Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,195,001 members, 7,956,717 topics. Date: Monday, 23 September 2024 at 05:22 PM

Fancy Acholonu Offers Alex Ekubo Her Heart Only After Breakup! - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Fancy Acholonu Offers Alex Ekubo Her Heart Only After Breakup! (280 Views)

Lady Laments As Boyfriend Posts Engagement Photos 2 Days After Breakup / What If You Discover You're Pregnant After Breakup? / How Do You Break Up With A Girl Without Breaking Her Heart? My Story (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Fancy Acholonu Offers Alex Ekubo Her Heart Only After Breakup! by zedegit: 6:16am On Dec 30, 2022
HomeNigeriaAfricaWorldVideoSportEntertainmentMost popular
Fancy Acholonu say sorry afta she serve Alexx Ekubo 'breakfast'
Alex and FancyWIA DIS FOTO COME FROM,INSTAGRAM/@FALEXXFOREVER
8 hours wey don pass
Nearly two years afta di celebrity break-up wey scata social media, ex-fiancé of Nollywood actor, Alexx Ekubo don apologise for di breakfast she serve am few months to dia wedding.

Fancy Acholonu for one emotional post on Instagram tok say she dey sorry for di pain and hurt him and im family don go through sake of dia breakup.

She say how she handle di mata bin dey out of her character as she suppose control her emotion and no over react.

“Like our shirt tok, Nothing make sense wen we dey apart @alexxekubo you still get my heart. I miss you, I love you, and I dey truly sorry for all di hurt and pain you and your family bin go through sake of our break up.

“My actions on how I take handle di mata bin dey out of character. I suppose don control my emotions and no dey overactive. I bin say too much.

"Please forgive me. I don learn my lesson on how to handle situation better.” She tok.

Fancy add say she still love and miss Alex as "nothing make sense" wen dem dey apart.

Di actor however neva react to her post as at wen we file dis tori.

Skip Instagram post

Wetin we call dis Video,Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of Instagram post
Di couples bin dey engaged and dey plan dia wedding wen Fancy announce dia breakup for social media for August 2021.

She use di same foto she take announce dia break up take write how she dey sorry and ask for forgiveness.

Meet Fancy Acholonu, di woman wey Nigerian actor Alexx Ekubo dey set to marry
3rd May 2021
Alex Ekubo, Fancy Acholonu wedding date get K-leg- See wetin we sabi
27th August 2021
How di tori of dia love take waka
Alex and Fancy
WIA DIS FOTO COME FROM,ALEX EKUBO/INSTAGRAM
For May 3rd 2021, di Nollywood actor, Alexx Ekubo bin enta social media to announce im engagement to im ex-fiancé.

Di 35-year-old Nollywood actor den write wit excitement say;

"I ask di love of my life Fancy Acholonu to marry me…"

Fancy Acholonu come also post di same foto ontop her own personal account, where she reply:

"...& I tok YES to di love of my life."

Later on Monday 10th May of di same year Alex announce di wedding date as November 20, 2021.

And both of dem create new Instagram handle (@falexxforever) wey carry dia two names wia fans go get informate, fotos and evri tin about di upcoming wedding.

Wedding IV
WIA DIS FOTO COME FROM,SCREENSHOT
Di Nollywood actor later announce say both di traditional and white wedding go hold for November of dat year.

Di wedding wey dem nickname, Falexx Forever, go hold for Imo state.

Alex Ekubo traditional marriage go hold on November 20, 2021.

And di Church wedding between di actor and im fiancée Fancy Acholonu go happun on November 27, 2021.

E be like shock wen on Wednesday 25 August, 2021, some news report say Alexx Ekubo and Acholonu don call off dia wedding engagement.

Later, Fancy Acholonu confam to her fans and di public say her engagement and upcoming wedding with Alexx Ekubo don end.

"Hey guys, I dey write to info you all officially say I don end my relationship, engagement and I don call off di wedding with Alexx Ekubo."

"I know say dis fit shock many pipo. I make di best decision for myself, becos e dey important say evri one find dia happiness and live in dia truth."

"At dis time, my family and I ask una to please respect our privacy . Thank you so much!" Fancy post for her Instagram handle.

Social media
WIA DIS FOTO COME FROM,INSTAGRAM
Who be Fancy Acholonu?
Fancy Acholonu
WIA DIS FOTO COME FROM,INSTAGRAM
Her full name na Chigozie Fancy Acholonu and tori be say na for Los Angeles, United States dem born am.

Her parents na Nigerians from di Igbo ethnic group and even though dem raise her for Nigeria, she do her university abroad.

She graduate from Los Angeles City College wia she gain BSc. for Business Administration and Management for 2012.

Acholonu biography ontop Instagram show say she bi oga of three companies, of which one of dem dey sell luxury jewellery.

Like her ex-fiancé Alexx, she sef na actress and model.

Who be Alexx Ekubo?
Alexx Ekubo
WIA DIS FOTO COME FROM,FACEBOOK
Alexx train as lawyer for di University of Calabar, but na inside acting e really shine and later see fame.

Alexx win best supporting actor for di 2013 Best of Nollywood Awards ontop im role inside di feem Weekend Getaway.

Although im first major role as actor na Ladies Men.

Di actor dey popular wit young Nigerians.

E no tey afta e chop breakfast, Alexx post fotos of anoda of im achievement as di governing council of the Institut Supérieur de Communication et de Gestion (ISCG UNIVERSITY) confer am wit Doctorate (Honorary) Degree in Arts & Culture.

(1) (Reply)

7 Days Of Valatine / God When? 5 Ways To Make The Most Out Of Being Single / Hakimi Syndrome

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.