Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,193,923 members, 7,952,716 topics. Date: Wednesday, 18 September 2024 at 10:12 PM

Chiefotota's Posts

Nairaland Forum / Chiefotota's Profile / Chiefotota's Posts

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (of 7 pages)

Politics / Abeg Borrow Yoursef Some Brain – Dino Melaye Pepe Shehu Sani As Apc Dump Sani by chiefotota(m): 4:59pm On Oct 20, 2018
News just break now say Sen. Shehu Sani, wey dey represent Kaduna Central don discharge from APC, after APC fall Sani hand, and his colleague, Sen. Dino Melaye, nor waste time at all, he don enter Twitter dey tell Shehu Sani ‘ntonyi’.

Shehu Sani, wey APC National Chairmo, Adeams Oshiomhole promise to give automatic ticket to return and contest for his Senatorial seat under APC, resign his membership of APC today Saturday, e clear from all indication se, Sani dey resign, after APC submit anoda pesin name, as dia candidate for Kaduna central Senatorial district.

Dino wey be like se don dey find as he wan take bash Shehu Sani, he say he nor understand wetin make Sani stay back for 'cash & carry party (APC)', he say APC nor like Sani, dat na why Sani suppose don discharge from di party since. Read wetib Dino talk exactly here:
http://www.ototaspalmyjoint.com/abeg-borrow-yoursef-some-brain-dino-melaye-pepe-shehu-sani-as-apc-dump-sani/

Celebrities / Babe With Tribal Mark Wan Make We Epp Her Get Attention To Model For Rihanna by chiefotota(m): 12:18pm On Oct 09, 2018
Dis Naija babe for Twitter, @adetutuoj8811, wan to model for Rihanna, she dey beg Nigerians for Twitter and all social media, to epp her with retweets so dat she fit get di attention of Rihanna.

Di tin wey make her mata special na di fact se she be proud Yoruba babe, with tribal marks, see her tweet:

http://www.ototaspalmyjoint.com/tribal-marks-yoruba-babe-wan-make-nigerians-on-social-media-epp-her-get-rihanna-attention-for-her-to-model-for-rihanna/

Celebrities / Abeg Who Get Dis Osusu Wey Kcee Use Pose? Efcc, I Don Blow Whistle by chiefotota(m): 12:54pm On Oct 05, 2018
We nor know weda Kcee house don turn CBN, but with dis osusu wey he use pose for dis pishure, we dey suspect di guy.

He share dis pishure on Instagram with dis money with di caption “They don’t know”.

But just in case, whistle blowing policy still dey work, make EFCC know se na we for Ototas Palmy Joint fess blow dis whistle.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/abeg-who-get-dis-osusu-wey-kcee-use-pose-efcc-i-don-blow-whistle/

1 Like

Agriculture / Amadioha… Sorry Thunder Don Faya 23 Cow Die For Ekiti State by chiefotota(m): 11:39am On Oct 03, 2018
As as how dis tin take happen we nor know, but thunder don faya 23 cows to death for Okeowa Eluju community wey dey , Ijero Local Government Area for Ekiti state, according to report for News Agency of Nigerian, NAN.

According to di gist, di Fulani herder wey get di cows, Abdulkadri Kadiri, yarn say dis tin wey happen to im cows so, na korret bad market, he say he go check his cows, after heavy rain fall finish, but as he reach, he see se 23 of di cows don kpai. He say for all im 35 years for dis cow business, he never see dis type of tin before, he say he sure se na God do dis tin, base on se he nor see blood or any wounjury for di cow body, and besides, he nor get any quarrel with anybody.

Di village chief for di community, High Chief Joseph Alofe, say he dey sorry for di Fulani herder, base on se na korret guy, he say dis tin dey strange, but he dey call on government and people wey get level to assist Abdulkadri Kadiri arrange his business again.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/amadioha-sorry-thunder-don-faya-23-cow-die-for-ekiti-state/

Politics / Bad Market For Ambode As Apc Don Officially Declare Sanwao-olu Winner by chiefotota(m): 11:27am On Oct 03, 2018
Clement Ebri, di Chairman of di committee wey APC National Working Committee set up to contest primaries for di candidate to represent APC for Lagos governorship election, today Wednesday for press conference don declare Jide Sanwao-Olu as di winner of di controversial APC primary election.

Oga Clement Ebri for anoda press statement on Tuesday bin deny se im committee nor dey comfortable with di arrangement wey di state APC chapter take conduct di election, so therefore, di party APC don postpone di Primary indefinitely, base on di political tension for Lagos.

For di controversial election, di state Guvnor, Akinwumi Ambode get 72,901 votes, di ‘anointed’ aspirant Sanwoolu get 970, 851 votes.

Meanwhile before di primary election, almost all di APC stakeholders for Lagos state, including di state Deputy Guvnor, abandon Guvnor Ambode.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/as-e-dey-hot-bad-market-for-ambode-as-apc-don-officially-declare-sanwao-olu-winner-of-apc-lagos-governorship-primaries/

Fashion / Creativity Or Kolomental? Farmer Make Wedding Dress With 40 Bags Of Cement by chiefotota(m): 12:00pm On Sep 29, 2018
Dis be like creativity, but at di same time, e still sound like kolomental. 28 years Chinese farmer, Lili Tan, use 40 empty bags of cement take create wedding gown in 3 hours and her pishure and video don trend for Chinese social media with over 5million views.

Di babe yarn say she create di wedding gown out of se she dey bored for house, wen rain dey fall. She say nobody train her how to sew o, but na just play play, she play make di gown and she dey bow for di kind attention wey her video and pishure get for Chinese social media.

http://www.ototaspalmyjoint.com/creativity-or-kolomental-farmer-create-wedding-dress-with-40-bags-of-cement-in-3hrs/

Romance / Pastor Ans For Divorce, Say Im Wife Na Devil Wey Nor Let Am Receive Anointing by chiefotota(m): 1:46pm On Sep 27, 2018
Wan pastor Michael Adebowale, don run go beg Iseyin Customary Court for Oyo State, make di court epp skata im 4 years old marriage, base on se he claim se his wife, Ashabi na di winsh wey nor dey let am fit receive anointing from God again.

He yarn di court se im wife na devil, he say he notice se God nor dey gree answer im prayers again, because he dey stay with devil inside house as wife. He say di wife nor dey gree follow am pray or even go church, her work na to do aproko for town and go dance owambe for party, he yarn di court say he don drive di wife from his house o, but he just wan to formally end tins legally with her so dat, he go start to receive anointing from God.

Di court don adjourn di case to October 5, make di wife for con talk her own side of di story.

http://www.ototaspalmyjoint.com/my-wife-na-di-devil-wey-nor-dey-wey-nor-dey-let-me-receive-anointing-from-god-pastor-tell-court-to-skata-his-marriage/
Jokes Etc / Edo State Guvnor Obaseki Dey Crash For Un Meeting For Yankee by chiefotota(m): 12:24pm On Sep 26, 2018
So Buhari carry Edo state Guvnor, Godwine Obaseki follow body go United Nations General Assembly for New York, but instead of di Guvnor to network as as how to bring investors to Edo state, oga Guvnor dey crash like who chop beans.

See more pishures:http://www.ototaspalmyjoint.com/see-pishure-of-edo-state-guvnor-obaseki-dey-crash-for-un-meeting-for-yankee/

Health / Russian Man Lock Im Head Inside Cage To Stop Smoking by chiefotota(m): 4:09pm On Sep 19, 2018
Dis Russian man, dey try to stop smoking, so im and his wife come with dis idea to use cage lock up his head, so dat he nor fit put cigar for mouth.

Di key to di cage, dey with his wife, she dey only open di cage, wen di man wan eat.

See more pishures: http://www.ototaspalmyjoint.com/russian-man-lock-im-head-inside-cage-to-stop-smoking/

Foreign Affairs / Parliament Ban Female Lawmakers Not To Come Parliament With Fake Nails by chiefotota(m): 9:22pm On Sep 10, 2018
Di speaker of Tanzania, Job Ndugai don ban female lawmakers make dem nor ever for dia life, fix fake nails and fake eye lashes wen dem dey come parliament again.

He also say dis ban, concern females wey dey visit di parliament, make dem nor wear anything fake come parliament, if not, dem go get problem.

Find out di reason for dis ban wey also short dress and jeans for:
http://www.ototaspalmyjoint.com/tanzania-ban-female-lawmakers-make-dem-nor-enter-parliament-with-fake-eye-lashes-and-nails/

Fashion / Kolomenta Or Fashion? Simple Yes Or No by chiefotota(m): 6:53pm On Sep 08, 2018
Nothing wey people nor go wear dis days in di name of se I wan show dem se I be korret guy of babe, wey sabi, we just spy dis sister with wetin she wear, we nor even sure wetin to call her, so make una epp up, dis na fashion or kolomenta?

Di babe remind me of dah year for Benin, wey dem dey catsh craze, many mechanic lost, because people wey dey catsh craze mistake dem for madness, I sure se if na dah time, no how dis sister go escape.

http://www.ototaspalmyjoint.com/kolomenta-or-fashion-simple-yes-or-no/

Politics / Pack Well, Comedian I Go Dye Faya Uduaghan, Warn Am Not To Contest Senate Seat by chiefotota(m): 9:32am On Sep 05, 2018
Nor be news again se former Delta state Guvnor, Emmanuel Uduaghan, wey just defect from PDP to APC wan to contest for Senatorial seat from di state. Naija Comedian, I Go Dye, nor think se Uduaghan get anything to contribute to develop di state as Senator, so he dey ans Uduaghan to pack well.

For di open letter wey I Go Dye post for Facebook, he wonder wetin Uduaghan at 64 years wan offer di state, wey he nor fit contribute to di state at 53 years wey he take become Guvnor, I Go Dye nor belive se Uduaghan contribute much to infrastructural development of di state, for 16 years wey Uduaghan serve as Commissioner for Health, Secretary to the Delta State Government and also as Guvnor, especially with di over Five trillion nine hundred of over Five trillion nine hundred and seventy one billion two hundred million (5,971,200,000,000) wey enter di state wey Udu take be Guvnor.

See di full letter: http://www.ototaspalmyjoint.com/uduaghan-to-pack-well-wetin-you-wan-achieve-as-senator-wey-you-not-fit-achieve-as-guvnor-i-go-dye/

Jokes Etc / Na Which Politician Face Dem Use Carve Dis Masquerade? by chiefotota(m): 1:11pm On Sep 04, 2018
If you take time observe dis masquerade well, you go discover se di tin look like one of Naija politician, from South-East Geo-political zone, we nor sure who di politician be, so make pesin epp us abeg.

http://www.ototaspalmyjoint.com/na-which-politician-face-dem-use-carve-dis-masquerade/

Romance / Husband Tear All His Wife Documents Because Dem Get Misunderstand by chiefotota(m): 11:36pm On Aug 31, 2018
We nor sure wetin cause di yawa, but according to Facebook user, Gina, dis na di documents of a wife wey get quarrel with her husband, to register his anger, di man tear all di wife document, just in di name of se he dey vex.

If you look at di pishure very well, you go see NYSC cert, together with her University cert.

See more pishure for: http://www.ototaspalmyjoint.com/husband-tear-all-his-wife-documents-because-dem-get-misunderstand/

Celebrities / Between Rmd And Don Jazzy Na Who Finish Work Dis Kilt Skirt? by chiefotota(m): 12:01am On Aug 31, 2018
Doro Boss, Don Jazzy and Nollywood orijina Warri fine boy wey wan use packaging kee (kill) imsef, Richard Mofe-Damijo, currently dey run some runz for Johnnie Walker Wiskey for Scotland, na RMD fess share pishure of imsef rocking di Kilt den letter, Don Jazzy share his own pishure.

Between both of dem, na who finish work with di skirt?

see more pishures here: http://www.ototaspalmyjoint.com/between-rmd-and-don-jazzy-na-who-finish-work-dis-kilt-skirt/
Fashion / Simple Yes Or No, Rmd Make Sense For Dis Scottish Kilt? by chiefotota(m): 10:44pm On Aug 30, 2018
SIMPLE YES OR NO, RMD MAKE SENSE FOR DIS SCOTTISH KILT?
Nollywood orijina fine boy, Richard Mofe-Damijo, aka RMD currently dey run small package with Don Jazzy for Johnnie Walker, and dem di Scotland for di mata.

RMD share dis pishure for Instagram, with im Scottish shirt wey dem dey call ‘Kilt’, wetin una think? Make we even epp am caption di pishure.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/simple-yes-or-no-rmd-make-sense-for-dis-scottish-kilt/

Jokes Etc / Imagine Buhari Face Wey He Hear Say Donald Trump Dey Last 2mins For Bed by chiefotota(m): 7:26pm On Aug 29, 2018
Na dis week, gist enter town wen US Presido Donald Trump, call we Presido, Muhammadu Buhari, “lifeless”. As di news make belle purge Buhari, we sure se Trump dey White House dey laff, he nor know say Buhari go laff last.

Now gist about Trump don enter town, Stormy Daniels, di ashawo wey Trump run some horizontal refreshment, dah year, don burn Trump cable, she say Trump nor dey last more dan 2minutes for bed. We dey try imagine Buhari face, wen Osinbajo break di news of 2mins give Buhari.

See more pishures of Buhari face here:
http://www.ototaspalmyjoint.com/imagine-buhari-face-wey-he-hear-say-donald-trump-dey-last-2mins-for-bed/

Agriculture / Pres. Museveni Dey Blame Ugandans With Big Head For Di Poverty Wey Dey Di Countr by chiefotota(m): 7:05pm On Aug 29, 2018
I nor know why we dey get leaders wey be like se dia brain dey shake for dis Afrika, can you imagine se di Presido of Uganda, Yoweri Museveni, dey blame Uganda citizens wey get “big-head” se na dem dey responsible for di poverty wey dey di country?

Di Presido yarn say na di failure of “big headed” citizens to improve agriculture, dey responsible for di poverty. He accuse di big head citizens, say dem refuse to adopt modern day way of agriculture, and because of dis, osusu wey dem suppose dey make from farming, dey pass dem by, he yarn dis opata, on Tuesday, for di opening of cement factory for Tororo district.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/president-museveni-dey-blame-ugandans-with-big-head-for-di-poverty-wey-dey-di-country/

1 Share

Politics / Lecturer Wey Dem Faya For Rape Wan Contest For State House Of Assembly by chiefotota(m): 12:29pm On Aug 29, 2018
Dis na campaign poster of Dr. Hycenth Ogwuru, di former lecturer of Economics department, Abia state University, ABSU, dey contest for Abia state House of Assembly under APC.

Di koko of di gist, according to human rights activist, Prof. Chidi Odinkalu, dem sack dis very lecturer 3 months ago, base on rape, so Prof. wan make we stop di lecturer from getting power, and if di rape gist na true, we join to call for di people of Abia to reject Hycenth Ogwuru.

sOURCE: http://www.ototaspalmyjoint.com/lecturer-wey-abia-state-uni-faya-for-rape-wan-contest-to-state-house-of-assembly/

Politics / Angry Youth Trek From Lagos To Abuja To Warn Buhari Not To Contest 2019 by chiefotota(m): 4:46pm On Aug 23, 2018
At a time wey we Presido, Muhammadu Buhari trek 800meters to prove to Nigerians se he dey very fit to re-contest for 2019 Presidential election, one of awa guy, Isa Mohammed Munlaila, wey say Buhari nor try at all for dis about 4years wey don dey run tins, don start his own trekking from Lagos to Abuja to warn Buhari make he nor try contest 2019 election.

Di guy carry coffin for head wey he paint with Naija colour, and write “RIP APC”, he yarn journalist, say youths dey para for Buhari, he say owu dey blow for di country, he say Buhari don fail to do wetin he promise, so make Buhari nor even think of 2019 at all at all.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/angry-naija-youth-dey-trek-from-lagos-to-abuja-to-warn-against-buhari-not-to-contest-2019/

Celebrities / If Buhari Like Make He Trek From Abuja Reach Jericho, Who He Epp? Charly Boy by chiefotota(m): 5:11pm On Aug 22, 2018
Charly Boy, aka Area Fada, for di tweet wey he share today Wednesday, don respond to di news headline wey trend, after we Presido, Muhammadu Buhari, trek 800m on Sallah day.

Area Fada yarn say if Buhari like make he from Abuja trek to Jericho, dat nor change anything, he say Buhari na confirm failure, and we need to vote am out, he say Buhari govt. nor epp anybody, Nigerians na suffer we dey since Buhari come, he say even his late fada, Justice Oputa, before di papa kpai for 97years, dey trek 1 mile everyday, so make Buhari go rest and give chance for young people.

See di tweet: http://www.ototaspalmyjoint.com/if-buhari-like-make-he-trek-from-abuja-reach-jericho-who-he-epp-charly-boy-faya-buhari/

Sports / Turkish Football Club Sell 18 Player, Use Di Money Buy 10 Goats To Sustain Club by chiefotota(m): 6:40pm On Aug 21, 2018
One of di oldest clubs for Turkey Gulspor FC, wey dem found for 1954, don sell 18 of dia players for 15,000 Turkish lira ($2,600), use di money buy 10 goats, wey dem dey use generate osusu to sustain di club from sales of milk and meat.

Di Presido of di club wey dey Turkey lowest divisions, Kenan Büyükleblebi, yarn CNN Turkey, say dem gat to sell di players base on se no funds for di club, he yarn say nor sponsorship for di leagues, so dem gat to think out of di box to raise funds to run di club, he say with dia 10 goats, dem generate profit of 4,000-5,000 lira yearly, and dem plan to increase di goats to 140 in 6 years.

He say he know se di idea dey funny, but goat business na korret business, dem get plenty young players, di way forward na to get funding from dia goat investments to use train di young footballers.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/turkish-football-club-sell-18-player-use-di-money-buy-10-goats-to-sustain-di-club/

Religion / Patriotic Muslim Broda Want To See Pvc Before He Give Out Sallah Meat by chiefotota(m): 7:48am On Aug 21, 2018
As di tradition of Sallah for Naija be, on Sallah day, awa Muslim brodas dey share di Sallah rice and meat with friends, same way we Christian brodas dey share Christmas rice and chicken with friends.

But for today Sallah, dis Facebook user, as a way to take encourage Nigerians, to go get dia Permanent Voters Card (PVC), he say who wan eat Sallah meat must fess show PVC, who agree with Yakub?

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/eid-mubarak-awa-patriotic-muslim-broda-want-to-see-pvc-before-he-give-out-sallah-meat/

Travel / Watch As Passengers Use Umbrella Cover Diasef Inside Train by chiefotota(m): 2:05am On Aug 12, 2018
If you check well, you go discover se for Philippines, na raining season dem dey, dis passengers for Manila, di capital city of Philippine, enter train and rain catsh (catch) dem along di journey, nai all man arrange umbrella take cover diasef, to avoid cold.

As dem rain dey fall, people wey nor get umbrella, use dia (their) phone dey film di drama, watsh (watch) di video on:
http://www.ototaspalmyjoint.com/watch-as-passengers-use-umbrella-cover-diasef-inside-train/

Fashion / Simple Yes Or No, Dis Ibb Agbada On Top Canvas Make Sense Or Not? by chiefotota(m): 3:05pm On Aug 09, 2018
We Senate Presido, Bukola Saraki, yesterday visit we former military head of state, Ibrahim Babangida, aka IBB for Mina yesterday, Saraki share dis pishure wey dem snap for Twitter and awa okpolo (big) eye notice IBB wear canvas under agbada, so we dey ans, weda di fashion style enter or not?

http://www.ototaspalmyjoint.com/simple-yes-or-no-dis-ibb-agbada-on-top-canvas-make-sense-or-not/

Romance / Husband Hammer $8.8m As Court Fine Man Wey Dey Knack His Wife by chiefotota(m): 12:21pm On Aug 01, 2018
One guy for North Carolina don buy market, base on se court don order di guy, Francisco Huizar, to pay another man, Keith King, $8.8 million as compensation for having horizontal refreshment (sexual affair) with di man wife.

According law, na crime for North Carolina, for pesin to dey knack (have sex) another pesin wey dey married, dis Huizar guy, don dey knack dis married woman, Danielle Swords, for di last 16 months, as soon as di husband know se na crime for di state and he fit use di mata take hammer, after he catsh (catch) dem for bed, he carry di guy to court.

Check ut di funny reason wey make di court fine di guy $8.8million:
http://www.ototaspalmyjoint.com/husband-hammer-8-8m-as-court-fine-man-wey-run-horizontal-refreshment-with-his-wife/

Sports / Nff Don Offer Ikeme Coaching Job After Dem Train Am Finish by chiefotota(m): 12:06pm On Aug 01, 2018
As news break last week end se we Super Eagles goalkeeper, Carl Ikeme, dey retire from football, Nigeria Football Federation, aka NFF, don dey offer to give Ikeme couching job as part of Super Eagles goalkeeper trainer.

According to statement from NFF Communication department, wey NFF seke (General Secretary), Mohammed Sanusi, sign, di statement yarn say NFF go find money take send Ikeme for training as coach wey dey train goalkeeper, he se dis news of Ikeme retirement weak everybody like dodo, base on se we nor se Ikeme for di period of time wey he keep for we Eagles, dey loyal, if not for di sickness tin, but di way to pay back dah loyalty, na to train and give di guy job, so dat owu (hunger) nor go blow.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/nff-don-offer-ikeme-coaching-job-after-dem-train-am-finish/

Crime / Wife With Husband Fake His Death To Scam Family/friends To Raise Money For Buria by chiefotota(m): 7:12pm On Jul 28, 2018
One scam guy for Thailand, Tachawit J., arrange with his wife, dem fake se di guy don die, post di guy pishure with cotton wool for his nose, di wife share di pishure for Facebook to raise money from di guy family members and friends for burial.

Wen dem ans (ask) di wife wetin kee (kill) her husband, he say di guy died of cancer and asthma, di next tin be se she start to rag di guy friends with members of his family for money to take bury di guy, she even tell di guy mama say no money to buy coffin and transport di dead body to village, di guy mama send THB20,000 (about $600) make she use transport di body con village.

Watch di video to find out how dem take catsh dem and see wetin di guy mama do to di guy:
http://www.ototaspalmyjoint.com/wife-kolabo-with-husband-fake-his-death-to-scam-family-and-friends-to-raise-money-for-burial/

Fashion / Simple Yes Or No, Simi Sexy For Dis Pishure Or She Has Gone Mad Again? by chiefotota(m): 2:52pm On Jul 26, 2018
Simi dey sing good music wey we like, but for dis pishure some people thing say she don cut rope join those artist wey don go mad in di name of fashion, we nor fit talk weda she sexy or na di kolomenta tins, but even she sef for di post wey she for share di pishure confirm se her mama go call her in 5...4...3...2...�

See di post: http://www.ototaspalmyjoint.com/simple-yes-or-no-simi-sexy-for-dis-pishure-or-she-has-gone-mad-again/

Fashion / Wetin Go Happen If Your Boyfriend Show Up Your House With Hair Style? by chiefotota(m): 8:34pm On Jul 20, 2018
We nor understand weda dis na creativity or wetin dis pesin get for mind, but regardless of wetin dey dis guy mind, as a babe, wetin you go do if your boyfriend show your house with dis hair style?

http://www.ototaspalmyjoint.com/wetin-go-happen-if-your-boyfriend-show-up-your-house-with-hair-style/

Crime / Since We Nor Fit #endsars, One Concern Nigerian Don Give Us Steps To #foolsars by chiefotota(m): 8:20pm On Jul 20, 2018
Base on se dis campaign make we government stop di rubbish wey some bad police officers wey dey inside SARS nor be like say di tin dey work, dis concerned Nigerian wey dey work with bank, don give up solution of wetin to do to #FoolSARS since we nor fit #EndSARS.

Di banker take time to break di steps wey we fit use to transfer money to fool SARS or any police wey wan kollet money from us wey dem nor work for, read di process:

http://www.ototaspalmyjoint.com/since-we-nor-fit-endsars-one-concern-nigerian-don-give-us-steps-to-foolsars/

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (of 7 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 73
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.