Ekene101's Posts
Nairaland Forum › Ekene101's Profile › Ekene101's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 53 pages)
yad2eidi:shey pics dem dey upload here na from Jamaica or na Spain I dey stay. Una go just wake up begin type with una free 10mb, even with steady update this one still won come derail thread, oga suffri dey ur Benin republic. Go alexo thread for telegram go see wetin boys use ak dey do. If ur aim na to make opposition loosegad say d stress no serious e no go work,d killings don too much. People come down from car,drop person,still collect money from him pocket after dem still spray am more bullets,still echo their slangs,video am enter motor move in two separate locations in one night and u dey talk nonsense say d matter no serious, Continue. |
af0nja2000:Arrest the idiot make him go sign undertaking. If he hear say u and person dey quarrel or argue,even if him naked dey bath for bathroom na unclothedness he go use run come separate una make anything no happen to you. Undertaking and blood covenant,I no know which one worse pass. My guy wey dem carry go state cid go sign undertaking for almost similar matter know how far na, he gats leave the entire Nigeria before him mind touch ground. |
kingthreat:This one one side don involve national body with high grade tools so, the rivals don dey urge their national body to get involve too. The massacre Edo state is about to witness in coming days will go down In history except something is done quickly and I mean very fast. |
So cultists don graduate from pa,awka made and cut to size to better ak and other automatic weapons. The one used to kill those guys in Benin no be child's, d video just dey like scene from war Film. May God protect people in Edo state from these blood suckers. With the kind weapon those guys used, this war isn't ending anytime soon. Make everybody save their head. |
Arobaga:na wah oo
|
Skip those unnecessary rantings above, anybody with useful stories of the ills of cultism or advice should share with us,we are not here to flex muscles or brag who is weak or strong, we are here to condemn cultism. So painful everything we have Been preaching against,these two adult babies above chose to prove otherwise,yet they claim they are against cultism. Now I see why Edo state government and other states government chose to let youths kill themselves, because them no fit ever get sense. Common online una don dey say drop location,then how those offline go listen to wetin we dey preach here, see as una dey mumu this January 2024. Abeg make una get out, killing just dey almost all Nigerian youths blood, cultist or not. Any small talk drop location. Make una get out again, go quote urselfs on another abandoned thread and share location for ur mortal Kombat. Very anyhow unserious people. |
The aye eiye behead few days ago family dey wail, he younger brother for up town dey beg eiye to release him senior brother head make dem fit bury am. He say d tin na big shame to him family say dem kpai him brother,behead am and still carry d head along, now dem no fit just bury am without the head as d tin go cause their family stigma for life. This na man with wife and kids nai dem behead like stray dog ,carry him head move. I just wonder how d family dey feel right now and how people go constantly dey reference the incidence. Just imagine wetin that guy cause full family by joining cult with him own hard earned money and still died in the meanest and most disgusting and disgraceful way ever. Children will grow old to hear how their father was shot and beheaded, wife will be referred to as the woman her husband was behead and head taken along. God forbid,I better go die for Libya sea trying to cross into Europe. |
freshkpomo:baba na u even dey gimme ginger to continue to dey post here,the threats here on a daily basis no be small thing. You see those illiterates killing each other are those who has realized the have derailed in life and wants to take as much innocent souls down with them so they don't go alone. Just like a runs girl in most cases that got cutup by her serious boyfriend but will do everything to lure her faithful friend to go into that cheating lifestyle so they both loose at the end. Cultists are scared of loosing alone,so they try as much as possible to sink innocent souls down with them. Flee from cultism. Everything posted here is not makeup for movie,they are people like you and I. SAY NO TO CULTISM !!! |
Reelmii:I no first talk am say na poor man pikin dey do cult,rich man pikin na fraternity. That guy fit never even bath for days now,no room of his own, na cult him dey use squat with people till hand touch am so. If dem even check well,na another location him for come, still dey form hard man with dirty boxers and human hair wey him no see 50naira buy razor shave. But him go Sabi handle cutlass and axe pass Achilles and Spartacus. Now leg don touch am. |
freshkpomo:I swear, you are very right. If every frat collapse their structure like NAS, this thing go reduce. I observe that NAS is one of the frat you don't see on the street doing nonsense, since they said they stopped initiation in schools. |
Messi76:this na Ayes vikings drop for abavo in-between Agbor/abraka. |
PhillipPHD:It can, the elites in the game do things together in bigger ways. It's the hungry illiterate street urchins that are the ones spoiling the society for everyone. I saw a video recently of top men from different frats attending a function just recently with all the crisis. You expect people wey get business that pays them millions,competing on who is more wealthy with investments to carry gun enter street go kill person unto color. 98% of cultists always caught are from poor background. |
Hardcore11:Just only Edo state alone,more than 50 people no see New year from the last 6months till now just because of color. Nobody from uptown gree come home for Christmas,even the ones wey dey still kill themselves. Some no even pass the crossover. I see one video wey dem gun matured man ontop reservoir where him sleep. Like how people go they think of better things for the new year,some people go mount somewhere dey map how to drop another person. Truly no be everybody be human being,some na robocop. Just to know how Nigeria violent reach, small Christmas party dem organize, person on spiderman costume and person on Father Christmas costume begin fight scatter the show. Spiderman and father Christmas dey fight for children party.. Nigeria my country..na our own dey different and violent from people we copy from |
FuckYou:They are free just like this guy killed this new year day.
|
There is this two brothers we lived together sometime back in another state. First son victor(not real name) gained admission 2009 to Madonna university,his father spent over a million naira for the school stuffs including rent and even furnished his apartment like a salary earner(pops man na shell worker, contractor to be precise,so bar dey) not up to 4months,guy joined cult(don't know which cult) and had issues with buccaneers. And that school, buccaneers still get weight there, the day they came for victor,he was Lucky to be in the village that weekend, got hold of one eiye guy because alora and eiye had issues that period,threw him from 4story building saying he should fly since he's an AirLord. They got to his room, but couldn't find him, a neighbor later called to inform him of what happened that night. From village that guy came back to his parents house. The following year,his father secured admission for him and his younger brother who just finished secondary school(let's call his brother John) into unizik, still within a space of 3months,John joined vikings at awka, buccaneers came for victor again in awka and both of them fled back home after another millions have been wasted. John didn't stopped there,he started rigmarolling with area vikings and soon platoon deckhands begin look for John because his father is loaded,officing has started. Victor on the other hand was secured European visa and has travelled to those garian country,he's in Facebook and TikTok daily doing videos,no school,no work no nothing. He came home one time for visit with nothing but headwarmers used during winters,some with rabbit design, some panda,some goat sef. John on the other hand is now a professional photographer,the dad is very old and retired,can't even pay rent anymore and landlord has asked him countless times to retire back to the village so he can die there with his umunnas but epa too stubborn,he refused to move till this minute,he can barely walk again with his poor sight. You know ibo men don't marry on time,so these guys are still young boys,but cultism ruined their lives and the father is now very old. The third son said he wants to do music,till date no one knows where that one is since he moved to lagos, that one join street eiye back then in secondary school. Thank God both of them are still alive because I see their updates on Facebook regularly,but cultism ruined those guys big time. |
Better projector |
Maphites still kpai aye few days ago for Benin, even as all these dey go on some people dey prepare to go join cult. Anyways ground no dey full, anything dem give am nai e dey collect. |
Mhizzard:one man I know that own about 3 filling stations and numerous other businesses drove down with his highlander to a location where apc was sharing 1k5 during campaign. People dey abuse d man say upon all him money,na 1k5 free money he drive down come queue to collect. Some rich folks rather keep theirs a d spend free stuffs. |
Dem don still kpai another aye. This one dey here dey hype dem from where him dey hide him head. See as people dey look am dey struggle with him life just few weeks to new year.
|
Makamatic:leave am make he dey cap rubbish. Only him confra for Edo state get war with almost 4 other confra, even eiye wey dey loosegad die due to their numbers and illiteracy don kpai two of them after them kpai that guy wey I post wey him head and leg dey backo bag. Them dey deny say na Jew them be. Na online dem dey form iron man, even for Owerri baggers fall former axehead,him brother run come the scene with axe begin mumu himself dey chase people,yet them say no be their member na Jew. Very funny set of confra wey dey start wetin dem no fit finish. No confra good,all na death trap just as e be cult,na just to cut your life short but you see this ayes, Na black goat them truly be wey no get sense,before eiye, maphites and baggers. Make he no worry,dem go still post am here after small pikin don behead am, as he no won get sense. Online ironman. |
Shakathezulu1:me and them,who dem dey behead daily? |
Makamatic:ThankGod say another person don confirm am. Dem go map person or won go drop am,na bike men dey wait them wey go carry dem escape. Bike man go dey sync u won know if u dey game make dem go cast u and carry dem to ur location for dropping. Auchi don finish unto confra matter,na just say Auchi king no dey give them the opportunity just as oba silent. If not Auchi for too worst. |
Shakathezulu1:only strong thing dem do me be say dem make town unsafe for everyone, person no fit dey go certain places for fear of wrong identity. Me wey dey Waka freely and aye men wey all of dem don run go gather for one of their member location for fear of beheading from almost 3cults dem dey problems currently with who dey see strong thing? Strong man strong man,but una dey hide, dey use external dey pull hit make dem no identify una, yet dem still dey kpai them. Eiye don still kpai this one for Benin.
|
Get sense abeg.. All na scam..
|
Even the police and vigilante don belong,na them dey pull most of these hits for their confra. Benin wey be minority still dey kpai dem selves mumu people. More than 14 people have gone down since my last update but I chose not to post it because nobody dey pay me,who get sense make him hear. But sentiment aside,this aye people are the problem everywhere,they are always the first to knack which leads to these unnecessary kpaings. Make them dey use their sense sometimes, everything no be violence,if dem knack dem now, dem go say no be their member. U wey won go join aye, dem Sabi deny casualty,if dem knack na legit,but if dem knack u or any of their member,d person na Jew according to them. I no tell you say others good o,abeg run from even town hall meeting talkless of anything colour. Dem go post u here if u no get sense. |
Another one down again this morning. Benin make una rest abeg
|
Another Man down in Uwelu Benin city...In a Clash between Eiye men vs Black axxe Hide ur head oo. See as this one family just dey cry.
|
Perkins1:bros no be carry talk matter, I believe say Auchi people still dey here dey read update. Ayes don bam almost all the whole bike men for Auchi finish,minus those igarra bike men o, because those ones na eiye or jurist dem the do. I mean aboki real aboki. The one wey dem shoot for ehekhi girls road close to Suleiman street wey cause war some months ago,na better aboki. Person no know who be who again for the auchi lifestyle like this. No go carry dey mend person wey u no know o. |
Leone001:Na so one idiot for warri around 2007 say make I buy raw egg,chelsea dry gin and grinded pepper make him hatch him papa for eiye unto say na fowl him papa be no be me. D mugu say na him be ibaka for coconut nest,say if him papa get any issues men go fall out. D next day,na one small arobaga stab am die, him squard no fit do anything till tomorrow,even him grave now na one woman put caravan now dey sell soup things. |
Update from Benin eiye and black axxe don clashed for oluku area side one man don already go down abeg hide your head if u re living around that side. Black axxe first kpai two eiye guys last week around that location. Medical side to be precise. |
.