Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,084 members, 7,818,249 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 11:10 AM

My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also (1432 Views)

My Igbo Friend Never Hits On Me / Just How Much Insults Are U Ready To Tke From Ur American Wife because Of Greencard / What To Do When Your American Wife Throws Your Stuffs On The Street. (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by Nobody: 3:26am On Jan 09, 2012
My friend Nnamdi just phone me from minnesota in the USA yesterday.He say im black american wife dey dey threaten to divorce him because he no dey take the domestic chorus for house seriously.According to wetin im tell me he say na house husband im be or wetin dem dey refer to for yankee as a stay at home dad.Na im black american wife be the breadwinner for their house so accordinly na im dey wash the kitchen,the plates,dey cook food and also dey baff the two children wey the woman born for him.From wetin im tell me he say im black american wife dey vex with am and they threaten to divorce am because he no dey clean the house well.She say she no fit for a lazy husband but wetin come dey worry Nnamdi be say she also threaten to deport am back to nigeria.Right now Nnamdi dey worry over the matter and accordin to wetin im tell me he say he don beg the woman but she still wan insist on im divorce and im eventual deportation back to naija.Me sef as i come analyse wetin Nnamdi tell i just come dey suspect say maybe na another woman wey Nnamdi get for outside na im black american wife hear about wey dey vex am.I ask Nnamdi if no be another woman he roll with for outside wey dey make im blk american wife vex but he say he no get another woman apart frm im blk american wife.I no really believe Nnamdi because back then for school Nnamdi na chronic womaniser so e no go make sense say a woman wan divorce u because u no clean una house properly.From wetin i dey suspect i sure say Nnamdi mama don marry one small 18 yr old girl for Nnamdi back for im village and somehow im blk american wife hear about the matter and the thing come vex am.Anyway na wetin me suspect be dat. shocked.Omo my fellow nairalanders na wetin Nnamdi go do to prevent this imminent divorce and eventual deportation.He say he no wan come naija come dey suffer suffer oooo grin
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by babsjnr(m): 4:25am On Jan 09, 2012
U again lefulefu
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by Nobody: 5:14am On Jan 09, 2012
mschew!

Jaybee can you do me a favor? tongue
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by Mynd44: 9:03am On Jan 09, 2012
*hisses*
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by Nobody: 9:30am On Jan 09, 2012
You keep a lot of hopelessly st[i]u[/i]pid friends. . .
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by db10dtruth(m): 12:30pm On Jan 09, 2012
grin grin grin I think if Nigerian woman do half of wetin dis blck oyibo woman do na him mama house u go beat am go abi

tell ur friend e beta no form yo yo nigga wen e eventually cum back 2 village o
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by SAFO(m): 12:44pm On Jan 09, 2012
This week it's Nnamdi next week it's your Hausa friend. grin
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by Yorisb: 1:13pm On Jan 09, 2012
Abeg make dem deport that Nnamdi guy make im sef come join us for this subsidy removal protests. Lol

Oh boi this sun dire 4 body no be small oo.

Tut tut! angry
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by Nobody: 1:21pm On Jan 09, 2012
@lefulefu, are you still in the Village? From your last statement say Nnamdi no wan COME naija, shows ur still enjoying the village champs. Anyway, back to the post, let him try to clean the house well na to avoid the divorce till him get him papers.
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by MrsChima1(f): 3:28pm On Jan 09, 2012
Another Igbo friend lebiggestfool? 

You need to get you some better friends both Igbos and Black Americans.  But the birds of the same flock flies together.  Carry on.
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by Mynd44: 4:37pm On Jan 09, 2012
The guy mumu. He should have gone for a white woman instead
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by Eiregirl(f): 4:40pm On Jan 09, 2012
db10dtruth:

grin grin grin I think if Nigerian woman do half of wetin dis blck oyibo woman do na him mama house u go beat am go abi

tell your friend e beta no form yo yo nigga wen e eventually precipitate back 2 village o

Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by Nobody: 5:26pm On Jan 11, 2012
Mynd_44:

The guy mumu. He should have gone for a white woman instead
abi oooo my broda grin grin grin grin
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by Nobody: 5:40pm On Jan 11, 2012
Vikin:

@lefulefu, are you still in the Village? From your last statement say Nnamdi no wan COME naija, shows your still enjoying the village champs. Anyway, back to the post, let him try to clean the house well na to avoid the divorce till him get him papers.
yess ooo i still dey village.i dey follow my village pallies dey protest over the subsidy dem don remove from fuel,toto and beer sad sad
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by Mynd44: 5:48pm On Jan 11, 2012
lefulefu:

abi oooo my broda grin grin grin grin
You are too predictable
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by OneNaira6: 5:26am On Jan 12, 2012
OP
You keep making up stories, u no get life? Today is nnamdi, tomorrow is your Hausa friend, next day is another Igbo man.
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by Mynd44: 5:38am On Jan 12, 2012
^^^
You dey mend the mugu
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by Nobody: 7:09pm On Jan 12, 2012
i think lefulefu's name should be added as a tag to alert the spamb0t. lipsrsealed
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by MrsChima1(f): 8:40pm On Jan 12, 2012
MsDarkSkin:

i think lefulefu's name should be added as a tag to alert the spamb0t. lipsrsealed

You know you were wrong right? [size=2pt]You told that man he got faded ass raccoon head? I fell on the floor![/size]
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by Mynd44: 8:50pm On Jan 12, 2012
This is sad
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by Nobody: 4:13am On Jan 13, 2012
Mrs, Chima:

You know you were wrong right? [size=2pt]You told that man he got faded Bottom raccoon head? I fell on the floor![/size]

LMAO!!! grin grin grin grin grin
Chima [size=2pt]you know it's true with his wack azz. that's why his mouth is open in the pik, easy access for claremont's nuts.[/size] tongue tongue grin
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by Mynd44: 7:55am On Jan 13, 2012
huh?
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by sexlog(m): 11:18am On Jan 13, 2012
Op, u no get better friends O! All your pals na yeye dem be as u self be yeye person.
Re: My Igbo Friend Im Blk American Wife Wan Divorce Am And Deport Am Also by Mynd44: 1:33pm On Jan 13, 2012
Well birds of a feather flock together. You are silly so I don't expect your friends to be any better

(1) (Reply)

Women Are Dangerous!!! / CNN'S World's 12 Sexiest Accents-nigeria Listed As 5th .Please vote via FB / Some Reasons Why A Guy Will Want 2 Date More Than A Girl?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 21
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.