Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,265 members, 7,818,906 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 07:46 AM

Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) - Dating And Meet-up Zone (18) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Dating And Meet-up Zone / Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) (37654 Views)

Romance Chat/hookups/Poems Section(PIDGIN ENGLISH ONLY) / Dave2's Mahjong Parlour with his Buddies! / The Beer Parlour (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (15) (16) (17) (18) (19) (20) (21) ... (30) (Reply) (Go Down)

Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 1:42pm On Jun 26, 2012
Idowuogbo: wetin dey happen hia sef? notin dey flow, una no sabi ginger correct jare!

AyoB wey u dey o!!!!!
e no gud make i start from u dis morning anyway let me pity cos u ar stil a kidz. If u dnt read paper cant u read bar notice boar wey dey ur back say jonathan subsidice ginjer
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 1:47pm On Jun 26, 2012
Sijo01:


abeg sofri jor. u nor dey pity 4person ni
em come ur bar come find solace, instead of u to giv am dat atmosphere, u jst dey misfire.
how much em dey hol u sef

Go Banana Island for Ikoyi. Ask how much one plot of land be, then make you multiply am by 2. Na the amount wey chief caretaker dey owe us be that.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 1:49pm On Jun 26, 2012
Sijo01:


abeg sofri jor. u nor dey pity 4person ni
em come ur bar come find solace, instead of u to giv am dat atmosphere, u jst dey misfire.
how much em dey hol u sef
e be like say u knw under stand my oga wela, d sumary be say na so him dey do always and no room 4dat any more
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 1:51pm On Jun 26, 2012
OPEYEMI AD: e no gud make i start from u dis morning anyway let me pity cos u ar stil a kidz. If u dnt read paper cant u read bar notice boar wey dey ur back say jonathan subsidice ginjer


Na to dey wash glass cup, serve drinks and ukwobi I employ you for. No be to dey do PRO of this bar.

If you no take your time, I go deport you back to the village.

By the way since saturday na so money don dey reduce for drawer. Do was those glass cups make you come do account.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Goldieluks: 1:53pm On Jun 26, 2012
Oga acidtalk why you come go employ this village boy wen dem dey call okpeyemi?
You wan use am pursue your customers? If na so him dey run him mouth anyhow naim be
say I no go dey come this your beer parlour anymore oh,abeg caution am quick quick.

Give me eva water make I take cool my head.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 2:10pm On Jun 26, 2012
acidtalk:


Na to dey wash glass cup, serve drinks and ukwobi I employ you for. No be to dey do PRO of this bar.

If you no take your time, I go deport you back to the village.

By the way since saturday na so money don dey reduce for drawer. Do was those glass cups make you come do account.
u knw say am nt on duty yestday, and na dat saturday i start work and i knw fit do dat kind tin, i been suspect dose customer and new security...people like goldie and co
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 2:12pm On Jun 26, 2012
Goldieluks: Oga acidtalk why you come go employ this village boy wen dem dey call okpeyemi?
You wan use am pursue your customers? If na so him dey run him mouth anyhow naim be
say I no go dey come this your beer parlour anymore oh,abeg caution am quick quick.

Give me eva water make I take cool my head.
na people like u we wan to evict, every day na so so water she dey take like fish
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Goldieluks: 2:15pm On Jun 26, 2012
OPEYEMI AD: na people like u we wan to evict, every day na so so water she dey take like fish


Water good for the body if u no know.

Abeg one bottle of spring water and a glass of palmy, I no sabi drink beer.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Mynd44: 2:23pm On Jun 26, 2012
OPEYEMI AD: na people like u we wan to evict, every day na so so water she dey take like fish
You too dey talk. Give me one bottle of star fast fast
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by iyatrustee(f): 3:19pm On Jun 26, 2012
Goldieluks: Oga acidtalk why you come go employ this village boy wen dem dey call okpeyemi?
You wan use am pursue your customers? If na so him dey run him mouth anyhow naim be
say I no go dey come this your beer parlour anymore oh,abeg caution am quick quick.

Give me eva water make I take cool my head.

u miss road? mtchew! angry angry
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Goldieluks: 3:21pm On Jun 26, 2012
iyatrustee:

u miss road? mtchew! angry angry



Ewoooo my momsi don land beer parlour. Wetin u go take? No worry I go pay.
grin grin
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by iyatrustee(f): 3:31pm On Jun 26, 2012
you go fit pay? ok oh! bar man, gimme alomo mixed with shepe, put small monkey tail inside. i wan show dat man small lesson today! wink wink
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Goldieluks: 3:37pm On Jun 26, 2012
No worry take anything. My personal banker Prof anukwu go pay.
But wait oh no go brake ur bobor waist oh..
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 3:43pm On Jun 26, 2012
Goldieluks:


Water good for the body if u no know.

Abeg one bottle of spring water and a glass of palmy, I no sabi drink beer.
haaa palmy in advance beer palour, na true say u mis road
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 3:45pm On Jun 26, 2012
Mynd_44:
You too dey talk. Give me one bottle of star fast fast
who go paid for it? cos d guy wey pay 4d two botles u drank don comot
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Goldieluks: 3:45pm On Jun 26, 2012
OPEYEMI AD: haaa palmy in advance beer palour, na true say u mis road


But I don take palmy here before. I talk am you to dey drink alomo bitters. (Wateva dat is).
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 3:46pm On Jun 26, 2012
iyatrustee:

u miss road? mtchew! angry angry
i thought am d only notice am, thank We are two
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 3:47pm On Jun 26, 2012
Goldieluks:



Ewoooo my momsi don land beer parlour. Wetin u go take? No worry I go pay.
grin grin
yeepa u mean u take after ur mother, no wonder
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 3:49pm On Jun 26, 2012
Goldieluks:


But I don take palmy here before. I talk am you to dey drink alomo bitters. (Wateva dat is).
dat one na before but nw we don advance u hear. alomo na water to me so nting dey hapen
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by iyatrustee(f): 3:52pm On Jun 26, 2012
barman! you get black label? i wan high wella wink wink
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 3:59pm On Jun 26, 2012
iyatrustee: you go fit pay? ok oh! bar man, gimme alomo mixed with shepe, put small monkey tail inside. i wan show dat man small lesson today! wink wink
haa a haa!! Mama u dey show urself. U self knw say she no go fit pay. d money all together in her 6 diferent acount na #6000
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 4:00pm On Jun 26, 2012
iyatrustee: barman! you get black label? i wan high wella wink wink
no na redlabel we get Big and smal one
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by iyatrustee(f): 4:01pm On Jun 26, 2012
OPEYEMI AD: haa a haa!! Mama u dey show urself. U self knw say she no go fit pay. d money all together in her 6 diferent acount na #6000

^^^ very true 6,000pounds na enof pepper! wink wink
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Sijo01(f): 4:28pm On Jun 26, 2012
OPEYEMI AD: u think say i dey lie, try to cal him nw and hear wetin he go talk

no worry, i go control anoda one
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 4:54pm On Jun 26, 2012
iyatrustee:

^^^ very true 6,000pounds na enof pepper! wink wink
6000naira make i write it in word if u dnt knw symbol again
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 4:57pm On Jun 26, 2012
Sijo01:

no worry, i go control anoda one
so u get dem plenty?chai ur boyfriend don buy market
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Jamesdman(m): 5:42pm On Jun 26, 2012
*enters bar. . .sights IDOWU two tables away from his*
mk i try wetin Chris Brown do when he meet Drake for bar, maybe e go work for me!
Ermmm. . .barman, send two bottles of champagne go IDOWU table, tell her say na peace-offering from me to her!!
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Foxybone(m): 5:47pm On Jun 26, 2012
Why be say Opeyemi think say I be babe... **Cocks his gun and faces him squarely** You be gay?... **Attampts to shoot, instead, a flag came out, drops gun and runs out, wildly pursued by Opeyemi**... Abeg make una save me from Opeyemi hand o.... My A**e still be Virgin o>>>>... shocked shocked shocked shocked
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Mynd44: 5:53pm On Jun 26, 2012
OPEYEMI AD: who go paid for it? cos d guy wey pay 4d two botles u drank don comot
E bi like say you want make I burst your head abi?
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 7:44pm On Jun 26, 2012
James-dman:
*enters bar. . .sights IDOWU two tables away from his*
mk i try wetin Chris Brown do when he meet Drake for bar, maybe e go work for me!
Ermmm. . .barman, send two bottles of champagne go IDOWU table, tell her say na peace-offering from me to her!!
my frnd firt me too go firt, u own firt fit be shit o, by d way give me money first before i take ur order
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 7:52pm On Jun 26, 2012
Foxybone: Why be say Opeyemi think say I be babe... **Cocks his gun and faces him squarely** You be gay?... **Attampts to shoot, instead, a flag came out, drops gun and runs out, wildly pursued by Opeyemi**... Abeg make una save me from Opeyemi hand o.... My A**e still be Virgin o>>>>... shocked shocked shocked shocked
guy y my name dey ring 4ur head lik caler tone, nw dat u show us ur work wit efidence i bann 4u o, tuale, mind u dnt try to visit us today night o cos i dn buy dog 4rm 190hand
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by OPEYEMIAD(m): 7:55pm On Jun 26, 2012
U for shoot dat gun nw, na today i wil show u dat am from vilage

(1) (2) (3) ... (15) (16) (17) (18) (19) (20) (21) ... (30) (Reply)

I Need A Rich Sugar Mummy Who Can Take Care Of Me Financially / For Those In Need Of Sugar Mummy In Abuja / I Need A Sugar Mummy

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 45
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.