Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,285 members, 7,818,959 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 08:59 AM

Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) - Dating And Meet-up Zone (24) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Dating And Meet-up Zone / Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) (37656 Views)

Romance Chat/hookups/Poems Section(PIDGIN ENGLISH ONLY) / Dave2's Mahjong Parlour with his Buddies! / The Beer Parlour (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (21) (22) (23) (24) (25) (26) (27) ... (30) (Reply) (Go Down)

Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Brite02(m): 1:27pm On Jul 30, 2012
barman, i don come back from leave...give me two bottles make i take start work today......who be that wey u dey run NGO for?
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Mygoldie(f): 1:55pm On Jul 30, 2012
Bar man una get cold sprite?
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 2:55pm On Jul 30, 2012
Mygoldie: Bar man una get cold sprite?

mumu, where were you when your foolish boyfriend (sexkillz) humiliated me and my family today?
i was expecting you to come and fight for me.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Mygoldie(f): 5:29pm On Jul 30, 2012
acidtalk:

mumu, where were you when your foolish boyfriend (sexkillz) humiliated me and my family today?
i was expecting you to come and fight for me.

I no dey bunk. Wetin make una dey fight. Him no be my boyfriend you hear. Wetin go make me fight for you sef? And by the way na you be mumu.
angry
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 5:56pm On Jul 30, 2012
Mygoldie:

I no dey bunk. Wetin make una dey fight. Him no be my boyfriend you hear. Wetin go make me fight for you sef? And by the way na you be mumu.
angry

Shut up !
You no fit fight for me but you dey come here come dey drink free beer and pepper soup everyday dshey?

No be your fault, na me wey dey pity you dey give you free food I blame.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Mygoldie(f): 6:49pm On Jul 30, 2012
acidtalk:

Shut up !
You no fit fight for me but you dey come here come dey drink free beer and pepper soup everyday dshey?

No be your fault, na me wey dey pity you dey give you free food I blame.


How you take give me free food lie lie.
I pay all my bills na, why you no wan let me rest whenever I come this your beer parlour. Allow me take my drink peacefully abeg.

Get me two bottles of small stout
.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Chimezie198(m): 8:24pm On Jul 30, 2012
Hmm. . . . . Goldie dey drink Small stout?

*still sipping my watery beans with straw*
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 9:17pm On Jul 30, 2012
Mygoldie:


How you take give me free food lie lie.
I pay all my bills na, why you no wan let me rest whenever I come this your beer parlour. Allow me take my drink peacefully abeg.

Get me two bottles of small stout
.

I don't give you receipt before?
Na people wey dey pay sabi as my receipt be. But as for you, you are a perpetual beggy beggy customer.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Mygoldie(f): 10:16pm On Jul 30, 2012
acidtalk:

I don't give you receipt before?
Na people wey dey pay sabi as my receipt be. But as for you, you are a perpetual beggy beggy customer.


Me beg?? Na you I beg abi na who I beg? Your head no correct.
Take your money make you give me my receipt.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 4:44am On Jul 31, 2012
Mygoldie:


Me beg?? Na you I beg abi na who I beg? Your head no correct.
Take your money make you give me my receipt.


Take this money back e don tear.
Find better one give me.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Mygoldie(f): 9:13am On Jul 31, 2012
acidtalk:

Take this money back e don tear.
Find better one give me.

Na who give you tear tear money, abi you dey see double?
Abeg give me my change jor, no waste time.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by iyatrustee(f): 4:39pm On Jul 31, 2012
mtchew! @d poster above me. undecided
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 4:50pm On Jul 31, 2012
iyatrustee: mtchew! @d poster above me. undecided

You sabi am before abi na she you talk say snatch your boyfriend?
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by iyatrustee(f): 4:58pm On Jul 31, 2012
my guy, na her sister goldieluks snatch my boyfriend! cry but she na potential snatcher too cos dat her kurukere moves dey taya me. sad
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Idowuogbo(f): 5:03pm On Jul 31, 2012
Who dey hia? Barman! Abeg mix schnapps, palm wine and alomo come give me Biko! It get wan assignment I wan knack today mehn.... My eye must dirty b4 I comot hia. Tinapa hr starts @ 5, it about to oshamooooo!!! cool
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by iyatrustee(f): 5:07pm On Jul 31, 2012
dat kombination deadly badosky! shocked shocked
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 5:08pm On Jul 31, 2012
iyatrustee: my guy, na her sister goldieluks snatch my boyfriend! cry but she na potential snatcher too cos dat her kurukere moves dey taya me. sad


Who be your bobo wey you dey fear make she no snatch?

Shey no be that police officer?
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Idowuogbo(f): 5:13pm On Jul 31, 2012
iyatrustee: dat kombination deadly badosky! shocked shocked
Deadly gini? I say I wan samba something today.I gats clear eye to handle d gidigbam na! U think say it easy to row boat on top sand? Liv me o! I must confess Jesus is lord tonite. cool
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Mygoldie(f): 6:04pm On Jul 31, 2012
Idowuogbo: Who dey hia? Barman! Abeg mix schnapps, palm wine and alomo come give me Biko! It get wan assignment I wan knack today mehn.... My eye must dirty b4 I comot hia. Tinapa hr starts @ 5, it about to oshamooooo!!! cool


See wetin human being wan drink!!!
Na to wear pant enter street naim remain for you oh, ah ah.
shocked shocked angry




iyatrustee: my guy, na her sister goldieluks snatch my boyfriend! cry but she na potential snatcher too cos dat her kurukere moves dey taya me. sad

forgive my sister for she no know wetin she dey do. But where you enter since?? shocked


Acidtalk bar man, carry your short body come here, you no dey see VIP customers around??
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Chimezie198(m): 6:19pm On Jul 31, 2012
Idowuogbo: Who dey hia? Barman! Abeg mix schnapps, palm wine and alomo come give me Biko! It get wan assignment I wan knack today mehn.... My eye must dirty b4 I comot hia. Tinapa hr starts @ 5, it about to oshamooooo!!! cool
Choi. . . . . . . U be correct babe.

Abeg tell am make him carry two bottles come cuz me too go shark.

No vex I bin forget my wallet for house.

@Acidtalk. Abeg u fit find me toothpick ?
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by iyatrustee(f): 6:31pm On Jul 31, 2012
chimeme dey form! simply tell goldie, badosky or iya to buy u drink and no be all dis i forget my wallet lie lie. undecided

mygoldie, i ve been busy so tey nairaland vamoose from my memory! embarassed
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Chimezie198(m): 6:54pm On Jul 31, 2012
cheesy cheesy cheesy
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by tomnmenace(m): 7:03pm On Jul 31, 2012
All dis people sef! mtsscheewww!
Me! I no wan anytin to do wit dat woman again #*puffs n draws on his ciggarette*#
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Chimezie198(m): 7:13pm On Jul 31, 2012
tomnmenace: All dis people sef! mtsscheewww!
Me! I no wan anytin to do wit dat woman again #*puffs n draws on his ciggarette*#
bro . . . Abeg if u smoke small u give me make I smoke small too. Cold dey catch me.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by iyatrustee(f): 7:16pm On Jul 31, 2012
make dat cold kill you! tongue
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Chimezie198(m): 7:29pm On Jul 31, 2012
iyatrustee: make dat cold kill you! tongue
Ewwww . . . . . Na so u hate me reach??

Eww . . . . Eww . . . . . Cold oooooh.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 8:27pm On Jul 31, 2012
Chimezie198: bro . . . Abeg if u smoke small u give me make I smoke small too. Cold dey catch me.

Dem swear for you make you no dey spend your own money?
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Chimezie198(m): 9:40pm On Jul 31, 2012
acidtalk:

Dem swear for you make you no dey spend your own money?
bro cold wan freez me ooh. . . . Find me toothpick nah? Make e be say if dem call pple wey chop meat I go follow too.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by kolajoo(m): 9:48pm On Jul 31, 2012
acidtalk: Dem don use 'forming' scatter all of una head.

So because na time for pidgin now all of una come dey form butty? Una papa.

Whereas na people wey grow up for Mushin, Agege, Orile, Ijora badia, Okomaiko, Akute, Abule Egba, Bariga and Ajegunle full here.

Who una wan come form for?

*WAKA*

I rep* shomolu/bariga and am so proud of my hood. Still omomummy
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by sashaa(f): 10:34pm On Jul 31, 2012
Dis bar get puff puff so?
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 7:40am On Aug 01, 2012
kolajoo:

I rep* shomolu/bariga and am so proud of my hood. Still omomummy

Correct guy,
How people for your end? Hope una no dey disturb Fashola and him people oh!
Wetin make I give you?
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Sijo01(f): 10:03am On Aug 02, 2012
*peeping into the bar through the window*

(1) (2) (3) ... (21) (22) (23) (24) (25) (26) (27) ... (30) (Reply)

I Need A Rich Sugar Mummy Who Can Take Care Of Me Financially / For Those In Need Of Sugar Mummy In Abuja / I Need A Sugar Mummy

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 29
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.