Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,049 members, 7,821,606 topics. Date: Wednesday, 08 May 2024 at 03:35 PM

Chiefotota's Posts

Nairaland Forum / Chiefotota's Profile / Chiefotota's Posts

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (of 7 pages)

Politics / Efcc Don Arrest Buhari Guy, Former Sgf, Babachir Lawal by chiefotota(m): 9:42pm On Jan 24, 2018
Las-las EFCC don arrest president Buhari guy, for Secretary to Government of di Federation (SGF), Babachir Lawal, aka ‘grass-cutter’. EFCC tori guy, Samin Amaddin, confirm dis gist today, he say EFCC dey press Babachir Lawal neck, make he vomit di N200 million wey he use take clear grass for IDP camp for North East wey he still dey office as SGF.

Una remember say Buhari sack Babachir after Senate blow whistle say Babachir chop di osusu wey dem pay his company to clear grass for North East, dem Buhari set up committee wey Vice Presido Yemi Osinbajo head to investigate di matter.
http://www.ototaspalmyjoint.com/e-dey-hot-efcc-don-arrest-buhari-guy-former-sgf-babachir-lawal/
Celebrities / Reekado Banks Don Vanish As Court Throwey Im Manager/brother For Kirikiri by chiefotota(m): 1:45pm On Jan 24, 2018
Gist break last week se OAP/Comedian Uwa Idahosa, drag Mavin artist, Reekado Banks go police station, onto se Reekado Banks kollet N2million to perform for one wedding, but he nor show up for di event, and he dey refuse to remit di N2m, police now don dey claim se Reekado Banks dey on di run, but im manager wey also be im brother, Temi, don dey chop beans for inside Kirikiri prison, base on di invitation wey police send to Reekado and im manager, only di manager show up, so police carry di manager/brother to court yesterday Tuesday, and di court don throwey di manager inside Kirikiri till February 19, wey di court go reason di matter again.

Read di full gist here: https:///p8ePqh-1X2

1 Like

Crime / Igbo Smoker Mistakenly Send Message To Police Asking For Igbo by chiefotota(m): 12:15pm On Jan 24, 2018
Police for Florida, US, share screenshot of di message wey one of their officers receive from one unidentified guy wey wan buy igbo.

I sure se if to say dis happen between Naija police and a Nigerian, di police for bracket di guy arrest am, but di Florida police guy instead advise di guy say igbo dey bad for his health, see di Facebook post wey Florida police department share:

https:///p8ePqh-1WV
Jokes Etc / Pishure Of Fashola After 3 Years As Minister Of Power According To Twitter User by chiefotota(m): 5:14pm On Jan 23, 2018
Twitter user, @jacksonpbn, finish former Lagos state guvnor, now minister of power, Babatunde Fashola for dis tweet wey he share, di guy share pishure wey be like burnt offering

see di full pishure for: https:///p8ePqh-1WO

Sports / Australian Open: 21 Years Unknown Player Don Knockout Novak Djokovic by chiefotota(m): 5:35pm On Jan 22, 2018
21 years South Korean Hyeon Chung, wey nor get respect for world champion, don knockout Novak Djokovic from Australian Open.

Di Korean guy, knack Djokovic wey dey sufer elbow injury 7-6 (7-4) 7-5 7-6 (7-3) to reach di last 8, he go play with another unknown American guy, Tennys Sandgren wey also beat fifth seed Dominic Thiem.

Djokovic don win Australian Open championship 6 times before, 2008, 2011, 2012, 2013, 2015 and 2016.

http://www.ototaspalmyjoint.com/australian-open-21-years-unknown-player-don-knockout-novak-djokovic/
Foreign Affairs / Police Don Arrest 10 Catholic Priest For Protesting Against Dr Congo Presido by chiefotota(m): 4:46pm On Jan 22, 2018
Security guys for DR Congo don arrest 10 Catholic priests and some parishioners wey protest yesterday Sunday, dey ans di Presido of di country, Joseph Kabila to step down.

Catholic Church for DR Congo, call for protest make Kabila, wey im time for office don expire since 2016, but refuse to leave office. Catholic Church bin arrange one committee, wey reach agreement with Joseph Kabila and opposition, for Kabila to arrange election for 2017, but 2017 don pass and Kabila still dey hold ground.

Na like 6 people kpai (die) for di capital, Kinshasa, wen police faya bullets and tear gas, for di protest wey happen across di country.

http://www.ototaspalmyjoint.com/police-don-arrest-10-catholic-priest-protesting-dr-congo-presido/
Sports / Nff Presido Amaju Pinnick Don Arrange Job To Epp Save Ex Super Eagles Oruma From by chiefotota(m): 10:52am On Jan 22, 2018
Epp don finally dey come for we former Super Eagles player, Wilson Oruma, wey some 419 guys, job (scam) all im life savings in di name of oil money investment. Di jobmen (419 guys) trick Oruma say if he invest into oil business, he go hammer di kind hammer wey go make his bread long (rich). Innocently Oruma invested more dan N2billion, only for di guys to gbaga (run away), since den, Oruma nor be imsef again.

But good news don come now, as we Nigeria Football Federation (NFF), presido, Amaju Pinnick, don let God speak to rham to epp Oruma. Amaju yarn say his foundation, go personally pay Oruma hospital bills, while NFF don arrange job for Oruma as assistant coachy for one of Naija junior teams.

Amaju yarn Vanguard say he need to epp Oruma base on se Oruma na Warri guy like am too, he also say plans don dey on ground between NFF and WAPIC Insurance, to start to arrange pension tins for ex Super Eagles players, but he just hope di players go gree tap into di deal, to avoid dis kind stories dah touch in future.

http://www.ototaspalmyjoint.com/nff-presido-amaju-pinnick-don-arrange-job-epp-save-ex-super-eagles-oruma-owu/
Nairaland / General / Check Out Dis Invitation To Cut Pikin Dada by chiefotota(m): 10:42pm On Jan 21, 2018
So dis invitation card, na to invite friend and family just to cut dada from pikin hears o.

Make dem sell asuebi join na.

http://www.ototaspalmyjoint.com/check-dis-invitation-cut-pikin-dada/
Romance / Barack Obama 19 Years Pikin, Malia And Her Boyfriend Dodge From School Go Play L by chiefotota(m): 8:12pm On Jan 21, 2018
Na school US former presido, Barack Obama send his 19 years old daughter, Malia Obama go for Harvard University for Cambridge, but e clear say di pikin dey do some extracurricular activities.

TMZ report with pishure of Malia and her 19 years old British boyfriend, Rory Farquharson, as dem leave their school for Cambridge go play for Soho wey dey New York City.

See their love bird pishure for:

http://www.ototaspalmyjoint.com/barack-obama-19-years-pikin-malia-boyfriend-dodge-school-go-play-love-new-york/
Crime / Angry Protesters Don Skata Statue For Looking Satanic by chiefotota(m): 2:18pm On Jan 20, 2018
Early December last year, Greek artist, Kostis Georgiou, arrange dis statue wey he call ‘Phylax’, meaning guardian for Greek language, dem display di statue for Palaio Faliro area, wey dey Athens for Greece, but some people complain say di statue wey get wings like angel, dey evil.

Now some people don take di complain to another level, about 10-15 protesters, tie di statue join di back of their truck, fall down di 8-metre high statue, dem even break di wings say di statue dey satanic, according to Reuters, di protesters wey dress in black like who dey go obituary, some of dem na church people and others na far right political groups.

Di mayor of Palaio Faliro, Dionysis Hatzidakis, don carry di matter go court, he say dem go try to fix di statue and mount am again for di same place.

Di artist wey design di statue, Kostis Georgiou, say he don transfer di statue to a safe place, he say he shock se na common statue, go dey make people protest.
see di picture of di satanic statue:
http://www.ototaspalmyjoint.com/angry-protesters-don-skata-statue-looking-satanic/
Celebrities / Bone Hook For Reekado Banks Throat As Comedian/oap Uwa Idahosa Drag Di Singer Go by chiefotota(m): 2:03pm On Jan 20, 2018
Be like se Mavin Records artist, Reekado Banks don swallow bone wey hook for im throat as, Naija Comedian/OAP, Uwa Idahosa, don drag di singer go police station.

According to di gist wey TheNET report, Uwa Idahosa on behalf of one guy wey do wedding, arrange Reekado Banks as guest artist for di wedding for N2,000,000, but on di day of di wedding, nobody see Reekado not to talk of Banks, so ‘norma-norma’ (normally) we expect Reekado to refund di osusu wey he don kollet, but he refund only N800,000.

So Uwa don report di matter to police for Ogba area for Lagos, and police don give Reekado Banks and his manager till Monday to vomit di N2,000,000.

OpataYarn

Reekado Banks, be like se you nor know who Uwa Idahosa be, dah guy dey train for stadium o, abi you never see his chest wey big like Dangote cement? Nor let dah guy handle you, you wont survive it, na me dey tell you.

http://www.ototaspalmyjoint.com/bone-hook-reekado-banks-throat-comedianoap-uwa-idahosa-drag-di-singer-go-police-station/
Crime / Police Seize 1,600 Pounds Of Cocaine Wey Drug Lords Code Inside Pineapples by chiefotota(m): 1:32pm On Jan 19, 2018
Police for both Spain and Portugal don burst 1,600 pounds of cocaine worth thousands of dollars wey some Colombian brothers ship into Europe from South America.
Di guys code di cocain inside fresh pineapples, dem arrange di coke in a way wey be se you go just think say na pineapples, dem arrange di cocaine pineapples together with other normal fresh pineapples inside container.
Di drug lords get lab near Madrid, for Spain wey dem dey operate from, but police don dey investigate dem since on code. Dis cocaine pineapples container, land for seaport for Lisbon, and dem suppose arrange dem enter one address for Spain before market fall press dem, according to police report, already police don arrest about 9 members of di drug gang.

To see di video, visit
http://www.ototaspalmyjoint.com/police-seize-1600-pounds-cocaine-wey-drug-lords-code-inside-pineapples/

1 Like

Celebrities / Hulk Hogan Say If He Run For Us Senate, He Go Win One Hand by chiefotota(m): 12:12am On Jan 19, 2018
Former wrestling champion, Hulk Hogan, don yarn say if he contest for US Senate to represent, Florida, he go win di election one hand.
Di truth be say, Republican strategist, wey be former adviser to Donald Trump, Roger Stone, don dey put pressure for Hulk Hogan head to contest against Florida Governor, Rick Scott, for Republican primaries, but Hogan never make up im mind yet, for now, di wrestler yarn say di Senate seat, nor really dey im mind o, but any tin fit happen at any time, so he fit change im mind.

http://www.ototaspalmyjoint.com/hulk-hogan-say-run-us-senate-go-win-one-hand/
Nairaland / General / Zimbabwe Embassy Kollet Gate Fee For Zimbabweans To See Their New President by chiefotota(m): 3:07pm On Jan 16, 2018
Zimbabwe citizens wey Namibian, don para, as Zimbabwe embassy for Namibia, charge dem gate fee of $16 (£9) for dem to see their new presido, Emmerson Mnangagwa, wey visit Namibia yesterday Monday.

read di full gist why and how di embassy take kollet di gate fee for
http://www.ototaspalmyjoint.com/zimbabwe-embassy-kollet-gate-fee-zimbabweans-see-new-president/
Sports / Joseph Parker Say His Training Dey Make Fear Catch Anthony Joshua by chiefotota(m): 3:00pm On Jan 16, 2018
New Zealand World Boxing Organization (WBO) heavyweight world champion, Joseph Parker, don dey rake, he say di train wey he dey train for di fight wey he suppose fight with Naija/UK boy, Anthony Joshua on March 31 dis year, don already dey make Anthony Joshua, wey hold International Boxing Federation (IBF), World Boxing Association (WBA) and International Boxing Organisation (IBO) heavyweight belts dey fear already.
He tell ESPN say he know say Joshua don dey fear already, he say dat fight go be light party, because di world go bow how he go use beat Joshua for Principality Stadium, Cardiff.

http://www.ototaspalmyjoint.com/joseph-parker-say-training-dey-make-fear-catch-anthony-joshua/
Crime / Police Arrest 35 Years Old Pesin Papa Wey Use His Penis Tear 2 Goat Nyansh by chiefotota(m): 8:21am On Jan 16, 2018
One 35 years onld man for Kenya don land for court after he use his fat penis, refresh his neighbour 2 goats horizontally, in case you never understand, dis man wey konji hold for work, kolobi (catch) his neighbour goats, 2 of dem, insert his penis for di goat their nyash, one after di other till both goats die.

Police wey carry di man go court, also carry di dead goats go court as evidence, for Kangundo area, of Nairobi.

Di court judge grant di guy bail with about $1,000, make di guy fit go hospital go treat imsef, onto se police don panel beat di man, di case go resume January 29. Di man fit spend up to 14 years for prison according to Kenya law if dem judge am guilty.

http://www.ototaspalmyjoint.com/police-arrest-35-years-old-pesin-papa-wey-use-penis-tear-2-goat-nyansh/
Celebrities / Watch Rudeboy Okoye Of Di Psquare Department Rehears With His Girls Band by chiefotota(m): 1:32pm On Jan 13, 2018
Paul Okoye, aka Rude Boy of di Psquare department, just flash both pishure and video of imsef, and some babes wey he call “Rudicals” for Instagram, as dem rehears together, he say dem be members of im band, girls only band.
Watch di video:
http://www.ototaspalmyjoint.com/watch-paul-rudeboy-okoye-di-psquare-department-rehears-members-im-girls-band/
Religion / Benue Killings: Pastor Paul Enenche Open Faya On Every Killer For Naija by chiefotota(m): 12:46pm On Jan 13, 2018
Senior pastor and general overseer (GO) of Dunamis International Gospel Church, medical doctor wey run leave hospital start God work, Pastor (Dr) Paul Enenche, nor happy with di way Fulani herdsmen dey carry kee (kill) people everywhere for Naija, I say di man of God para nor be small on di first day (Jan cool of dis 21 days prayer and fasting wey most Naija churches dey do for January.

Di man of God dey provoke onto se some people think say dem get too head for dis country, Pastor Eneche open faya (fire), call on God to send faya consume all di enemies of di church of God for Naija.

Watch di video: http://www.ototaspalmyjoint.com/benue-killings-pastor-paul-enenche-open-faya-every-killer-naija-supports-pray-god-waste-dem-generation/
Celebrities / Funke Akindele ‘jeniva’ Don Land Her First Hollywood Role For ‘avengers by chiefotota(m): 3:29pm On Jan 12, 2018
Nollywood big girl Funke Akindele, aka Jeniva, don land her very first Hollywood acting role, together with other korret Hollywood actors like Robert Downey Jr, Chris Hemsworth, Zoe Saldana, Benedict Cumberbatch and Scarlet Johansson.

Funke name appear as one of di actors wey go feature for Marvel Studios’ Avengers: Infinity Wars. She go act as on of di bodyguards (Dora Milaje) of Black Panther, di spiritual doro buchi of Wakanda country wey dey Africa.

My sister, even if na waka pass sef, congratulations, koeazy.
Jokes Etc / Di Imo State Worker Wey Rochas Okorocha Use His Salary Build Statue Don Threaten by chiefotota(m): 3:14pm On Jan 12, 2018
Wait o, suicide na public announcement?

Dis Imo state civil servant, don threaten to kee imsef, if Rochas fail to pay di N900,000 wey di state dey owe. He claim say owu wan finish his family.

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (of 7 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 51
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.