . Now him they ekp but no they go school , him no fit follow him temple members do thing again because a whole kpoai na him them go come they wembly if e Bleep up . Now na zone e they follow do things . They follow small children up and down they K alignment . School done close for am so , na alignment and thug they help am and you know ekpoma matter , them no they gree kill indigene if e set , na outsider them they kill .
leave am make he dey cap rubbish. Only him confra for Edo state get war with almost 4 other confra, even eiye wey dey loosegad die due to their numbers and illiteracy don kpai two of them after them kpai that guy wey I post wey him head and leg dey backo bag.

Them dey deny say na Jew them be. Na online dem dey form iron man, even for Owerri baggers fall former axehead,him brother run come the scene with axe begin mumu himself dey chase people,yet them say no be their member na Jew.

Very funny set of confra wey dey start wetin dem no fit finish.

No confra good,all na death trap just as e be cult,na just to cut your life short but you see this ayes, Na black goat them truly be wey no get sense,before eiye, maphites and baggers.

Make he no worry,dem go still post am here after small pikin don behead am, as he no won get sense. Online ironman.

9 Likes 3 Shares

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Shakathezulu1: 5:41pm On Dec 11, 2023
Makamatic:


Aye no do am anything , na truth him they talk .. see that their number 1 man wey them pick for ekpoma last year , shebi last last them done pull string release am but him no graduate . Now him they ekp but no they go school , him no fit follow him temple members do thing again because a whole kpoai na him them go come they wembly if e Bleep up . Now na zone e they follow do things . They follow small children up and down they K alignment . School done close for am so , na alignment and thug they help am and you know ekpoma matter , them no they gree kill indigene if e set , na outsider them they kill .
Who ask you all this story. Cho cho cho like bird. Rest Oga.

If anyone must blame any cult, blame all, instead of picking a side.
Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Shakathezulu1: 5:43pm On Dec 11, 2023
ekene101:
me and them,who dem dey behead daily?
Allow them to dey behead theirselves dey go now.
Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Makamatic: 6:37pm On Dec 11, 2023
Shakathezulu1:

Who ask you all this story. Cho cho cho like bird. Rest Oga.

If anyone must blame any cult, blame all, instead of picking a side.

Who be this man wey they follow me they yarn shafa talk . You think say any confra na good thing . U never see things , u done they ur uncle go they shout for dream say them wan kill am , u done they blood of people wey u done fall go they disturb u , u done they them flog u jazz for sleep u wake see that place done swell up them attack u cuz them no fit kill u physically . Beta leave aye cause last last if u die , if them deny u finish , them go still call u obote .

13 Likes 3 Shares

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by freshkpomo(m): 7:39pm On Dec 11, 2023
Makamatic:


Who be this man wey they follow me they yarn shafa talk . You think say any confra na good thing . U never see things , u done they ur uncle go they shout for dream.


The one when them nor deny them go dey laugh am say him loose guard like one when currently dey rant for Alex page currently. The Aye them kill for Ogida na so them say him loose guard too say why him go come out when war dey, imagine family man make him nor come find wetin wife and pikin go chop because say him join una useless cult. Na where the man dey cut ticket na him one Camry drive come blow am. All the Ayes when die from this lagbaja Matter plan Christmas with their family oh, but their mumu brothers go gamble somewhere with their lives and this type of thing is always common with black ass, they do before them think. Them dey mock Eiye say them nor dey coordinated but it seems na them worse because many times them dey always first pull hit dey form super man at the end na own goal them score..

Make we see truth dey talk am, aye nor dey try and even some of their members don dey shame for their actions and currently the only people when dey join Aye na bike men and HK boys and those community boys when dey so land grabbing thugs. I am not endorsing any cult group but some cult dey when their members get small peace of mind but you see Aye, from north to south their members nor dey get peace. As a Benin person I dey use hand hold head anywhere I travel go because I don notice them dey use Aye eye look Benin people well well the way they feel all Yorubas are Eiye and all igbos are Vikings.


The day we drop color na that day you go know say that Eiye guy or aye guy love you die and fit die for you. I saw what the youths dis with endsars, how they dropped colours to fight with one voice, I just watched a video from Benin today and I felt irritated how Benin youth will slaughter another Benin youth and stand there watching him roll in pain till he dies. The question now is WHO IS YOUR BROTHER?

16 Likes 3 Shares

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Hardcore11: 7:40pm On Dec 11, 2023
Makamatic:


Who be this man wey they follow me they yarn shafa talk . You think say any confra na good thing . U never see things , u done they ur uncle go they shout for dream say them wan kill am , u done they blood of people wey u done fall go they disturb u , u done they them flog u jazz for sleep u wake see that place done swell up them attack u cuz them no fit kill u physically . Beta leave aye cause last last if u die , if them deny u finish , them go still call u obote .
na wa wahala many
Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Shakathezulu1: 8:29pm On Dec 11, 2023
Makamatic:


Who be this man wey they follow me they yarn shafa talk . You think say any confra na good thing . U never see things , u done they ur uncle go they shout for dream say them wan kill am , u done they blood of people wey u done fall go they disturb u , u done they them flog u jazz for sleep u wake see that place done swell up them attack u cuz them no fit kill u physically . Beta leave aye cause last last if u die , if them deny u finish , them go still call u obote .
How old are you. If you are over 18, then shame on you. How can a man be ranting like this.
If no be say, na 1diot, you be. So na only Aye dey disturb everywhere. Be like say, Aye don do you strong thing.
Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by CANADIANWEED: 9:26pm On Dec 11, 2023
Shakathezulu1:

How old are you. If you are over 18, then shame on you. How can a man be ranting like this.
If no be say, na 1diot, you be. So na only Aye dey disturb everywhere. Be like say, Aye don do you strong thing.
U this guy make dey defend aye up and down abeg make i ask you, ayes dey pay u to defend them? grin

5 Likes 2 Shares

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Makamatic: 1:49am On Dec 12, 2023
Hardcore11:
na wa wahala many

Omo bros ... Wetin my uncle go through as a rugged man wey them use as thug for Edo elections , them still give am ticket make him boys they sell which is to show u how rugged e be to they Waka with politician. we thank goodness for him life . When we small My papa na him they always bail am from police and prison because him loyal to am die , if my papa call am 2 am , he go deliver . When my uncle start to they see thing , him almost run mad , na from one church to another for deliverance , him done spend money for juju , now na money for church , Las Las na one small pastor for ogida wey get anointing diliver am . Since then my uncle no they miss church oo . When one small boy follow am talk anyhow na wetin him tell the small boy shock me " him say na this peace wey I use blood , tears and sorrow find , nothing go take am away from me " afta all the hardman and years of violence , juju and things he still find peace , peace wey him no consider for him youth . Last last at old age him use tears and sadness find the peace .

22 Likes 2 Shares

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by ekene101: 7:52am On Dec 12, 2023
Dem don still kpai another aye. This one dey here dey hype dem from where him dey hide him head. See as people dey look am dey struggle with him life just few weeks to new year.

2 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by gamechanger547: 8:54am On Dec 12, 2023
Dem no dey tell person na wen e reach person we no dey hear advice turn him go know say life no get part 2.

Every frat get Educated ones and illiterates, Every frat get rich folks and poor, Every frat get tools.

Every frat get stubborn ones and gentle ones, Every frat get Judas, Every frat get cowards too but most members no go gree tell you the truth but na to dey pant another frat black or red!

Let be candid, confraternity has majorly gone to the dogs!! No gain but deaths and maiming. People are dying 💀 almost on daily basis due to cultism and 90% of these deaths go unreported. Even some people frat dey deny dem as members when they get killed just to hide level of their loses.

Do people know what it means to lose people! Not random people but people who look up to you and wanna be like you or make impact like you People you left and expected them to graduate only to hear they've been cut down due to cultism several years after! Just because of colour.

Externals bringing people down when eaten, when chatting outside campus gate, when drinking! When there is no clash? Though they got revenged but can the dead come back to life?

People lost body parts, can't continue their education and had to drop out of school.

Even, how are some who graduated alongside us, before or after us doing! Some are not finding things easy.

The truth is cultism ain't good, some people will say otherwise but are they prepared to leave their Children and Wife for someone else to take care of? Are you ready to die a slow and violent death? Use to have a pal who was ready to die for the cause, but hits after hits he didn't die but lost body part instead of dying! He ain't finding it easy! Him still be strong man but things no arrange.

How you go feel make another person dey run your wife after you die due to cultism? Or make your children dey bare another person name? That is make dem change their surname to another person own? Or even if your wife is 100% loyal, but nobody to provide for them after you're gone? Na mouth most people dey get say, I go do this and that? After dem kpai you nobody go remember your family in less that 6months again. If it ain't you, it can never be you! Nobody can take your place in your family except you just want to throw it away.

Every confraternity have their stronghold, strength and weakness.

Aye, Eiye, Vikings, Buccaneer, Maphite, 22, atabor, kK pirate etc. No confraternity is a pushover anymore.

People will not tell you the truth, Aye and Eiye are eternal enemies and each other number 1 enemy. So why go join wetin no go give you rest? Or wetin go increase your chances of dying quickly!!!

Aye and Vikings are also coming close.

Cultism have killed or maimed more people than you can ever imagine and the best thing is for you to get out of it, make money, live a good life and stay safe with your loved ones.

All we need is No to Cultism!

23 Likes 3 Shares

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by gamechanger547: 9:07am On Dec 12, 2023
ekene101:
Dem don still kpai another aye. This one dey here dey hype dem from where him dey hide him head. See as people dey look am dey struggle with him life just few weeks to new year.
You're doing a good job.

Let the young ones know the truth so that they won't hype them to early death.

Nobody be Superman.

Use to know a guy called ironbody, he's over 6ft tall, he use to hide his head when we were in School, he became gentle and everyone liked him.

Fast forward to several years after we graduated, I heard he moved to another school and became terror, and alas buccaneers brought him down badly.

What did he gain! Nothing.

Left the game decades ago when it was strictly campus thing, that's before it hit the streets.

I would advise the young ones to stay far away from Cultism.

11 Likes

(1) (2) (3) ... (619) (620) (621) (622) (623) (624) (625) ... (643) (Reply)

Viewing this topic: StormpyBee, Bukolaolamipo and 4 guest(s)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 92
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.