Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,155,835 members, 7,828,052 topics. Date: Tuesday, 14 May 2024 at 10:50 PM

Chiefotota's Posts

Nairaland Forum / Chiefotota's Profile / Chiefotota's Posts

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (of 7 pages)

Health / More Feather For Okonjo Iweala Red Cap As Who Give Her Anoda Appointment by chiefotota(m): 12:48pm On Apr 25, 2020
We former finance minister, Ngozi Okonjo-Iweala, don add anoda feather to her red cap, with anoda international appoint, from World Health Organisation (WHO). WHO appoint her as wetin dem call Special Envoy for Access to COVID-19 Tools (ACT) Accelerator.

Dis appointment wey dem appoint her and one British business executive, Sir Andrew Witty, go see Iweala and di British guy to “mobilise international commitment” for di COVID-19 fight, dem go epp make sure se dem get kolabo from all di kontriz for di world, to sharpadly arrange deve (development), produce, plus also share COVID-19 drugs, test kits and vaccines around di would.

Di oga at di top for inside WHO, Tedros Ghebreyesus, break dis news online from Geneva.
Source: https://www.ototaspalmyjoint.com/more-feather-for-okonjo-iweala-red-cap-as-who-give-her-anoda-appointment/

Health / Ashawo Say Make Govt. Add Dem To Essential Workers During S/africa Coro Lockdown by chiefotota(m): 9:43pm On Mar 26, 2020
Sex workers for South Africa dey call on Presido, Cyril Ramaphosa, to add ‘ashawo join di list of pipo wey go kollet osusu from Government, for Govt. ‘Temporary Employee Relief Scheme’.

According to one of di top ashao for di kontri during television interview, she say during dis lockdown, ashawo too dey go on lock down, she say dem need to go on lockdown, base on se dia work involve body contacts, so base on di social distancing level, ashawo nor go dey work, but she say govt. suppose find dem small tin, di way dem dey find oda South Africans small tin, because na from dia ashawo work dem dey feed dia families, so make govt. find dem small tin, make owu nor blow dem.

See di interview: https://www.ototaspalmyjoint.com/ashawo-say-make-govt-add-dem-to-essential-workers-during-south-africa-lockdown/

Events / I Go Dye Don Postpone Im 25yrs Anniversary Show Because Of Coronavirus by chiefotota(m): 9:53pm On Mar 18, 2020
Naija Comedian, I Go Dye, don postpone im 25 years anniversary show wey he call “I Go Dye Standing, “Kinging with the Kings” to avoid stories dah toush, base on di Coronavirus wey dey threaten.

He nor give new date for di show, but according to di post wey di Comedian for di press statement wey he drop, he say he don already spend N50million, base on logistics, for show wey suppose happen on April 12, wey be Easter Sunday 2020, for GRA, Benin city, Edo state.
See di statement here: https://www.ototaspalmyjoint.com/i-go-dye-don-postpone-im-kinging-with-the-king-show-because-of-coronavirus/

Celebrities / Samklef Say He Don Taya To Dey Beg Artist Wey He Epp Blow For Kolabo by chiefotota(m): 10:16pm On Mar 17, 2020
Una remember Samklef dah year abi? Wey produce beat for dem Wizkid and co to use blow? Correct, baba say he don taya to dey beg artist to kolabo with am.

We nor know who ans am, but he say for doz pipo wey dey wonder why he nor dey drop hit beats and music again, he say make we blame artist, wey refuse do kolabo with am, he say wen dis same artist need im epp, na so dem dey beg am o, but now make dem folo kolabo, dem dey shakara. See di video wey he use complain:
https://www.ototaspalmyjoint.com/samklef-say-he-don-taya-to-dey-beg-artist-wey-he-epp-blow-for-kolabo/

Health / Prof. Iwu Don Set To Kollet Govt. N36m Base On Cure Wey He Discover For Covid-19 by chiefotota(m): 9:18pm On Mar 02, 2020
Prof. Maurice Iwu, di former Chairmo INEC, don dey ready to kollet di N36million wey we Minister of Science and Technology, Ogbonnaya Onu, promise to give any scientist wey fit discover cure for Coronavirus, base on se, Prof. Iwu, say he don discover cure for di world number 1 deadliest disease as of today.
Prof. Iwu, wey be di oga at di top for Bioresources Institute of Nigeria, lead im guys wey dey run research tins, to go see Ogbonaya Onu and we Minister of Health, Dr. Osagie Ehanire today Monday for Abuja, he yarn dem say dem discover one medicine since 2015, wey dem sure se fit epp treat Coronavirus, he say wetin dem need now, na for Government to give dem support, so dat dem fit arrange di treatment to drugs for di Coronavirus.
https://www.ototaspalmyjoint.com/prof-iwu-don-ready-to-kollet-fed-govt-n36m-base-on-di-cure-wey-he-discover-for-coronavirus/

Celebrities / Simple Yes Or No: Dis Falz New Look Make Sense Or Not? by chiefotota(m): 4:03pm On Nov 12, 2019
We nor sure weda na swag or creativity, but Falz just share dis pishure of imsef, all his bia-bia white like wetin dem use white colour Berger paint dye.

Abeg make we advise Falz, dis white bia-bia make sense or not? Because Falz dey like amadioha wey dey form swag. see more pishures:
https://www.ototaspalmyjoint.com/simple-yes-or-no-dis-falz-new-look-make-sense-or-not/

Celebrities / Timi Don Set To Drop Christmas Album As He Sign International Record Deal by chiefotota(m): 11:07pm On Nov 05, 2019
E dey like se Naija RnB singer Timi Dakolo, fawo don lay cook egg, as di ‘Iyawo Mi’ singer, don sign recording contract with international music label, Virgin EMI Records, wey get konnet with Universal Music Group.
We nor sure di details of di deal wey Timi sign, but according to gist, na Efe Ogbeni, wey dey manage Christmas album, draw di konnet, after EMI hear di Christmas album wey Humberto Gatica and Frederic Gassita produce.
Timi wey nor fit hide im joy break di news for inside Instagram, he also tell us say im new album, “Merry Christmas Darling” go drop dis week Friday. See di post:
https://www.ototaspalmyjoint.com/timi-dakolo-don-set-to-drop-christmas-album-as-he-sign-record-deal-with-virgin-emi-records/

Education / 12 Years Pikin Wey Papa Teash For House Get Admission To University Of Ghana by chiefotota(m): 2:37pm On Oct 29, 2019
One 12 year-old boy, Viemens Bamfo, folo among di about 2,900 students wey just get admission enter University of Ghana, to study Public Administration.

Di pikin wey hope to become Presido for Ghana and make di kontri as independent as UK, China and America, pass di entrance exams with flying colours, after im papa, Robert Bamfo, wey be chemical engineer, teash am book from house.

Read di full gist and video: https://www.ototaspalmyjoint.com/12-years-pikin-wey-papa-teash-for-house-don-get-admission-to-university-of-ghana/

Celebrities / Simple Yes Or No, Tiwa Saveg Try For Dis Pishure? by chiefotota(m): 5:32pm On Oct 05, 2019
Nothing wey awa celebs nor go do to take enter news o. Make we put mout for dis mata, dis na di pishure wey pesin mama, Tiwa Savage, aka mama Jamjam share ontop her Instagram page, dis pishure make sense or not?

See di full pishure:
https://www.ototaspalmyjoint.com/simple-yes-or-no-tiwa-saveg-try-for-dis-pishure/

Celebrities / Mad Melon Wey Folo Sing Danfo Driver Hit Music Don Kick Bucket by chiefotota(m): 1:12pm On Sep 26, 2019
We nor sure wetin Daddy Showkey tell Mad Melon, one of di guys wey sing ‘Danfo Drivers’, but according to Daddy Showkey, for di video wey he take announce di death of Mad Melon, Showkey claim say “if dem dey tell pipo, dem nor dey hear.”

Showkey break di news say Mad Melon don kick bucket with di video wey he share ontop his Instagram page. We nor sure yet wetin kpai Mad Melon, but from Showkey video, he dey like se Mad Melon kpai, from something, wey Showkey don warn am about before.

Mad Melon and im guy, blow for early 2000, with dia popular song, ‘I am a Danfo Driver’.

See Daddy Showkey video:
https://www.ototaspalmyjoint.com/mad-melon-wey-folo-sing-danfo-driver-hit-music-don-kick-bucket/

Jokes Etc / Chief Otota On Top Buhari Ministerial List by chiefotota(m): 5:18pm On Aug 23, 2019
Wen Buhari appoint a former Guvnor, wey server as Guvnor for 8 years, as Minister of Interior, but he nor understand what his job, is as Minister of Interior.


Anoda wan from 'My Landlord Wife' series.

https://www.youtube.com/watch?v=4lTJGA5q3hk

Politics / Chief Otota In Community Beating by chiefotota(m): 12:19pm On Aug 20, 2019
As dem refuse to behave well for Naija, dem even refuse to let us protest peacefully, no wahala, na to dey block dem wen dem travel out and give dem beta community gather beating just like dem do Sen. Ike Ekweremadu.


https://www.youtube.com/watch?v=q74gpk3CWqM
Jokes Etc / Chief Otota In ESPIRIT D CORP by chiefotota(m): 10:01pm On Aug 10, 2019
Police now wey Army fall una guys, how market?
#whereisespiritdcorp anoda wan from my landlord wife series.

https://www.youtube.com/watch?v=iyqulrdBF6E
Health / Five Health Benefits Wey To Drink Beer Dey Give Body by chiefotota(m): 3:18pm On Aug 07, 2019
According to dis report, Beer wey be di number tiri (three) most popular drink wey human being dey consume after water and tea, get some health benefits, dis benefits even though dem go surprise you, but dem dey interesting.

Some research show se link dey between moderate alcohol drinking “and a 30% reduced risk of type 2 diabetes.”
One of di tins wey dey inside beer, ‘Dietary silicon’, dey epp develop bone and konnet tissue. Di research say pipo wey dey drink beer with sense (moderate drinkers), dey “38% likely to have osteoporosis” dan pipo wey dey kari drink any how high.
Base on di hops, barley and wheat wey dem take dey make beer, beer get nutients like calcium, potassium and magnesium. Beer also get ‘soluble fiber’, dah means two full cups of beer fit give you 10% di daily fiber wey you need.

Di oda two benefits of drinking beer see dem here: https://www.ototaspalmyjoint.com/five-health-benefits-wey-to-drink-beer-dey-give-body/

Politics / Chief Otota In Animal Kingdom by chiefotota(m): 5:27pm On Aug 05, 2019
At a time, na rat chase Buhari from #AsoRick, den ant don eat Chief Justice of Nigeria certificate, even snake too don drive Ondo #LawMaker from di state House of Assembly, finally dis kontri na #AnimalKingdom.


https://www.youtube.com/watch?v=lvK9GVJmnEA
Politics / Economic Guru Mismarck Rewane Dey Advise Nigerians To Ready For Fuel Increase by chiefotota(m): 1:29pm On May 15, 2019
Dis tori go sawa some pipo belle, but according to Naija top Economic guru, oga Bismarck Rewane, wey serve as Chairmo wey advise Fed. Govt. for di Technical Advisory Committee on Implementation of the National Minimum Wage, he dey warn Nigerians to ready because, Fed. Govt. go need to increase di price of fuel.

Oga Bismarck, yarn dis fuel increase talk today Wednesday for di presentation we he do for Lagos business school breakfast session, he say di osusu wey Government dey spend on top fuel subsidy too mush, and government dey reason as as how to reduce dis subsidy payment, he say for inside 2018, World Bank say Naija spend N731 billion for fuel subsidy, he say now Government dey plan to dey reduce dis subsidy small small, so therefore, make we ready to pay more for fuel, as dat na di only way out.

Source: https://www.ototaspalmyjoint.com/economic-guru-mismarck-rewane-dey-advise-nigerians-to-ready-for-fuel-increase/

Politics / Doctors Don Order Buhari To Remain For London Base On Se Im Health Don Cast by chiefotota(m): 3:50pm On May 03, 2019
We nor sure where Sahara Reporters from get dis story from, but dem dey claim say dem get source from inside Aso Rock, wey inform dem say Buhari go extend his private visit to London, beyond May 5, wey he bin talk say he wan come back to Naija.

According to di exclusive report, Sahara dey claim say Buhari health don get complications, base on dis complications so, doctors dey order Buhari to remain for London, make dem finish his treatment.

https://www.ototaspalmyjoint.com/sahara-reporters-say-buhari-health-don-cast-doctors-say-make-he-remain-for-london-beyond-may-5-to-continue-treatment/

Celebrities / Funke Akindele Account Don Add Weight As Dettol Arrange Her Endorsement Deal by chiefotota(m): 8:25pm On Apr 17, 2019
More blessings for Nollywood actress, Funke Akindele, aka Jenifa, as RB Nigeria, wey dey make Dettol soap and oda Dettol products, don arrange endorsement deal for di actress, wey God just bless with ejima, not long ago.

We nor sure how mush alert di deal land for Funke bank account, but gist for some background, dey claim say di deal, make Funke account add weight, base on se di money loooooong.

RB Nigeria, unveil Funke today Wednesday for Radisson Blu Hotel, Ikeja Lagos, as dem launsh dia new “Dettol Clean Naija” campaign, wey dem wan use take encourage Nigerians to dey clearn up, make Naija for dey healthy.

Source: https://www.ototaspalmyjoint.com/funke-akindele-account-don-add-weight-as-dettol-arrange-her-endorsement-deal/

Crime / Omila Burst Police Station Thief 3 Rifles As Police Go Watsh Uefa Matsh by chiefotota(m): 3:50pm On Apr 17, 2019
Market don fall press police officers wey dey Kobujoi Police Station, for Nandi County, Kenya, as some bad guys, burst di police station, go thief 3 rifles with bullets, as di police guys, wey dey duty, go watsh UEFA Champions League matsh for viewing center.

As di officers return from viewing center, dem discover se di OC (Officer in Charge), room wey dem dey keep gun dey open, as dem enter di room, dem see say 3 rifles with magazines wey contain 20 rounds dey miss, but di omila guys sorry for dem leave 2 oda magazines wey contain 17 and 20 rounds for dem.

Police right now don start to investigate and search for di omila everywhere.

For more funny but true stories, check www.ototaspalmyjoint.com

Events / Oritse Femi Mark Present For ‘axemen’ Aka Convention by chiefotota(m): 10:23pm On Apr 14, 2019
Axemen confraternity, aka (NBM) of Africa, gada demsef for Ibro Hotel wey dey Abuja, from April 11-14, to hold dia annual national convention of di group wey start from University of Benin, since late 1970s.
Di presido of NBM of Africa worldwide, Engr. Felix Kupa, for his address clear di doubt wey pipo get about di group, he say make di full wide world know se, NBM nor be violent group as some pipo think, he say dem dey against violent and dem dey work with security guys to arrest di bad guys wey dey part of di group.
The group and dia members share, videos plus pishure from di Abuja event for dia Facebook page, and we sight purpular Naija singer Oritse Femi with some ‘ayei men’ for some of di pishure.

See videos and pishure: https://www.ototaspalmyjoint.com/oritse-femi-and-oda-axemen-mark-present-for-neo-black-movement-national-convention-for-abuja/

Health / Report Don Catsh South South Zone As Di Zone Wey Get Di Highest Pipo With Hiv by chiefotota(m): 11:12am On Mar 15, 2019
If you be young pesin wey dey do horizontal refreshment (sexual intercourse) without condom, listen well cos dis tori go favour, especially if you dey South-South zone. South South zone, according to 2018 Nigeria HIV and AIDS Indicator and Impact Survey (NAIIS) report wey dem just release, na di zone wey get di highest number of pipo wey get HIV/AIDS.

South-South Zone carry 1st with 3.1 per cent for di survey wey dem carry out on top pipo wey dey between 15-64years, number 2 for di list na North Central zone with 2.1 per cent, South East zone na number 3 with 1.9 per cent, South West zone carry 4th with 1.2 per cent, North East dey stroll for di list as number 5 with 1.1 per cent, las las for di list na North West zone with 0.6 per cent.

We Minister of Health, Prof. Isaac Adewole, yarn say government go use dis survey take arrange korret work wey government dey do to fight against HIV/AIDS for inside Naija.


Source: https://www.ototaspalmyjoint.com/report-don-catsh-south-south-zone-winsh-as-di-zone-wey-get-di-highest-pipo-with-hiv-aids/

Business / As E Dey Hot: Buhari Don Use Broom Chase Godwin Emefiele From Cbn by chiefotota(m): 7:21pm On Mar 04, 2019
Buhari government, don today Monday write letter give Godwin Emefiele, di Guvnor of Central Bank of Nigeria (CBN), say make Emefiele with speed, remove unto compulsory leave, before his time go expire as CBN Guvnor.

Emefiele wey don dey hold ground for CBN since June 3, 2014, wey former Presido Goodluck Jonathan, appoint am, shock wey he receive di letter for his office today Monday. Before Emefiele enter CBN, he fess dey hold ground as one of di ogas at di top for Zenith Bank.

Source: https://www.ototaspalmyjoint.com/as-e-dey-hot-buhari-don-use-broom-chase-godwin-emefiele-from-cbn/

Romance / Five Years After Marriage, I Still Be Virgin, My Husband Refuse To Toush Me by chiefotota(m): 8:47pm On Jan 04, 2019
We nor sure where dis tin for happen, but according to dis gist for insidearewa.com.ng dis babe dey claim say he husband wey she marry 5 years ago as virgin refuse to toush her, base on horizontal refreshment tins.

According to di babe, di tin start like play, but na 5 years don complete so, and bros refuse to toush her, as she para confront guy man, she discover se bros na member of gay cult wey nor suppose toush dia wives until 8 years after marriage, and di sex go happen after bros don fess wipe pig. See di full gist: https://www.ototaspalmyjoint.com/five-years-after-marriage-i-still-be-virgin-my-husband-refuse-to-toush-me/

Celebrities / Simple Yes Or Nor. Mr Eazi Na Woman Wrapper Or Lover Boy by chiefotota(m): 6:42pm On Jan 03, 2019
For dis fine pishure wey dey tear social media, Naija
singer, Mr. Eazi dey epp im babe, Temi, wey be Otedola pikin losen her hair.

Di pishure make we nor lie, make sense, but wetin we like
find out be se weda dis work wey Mr. Eazi dey do so na woman wrapper or Mr.
Romantic?

https://www.ototaspalmyjoint.com/simple-yes-or-nor-mr-eazi-na-woman-wrapper-or-lover-boy-for-dis-pishure-wey-he-epp-im-babe-temi-otedola-losen-hair/

Religion / Guvnor Ajimobi Arrange Law Make Religious Bodies Dey Pay Security Levy by chiefotota(m): 12:23pm On Nov 28, 2018
Oyo state now don ready to dey charge religious organisations like church, mosqu plus large, medium and small manufacturing and services companies wetin di state government call annual security levy, to take arrange di state security trust fund.

All dem large, medium and small manufacturing and services go dey pay N100,000, N80,000, N60,000, people wey dey trade, do agriculture and forestry/solid minerals go pay dey N80,000, N50,000 and N30,000.

Find out how mush church and oda religious groups go dey pay: http://www.ototaspalmyjoint.com/guvnor-ajimobi-arrange-law-make-religious-bodies-dey-pay-security-levy/

Celebrities / Danny Young Dey Threaten To Sue Her Tiwa Savage For Music Theft by chiefotota(m): 10:05pm On Nov 27, 2018
Naija artist, Danny Young, don threaten to sue Mavin first lady, Tiwa Savage for song theft.

Danny young last week end for di video wey he share on Instagram, accuse Tiwa Savage say Tiwa thief part of di lyrics for im 2009 hit track ‘Oju Tiwon’ for Tiwa new single wey she call ‘One’.

Part of di lyrics for both songs, dem use di line “my life don better”, some people for social media dey talk say di very line na from one Yoruba proverbs, so Danny nor fit claim ownership. But for di tweet wey Danny share today Tuesday, he dey rake say he don contact his lawyer.

Read di full gist: http://www.ototaspalmyjoint.com/danny-young-dey-accuse-tiwa-savage-se-she-thief-his-lyrics-threaten-to-sue-her/

Celebrities / Harrysong Lead Praise And Worship For His Former Church For Warri by chiefotota(m): 8:09am On Nov 26, 2018
Harrysong, aka di king maker, yesterday Sunday attend his former church, Church of God Mission, for Odibo, Warri, he attend di church base on Harvest and Thanksgiving tins, and di news for here be se, he nor just go as normal church member.

Harrysong lead praise and worship session during di service, and he share video of di service.

See di video: http://www.ototaspalmyjoint.com/harrysong-lead-praise-and-worship-for-his-former-church-for-warri/

Crime / Video: Mother Of 3 Send Her Pikin To Thief Oyinbo Woman Hand Bag by chiefotota(m): 7:52am On Nov 26, 2018
We nor sure where dis tin for happen, for dis lady for dis video, with her three kids, obviously encourage her daughter to thief dis oyinbo woman hand bag from under her seat, while di woman dey busy with her work.

Watsh video: http://www.ototaspalmyjoint.com/mother-of-3-send-her-pikin-to-thief-oyinbo-woman-hand-bag-watsh-di-video/

Crime / Di Number 1 Omila For Offa Bank Robbery Don Kpai For Police Hand by chiefotota(m): 2:09pm On Nov 21, 2018
Di number one man of di omila guys wey go rob bank for Offa Kwara state, don kpai for inside police cell according to information wey Kwara State Attorney General and Commissioner for Justice, oga Kamaldeen Ajibade, carry con Ilorin High Court wey dem dey for judge di case.

Oga Attorney General tell di court say he receive information from police headquarters from Abuja, say Michael Adikwu, wey lead his guys to rob bank on April 5th, 2018, don kpai, he tell di court judge, Justice Halimat Salman, say base on dis new development, dem go need to adjourn di case, make he for go fit rearrange di case against di remaining 5 suspects, base on dem nor fit judge case against dead body and di oda members of di gang wey come court, nor come with lawyer to defend dia case.

Di judge, Justice Halimat Salman... to find out wetin di court judge dey talk, visit:
http://www.ototaspalmyjoint.com/di-number-1-omila-for-offa-bank-robbery-don-kpai-for-police-hand/

Politics / Obama Na Hypocrite, He Follow Campaign Against Me For 2015 – Gej Faya Obama by chiefotota(m): 10:48pm On Nov 20, 2018
As we former Presido, Goodluck Ebele Jonathan mark his 61st bithday, he don lauch new book wey he call ‘My Transition Hours’ and for di book, he describe former US Presido, Obama, actions before 2015 election as hypocrisy.

Jonathan for di book talk about some of di high points of his government, he talk about Chibok girls and why INEC post pone di election for 6weeks, he talk say Obama, follow for people wey work against am for di election wey let am lost di election.

He say March 23, 2015, Obama release wan video wey he take codedly campaign for Nigerians to vote for Buhari dah year. He say Obama nor try all, na last Obama carry.

Di book launch make sense as top guys wey get level for politics for Naija and Afrika, all come togeda and and all of dem agree say Jonathan deserve accolades.

http://www.ototaspalmyjoint.com/obama-na-hypocrite-he-follow-campain-against-me-for-2015-election-goodluck-blast-obama-for-my-transition-hours-book/

Politics / Atiku No Talk Say He Go Reduce Fuel Price – Atiku Campaign Organisation by chiefotota(m): 12:42pm On Nov 20, 2018
One member of strategic think, Atiku Campaign Organisation, oga Wole Akin, don deny se PDP Presidential candidate for 2019 election, Atiku Abubakar, promise to reduce di price of fuel.

Wole Akin appear as guest today Tuesday for one political show for radio to discuss Atiku campaign document wey Atiku say he wan use take Get Nigeria Working again. One of di host for di show, ans oga Wole, di plan wey Atiku wan use reduce fuel price, base on se PDP for di statement wey dem release weeks ago yarn say, Atiku go reduce fuel price to about N90.

Oga Wole say Atiku never for im life make dah promise, he say di only tin wey Atiku dey talk about and wey Nigerians fit use take hold Atiku accountable if he win di election...

read up di full gist for: http://www.ototaspalmyjoint.com/atiku-nor-talk-say-he-go-reduce-fuel-price-na-deregulation-atiku-promise-atiku-campaign-organisation/

Crime / Crowd Gada Beat Lazy Youth Wey Dey Thief Women Pkata (pant) For Imo Community by chiefotota(m): 4:41pm On Nov 12, 2018
At a time wey rumour full town say yahoo boys new move now na to dey sell babes kpata between 200-300k for retuals, market don fall press dis lazy youth for Umuokoro community, wey dey Imo state.

Di guy move from his own Obowo community to anoda community, just to con thief babes pant, he never talk wetin he dey do with di pants o, but crowd don gada beat di guy break im head.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/crowd-gada-beat-lazy-youth-wey-dey-thief-women-pkata-pant-for-imo-community/

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (of 7 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 92
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.