Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,194,717 members, 7,955,691 topics. Date: Sunday, 22 September 2024 at 12:59 PM

Chiefotota's Posts

Nairaland Forum / Chiefotota's Profile / Chiefotota's Posts

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (of 7 pages)

Career / Tv Station Sack News Caster Wey Call Her Male Colleague ‘handsomes' For Live Tv by chiefotota(m): 1:44pm On May 29, 2018
Make una con see as dis fine babe take wan lost her job for common compliment wey she jokingly, compliment her handsome colleague during news broadcast for Kuwait TV.

Ministry of Information for Kuwait don suspend dis fine babe, Basima al-Shammar, wey be news caster for Kuwait TV. Yawa gas wen di guy dey try to adjust his ‘Arab scalf’ during live news presentation, di guy actually nor know se dem don go live, so di babe, just casually tell am say nor need to do any adjustment, because “he was already handsome.” Na her crime be dat o.

Now dem don suspend her even after she explain say she nor mean any tin, di Ministry of Information dey investigate di mata, because dem consider her action to be flirting with di guy for live TV.

See di video wey don go viral for Arab social media: http://www.ototaspalmyjoint.com/kuwait-min-of-info-don-sack-female-news-caster-wey-call-male-colleague-handsome-for-live-tv/

Romance / Prince Harry And Meghan Wan Dodge Enter Canada For Royal by chiefotota(m): 3:58pm On May 28, 2018
In di spirit of di honeymoon wey suppose happen, after weddings, Prince Harry and im wife, Meghan don dey plan to remove on code, enter Canada for their honeymoon.

According to di aproko we hear, Duke and Duchess of Sussex, dem plan to enter Fairmont Jasper Park Lodge, aka “The Royal Retreat” wey dey Alberta, for Canada for their honeymoon.

Base on dis August visitors wey di resort center dey expect, dem don make some special order of some goodies wey dem nor dey get normally, just to make sure se di Prince and im wife, dey very ok. Some special security of both Canada and British security guys, go also secure di place wen dem come, to avoid stories dah toush (touch), for now, no date for wen dem plan to enter di place, and di Royal family never officially confirm dis gist.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/royalwedding-prince-harry-and-meghan-wan-dodge-enter-canada-for-royal-honeymoon/
Celebrities / Davido Don Sign New Artist Idowest For Im Record Label by chiefotota(m): 1:35am On May 24, 2018
Davido don enter news again dis week, base on di new artist wey he just sign into im record label, Davido Music Worldwide, aka DMW.

Davido officially break dis news of im news artist, Idowest wey he just sign, for his Twitter age on Wednesday night. Davido yarn say Idowest don prove imsef, now na time to make osusu.

We just hope just hope se dis Idowest read di contract before he sign di deal.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/davido-don-sign-new-artist-idowest-for-im-record-label/
Religion / Catholics Protest As Dem Bury Benue Priest Wey Herdsmen Kpai For Benue by chiefotota(m): 2:32pm On May 22, 2018
Catholic Bishops today Tuesday kolabo with their Parishioners protest across Naija, as Makurdi Catholic Diocese bury di 2 Priest and other church members wey Fulani herdsmen kpai for Benue state.

For di burial wey happen for Makurdi Benue state, di Bishop of Abuja Catholic Diocese, John Cardinal Onayikan, yarn Catholics and Christians to take tins easy, he yarn say he nor se dis kee kee (killings) wey Fulani herdsmen dey kee people any how so nor good, but make Christians nor return faya (fire) for faya.

He say make we nor let politicians, religion and ethnicity divide us, he say di Priest and di church members wey dem kee, na martyrs of di church, he call of government to do something about dis herdsmen killings before water pass garri.

See pictures of di protest and burial for:
http://www.ototaspalmyjoint.com/catholic-bishops-and-parishioners-protest-as-dem-bury-benue-priest-wey-herdsmen-kpai/
Webmasters / Buhari Sgf Boss Mustapha Don Use N64million Arrange Website by chiefotota(m): 7:45pm On May 21, 2018
Naija secretary to the government of the federation, aka SGF, Boss Mustapha, today launch new website for office, www.osgf.gov.ng.

Oga Mustapha today Monday, officially present di website to public for im office for Abuja, he yarn say na N64 million dem use arrange di website. He yarn say government bin don budget N65m for di site for inside 2017 budget. He yarn say di old site, na old school, with old technology, and dat old site nor get korret technology and security features.

He yarn say dem follow due process to use arrange dis website so make we nor fear at all, he say di N64 million also incude laptops, training and consultancy services tins.

Di major tin according to oga Mustapha, wey make dis website special, na se di website get e-participation platform, wey Nigerians fit use give feedback, request for information from government, and also complaints.

http://www.ototaspalmyjoint.com/buhari-sgf-boss-mustapha-don-use-n64million-arrange-website/
Crime / Yawa For Port Harcourt As Olokpa Faya Army Officer With Gun by chiefotota(m): 1:55pm On May 17, 2018
Olokpa (Policeman) wey dey Rumuekani Police Station, for Ada George Road, Obia Akpor, area for Port Harcourt, don gbaga (run) comot from their duty post, after one of their policeman, faya one army officer wey wear mufty dis morning.

We nor really get di details of wetin really happen, but even people wey dey stay for di area too, don discharge leave area to avoid stories dah touch. Di police guys gat to move, base on se their guy buy market, make dem for nor kollet slap and beatting for crime wey dem nor commit, nai make dem remove.

Di Commissioner of Police for Rivers state, oga Zaki Ahmed, confirm dis gist, but he say nothing like se sodja dey chase police, both Police and Army ogas at di top, dey work to make sure se di mata nor bad pass like dis.

http://www.ototaspalmyjoint.com/yawa-for-port-harcourt-as-olokpa-faya-army-officer-with-gun/
Events / Bet Don Nominate Tiwa Savage And Davido For 2018 Bet Awards by chiefotota(m): 11:42pm On May 16, 2018
More blessings don continue to fall on Davido as BET Awards, today Wednesday release di names of nominees for 2018 BET Awards, BET nominate Davido and Tiwa Savage for Best International Act category, dem go fight for di award with:

Booba (France)

Cassper Nyovest (SA)

Dadju (France)

Davido (Nigeria)

Distruction Boyz (SA)

Fally Ipupa (Dr. Congo)

J Hus (UK)

Niska (France)

Tiwa Savage (Nigeria)

Stefflon Don (UK)

Stormzy (UK.

DJ Khaled get 6 nominations.

http://www.ototaspalmyjoint.com/bet-don-nominate-tiwa-savage-and-davido-for-2018-bet-awards/
Religion / Pastor And Imam Para As Uganda Govt. Put 18% Tax On Top Sales Of Bibles And Kora by chiefotota(m): 1:14pm On May 16, 2018
Pastors and Imams for Uganda nor dey happy with Uganda government, base on se Uganda Revenue Authority (URA) don arrange 18% Value-Added Tax (VAT) on top di sales of religious materials like Bible, Koran, prayer and hymn books. Di religious leaders dey para se dis tax nor make sense, base on se di sales of all dis religious materials nor be for profit but na for “spiritual nourishment” of Ugandans.

Archbishop Stanley Ntagali of di Church of Uganda, aka Anglican Church, write petition give URA, after dem seize about 9,120 prayer and hymn books wey Anglican Church import from Kenya, but di Commissioner General of URA, Madam Doris Akol, say she nor get power to release di books, she dey insist se make di church pay di tax wey dey on top di religious books head.

Dem be nor dey tax all dis religious books before before, but di Commissioner General say di law wey dem be nor take dey tax Bible and Koran dey wrong, she dey insist say both Christians and Muslims must pay tax for bible, Koran and other materials.

Oga Ramathan Mugalu, wey be di secretary general of Uganda Muslim Supreme Council, yarn too say he dey against di law, he make example se even di Presido of Uganda, Museveni bin don fess talk say make dem nor tax imported prayer materials, especially di ones wey dem nor dey sell.

http://www.ototaspalmyjoint.com/pastor-and-imam-para-as-uganda-govt-put-18-tax-on-top-sales-of-bibles-and-koran/
Romance / Re: You Nor Go Believe Wetin Dis Lazy Youths Do For Bus Stop Till You See Di Video by chiefotota(m): 10:19pm On May 14, 2018
You nor notice se di babe na white?
Chizuru01:
That's why Donald Trump hates black
NYSC / Funny Video As Lagos Kopas Epp Orobo Kopa Climb Man‘o’war Obstacle by chiefotota(m): 10:17pm On May 14, 2018
Instablog9ja share dis hilarious video of dis orobo (fat) kopa wey dey try climb Man ‘O’ War obstacle for Lagos NYSC camp.

Watch dis video: http://www.ototaspalmyjoint.com/watch-funny-video-as-lagos-kopas-epp-orobo-kopa-climb-manowar-obstacle/

Crime / United Airline Chase Naija Woman Comot From Flight Se She Get Body Odour by chiefotota(m): 7:47am On May 13, 2018
Una nor go belive, but one Naija woman, Queen Obioma, don drag United Airlines go court for Yankee, she dey claim say di airline remove her and her children from plane because she get body odour.

According to di tori wey dey for Houston Chronicle, she claim say as she enter flight, she notice another man for her seat, make di guy stand, di guy refuse, after much talk, she agree to go di guy seat go sidun with her children, but make she fess go toilet go arrange hersef, but as she return, di re block her again make she nor enter di new seat, before she understand wetin dey happen, one of di flight crew tell her to come down, wetin be her crime? Di very man complain say he nor fit enter di same plane with her, say she get body odour.

Na so dem take drive her and her children from di plane, wet from Lagos to Ontario Canada but dem transit for San Francisco, dem las-las delay her for like 5hours before she join another plane, so now she don drag di airline to court for Texas, she dey seek “punitive damages and legal fees”.

Di airline yarn say dem never get any court notice on di mata for now.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/united-airline-chase-naija-woman-comot-from-flight-se-she-get-body-odour/
Romance / You Nor Go Believe Wetin Dis Lazy Youths Do For Bus Stop Till You See Di Video by chiefotota(m): 7:13am On May 13, 2018
We nor sure, but from di background noise, dis rubbish be like se na for Yankee e for happen. Dis 2 lazy youths just arrange theirsef onto horizontal refreshment for bus stop, di idiot guy guy, tell di babe to touch her toe, before we know wetin dey, di guy don com, watch di video:

http://www.ototaspalmyjoint.com/you-nor-go-believe-wetin-dis-lazy-youths-dey-do-for-bus-stop-till-you-see-di-video/

Crime / Russian Thief Paint Im Face Green Make Police Nor Fit Recognize Am by chiefotota(m): 4:42am On May 10, 2018
Market don fall press wan 23 omila (thief) for Russian city of Krasnodar, di guy paint im face with green pain thief one lady purse for train station, with di mind se make dem nor fit identify am, but di lady was fast to report di mata to police.

As police show di area, dem nor even waist time to catch di guy with di purse for im hand, he tell police say he pain im face green, make people nor fit recognize am, but before he go wash his face, and discharge di purse, police nab am.

Find out wetin Police do to di guy here: http://www.ototaspalmyjoint.com/russian-thief-paint-im-face-green-make-police-nor-fit-recognize-am/

Crime / Horse Don Sue Former Owner For Animal Cruelty, Demand $100,000 As Damages by chiefotota(m): 1:45pm On May 08, 2018
We don fess talk say all dis oyinbo people nor well, but be like se we under estimate their level of madness, infact, dem dey kolomental. One 51 years old woman, Gwendolyn Vercher, for Oregon for Yankee, don land for court, base on se her former horse wey im name be Justice, sue her and dey deman a whole $100,000 for damages for wetin odditycentral.com call animal cruelty.

Di woman actually leave di horse for outside during winter, na her crime be dat o. Some ovasabi lawyers from Animal Legal Defense Fund for Portland, drag di woman to court, on behalf of di horse, dem tell di court say di horse suffer well well wen di former owner take leave di horse outside for winter, so make di woman remit di 100k, make dem use treat di horse.

Na wan ovasabi neighbour call to report to people wey dey take care of animals, to come carry di horse, den Sound Equine Options con epp (help) di horse, dem carry di horse go see Vet Doctor for Eagle Fern Equine Hospital for Estacada, den di dockay (doctor) say di horse don emaciate, get skin and penis also infection, now di lawyers dey ans (ask) court to order di woman to pay 100k.

read up more details here: http://www.ototaspalmyjoint.com/horse-don-sue-former-owner-for-animal-cruelty-demand-100000-as-damages/
Sports / Football Fatanic Climb Crane To Watch Match After Dem Ban Am From Stadium by chiefotota(m): 4:43am On May 08, 2018
Hahahaha, dis wan kee (kill) me, I dey tell you. Dis fanatical football fan Ali Demirkaya, a.k.a. ‘Amigo Ali’, of Turkish club, Denizlispor, don prove to everybody se im na korret die hard fan, Amigo Ali go rent crane to watch and support his club over di weekend, after dem ban am fron entering di stadium for 1 year, base on se he misbehave.

Di 37 years old fan, yarn say nothing fit stop am make he nor watch and support im club, he say he go contest di ban, but how ever, he go continue to watch his boys, dat na why he go spend money rent crane.

But las-las, Police spoil di guy groove, as dem show di background and order di crane driver to bring di guy down, but Ali still dey hold ground, se he go find another way. Dis nr be di fess time wey he dey try dis tin.

If you go like see more funny stories, visit:
http://www.ototaspalmyjoint.com/football-fatanic-climb-crane-to-watch-match-after-dem-ban-am-from-stadium/

Education / Zambian University Ban Female Students Make Dem Nor Dress Half Naked To Library by chiefotota(m): 4:39pm On May 07, 2018
University of Zambia wey dey their country capital for Lusaka, don warn their female students not to dress half naked come school library again, base on se di babes dey distract guys wey con read book, but some of di female students say di new library rule for female students na rubbish.

Check out di ban notice and di response from female students:

http://www.ototaspalmyjoint.com/zambian-university-don-ban-female-students-make-dem-nor-dress-half-naked-to-library/
Crime / South Africa Omila Drive Stolen Car Straight To Prison by chiefotota(m): 4:31pm On May 07, 2018
Wen God wan punish devil, Warri go say na on market day, dis na exactly wetin happen to dis 4 omila (armed robbers) wey thief car for Cape Town, South Africa.

Di guys thief dis car, den as police chase dem, dem drive di car go di same prison, Pollsmoor Prison, wey dem be for arrest Mandela, park di car run with leg go hide, but police arrest dem for where dem for hide inside di prison.

Read more details for: http://www.ototaspalmyjoint.com/south-africa-omila-drive-stolen-car-straight-to-prison/
Crime / School Administrator Wey Poopoo For School Field Don Land For Court by chiefotota(m): 4:23pm On May 07, 2018
Na wa o, for common shit again, nai pesin go reach court? God abeg o.

One 42 years old school administrator, Thomas Tramaglini, for Holmdel, New Jersey, don land for court, just because di guy shit for di school field.

According to gist for Huffingtonpost, di school Kenilworth School District, athletic coaches, say dem dey see shit for di field every time, base on se di shit tin don too much, na so dem run investigation abi dem set trap wait di pesin wey dey shit. We nor really sure as dem take catch di shitter, but according to Holmdel police Sgt. Theodore Sigismondi, he say dem don charge di guy to court.

See di face of di school administrator here:
http://www.ototaspalmyjoint.com/school-administrator-wey-poopoo-for-school-field-don-land-for-court/
Celebrities / Read As God Use Igodye Bless Sick Man Along Abuja Kaduna Express Way by chiefotota(m): 1:22pm On May 07, 2018
Pastors dey always talk say wen God wan bless pesin, nothing fit stop dah blessing, dis na di exact story of one sick man wey dey stay with his family for one of di villages along Abuja Kaduna express way.

According to dis story wey Comedian Ghana Must Go share on Facebook, God use Comedian IGoDye bless dis sick man miraculously. Ghana Must Go for di Facebook post say im and IGoDye dey drive back to Abuja from Kaduna yesterday Sunday after NAF (Nigerian Air Force) @54 Gala Night event wen IGoDye just say make dem stop over for one of di villages make he snap some foto, but after IGoDye snap foto finish, he just innocently ans (ask) of di owner of di house, na so di village people yarn IGoDye say di owner of di house dey inside, but di man nor well, and no money to take am to hospital.

IGoDye ans to see di man, dem take IgoDye inside to see di man, after he see di man finish, di Comedian was touched, na so he bless di man, we nor sure of wetin or how he take bless di man, but according to Ghana Must Go, IGoDye nor leave di man di same way he meet di man, meaning God use IGoDye bless di man and his family, even though di people nor even know who IGoDye be.

See full details here: http://www.ototaspalmyjoint.com/read-as-god-use-igodye-bless-sick-man-along-abuja-kaduna-express-way/
Fashion / Simple Yes Or No, You Go Spend Your $168 (n60,480) Take Buy Dis Jeans? by chiefotota(m): 12:05am On May 06, 2018
Dis jeans wey di designer call "extreme cutout" jeans dey trend online, and guess how mush online store Carmar dey sell di jeans…? A whole $168 (N60,480).

We dey wonder se as as how, pesin go spend a whole N60,480 take buy dis tin, and where di pesin wan wear di tin go?

See di back view: http://www.ototaspalmyjoint.com/simple-yes-or-no-you-go-spend-your-168-n60480-take-buy-dis-jeans/

Religion / Fall Down And Die By Faya, Naija Church Protest Fulani Herdsmen Killing by chiefotota(m): 2:28pm On Apr 29, 2018
Onto di protest wey Christian Association of Nigeria, aka CAN call make every church for Naija protest and pray across Naija, base on di badness wey Fulani herdsmen dey kpai (kill) innocent people for across Naija, Middle Belt people wey dey for Taraba, Jos, Kaduna, Nasarawa and especially Benue people, members of First Baptist Church, Ikeja, today Sunday, joint di protest.

Di members protest including small pikin dem for di church for Ikeja, with card board paper and banners wey dem write tins like: “Stop chaos and violence now or forget 2019”, “we demand freedom for those in captivity, lets live in peace & harmony”, “No to blood shed in Nigeria, stop herdsmen killing in Nigeria now” and others.

Members pray make God let all di bad Fulani herdsmen wey dey kpai people to fall and die, see more pishure:
http://www.ototaspalmyjoint.com/fall-down-and-die-by-faya-naija-church-protest-fulani-herdsmen-killing-for-middle-belt/

Religion / Zambian Pastor Cast Out Demon From Church Member Pant During Church Service by chiefotota(m): 9:33pm On Apr 28, 2018
We nor understand di demon wey dey dis babe pant, wey let dis pastor dey off her pant duing church service, we nor sure, but e be like say di man of God was cast out demon from di pant.

One Facebook user, Offwell Sikazwe, share di pishure for one Facebook group 'ZNBC Top Stories Online™' with dis caption: "FAKE PROPHETS PLZ LADIES DONT DO THIS TAKE YO PROBLEMS TO JESUS THAN TO A PROPHETS HAPPY SABBATH”

See di pishure of di pastor in action for: http://www.ototaspalmyjoint.com/zambian-pastor-cast-out-demon-from-church-member-pant-during-church-service/
Politics / Police Vs Dino: Dino Melaye, How Market? by chiefotota(m): 11:43pm On Apr 24, 2018
My people dey always talk say wen God wan punish devil, na on market day.
I nor dey forget di plenty political activities preceding 2015 election, dah year, Dino Melaye was one of those #LazyNigerianYouths wey follow blast and call President Goodluck Ebele Jonathan such name like "weak, woman, without balls, kindergarten president, etc" there was a particular episode during one of APC rally for Lokoja, Dino wished Jonathan and all PDP people the dreaded 'Ebola' disease, because of desperation to get to power, now wey di power don reach APC hand, my kweshun to Dino today wen i see di humiliating video be "Dino how market?" (with Parience Jonathan voice) Sheybe Dino don get di strong man for Aso Villa, now fear nor even let am enter his home state again?
as i dey my one corner dey laff Dino because i honestly no feel any sorry for di guy at all, my kweshun to mysef and all wey dey read dis be, "if police fit do dis kind tin to a whole Senator of the Federal Republic dis kind tin, na to avoid police o, dem nor be awa friends at all.

Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/police-vs-dino-dino-melaye-how-market/
Romance / Former Sa Presido, Jacob Zuma And His 24years Old Side Chick Don Welcome New Bab by chiefotota(m): 4:37pm On Apr 23, 2018
Former South Africa Presido, Jacob Zuma and his 24 years old fine side chick, Nonkanyiso Conco, don welcome new born baby together for wan VIP private hospital for Durban city, South Africa.

Dis pikin so, don let di babe, Nonkanyiso Conco, to resign for di NGO wey she for dey work, She Conquers, according gist wey we spy from media for South Africa. Di NGO gats to force di babe to resign, base on se she dey follow ‘sugar daddy’, and dat kind tin na abomination for di NGO. Di NGO dey actually dey try to encourage young women for South Africa to dey independent, make dem nor dey rely on old papa, to dey give dem money.

Read up details of as dem take dey plan their marriage here:
http://www.ototaspalmyjoint.com/former-sa-presido-jacob-zuma-and-his-24years-old-side-chick-don-welcome-new-baby/
Celebrities / Chimamanda Kollet Roasting For Blasting Hillary Twitter Bio Wey Start Wife by chiefotota(m): 2:38pm On Apr 23, 2018
We nor know who send Naija writer and feminist, Chimamanda Adichie, dis message, but he clear se she don fall her hand, and most Twitter user dey roast her, base on se she carry talk.

Yesterday Sunday for PEN World Voices Festival lecture, wey happen for Cooper Union, Manhattan, Chimamanda ans (ask) former US first lady and presidential candidate, Hillary Clinton, why her Twitter bio start with ‘wife’? instead her career achievements, read exactly wetin Chimamanda ans Hillary Clinton wey she use buy market:

"In your Twitter account, the first word that describes you is ‘Wife.’ And then I think it’s ‘Mom,’ and then it’s ‘Grandmother. And when I saw that, I have to confess that I felt just a little bit upset. And then I went and I looked at your husband’s Twitter account, and the first word was not ‘husband.’"

Now Twitter users dey ans Chimamanda, wetin concern her with another man wife bio? See di roasting wey she receive:
Jokes Etc / Watch Dis Hilarious Video Of Facebook User Wey Finish Work As She Mimic Cee-c by chiefotota(m): 12:02pm On Apr 23, 2018
Nor to small tin, a Facebook user, Agamugoro Glowryah O'gaga, after di Big Brother Naija show end, decide to give us something to remember and laff to, as she take out time create a video wey she for mime Big Brother controversial housemate, Cee-C.

Very hilarious, watch di video here:
http://www.ototaspalmyjoint.com/watch-dis-hilarious-video-of-facebook-user-wey-finish-work-as-she-mimic-cee-c/

Events / #bbnaija 2018: And Di Winna Na… Miracle With Di N25m by chiefotota(m): 9:17pm On Apr 22, 2018
After 85 days for inside Big Brother Naija house, Cee-C Miracle don finally win di star price of N25million cash, plus some other jara wey go make am add up to N45million. Wen di show start, he fess put only wan leg for ground like fawo (chicken) wey rain beat, for im eye, nai one after di other, dem evict all 15 housemates remaining Tobi, Cee-C, Nina, Alex and Miracle.

For di final match today Sunday, dem fess chase Nina, den followed by Alex, before I shout Cee-C, dem use koboko flog Tobi comot from di house, e con remain Cee-C and Miracle, but las-las dem announce… Miracle as di winner of di star price.

Congratulations Miracle.

Davido, Dice Ailes and Kaffy perform for di finals to groove di guest wey watch di live show for South Africa and di viewers across di whole wide world.

http://www.ototaspalmyjoint.com/bbnaija-2018-and-di-winna-na-miracle-with-di-n25m/
Events / Naija Dj’s Don Ready To Break Guinness World Record by chiefotota(m): 4:00pm On Apr 22, 2018
Siglo Innovation don dey kolabo with DeeJay’s Association of Nigeria to attempt to set another Guinness for Lagos Nigeria, as 200 Naija DJ’s don ready to play nonstop for 600minutes for di event wey dem call “DJ MIXATHON” World Biggest Party.

Di show dey go down live for Silverbird Galleria, for V/Island. We nor sure di list of di DJ’s wey go run di show, but e clear say Naija and Africa biggest DJ, DJ Jimmy Jatt endorse di show, see more details here:
http://www.ototaspalmyjoint.com/naija-djs-don-ready-to-break-guinness-world-record/
Celebrities / My Money Nor Be Through Music Or Oil Bunkering, My Money Na Legit – Duncan Might by chiefotota(m): 3:32pm On Apr 22, 2018
Naija artist, Duncan Mighty, aka Port Harcourt first son, don come out to clear di rumour wey some people dey carry about am se di plenty money wey he get, na through illegal runs.

Duncan Mighty for one interview with Saturday Beat, yarn say, his money na through hard work and di grace of God, he say God don bless am, and he nor fit hide wetin God do for rham, he say he understand why some people think se his money nor legit, dat na because he come from poor background. He yarn say some people dey talk say na through oil bunkering, but na lie, he say nor be even through music he make his money at all, he say he get other businesses, he yarn say he dey run construction company, so nor be music at all.

He advise im guys wey dey into music, to invest for other areas, especially wen dem dey trend, make dem use dat opportunity take launch other business, base on se their music fame fit epp dat other business to grow.

http://www.ototaspalmyjoint.com/my-money-nor-be-through-music-or-oil-bunkering-my-money-na-legit-duncan-mighty/
Celebrities / Igodye Promise To Support Evicted #bbnaija Housemate Rico Mama Put Business by chiefotota(m): 1:37pm On Apr 11, 2018
Original Warri boy, and top Naija Comedian, Igodye, don promise to support evicted Big Brother Naija housemate, Rico, for di restaurant business wey Rico plan to start.

Igodye for di pishure of Rico wey he share on Instagram dis Wednesday morning, yarn say he dey very proud of Rico, he say Rico na good example of Naija youth wey everybody suppose dey proud of, base on se at a time for inside Big Brother house, wey others, dey misbehave dey toushlight (romance) theirsef, Rico, hold im side tight. He say Rico na true symbol of a young African man wey get values, respect and dignity.

He promise to support Rico with his own small osusu, base on di restaurant business wey Rico talk about for di house se he go like open.

See Igodye post here: http://www.ototaspalmyjoint.com/igodye-promise-to-support-evicted-bbnaija-housemate-rico-mama-put-business/
Sports / 8 Out Of Di 42 Athletes Wey Cameroon Carry Go Commonwealth Games Don Vanish From by chiefotota(m): 1:30pm On Apr 11, 2018
Nor be small mata for Gold Coast Commonwealth Games, as 8 athletes from Cameroon, don discharge (run away) from camp.

According to Cameroon Team Chef de mission, Victor Agbor Nso, he say at at today Wednesday, na 8 don miss, 3 fess run, as dem dey reason wetin to do, another 5 don discharge from their rooms for di Games village.

3 of dem na weightlifters, di other 5 na boxers, so if anybody get information about di missing athletes, make una report to di nearest police station.
Source: http://www.ototaspalmyjoint.com/8-out-of-di-42-athletes-wey-cameroon-carry-go-commonwealth-games-don-vanish-from-camp/
Romance / Female Teacher Land For Court, After She Spiritual(sex) Her 15 Years Student by chiefotota(m): 10:45pm On Apr 10, 2018
Congeal don let wan 53 years old teacher land for court, after she run horizontal refreshment (sex)with her 15 years old student.

Yawa gas, wen di teacher, Deborah Lowe, send di boy, dirty love message after di boy block her for social media, after their horizontal refreshment for di teacher house, di boy mama read di message, na there breeze for blow di fawo (teacher) yansh open, as di boy mama read di message, she report di mata give police.

Di teacher tell di court say she nor dey guilty, she dey claim say di boy don reach 17years wey she take run shows with di boy, buy di boy dey claim say na lie, he be 15 wey dem fess start to run shows.

Read di message wey cast di teacher: http://www.ototaspalmyjoint.com/53-years-female-teacher-land-for-court-after-her-horizontal-refreshment-with-her-15-years-old-student-cast/

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (of 7 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 85
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.