Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,566 members, 7,809,065 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 10:08 PM

Chiefotota's Posts

Nairaland Forum / Chiefotota's Profile / Chiefotota's Posts

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (of 7 pages)

Celebrities / Beverly Osu Say As A Model To Go Naked, Na Her Work, Deny Pregnancy Rumour by chiefotota(m): 9:33pm On Apr 10, 2018
Former Big Brother Africa housemate and model, Beverly Osu don deny di rumour wey break for social media wey some blogs do ovasabi carry se she get belle.

She yarn say di pishure wey she snap hold her belle, wey let some people think say she get belle, na just aproko people just like carry fake news, she yarn say wetin happen for dah pishure be se, she chop bellefull, den she just snap foto, hold her belle nai people carry dey talk any how, she say she nor plan to carry belle for now.

She also yarn wey de mans her about nudity as a model say, unclothedness na part of di job as a model, she say fess tin be se, as a model, you be like mannequin, she say another tin be say, a model gat to dey proud of her skin, so she say yes, she fit go naked as a model, he nor mean anything, so far dem pay her well.

watch di videos:
http://www.ototaspalmyjoint.com/ex-bbafrica-house-mate-beverly-osu-say-as-a-model-to-go-naked-na-her-work-deny-di-rumour-se-she-get-belle/
Celebrities / Make Entertainers Use Influence Enter Politics And Make A Difference - Akpororo by chiefotota(m): 8:49pm On Apr 10, 2018
Naija Comedian, Akpororo dey call on entertainers to go into politics, and make entertainers use their power take make di deference for politics.

Akpororo yarn say entertainers dey very influential, especially on di youths, he encourage fellow entertainers to join politics and make di difference, he warn di wans wey go like join politics, make dem nor go enter power go do any how like we current politicians dey do o, he say any entertainer wey know se he go behave di way we politicians dey behave, make dat pesin just give chance.

Watch di video:
http://www.ototaspalmyjoint.com/make-entertainers-use-their-influence-and-power-enter-politics-and-make-di-difference-akpororo/
Celebrities / Timaya Arrange New Mansion by chiefotota(m): 5:47pm On Mar 30, 2018
We nor fit categorically tell una di details, but we fit confirm give una se Naija artist, Timaya, di Egberipapa 1 of Bayelsa, don arrange new house.

We nor sure where di house dey or di cost of di house, but Comedian IGoDye, share dis pishure of di house, and congratulate Timaya on Instagram.

See details: http://www.ototaspalmyjoint.com/timaya-launch-new-mansion/

Celebrities / Me Na Confirm Naija Delta Militant, Ras Kimono Explain Why He Sing Senseless Kil by chiefotota(m): 1:15am On Mar 24, 2018
Naija music living legend, Ras Kimono make surprise guest appearance for Friday Comedy Night with De Don, for Bar 32, for Opebi, Ikeja Lagos, dis Friday night.

De Don dey stage dey crack joke, wen Ras Kimono enter di background with his manager and a friend, na so fans start to agitate make Kimono bless di stage o, after mush (much) agitation, na so Ras Kimono wey dey plan his 35 years on stage concert dis year, carry mic climb stage o.

First he hail di fans, dem he yarn small about di state of Naija music, he make di fans understand se, even though wen all dis we young musicians dey sing kpangolo (rubbish) song, music for Naija never die. He use di opportunity talk about his most recent single ‘Senseless Killings’, he say di song nor really dey about boko haram/Fulani herdsmen killings, not even Naija Delta crisis, he say di song na about di senseless wey people dey kee (kill) each other for rituals, he also yarn say he be confirm Niger Delta militant.

Watch di videos: http://www.ototaspalmyjoint.com/me-na-confirm-naija-delta-militant-ras-kimono-explain-why-he-sing-senseless-killings/
Sports / Usain Bolts Don Resume Training With German Club, Dortmund by chiefotota(m): 1:03am On Mar 24, 2018
Former athletics legend, Usain Bolt, on Friday don resume training session with German Bundesliga side, Dortmund, dis training session so, nai go determine weda di former 100 metres champion go go further with his football career or not.

See training pishure here: http://www.ototaspalmyjoint.com/usain-bolts-don-resume-training-with-german-club-dortmund/
Politics / I Go Show Security Chiefs Pepper If Any Kidnapping Happen Again by chiefotota(m): 3:47pm On Mar 23, 2018
We Presido, Muhammadu Buhari, today Friday for Abuja, for di reception wey he use receive di Dapchi gehs wey boko boys just release, yarn say, if for any reason, anything like kidnapping of school children happen for any part of di country again, nai be se awa security oga at di top, go smell pepper.
He advise we security chiefs dem, to arrange better securities for we schools for across di country, because he nor wan hear say anything like abduction happen again.
He use di opportunity warn politicians wey dey politicize dis kidnap of school children, he say make we politicians take their time o, because who do any how, go see any how, he ans (ask) politicians, weda na everything dem dey use play politics? He say he don give security guys go ahead to deal with politicians wey play politics with dis kidnap mata.
Religion / Re: Amadioha… Sorry Thunder Kpai 16 People Inside Church For Rwanda by chiefotota(m): 2:07am On Mar 18, 2018
thanks, but there are no generally acceptable standards for how words are spelt in pidgin though, na me just dey do my tin, whats important for me, is communicating, sending my message and you understanding me.
CuteMadridista:
Lmao! this is the longest pidgin text I've ever read and I was just laughing cuz I didn't know this is how the words are spelt especially "Kpai" and "Wounjour"
Crime / Naija Guy Run Im Car Over Another Naija Guy Because Of 27 Euros For Madrid by chiefotota(m): 2:03am On Mar 18, 2018
One Naija guy for Madrid, Spain, owe dis other Naija guy, Chima, 27-Euros (about N12,000), on Friday here, March 16, Chima dey try draw di other Naija guy his money o, as dem dey ague over di money, na so Chima, wey im wife just born pikin, stand for di guy front of car, say di guy nor go move unless di guy pay am.

Una nor go believe, but dis other Naija guy, jam Chima, run car over Chima not once, but 2 times, right now, Chima dey struggle for his life for hospital.

We nor fit confirm if police don arrest di other Naija guy or not, as at di time wey eyewitness report dis story give us.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/naija-guy-run-im-car-over-another-naija-guy-because-of-27-euros-for-madrid/
Religion / Amadioha… Sorry Thunder Kpai 16 People Inside Church For Rwanda by chiefotota(m): 4:51am On Mar 12, 2018
If to se na amadioha shrine dis kind tin for happen, we for talk say, di gods are angry, but as na inside church so, make we kikwayet (keep quiet) before God vex.
Na 16 people nai don kpai (die) while some others wounjour, inside one Seventh-Day Adventist church wey dey Nyaruguru area for Rwanda, as thunder strike on Saturday, di church members dey inside church wey dey tin happen, dis same thunder also kpai one student di Friday before di Saturday, for di same area.
According to di report for inside AFP, like 3 other people from di church dey for critical condition for hospital, we just pray make God show mercy on di people we wounjour.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/amadioha-sorry-thunder-kpai-16-people-inside-church-rwanda/
Celebrities / 4 Days After Hospital Discharge Rick Ross, He Carry Im Daugters For Shopping by chiefotota(m): 1:37am On Mar 10, 2018
If you join people wey dey doubt weda Yankee rapper, Rick Ross dey ok, nor need, because just 4 days after hospital discharge di rapper, after he faint wey make dem rush am go hospital, Rick Ross don take im daughters out for shopping.

TMZ sight di rapper and im daughters and baby mama as dey go for shopping for Bal Harbour Shops wey dey Miami on Friday, di report say im senior girl, Toie, birthday suppose be 16 of dis month, and base on di hospital admission tins, dem don postpone am, but be like se dem still do di birthday shopping tins.

See more pishure: http://www.ototaspalmyjoint.com/4-days-hospital-discharge-rick-ross-garry-im-daugters-shopping/

Politics / 2019 Election: Pst Chris Okotie Fresh Democratic Party Plan Convention Saturday by chiefotota(m): 5:15pm On Mar 09, 2018
We can not categorically tell una now se Pastor Chris Okotie wan contest 2019 Presidential election, but we fit tell una se Fresh Democratic Party, di political party wey Pastor Okotie form and use contest 2007 abi na 2011 election sef, dey hold convention dis week end for Lasgidi.

For some weeks now, Pastor Okotie don dey talk about God plan to crown am, as Presido of Naija, so during kweshun and answer time for Pastor Okotie HouseHold of God church for Oregun Lagos, some members don ans wetin dem go do to epp make di “Abuja vision” come through, but di man of God continue to tell members say, nothing wey dem fit do pass to just pray make God do wetin God need to do.

Get more gist on dis Pst. Okotie 2019 runs for:
http://www.ototaspalmyjoint.com/exclusive-2019-presidential-election-pastor-chris-okotie-fresh-democratic-party-plan-convention-saturday/

Car Talk / Imagine Say You Open Your Car And See King Cobra Snake Inside Your Car Engine? by chiefotota(m): 12:30am On Feb 25, 2018
Imagine wetin e go be like to open di burnet of your car, and discover king cobra snake inside your engine?

One 55 years man for Thailand, Thaichai Kongnimit, on Thursday morning, enter im car, to drive to im work place, wen he notice wan unusual sound from di car engine, as e open di burnet to check wetin dey make di sound, wawu, na dis 15-foot king cobra snake di man see, with speed, he slam di burnet close, den dem call snake catcher, wey epp catch di snake.

Di snake catcher say he go free di snake enter bush, see snake wey we go press im neck vomit 36million, den roast di snake chop, abeg watch di video: http://www.ototaspalmyjoint.com/imagine-say-open-car-see-king-cobra-snake-inside-car-engine/

Romance / Babe Go On A Valentine Date Naked, Just Body Paint by chiefotota(m): 11:18pm On Feb 24, 2018
Dis model, Joy Jewell, for Yankee, meet dis comedian guy for online for Tinder, dem agree to hang out on Valentine’s day, but di babe, just decide to naked go on di date, but she paint her body, just to see whether di guy go find out. Una dey see madness?

Di guy claim say im mind tell am say di babe naked o, but he just wave di thought aside se e nor possible.

Watch di make up video here: http://www.ototaspalmyjoint.com/babe-go-valentine-date-naked-just-body-paint/

Crime / Re: Zambia Govt. Nab Bolivian Guy Wey Try Import Cocaine Wey He Code Inside 55 Condo by chiefotota(m): 2:31am On Feb 22, 2018
@gboxbaba
thanks, for your concern, but i don come too far to give up, i dey move ahead, and i dey trust God to epp me prove you wrong, thanks for taking out time to share your thoughts on what i do, God bless

1 Like

Pets / Snake Head Hang Inside Can Beer Trying To Drink Beer by chiefotota(m): 2:24am On Feb 22, 2018
I can not categorically tell una se dis na di snake wey swallow N36 million for Naija, but we fit tell una say dis tiger snake wan drink beer, but as e dey try to drink di beer, di snake head hang inside di beer can.

Snake catcher, Stewy, share dis video on Facebook wey im and im guy, dey try to epp di snake out of di beer container, he say na di people wey dey di area for Australia, call dem to con epp di snake, after dem try to but fail to epp di snake.

Watch di video of di snake here: http://www.ototaspalmyjoint.com/watch-snake-head-hang-inside-can-beer-trying-drink-beer/

Celebrities / Pop Artist Madonna Say Her Adopted Son, Go Be Di Future President Of Malawi by chiefotota(m): 6:50pm On Feb 20, 2018
Pop singer Madonna, today Tuesday don celebrate her adopted Malawian son, David Banda, for di pishure wey she share of di 12 years boy on Twitter, she refer to di guy as "future president of Malawi."

We can nor categorically tell una wetin her game plan be, but she get like 4 children wey her charity, Raising Malawi, adopt from Malawi.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/pop-artist-madonna-say-adopted-son-go-di-future-president-malawi/
Crime / Zambia Govt. Nab Bolivian Guy Wey Try Import Cocaine Wey He Code Inside 55 Condo by chiefotota(m): 5:05pm On Feb 20, 2018
Anti-drug authorities for Zambian, don nab one 27 years Bolivian guy, wey try to codedly import cocaine into Zambia.

Di guy, enter Zambia from Brazil, but he fess transit for Angola before he laslas land for Zambia, di Anti-drug guys, say di Bolivian guy, code 2.1kg of cocaine inside 55 condoms, den he put dem inside 55 bottles of roll-on.

Dem don dey reason di guy enter court, make he explain imsef.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/zambia-govt-nab-bolivian-guy-wey-try-import-cocaine-wey-code-inside-55-condoms/

1 Like

Politics / Kaduna State Govt. Demolish Di Secretariat Of Apc Faction Wey Suspend El-rufai by chiefotota(m): 9:32am On Feb 20, 2018
One faction of APC for Kaduna state, knack suspension letter for di state Guvnor, Mallam El-Rufai, di state government don faya back as bulldozer early mor-mor today Tuesday don demolish di secretariat, we nor fit talk who really send di bulldozer for now, but we sure se na di state government give di order, onto se some army guys nai escort and monitor di demolition.

Di secretariat building, na Sen. Suleman Hunkuyi of Kaduna North, wey di other faction of APC for di state bin don already suspend, get am.

Shehu Sani of Kaduna Central, na also member of dis factor of APC.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/e-dey-hot-kaduna-state-govt-don-demolish-di-secretariat-apc-faction-wey-suspend-el-rufai/

Technology Market / Re: Any Facebook Page With About 50k Likes For Sale? by chiefotota(m): 1:56pm On Feb 19, 2018
Please if you are serious, and your page is legit, hala me on 08035752120
friendlyadvice:

Ah ah wetin dey worry that guy? Sorry about that I go follow am yan perhaps he didn't know I sent you no vex
Technology Market / Re: Any Facebook Page With About 50k Likes For Sale? by chiefotota(m): 12:07am On Feb 19, 2018
Tried reaching out to this number, the receiver said he does not want anything to do with a Nairalander, so why you con put you contact here in the first place?
friendlyadvice:
08032773199
Nurudeen
Technology Market / Any Facebook Page With About 50k Likes For Sale? by chiefotota(m): 10:22pm On Feb 17, 2018
Any body with a facebook page with about 50k active followers for sale should please hola
Celebrities / Use Your Church Mind Remove Zuma Statue Now – I Go Dye To Okorocha by chiefotota(m): 6:16pm On Feb 17, 2018
If your know Naija Comedian, I Go Dye very well, you go know se, beyond comedy, he get deep passion for we country Naija, dat na why wen he nor dey stage dey make people laff, he dey use im social media platforms to contribute for nation issues.

Di original Warri boy, don dey beg di Guvnor of Imo state, Rochas Okorocha to use im church mind, remove di statue of Jacob Zuma, we Okorocha don rake say he nor go remove, after Zuma resign as South Africa Presido, onto corruption tins.

I Go Dye for di open letter wey he post on Instagram to Okorocha, yarn say wen dem accuse Zuma of corruption for South Africa, Zuma use im church mind, resign by imsef, so di comedian dey call on Rochas to do di same and listen to voice of people wey get sense, and remove di statue.

See I Go Dye open letter:

http://www.ototaspalmyjoint.com/use-church-mind-remove-zuma-statue-now-i-go-dye-okorocha/
Celebrities / I Be Pastor Nor Mean Se Make I Nor Do Secular Music Or Stop To Go Club – Kas by chiefotota(m): 2:33am On Feb 16, 2018
Naija artist wey don turn pastor Praise God Ministry for London, Kas dey plan “Kas Welcome Back Concert” dis Feb. 25 for Lagos, Kas wey singe “efimile” don reason us of as he dey manage combine imsef as pastor and secular artist.

He say from wen he small, nai he beg God to make am become popular musician, and God answer dat prayer, but along di line, di music and fame drag am away from God wankind wankind.

He claim say he finally get revelation from God on wetin he suppose do for God, now he dey do all those tins for God as pastor London, but dat wan nor stop am from being a musician, he say he still dey do his secular music, and he still dey go club and party, just dat he dey do all dis tins with sense. He say some people even dey claim say na because of tithe and offering make am enter church, but na lie, onto se, God don already fess bless am, so he nor dey into church because of money.

Watch di brief interview and also get info for di Kas Welcome Back Concert:

http://www.ototaspalmyjoint.com/i-pastor-mean-se-make-i-secular-music-stop-go-club-kas/
Jokes Etc / Di Crazy Reason Why Facebook Group Wan Make Okorocha Erect Buhari Statue by chiefotota(m): 12:48am On Feb 16, 2018
I nor understand una at all for dis country o. so dis Facebook group, Hope For Nigeria, do an analysis of wetin don happen to all di African leaders wey Imo state Guvnor, Rochas Okorocha, don erect, like play like joke, you go see say from Johnson Sirleaf of Liberia, to Mugabe of Zimbabwe and now to Zuma of South Africa, all dis African leaders nor dey office again, after Rochas erect their statue for Imo state.

Now dis guys for Facebook dey call on Rochas to arrange Buhari statue, see di Facebook post here:

http://www.ototaspalmyjoint.com/see-di-crazy-reason-dis-facebook-group-wan-make-okorocha-erect-buhari-statue/
Crime / Naija Army Promise N3m For Anybody Wey Blow Whistle On Boko Haram Leader Shekau by chiefotota(m): 12:30am On Feb 16, 2018
If you need urgent 3m cash, wey dey hot sef, fresh from CBN, listen to dis gist, e go favour you. Naija Army don promise to bless anybody wey fit give information wey go epp dem catch boko haram leader, Abubakar Shekau, 3metres (N3million) cash. So if you need di 3metres, just tell Naija Army where Shekau dey, with speed, dem go bless you.

Dis reward on top Shekau head so, dey come just some few days, after Army announce say Shekau dey on di run, dem claim say Shekau dress like woman with hijab dey try to run.

See Army tweet here: http://www.ototaspalmyjoint.com/naija-army-promise-n3million-anybody-wey-blow-whistle-boko-haram-leader-shekau/
Sports / Dem Suspend Me Because I Nor Gree Follow Dem Do Dagbo Runs – Sunday Oliseh by chiefotota(m): 11:40pm On Feb 14, 2018
Former Super Eagles coachy, Sunday Oliseh, don confirm se Dutch club, Fortuna Sittard don suspend am, but he say dem suspend am, base on se he refuse to run dagbo shows (participate in Illegal activities) for di club.

Oliseh claim for di tweet wey he share after di news of di suspension break say, na di Foreign Owners wan make he follow dem, don illegal activities, he nor tell us wetin di illegal activities be o, but he just yarn say he nor gree, see di tweet for:

http://www.ototaspalmyjoint.com/dem-suspend-i-gree-follow-dem-dagbo-runs-sunday-oliseh/
Romance / Indonesia Ban Valentine’s Day Celebration, Police Arrest Love Birds by chiefotota(m): 9:58pm On Feb 14, 2018
If you dey celebrate Valentine’s Day Wednesday, just dey thank God o, because in far away Indonesia, about 10 major cities today ban celebration of Valentine. Police even go round di cities dey arrest any couple wey try to show small love, na cell get you.

Dem make dis ban so, base on se dem wan try arrange Islamic tradition for di Muslim-majority country, dem feel say some citizens don dey too dey copy Western coulture, and dis imported culture dey encourage pre-marital sex and including gay sex wey dem dey try make crime for di country.

Police today arrest about two dozen couples, wen dem raid places wey couple dey hang out and where dem dey also sell Valentine’s gift items for Surabaya, di second largest city for Indonesia. For Mataram city, for di tourist island of Lombok, government also ban Valentine and police order to arrest people wey play love, for schools, but you free to play love for hotels and cafes.

Other cities wey dem for ban Valentine na Makassar, Depok and others.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/indonesia-ban-valentines-day-celebration-police-arrest-love-birds/
Jokes Etc / Hahahaha. Between #bbnaija Housemate Cee C And Fulani Herdsmen by chiefotota(m): 7:00pm On Feb 14, 2018
I nor sure wetin Big Brother Naija housemate, Cee C do to Nigerians wey dem dey faya her for Twitter every time, if you ans me, her only crime na se Tobi, another housemate, dey mumu for her in di name of love.

So if pesin dey drive, e better make pesin drive enter where Fulani herdsmen dey dan to drive go where Cee C dey? Una try.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/hahahaha-bbnaija-housemate-cee-c-fulani-herdsmen/

Music/Radio / Mr. 2kay Don Drop Di Video For Di Song ‘banging’ Ft Reekado Banks by chiefotota(m): 10:45pm On Feb 13, 2018
Mr. 2Kay, last week drop ‘Banging’ one of di singles wey dey his new album, wey he tittle ‘Elevated’, di water side boy, don drop di video of di single wey he feature Mavin artist, Reekado Banks, for di korret video, na Clarence Peters direct di video and dey shoot am for Lasgidi.

Meanwhile, di Elevated album number 3 for iTunes album sales chart.

See di video for: http://www.ototaspalmyjoint.com/mr-2kay-don-drop-di-video-di-song-banging-ft-reekado-banks/
Religion / Pastor Beg Court To Skata Im Marriage After He Give Church Member Belle by chiefotota(m): 4:17pm On Feb 13, 2018
One pastor for Ibadan, Oluwasanjo Eniola, don drag im wife go Customary Court, for Ibadan, he dey beg di court to skata their 20 years old marriage se he nor wan do again, base on se im wife, nor dey support im work as pastor.

He tell di court say im wife, Basirat nor dey support di ministry, he say di wife too dey give am problem for house, and na dis yawa wey im wife dey give am so, let am go give one church member belle, onto se di wife even move comot from house go Lasgidi, without his approval, and dis church member na, don born pikin for di pastor. He tell di court say he don taya for di marriage, make di court skata everything, make he fit face di ministry work with peace of mind.

Di wife, Basirat tell di court say make dem epp her beg di husband, she agree se yes she bin give di man yawa, but na because di husband dey give di babes for di church koloby (romance) for one corner, she say she still love di man, make di court give dem time to settle di quarrel, base on se nobody go gree marry her again after 4 pikin.

Di court don adjourn di matter till Feb. 28, make dem take time to try to settle their fight and try make di marriage work.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/pastor-beg-court-skata-im-marriage-give-church-member-belle/
Romance / Wen Beauty Dey Di Hand Of Di Make Up Artist, Any Other Caption For Di Pishure? by chiefotota(m): 4:10pm On Feb 13, 2018
Dis days, beauty nor dey di eyes of di beholder any more o, dem say na di hand of di make up artist di beauty dey, but dis very babe so, I nor sure which pesin hand hand her beauty dey o, who fit epp us?

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/wen-beauty-dey-di-hand-di-make-artist-caption-di-pishure/

Sports / Serena Williams Don Resume Tennis After Child Birth by chiefotota(m): 11:28pm On Feb 11, 2018
Superstar tennis player, Serena Williams, don resume back to play tennis, after her marriage and child birth. She resume tennis today Sunday, as she kolabo with her big sist, Venus, as dem defend US position against Netherland for Fed. Cup.

She bin go break, after she win Australian Open last year (2017), to go born di pikin wey dey her belle by di time she win di Australian Open, and also marry her guy. She bin actually play one game last December, against Jelena Ostapenko, but she lost di match.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/serena-williams-don-resume-tennis-child-birth/

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (of 7 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 73
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.