Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,194,629 members, 7,955,305 topics. Date: Saturday, 21 September 2024 at 10:01 PM

Chiefotota's Posts

Nairaland Forum / Chiefotota's Profile / Chiefotota's Posts

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (of 7 pages)

Religion / After 9 Years Couple Smile With Their Baby To Altar by chiefotota(m): 11:06pm On Feb 11, 2018
Dis couple today carry their pikin, Oghenemise, come church, Household of God Church, for dedication, wey dem call dem out, di shouting inside di church nor be here, everybody just dey clap dey follow di couple praise God, as di wife open mouth speak, she give brief testimony of as God take smile on her after 9 years of waiting.

She say sorry and cry was her case until last year wey on dis particular day, she con as usual cry give God for church, nai pastor tell her to go house se God don answer her prayer, and like play, before she know wetin dey happen, belle enter, long story short, she don carry her pikin con church for dedication.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/9-years-couple-smile-baby-altar/

Politics / Obasanjo Coalition For Nigeria Movement Na Political Waka Pass – Festus Keyamo by chiefotota(m): 10:17pm On Feb 11, 2018
Festus Keyamo on Sunday Politics for Channels TV, don give Obasanjo third force, Coalition For Nigerian Movement, blow bellow di belt, he practically call di movement political waka pass.

Seun Okinbaloye ans Keyamo whether he think say OBJ 3rd force go stand any chance to kollet power from Buhari for 2019 election, di SAN yarn say di time too short for OBJ 3rd force to make any impact for dat election, he say 2019 election na beteew APC and PDP, he say third force just be like people, wey dey waka pass for nollywood film, he say 3rd force na political waka pass, dem nor get level.

He also yarn say both Obasanjo and IBB, nor get di moral rights to advise Buhari not to contest election for 2019, he ans se wen dem dey power, wetin dem do to make Naija better?

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/obasanjo-coalition-nigeria-movement-na-political-waka-pass-festus-keyamo/
TV/Movies / #bbnaija: Princess Give K-brule Hand Job For Front Of Other Housemates by chiefotota(m): 2:38pm On Feb 10, 2018
Di devil wey dey Big Brother Naija 2018, house don start to work as Princess give K-Brule hand job last night for front of other housemates, as dem play truth or dare game. Dem tell her say she nor fit do am, so to prove to dem se she fit, nai she position for di wrok like se na government job, watch di video for:
http://www.ototaspalmyjoint.com/bbnaija-daughter-eve-princess-give-k-brule-hand-job-front-housemates/
Politics / Re: Time Don Reach Wey We Go Create State Police –prof. Yemi Osinbajo by chiefotota(m): 1:52pm On Feb 10, 2018
thanks, we don take note, we go do better next time.
Sports / Watch Dis Funny Video To Understand Why Nigerian Nor Fit Win Lagos City Marathon by chiefotota(m): 1:49pm On Feb 10, 2018
For those of una wey dey wonder and dey even vex why a Nigerian nor win or even come out among di top 10 for Lagos City Marathon, no need to find di reason, because we don conduct awa research and we fit tell una di reason.

If you watch dis video, you go discover se wey serious people from Kenya, Ethiopia and Uganda, dey prepare for di race, awa Naija brothers dey dey snap selfie dey dance Shaku Shaku.

Watch di funny video here: http://www.ototaspalmyjoint.com/watch-dis-funny-video-understand-nigerian-fit-win-lagos-city-marathon/

Celebrities / As Dem Carry Me To Mortuary, My Dead Papa, Chase Me Back To Life -julius Agwu by chiefotota(m): 3:47am On Feb 10, 2018
Naija Comedian, Julius Agwu say make we follow am thank dis God wey he dey serve o, base on se dis life wey he dey today so, na God keep am alive. Di Comedian say he don kpai finish o, he say dem dey carry am go mortuary, wey God use im papa take wake am up.

He say dis nor be joke at all o, on dat very day, dem dey wheel am to mortuary already, and some people wey he know wey don kpai (die) already, don already dey welcome am to di other side, wen all of a sudden, im paleh wey kpai 12 years ago, chase am se make he return back to where he dey come from, onto se his time never reach.

He say make God continue to bless im wife o, because na di wife, stand in di gap for rham during dis trying period of his life wey he take do dat operation wey dem remove tumour from inside im head.

He also use di opportunity call on people to give thie life to God, base on se na God get power.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/i-bin-die-dem-carry-dey-go-mortuary-papa-wey-die-12-years-ago-chase-back-life-julius-agwu/
Crime / Nans Dey Beg Naija Students To Stop To Spread Fake News For Social Media by chiefotota(m): 2:42pm On Feb 08, 2018
National Association of Nigerian Students (NANS), today Thursday, don draw ear dey warn all Naija students to abeg stop to spread fake hate news wey fit cause gbege for di country. dis warning dey come after di pishure and voice messages spread for Whatsapp and other social media platforms, of Fulani herdsmen attack for Lagos/Ibadan expressway.

Di guy wey dey talk for NANS, Bestman Okereafor, make dis press statement give News Agency of Nigeria(NAN) for Enugu.
Okereafor say make students stop dis bad tin, because if police arrest any student for spread fake hate news, NANS hand nor dey o. he also thank di Ogun state Police Command, wey arrest di matter with speed, before di tin turn to something else.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/nans-dey-beg-naija-students-stop-spread-fake-news-social-media/
Politics / Time Don Reach Wey We Go Create State Police –prof. Yemi Osinbajo by chiefotota(m): 2:32pm On Feb 08, 2018
Vice Presido, Prof. Yemi Osinbajo, don add im voice to di people wey dey call for creation of state police.

Osinbajo yarn dis korret talk today Thursday, for di opening ceremony of di 2 days security summit, wey Senate arrange to use address di insecurity for Naija, especially di Fulani herdsmen and farmers gbege wey don make plenty people kpai for Naija.

Osinbajo for di event wey dey currently dey happen for NAF Center for Abuja, also talk say make Nigerians stop to talk say Buhari dey support Fulani herdsmen to dey kpai people because Buhari na Fulani man, he say dat talk nor make sense, make we stop to talk like dat.
Source: https:///p8ePqh-222
Celebrities / Drake Bless Homeless Women And Children With Gift Items And $50,000 by chiefotota(m): 4:49am On Feb 08, 2018
American rapper, Drake don bless homeless children and women for Lotus House, wey dey Miami, with gift items and cash gist.

Drake and some of im guys, enter di background, he bless di children with toys and games, den di women get $150 worth of Target gift cards. He also bless di organization with $50,000.

According to di management of di home, dem dey very happy onto se di 50k go epp dem for di new home wey dem just open.

Source:

http://www.ototaspalmyjoint.com/drake-bless-homeless-women-children-gift-items-50000/
Romance / He No Be Di Papa Of Awa Twins, I Feel My Husband Know, But He Nor Wan Talk –wife by chiefotota(m): 11:29pm On Feb 06, 2018
One 26 years wife, Sandra, claim say she don dey married to her husband for 4 years now, dem get twins wey be 2years old, but she say nor be her husband be papa of di twins, she feel say di man know whats up, but he has never mentioned it, di confusing part be se, di husband dey take care of her and di twins wella, just dat he nor dey gree play with di kids and guy man, never run horizontal refreshment with her for some long time now.

Sandra conscience dey judge her, she wan advise.
Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/di-papa-awa-twins-2-years-i-feel-se-husband-know-wan-talk-wife-want-advise/
Crime / Di Islamic Sheik Wey Police Faya For #freezakzaky Protest For Abuja Don Kpai by chiefotota(m): 11:23am On Feb 06, 2018
Sheik Umar Qassem, wey police faya live bullet for Abuja, don kpai (die).

According to Adeyanju Deji, for di message wey he tweet dis morning, police shoot di Sheik 4 weeks ago, during di protest wey members of Islamic Movement of Nigeria, carry out make Nigerian government free their leader, Zakzaky, but di man finally give up today Tuesday.
See pishures:

http://www.ototaspalmyjoint.com/di-islamic-sheik-wey-police-faya-freezakzaky-protest-abuja-don-kpai/
Crime / Photos: Naija Police Abandon Their Airplane To Rotten Like Tomatoes For Lagos Ai by chiefotota(m): 11:10am On Feb 06, 2018
So we Nigerian Police Force get airplane and dem let dem airplanes dey rotten like tomatoes for airport for lack of maintenance?

Dis na pishure of plane wey belong to Naija police, di planes don turn to abandoned project Lagos airport, see more pishure:

http://www.ototaspalmyjoint.com/photos-naija-police-abandon-airplane-rotten-like-tomatoes-lagos-airport/

Crime / Another Slay Queen And Wetin Nigerians Expect From Her by chiefotota(m): 11:25pm On Feb 04, 2018
Dis na another slay queen I guess, na di pishure wey she share, but somebody, epp her her cover her nyash wey strong like wetin dem use clay build.

More pishure:
http://www.ototaspalmyjoint.com/another-slay-queen-wetin-nigerians-expect/

Crime / See Wetin Nigerians Do To Dis Slay Queen For Exposing Her Breast by chiefotota(m): 10:55pm On Feb 04, 2018
Una know as dis we girls dis days go just dress, like pepper people father eyes with “see my hot breast, come and touch it if you can?” aka slay queen, dis babe, we nor know her before, but jejely she snap with breast for public, since she nor fear God, and onto se today na Sunday, some people wey dey fear God decide to epp her cover her breast.

OpataYarn
Who do dis tin, izzit your breast? Abi na di fine girl be Buhari and other politicians wey cause Naija problem? I don’t like dis, make una stop am, fine babe, you fit open make we see even if na one copy of di breast?

See more funny/crazy pishure here:
http://www.ototaspalmyjoint.com/see-wetin-nigerians-dis-slay-queen-exposing-breast/

Celebrities / Don Jazzy For Dis Pishure Dey Like Who Wan Go Kollet Holy Communion For Shorsh by chiefotota(m): 10:46pm On Feb 04, 2018
Di pishure dey like pesin wey wan rush go shorsh, sidun for front seat, kollet holy communion.

Oya una put story wey pit tell us wetin Don Jazzy dey try do here.

See full pishure here: https:///p8ePqh-20r

Events / Una Meet Di 69 Years Woman Wey Get Di Most Tattoo For Body by chiefotota(m): 9:38am On Feb 04, 2018
Dis 69 years pesin mama, Charlotte Guttenberg, for Florida for Yankee, don kollet Guinness World Records for di most tattooed woman.

Tattoo cover 98.75 percent of her body, she yarn say she dey very happy to get dis Guinness award, base on se na dream come through, she do her very first tattoo wen she be 50 years, her husband, Chuck Helmke, sef na di man with di most tattoo.

See pishure of her and her husband for:

http://www.ototaspalmyjoint.com/una-meet-di-69-years-woman-wey-get-di-tattoo-body/

Celebrities / Check Out Omosexy As She Fresh Like Today Bread For Di Pishure by chiefotota(m): 11:36am On Feb 01, 2018
Who wan try awa Omosexy? See as Omotola fresh for dis pishure wey she snap for plane, she make sense finish, you nor go even know se she don drop engine (give birth).

OpataYarn

We just hope se as di dress na red dress so, we nor wan hear se she borrow ‘wedding bride’ dress o.
https:///p8ePqh-1ZO
Celebrities / If As Rmd, Market Fall Press Me And I Lost My Fame Una Go Still Love Me? - Rmd by chiefotota(m): 8:13am On Feb 01, 2018
Original fine Warri boy no pimples Nollywood actor, RMD, drop dis message wey make mega sense for Instagram yesterday Wednesday, he try to motivate fans and followers to keep their heads up, and be yourself, onto se all dis fame tins, plenty followers, Instagram likes and comments of awa pishure, nor really translate to love, he yarn plenty tins, just see di pishure and read di message for:

http://www.ototaspalmyjoint.com/rmd-market-fall-press-i-lost-fame-owu-blow-una-go-still-love-rmd-message-wey-make-sense/
Politics / Obasanjo And His Gang Don Launch Their 3rd Force, Coalition For Nigeria Movement by chiefotota(m): 4:01pm On Jan 31, 2018
As me and you dey talk so, di third force wey we former Presido, Olusegun Obasanjo talk about for di letter wey he use faya Buhari, APC and PDP red card, “Coalition For Nigeria Movement” don officially lauch today Wednesday for Shehu Musa Yar’Adua Centre, Abuja.

We nor know why for now, but Obasanjo, nor present for di launch, but some other top men wey get level like 2 former PDP guvnors, Olagunsoye Oyinlola and Donald Duke, mark present for di event.

https:///p8ePqh-1Zj

Travel / Emirates Airline Crew, Beat Up 71 Years Man, Tie Im Hand Like Prisoner For 8hrs by chiefotota(m): 3:19pm On Jan 31, 2018
Emirates airline don commit abomination, and di gods must hear dis. Di airline crew nor fear God, dem beat up 71 years old Naija granpapa, David Ukesone, because of se di man sidun for wrong seat.

According to gist for ABC News, di granpa dey travel from Naija to go connect with im family for America, so dem transit Dubai, na from Dubai to America, Jan. 23, di yawa for gas.

Di papa wey say he never travel plane for like 35years, enter toilet go ‘give peace a chance’, as he return, he miss im seat (35D), so as di flight attendant dey ans am to stand up, di paleh refuse to move from di seat, na so argument burst, di next tin, dem punch di man for face, tie im mouth and hand like criminal, look am up for 8 hours wey di flight dey air to Chicago.

Emirates don confirm di gist, dem say di man misbehave, so dem look am up, den hand am over to police wen dem reach America.

But di man wey go join im wife and children, his lawyer yarn ABC News say di man suffer injury for hand and leg, wey let dem admit am for University of Chicago Medical Center, dem don dey threaten court case.
See pishures for:

http://www.ototaspalmyjoint.com/emirates-airline-crew-beat-71-years-old-granpapa-tie-im-hand-mouth-8hrs-sidun-wrong-seat/
Crime / Cameroonian Gendarmes Attack Cross River Village by chiefotota(m): 5:40pm On Jan 30, 2018
Some Cameroon army guys, aka Gendarmes, Monday night attack Danare village for Boki Local Government Area for Cross River State. Di gendarme guys claim se dem dey fight some bad guys from Southern Cameroon wey cause trouble finish, run enter Naija con hide, for Danare.

Di Security Adviser for Cross River state, bros Jude Ngaji, yarn say dis matter pass his power, he say even police sef, nor get level to fight dis fight, because dis na international matter wey go gat to involve we Naija Army, he say dem don report di matter to people wey get power inside Naija to look into di matter, of which we Nigerian Army don already send one battalion to di area.

Dis nor be di fess time wey dis gendarmes dey attack Naija.
http://www.ototaspalmyjoint.com/cameroonian-gendarmes-attack-cross-river-village/
Politics / 80 Percent Of Di Teachers Wey Dey Nasarawa State Na Olodo – Commissioner by chiefotota(m): 8:29pm On Jan 29, 2018
Nasarawa State Government today Monday for Akwanga, Nasarawa state, don blow whistle se about 80 percent of di teachers wey dey teach school children for di state, dey incompetent.

Na di state commissioner of education, bros Ahmed Tijjani-Aliyu, blow dis whistle, wen he represent di state guvnor, Tanko Al-Makura, for di opening ceremony of di 2 days curriculum review for Colleges of Education, wey happen for College of Education, Akwanga.

He yarn say di guvnor, nor go sack di teachers o, wetin dem plan to do, na to continue to train di teachers, till their brain go open, onto se, dem must know book by faya by force, he yarn say di education for di country, don enter one chance, he advise di people wey dey arrange teachers for college of education for Naija, to use their mind, work very hard and train korret teachers from we colleges of education.
http://www.ototaspalmyjoint.com/80-percent-di-teachers-wey-dey-nasarawa-state-na-olodo-commissioner-education/
Family / My Wife Dey Naked Use Kpekus Swear For Me, Pastor Ans Court For Divorce by chiefotota(m): 8:17pm On Jan 29, 2018
I can not categorically say which church now, but one pastor, Bernard Towoju, today ans Customary Court for Igando, Lagos, to to skata his marriage, because he claim say his wife, Abosede, dey use kpekus (private part) swear for rham.

He yarn di court say di marriage nor fit work again, se no love again, he say di wife too stubborn and wayward, “she dey fight me all di time, even reach office, she don con fight me for office, everybody don know us, now sef, we don turn customer for police station, she even chase me commot from di house wey I build 10 years ago.” Di 53 years old father of 4, ans di court, “which kind wife go naked dey swear for her husband with her kpekus? Na wetin my wife dey do be dat, I can nor come and kee mysef, make we end dis marriage make everybody dey their own.”

Di 46 years old fashion designer wife, Abosede, yarn say she still love her husband, just dat di man dey catch her winsh, se na she be di cause of all his problems, but she say her hand clean, make di court just tell di man wey don run leave her and children for house for di last 10 years, make he come back.

Laslas di court, end di marriage.

see other news made funny for:
http://www.ototaspalmyjoint.com/wife-dey-naked-use-kpekus-swear-don-turn-customers-police-station-fight-pastor-ans-court-divorce/
Crime / E Better Make Pesin Be Thief, Dan To Smoke Igbo – Okorocha Advise Imo Youths by chiefotota(m): 2:06pm On Jan 29, 2018
Whether we like am or not, Imo state guvnor, Rochas Okorocha must trend, di yawa be, wetin dey make di guvnor trend?

As di guvnor Okorocha dey try to discourage youths of Imo state on di dangers of smoking igbo (weed), he don advise di youths for dis video, say e better make pesin be thief, dan for di pesin to dey smoke igbo.

For di video wey he speak with Ibo language, he yarn say, di state don arrange law wey be say go punish people wey dem smoke and sell igbo, he yarn say anybody wey dem catch, dem go demolish di pesin house, both smokers and sellers, he say as e be now, he prefer make pesin be thief, because theif, dem go only arrest you, he say nor be say he dey encourage thieves o, but if you reason di whole tin, you go discover se, na people wey smoke igbo dey thief, so if nobody smoke igbo, nobody go thief.

Watch di video: https:///p8ePqh-1YD
Celebrities / For Directors To Give Babes Role, Dem Go Ans You To Off Your Pant -naija Actress by chiefotota(m): 12:53am On Jan 29, 2018
Yoruba actress, Toyin Idowu, say to act film don taya her, di actress wey never feature for any film for some time now, yarn Vanguard say, nor be se she nor wan act o, but di directors for Naija film industry wan kee (kill) her career.

She yarn say for directors to give babes role, na war, dem must ans di babe to off her pant, spread leg for dem to enter di place. She say she nor wan call anybody name, but most times, na wetin dey always happen be dat, she say nor be only through acting, pesin take dey make am for dis life, she say di reason why most celeb relationship nor dey work, na dis “sex for role” wahala. She say she dey into serious relationship now, and she nor fit let acting chase her man away
http://www.ototaspalmyjoint.com/acting-don-taya-directors-give-babes-role-dem-go-ans-off-pant-spread-legs-nollywood-actress/
Jokes Etc / Obj And Pmb Gossip Nigerians For Au Summit, While Innocent Nigerians Dey Fight by chiefotota(m): 9:40pm On Jan 28, 2018
After former presido, Olusengun Obasanjo, blast we Presido, Buhari, advising him not to contest 2019 election, wey don set Nigerians up against each other, with some for Buhari back, and others for Obasanjo back, di 2 old papa wey Nigerians dey fight for, dey flex for di 30th African Union Summit wey dey go down for Addis Ababa, Ethiopia.

For di pishure wey don go viral, di 2 of dem dey laff and gist like people wey dey gossip Nigerians.
http://www.ototaspalmyjoint.com/obasanjo-buhari-dey-gossip-nigerians-au-summit-addis-ababa-innocent-nigerians-dey-fight-dem/

Crime / Twitter Story: Careless Mama Drop Her Pikin Off For School With Live Scorpion In by chiefotota(m): 10:54pm On Jan 27, 2018
Na wa o, nothing wey we nor go hear. Twitter user, @whytchik, just narrate story of how carelessness let a mother, drop off her Primary 1 pikin for school, with live scorpion inside di pikin shoe.
read di full gist for:
http://www.ototaspalmyjoint.com/twitter-story-careless-mama-drop-pikin-off-school-live-scorpion-inside-shoe/

Sports / Cavani Don Break Ibrahimovic 156 Goals Record For Psg by chiefotota(m): 9:07pm On Jan 27, 2018
Edinson Cavani don break Zlatan Ibrahimovic all-time goalscoring record of 156 goals for Paris Saint-Germain (PSG) today Saturday, as PSG beat Montpellier 4 kongo (4-0).

Cavani bin bracket Ibrahimovic 156 goals like 10 days ago, dem today he add another goal to make his own goals for PSG 157, di goal tortorri Cavani sotey, he off im shirt, throwey give crowd, den referee knack am yellow card.

Watch as PSG take celebrate Cavani:
http://www.ototaspalmyjoint.com/cavani-don-break-ibrahimovic-156-goals-record-psg/
Sports / Cavani Don Break Ibrahimovic 156 Goals Record For Psg by chiefotota(m): 8:36pm On Jan 27, 2018
Edinson Cavani don break Zlatan Ibrahimovic all-time goalscoring record of 156 goals for Paris Saint-Germain (PSG) today Saturday, as PSG beat Montpellier 4 kongo (4-0).

Cavani bin bracket Ibrahimovic 156 goals like 10 days ago, dem today he add another goal to make his own goals for PSG 157, di goal tortorri Cavani sotey, he off im shirt, throwey give crowd, den referee knack am yellow card.

Watch as PSG take celebrate Cavani:
http://www.ototaspalmyjoint.com/cavani-don-break-ibrahimovic-156-goals-record-psg/
Sports / Nff Don Arrange Oyinbo Coachy For Super Falcons by chiefotota(m): 2:31am On Jan 26, 2018
Nigeria Football Federation (NFF), don arrange new oyinbo coachy for Naija Super Falcons, di name of di new coachy, na Thomas Dennerby, from Sweden, he bin don coach Sweden national female team, his contract go last till 2010.

For di video wey NFF share for Twitter, di new coachy, yarn say he dey happy for dis job wey NFF don give am to coach African female football champion, he say he go use all di plenty experience wey he get for female football, move Falcons ministry to di permanent site.
http://www.ototaspalmyjoint.com/nff-don-arrange-oyinbo-coachy-super-falcons/
Crime / Middle Belt And Southern Groups Dey Call On Indigene To Boycott Cow Meat by chiefotota(m): 12:07pm On Jan 25, 2018
Two groups, Southern Nigeria Forum, and Association of Middle Belt Ethnic Nationalities, don run kolabo on as to deal with Fulani herdsmen wahala, for di meeting wey dem hold for Enugu, since e be like say Fed. Govt. dey slow.

Now dem dey call on indigenes of Middle Belt and Southern Naija to boycott cow meat for 21 days, as sign of respect for all di people wey Fulani herdsmen don kpai across Naija, starting from March 1, 2018.

Di group wey na Rev Okechukwu Obioha and Rev James Pam, sign dis agreement so, provoke say dem reject di committee wey Buhari set up, make Vice Presido, Yemi Osinbajo head, dem say di committee nor make any common sense, dem say make government send army go catch all di Fulani herdsmen, if dem know se dem serious.

Di group also say dem reject with strong words di creation of cattle colonies.
http://www.ototaspalmyjoint.com/middle-belt-southern-groups-dey-call-indigene-boycott-cow-meat/
Jokes Etc / Ibo Boys Don Put Obasanjo Letter To Buhari For Market by chiefotota(m): 9:50pm On Jan 24, 2018
In case you never read di letter wey Obasanjo use faya Buhari red card, no wahala, di letter don dey on sale. Guys wey dey sell newspaper for traffic, don add di letter to their newspaper for sale.
in case you like see or read a copy of di letter, den enter
http://www.ototaspalmyjoint.com/ibo-boys-don-put-obasanjo-letter-buhari-market/

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (of 7 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 66
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.