Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,474 members, 7,808,705 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 03:42 PM

Chiefotota's Posts

Nairaland Forum / Chiefotota's Profile / Chiefotota's Posts

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (of 7 pages)

Career / Twitter Don Appoint Okonjo Iweala As Part Of Board Of Directors by chiefotota(m): 1:58am On Jul 20, 2018
Twitter, Inc. (NYSE: TWTR) Thursday don announce former Naija Minister of Finance, Ngozi Okonjo-Iweala and Robert Zoellick as part of Twitter Board of Directors (the "Board"wink.

Madam Ngozi wey nor fit hide her joy, break dis good news for her Twitter.

Meanwhile Twitter wey appoint dem as new independent directors, yarn say di appointments go take effect immediately.

See her Tweet: http://www.ototaspalmyjoint.com/another-international-accolade-for-ngozi-okonjo-iweala-as-twitter-appoint-her-as-director/

Romance / Make-up Artist Discover Guy Wey Engage Her Dey Marry Bride Wey She Go Make-up by chiefotota(m): 12:40am On Jul 20, 2018
One make-up artist for Warri, wey her guy don engage her, dem don print card fix date for wedding for August 10 & 11, go do make up job for PH, only for her to discover say di bride dey marry di same guy wey she suppose marry.

One bride for Port Harcourt, same city wey her man dey stay, engage her to do make up for her wedding wey be June 20, as she reach Port Harcourt, as she reach di bride to be house, dis make up artist discover se di guy wey dey marry dis very babe, na di same guy, wey don engage her, do introduction and fix wedding date, she faint with speed.

Read up wetin di bride do to di make up artist:
http://www.ototaspalmyjoint.com/make-up-artist-faint-wen-she-discover-di-bride-wey-she-go-make-up-dey-marry-same-man-wey-don-fix-wedding-date-with-her/

Crime / Police Don Arrest 8 Boko Boys Wey Follow Kidnap Chibok Gehs by chiefotota(m): 2:40pm On Jul 18, 2018
Police for Maiduguri don arrest 8 boko boys (Boko Haram) wey follow kidnap 276 gehs from Government Girls Secondary school, Chibok, Borno state, for April 14, 2014.

Police parade di 22 criminals wey don dey commit badness for Borno, Adamawa and some other states for North, 8 out of dis 22 criminals, na boko boys wey follow kidnap di Chibok gehs. Na some gallant police guys wey part of Inspector General’s Intelligence Response Team (IGP’s IRT), na arrest dis guys for Borno state.

Dis criminals confess say dem be boko boys, and dem don carry out many suicide bombing for inside North-East wey don kpai many innocent Nigerians.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/as-e-dey-hot-police-don-arrest-8-boko-boys-wey-follow-kidnap-chibok-gehs/

Romance / Boyfrnd Kpai After Sex With Im Babe Wey Play Away Matsh With Yahoo Boy by chiefotota(m): 12:27am On Jul 15, 2018
Nor to small cinema for Warri, as one innocent guy wey dey stay around White House for Effurun, don kpai (die) for Warri Central Hospital after he run some horizontal refreshment (had sex) with im babe.

According to awa i-witness, di guy wey dem dey code his name for now, just do di normal horizontal refreshment with im babe o, den after some time, his penis start to rotten, as dem rush di guy go Warri Central Hospital, doctors nor fit save his life. Na so his friends para go his babe house, dem go discover se di babe for her death bed, as her kpekus (vagina) sef dey rotten, wen dem press di babe make she talk wetin happen, where she from bring sickness, she confess say she play away match (cheated) with one yahoo guy, wey don vanish, as nobody fit trace di guy again.

See wetin di i-witness talk:
http://www.ototaspalmyjoint.com/boyfriend-kpai-of-rotten-penis-after-sex-with-im-babe-wey-play-away-matsh-with-yahoo-boy/

Celebrities / Drogba Agree To Appear For Afro B Music Video Wey Feature Wizkid by chiefotota(m): 1:09pm On Jul 13, 2018
Football legend and 2 time Afrika footballer of di year, Didier Drogba don ready to appear for his first ever music video with London-based Ivori-Cost singer, Afro B.

Afro B early dis year, drop di song wey he call ‘Drogba (Joanna)’, but di song con blow recently wey he do remix of di song and feature awa own Naija Starboi Wizkid. Na base on dis blow wey di song blow so, di footballer, just play play tweet say make dem do di music video, he go like dey di video, with speed, both Wizkid and Afro B don accept to do di video for di song wey Team Salut produce.

See their Twitter exchange and di lyrical video of di music:
http://www.ototaspalmyjoint.com/drogba-agree-to-appear-for-afro-b-music-video-wey-feature-wizkid/

Crime / Guvnor Withdraw Police Guns, Give Dem Katapot To Fight Crime For Mexico by chiefotota(m): 10:01pm On Jul 12, 2018
Di Guvnor of Verracruz wey dey Mexico, Miguel Ángel Yunes Linares, don withdraw di guns wey some police officers for Alvarado dey use, he exchange their guns with katapot and stones, make di officers use fight crime.

Di guvnor withdraw di officers guns, after only 30 out of 130 officers, manage pass gun control test wey dem arrange for di officers to know weda, dem dey fit to use gun, meaning 100 officers fail di test, but di guvnor withraw all di officers wey dey di police department guns. But some local officers dey para, dem say di gyvnor wan put their life for danger because plenty criminal gangs plenty for di state.

See another pishure and video of di officers with katapot:
http://www.ototaspalmyjoint.com/guvnor-withdraw-police-guns-give-dem-katapot-to-fight-crime-for-mexico/

Politics / Banks Close Up For Ondo As Police Remove Police Security For Ekiti Election by chiefotota(m): 10:59am On Jul 11, 2018
Report wey just enter awa left ear now be se, some banks for Ondo state, don dey close down, base on Nigerian Police, don withdraw di Police security guys, wey dey secure di banks.

Police dey withdraw some of their officers, to go perform special duty for di election wey dey happen for Ekiti state dis week Saturday.

Read up details for dis gist for:
http://www.ototaspalmyjoint.com/banks-close-up-for-ondo-as-police-remove-police-security-for-ekiti-election/

Politics / Imo As State House Of Assembly Arrange Committee To Impeach Deputy Guvnor by chiefotota(m): 2:02pm On Jul 10, 2018
Na yawa (trouble) now don dey for inside Imo state House of Assembly, as di House today Tuesday don arrange committee, to investigate and impeach di Imo state Deputy Guvnor, Prince Eze Madumere.

If una dey observe tins for di politics for Imo state, you go discover se di Deputy, don run kolabo with some other politicians wey dey fight di state Guvnor, Rochas Okorocha, base on se Okorocha dey plan to arrange his son-in-law to take over as guvnor for 2019, we sure se dis impeachment drama so, na di punishment for di deputy, for fighting with Okorocha.

Read up more details for: http://www.ototaspalmyjoint.com/yawa-for-imo-as-state-house-of-assembly-arrange-committee-to-impeach-deputy-guvnor/

Crime / France Most Wanted Omila Don Escape From Prison With Helicopter by chiefotota(m): 2:29pm On Jul 01, 2018
One notorious omila (thief) wey fess be di most wanted omila for France, don escape from prison for Paris today Sunday with helicopter, wey police later discover for inside bush for northeastern Paris. Di 46yrs omila wey im name be Rédoine Faïd, escape from prison like wili-wili together with 3 other prisoners.

Find out how di guy wey don fess escape prison 2013, take escape frison for di second time:
http://www.ototaspalmyjoint.com/france-most-wanted-thief-don-escape-from-prison-with-helicopter/

Celebrities / Lagosians Put Up Di Lighter As French Presido Macron Visit Fela Shrine by chiefotota(m): 1:24pm On Jul 01, 2018
Lagos people make una hold una lighter and some igbo (marijuana) as French Presido, Emmanuel Macron don set to visit Fela Afrika Shrine for Lasgisi, dis week Tuesday.

According to di gist wey AFP report, Macron currently dey visit Africa for di African Union summit wey dey happen for Mauritanian, from there, Macron go enter Abuja to reason some security and terrorism tins with awa Presido, Muhammadu Buhari, na from Abuja Macron go bransh (branch) Lasgidi.

Read details of wetin he dey con do here:
http://www.ototaspalmyjoint.com/lagosians-put-up-di-lighter-as-french-presido-macron-visit-fela-shrine-dis-tuesday/

Romance / How Taxi Driver Take Save Twitter User From Abusive Boyfriend by chiefotota(m): 3:01pm On Jun 30, 2018
Dis Twitter user, Mother Confessor @Jenniieey, wey dey always use her platform to share and tell us other people stories dah toush (touch), today don get her own experience and she share di story of her life, as her boyfriend wey don mayan (high) with alchohol nearly kpai (kill) her.

According to her, she don love di guy thinking se dis guy go be her last bus stop o, but on dis very day, di guy come house high, di guy fess start to call her rubbish names, before she know wetin dey happen, na slap wey nor gree end start to land her face, di guy even threaten to throw her down from his 3 stories apartment, until God save her through taxi driver.

See her thread:
http://www.ototaspalmyjoint.com/tweet-story-how-taxi-driver-take-save-twitter-user-from-abusive-boyfriend/

Romance / Naija Artist Wey Dey Find Attention Dey Plan To Marry Sex Doll by chiefotota(m): 4:43pm On Jun 28, 2018
Dis Naija guy wey dey form actor/musician, Benjamin Nwachukwu, aka Shuga Shaa, don dey plan to marry his sex doll, wey he call Tonto Shaa.

Di guy fess trend wen he claim to buy car for di sex doll wey he call his babe, but dis time around, di guy dey try look for attention with another scope, se he wan to marry di sex doll. He say im mama know about im relationship with di sex doll, and di reason why he wan to marry di sex doll, na because sex doll, unlike we normal babes, nor dey stress am.

http://www.ototaspalmyjoint.com/naija-artist-wey-dey-find-attention-dey-plan-to-marry-sex-doll/

Sports / Nigerians Use Amadioha Swear For Referee Wey Nor Give Us Second Penarity by chiefotota(m): 11:36am On Jun 27, 2018
With Nigrians, Twitter or even social media nor fit dey boring at all. After di World Cup matsh (match) against Argentina wey we lost, most Nigerians dey para, base on di penarity (penalty) wey referee nor give us, after ball touch Argentina player hand inside their box.

These Nigerian nor even take tins easy with ref. at all, dem find di ref enter social media, take time to swear for di ref, some claim say dem dey swear for di ref for Okija shrine, others say di ref go die for plane crash, di wan wey kee me, pesin wey nor get joy say di way di ref cheat on Naija, im wife go cheat on am. See reactions:

http://www.ototaspalmyjoint.com/nigerians-use-amadioha-swear-for-referee-wey-nor-give-us-second-penarity/

Crime / Police Discover Igbo And Cocaine Wey Dem Code Inside Replica World Cup by chiefotota(m): 10:42am On Jun 27, 2018
Korret Police guys for Argentina wey sabi their work, don burst some guys, wey try to smuggle igbo and cocaine codedly into Argentina last week Friday.

Di minister for security tins for Buenos Aires, Cristian Ritondo, confirm dis news with di pishure wey he share for Twitter, he say dem don arrest 4 guys and 2 babes for di mata, di guys, code di igbo and cocaine inside replica World Cup trophies, wey dem claim say na trophies for "Narcos de la Copa".

Di cups contain 22 pounds of cocaine and 44 pounds of igbo, with more dan $14,000 cash. Dem also seize 2 shakabula (guns) plus cars from di criminals.

For more details and pictures, Visist:
http://www.ototaspalmyjoint.com/police-discover-igbo-and-cocaine-wey-dem-code-inside-replica-world-cup/

Politics / Naija Don Overtake India As Di Country Wey Poverty Wear Face Cap by chiefotota(m): 8:00pm On Jun 25, 2018
According to latest reports wey World Poverty Clock just release, dem say Naija don overtake India as di country wey get di largest number of people wey owu (poverty) dey blow their citizens.

Di report talk say, poverty dey grow with speed inside Naija, dem say na 6 people dey enter poverty level every minute, dat wan mean se na Naija get di highest number of poor people for di world.

Di report claim say while India dey work to reduce poverty, Naija dey take over, dis latest report of May 2018 show se Naija get estimate of 87 million people wey owu dey blow, while India own now na 73 million people. Di mata bad weller inside Africa because dem say DR Congo very soon go even take over di number 2 position from India.

http://www.ototaspalmyjoint.com/naija-don-overtake-india-as-di-country-wey-poverty-wear-face-cap/

Crime / Uk Court Ban 24yrs Boy From Contacting His Parents For 5yrs Cos He Dey Beg Money by chiefotota(m): 9:05am On Jun 22, 2018
One court for Southampton, England, don give order to ban one 24 years lazy UK youth, Matthew Kerley, make di guy nor contact his parents on phone or even go near dem for 5 years, base on se di guy dey always rag (request) his parents for money.

Di court give dis order late last year actually, and sentence di guy to 32weeks for prison, for harassing his parents, but some how, after di guy do di 32 weeks finish, he fess behave imsef, but after some time, he still continue to rag both im papa and mama, one particular day, di guy call dem up to 30 times, plus sms, di tin wey dey let di parents para na se, he dey even make dis call for middle of night to worry their sleep.

Di parents gat to return to di court to complain, find out wetin di court do di guy dis time for:
http://www.ototaspalmyjoint.com/uk-court-don-ban-24yrs-boy-from-contacting-his-parents-for-5yrs-because-he-dey-beg-dem-money/

Sports / Nigerians Enter Russia For World Cup With Visa-free, Don Dey Run Enter Finland by chiefotota(m): 5:10pm On Jun 20, 2018
Naija, dis country don round up, any small chance wey anybody get dis days, na to run commot from di country. Some football fans wey enter Russia for World Cup, unto di visa-free entry wey Russia give for football lovers to fit easily enter, Russia to watsh (watch) football, don run enter Finland go seek asylum.

According to Finland border guards, dem tell journalist say na 5 people recently cross Russian border enter Finland to seek asylum, di 5 people na from Nigeria, Chinese and Morocco.

http://www.ototaspalmyjoint.com/worldcup-nigerians-wey-get-free-entry-to-russia-don-dey-run-enter-finland-illegally-go-seek-asylum/

Foreign Affairs / Signboard Direct People Wey Be Liberals To Keep Driving Until Dem Leave Di Texas by chiefotota(m): 6:34am On Jun 20, 2018
Dis pishure of dis signboard trend yesterday Tuesday America social media, after Facebook user, Kyle Mccallie post di picture of di signboard on Facebook.

I nor know weda na crime for pesin to be liberal, but di signboard dey direct people wey be ‘Liberals’, make dem just continue to drive their cars, until dem drive commot from di state of Texas.

http://www.ototaspalmyjoint.com/signboard-direct-people-wey-be-liberals-to-keep-driving-until-dem-leave-di-texas/

Travel / Una See Di 9th Wonder On Di World, Chinese Villagers Carve Road Inside Mountain by chiefotota(m): 12:16pm On Jun 15, 2018
Dis pishure nor be fild trick at all, dis na di 1.5km road wey villagers for Shenlongwan Village wey dey Changzhi City, for North China carve out from mountain, and di place don already turn to tourist site.

Dem carve di road out of di mountain, to konnet Shenlongwan village wey dey far far place inside mountain, with other Chinese cities.

Di villagers, personally use 15 good years 1985 – 2000, take carve di road wey don dey know now as ‘Ninth Wonder of the World’.

http://www.ototaspalmyjoint.com/una-see-di-9th-wonder-on-di-world-chinese-villagers-carve-road-inside-mountain/

Events / Watch 2,500 Women Naked Baff For River To Raise $342,000 For Charity by chiefotota(m): 12:23pm On Jun 12, 2018
Nothing less dan 2,500 women, both old mama and youngee, last Saturday cut chain (craze) for Republic of Ireland, as dem naked jump enter Magheramore beach in di name of Strip and Dip. Di organizers of di event, use di event take raise $342,000 for cancer charity.

Dem actually use di annual event, take break Guinness World Record, di previous record of naked women wey baff naked for beach, na di one wey 786 women set for Western Australia, 3 years ago.

See di video:
http://www.ototaspalmyjoint.com/video-more-dan-2500-women-naked-baff-for-river-to-raise-342000-for-charity/

Health / Meet 18 Years Old High School Student Wey Skin Condition Make Look Like Granpapa by chiefotota(m): 9:24pm On Jun 10, 2018
Dis 18 years old high school student for China, dey suffer rare skin condition wey make am look like 80 years old granpaleh (granpa).

Di guy tart to notice say im skin dey sag some years ago, like play like play, he don turn old man in few years, even though di tin nor get any efect to im health, di guy say people dey sometimes dey use di old face yab am, but he nor fit kee (kill) imsef, so he don accept di condition like dat.

Find out more details about wetin dem dey do medically to epp di guy with more pishure for:

http://www.ototaspalmyjoint.com/meet-18-years-old-high-school-student-wey-skin-condition-make-look-like-old-man/

Fashion / Simple Yes Or No, Dis Kcee Gadging (dress Up), Make Sense Or Not? by chiefotota(m): 2:24pm On Jun 10, 2018
If you wan talk of one Naija artist wey dey try for gadging (dress sense), Kcee, na one of di artist wey dey try im best no doubt.

Check out wetin he wear here, di enter or e nor enter?

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/simple-yes-or-no-dis-kcee-gadging-dress-up-make-sense-or-not/

Romance / People Papa And Mama Naked Dey Drive Bicycle For London by chiefotota(m): 2:15pm On Jun 10, 2018
Na wa o, na which kind sport be dis abeg?

KCee share dis pishure of dis 2 people papa and mama wey naked like Adam and Eve, before dem chop apple dey drive bicycle for di streets of London, for open day light.

See di close-up pishure: http://www.ototaspalmyjoint.com/people-papa-and-mama-naked-dey-drive-bicycle-for-london/

Travel / Buhari Don Ready To Dodge Enter Morocco On Sunday Go Take Fresh Air by chiefotota(m): 10:32pm On Jun 09, 2018
Base on se di heat for di country don too mush (much), we Presid, Muhammadu Buhari, don ready to dodge enter Kingdom of Morocco Sunday, to go take small fresh air for 2 days.

According to di statement wey oga Garba Shehu, wey be one of di tori guys to Buhari release Saturday evening, he yarn say Buhari dey enter Morocco, base on se di King of Morocco, King Mohammed VI, send Buhari invitation card, make di 2 leaders for reason some socio-economic tins, wey dey affecting both Naija and Morocco.

So therefore, Buhari go remove from Abuja on Sunday, make he just remember to buy Gala wen he dey come.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/buhari-don-ready-to-dodge-enter-morocco-on-sunday-go-take-fresh-air/

Crime / Court Order Police To Give Dino Melaye Int. Passport Make He Go Us For Treatment by chiefotota(m): 2:43pm On Jun 07, 2018
Justice Mabel Segun-Bello, of Abuja magistrate court for Wuse, don order police to free Sen. Dino Melaye international passport, make Dino fit travel to America for im hospital appointment wey be June 28.

She give dis judgement, after Dino lawyer, John Odubela (SAN), ans (ask) di court to tell police make dem release Dino passport wey police seize, di lawyer tell di court say Dino wey be asthmatic patient, don get dis appointment with doctor for America, even before di gbege (trouble) wey he get with police start.

So after di court reason every every, di magistrate order di Commissioner of Police for Abuja, to transmission di passport give Dino, di court give Dino 20days (June 18 – July 8 2018) to travel, di court say make Dino make sure se he return di passport give Police, wen he return back.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/court-don-order-police-to-transmission-sen-dino-melaye-int-passport-make-he-go-us-for-treatment/
Health / Naija And Ghana Top Countries Wey Babes Dey Google Abortion Drugs by chiefotota(m): 9:46pm On Jun 06, 2018
I nor understand why e be like se na we dey always carry first for bad tins, because base on di research wey BBC’s 100 Women project do, dem don discover se na Ghana and Nigeria dey top di list of countries wey gehs (girls) dey always look for abortion medicine through Google search.

Base on di data from Google analysis, dem discover se out of 25 top countries for di whole wide world, na Ghana and Naija dey top di list wey people for dey search for di abortion drug wey dem call ‘Misoprostol’.

Di research show se babes dey try order for di abortion drugs online, for countries wey be their laws dey against abortion. For Ghana and Naija, di law nor agree with abortion, unless on special cases.

View di data here: http://www.ototaspalmyjoint.com/naija-and-ghana-dey-on-top-di-list-of-countries-wey-babes-dey-google-abortion-drugs/
Sports / Mexico World Cup Squad Arrange Farewell Groove With 30 Ashawo by chiefotota(m): 7:37pm On Jun 06, 2018
As Naija Super Eagles arrange farewell friendly matsh (match) with DR Congo, before dem move from Naija for di Worlf Cup, Mexico World Cup squad don their own farewell with party, wey dem invite 30 ashawo to groove di players for Mexico, before di team move enter Europe for di World Cup.

Nine members of di team wey fly from Mexico Tuesday, arrange di groove for one coded house for Mexico last Saturday, with ashawo gehs (girls) everywhere, after their friendly matsh with Scotland for Aztec Stadium, wey Mexico win 1-0.

Officials wey dem for Mexico football, yarn say nor be dem arrange di party for di players, and besides, nobody fit sanction players for wetin dem do with their free time, so far dem nor miss training.

http://www.ototaspalmyjoint.com/mexico-world-cup-squad-arrange-farewell-groove-with-30-ashawo/
Politics / #nottooyoungtorun: Hushpuppi For President? by chiefotota(m): 2:18pm On Jun 02, 2018
As Naija Youth dey celebrate dis victory of dis we ‘Not Too Young To Run’ bill wey we Presido, Muhammadu Buhari just sign into law, we for http://www.ototaspalmyjoint.com/nottooyoungtorun-hushpuppi-for-president-simple-yes-or-no/ , dey try search for di korret Naija youth, wey nor be ‘Lazy Youth’, wey we wan present for 2019 as President, we dey suggest Hushpuppi for Presido come 2019. At least he suppose fit epp change di country to designers country.

Oya who support di motion, simply YES or NO?

Celebrities / I Write More Dan 300 Song Wen I Dey Inside Prison – Ex-convict, Saucekid (sinzu) by chiefotota(m): 2:38pm On May 31, 2018
For dis life, wen you go prison, na di prison wey you go, go determine wetin you go become after you come out.

Naija rapper, wey just gain freedom after almost 2 years for Yankee prison, Sauce Kid, aka Sinzu, don confirm give Ovie of NotJustOk TV for dis interview wey dem run for Huston, say he write over 300 songs, for di period wey he take dey for inside jail for America.

He yarn say honestly, dis prison experience don let am dey humble, he say wey some people go enter jail, and dem nor dey use their time for prison well, but he made good use of his time for prison, and very soon, Nigerians go start to feel am.

He say wen he dey inside jail, he dey work and dem dey pay about $16 per month, but di best tin wey happen, wey he dey prison, na di music wey he write, out of which he say he don already record about 17 tracks.

He confirm say im deal with Davido, dey very real, he say he fit even drop like 5 track once but, he go take tins easy. He also confirm say he get music wey he don do with Falz, he dey gbadu (like) Falz style of music, but di music never come out.

He yarn many tins, just watch di video: http://www.ototaspalmyjoint.com/i-write-more-dan-300-song-wen-i-dey-inside-prison-ex-convict-rapper-saucekid-sinzu/
Sports / Zinedine Zidane Don Resign As Real Madrid Coachy by chiefotota(m): 1:23pm On May 31, 2018
Zinedine Zidane today Thursday, don confirm give news people say by next year, wen im contract end as coachy of Real Madrid FC, he dey move from Real Madrid..

Dis news so dey come, just less dan a week after he lead di club to win their third UEFA Champions League tittle, back to back to back, under Zidane as their coachy.

We wish am all di best.

http://www.ototaspalmyjoint.com/as-e-dey-hot-zinedine-zidane-don-confirm-say-he-dey-move-out-of-real-madrid-next-year/
Religion / Video: Christians Crowd Catholic Church See Virgin Mary Statue Wey Dey Cry by chiefotota(m): 11:20pm On May 30, 2018
Nor be small cinema for Our Lady of Guadalupe Catholic Church, for di city of Hobbs, wey dey New Mexico, as di virgin Mary statue wey dey di church, dey cry tears wey dey smell rose flour.

Di Parish Priest wey dey di church, Father Jose ‘Pepe’ Segura, yarn say one of im parishioners after Sunday Mass nai con tell am say di virgin Mary statue wey dey di church, dey cry, and di tears dey smell rose, wen he go see di statue, he tell dem to clean di tears, but he shock wey he notice fresh tears continue to flow. He say wetin dis tin mean be se, Mary dey cry because of di violence wey dey happen for di world, so make di world repent.

Read di full gist and watch di video on: http://www.ototaspalmyjoint.com/video-christians-crowd-catholic-church-for-new-mexico-to-see-virgin-mary-statue-wey-dey-cry/

Romance / Man Divorce Wife Less Dan 15mins After Dem Marry Because Of Bride Price Balance by chiefotota(m): 2:00pm On May 29, 2018
Di tin wey money dey cause for dis world nor be here at all. One guy for Dubai don divorce im wife, in less dan 15 minutes wey dem marry for Sharia court for Dubai. Yawa gas, wen di wife papa start to drag di guy for di balance of her bride price, just outside di sharia court wey dem for marry.

Di guy and im father-in-law agree se di guy go fess pay half of di bride price wey be 100,000 Dirhams, di currency wey dem dey use for Dubai/UAE, if you convert am, dat na $27,224. So di guy pay half as dem agree 50,000 Dirhams ($13,612), but as dem just come out from di sharia court wey dem for sign di marriage register, dem never even comot from di building wey di father-in-law start to drag di guy for balance.

Oya if you wan read di balance od dis gist, visit: http://www.ototaspalmyjoint.com/husband-divorce-wife-less-dan-15mins-after-dem-marry-because-of-bride-price-balance/

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (of 7 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 83
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.