Franvincoop's Posts
Nairaland Forum › Franvincoop's Profile › Franvincoop's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 27 28 29 30 31 32 33 34 35 (of 70 pages)
Bros no vex, I wan ask say according to the Nigeria–UK prisoner transfer programme, if UK asks for transfer of Nnamdi Kanu who is a British citizen in exchange for Ekweremadu who is a Nigerian citizen, how e go dey? BlackPantherxXx: |
If Democrats field AOC, Republicans will field MTG... E go sweet die cr7lomo: |
Bros, I wan join mouth for this ur wisdom. Not only Indians, Pakistani dem dangerous pass Indians. Marry 1st wife, bring come UK, give am belle as she born, divorce am, marry 2nd one bring come UK, divorce am, marry 3rd one. All the wives go get stay and subsequent citizenship through the child route, now now 5 years don reach dem apply for ILR. Quietly no noise but Nigeria, dem cast everything online for few cents per like. aswani: |
Damn niggar, where my original damn niggar dey? EFCC abeg make una free Slawomir, oh my God since wey una raid that yahoo factory with Chinese connect, I never see my guy, na im be the COO for that place. To your matter, na when u reach 64 years and just 6 months to your 65th birthday wey u go knowsay life sweet. Ask Ned Nwoko. VOsimhen144: |
I go do am "a la Hakimi", choose that 800 million, afterall my mama get charity organisation. Smart move... ![]() badaru911: |
Wetin dey sweet me na say the same knife wey Wike use stab Atiku, na the same knife dem use stab am back. The name of the knife na G5. But the sweetest part be say, the knife be don blunt and rust as na since 2023 wey dem last sharpen am. Imagine say dem stab u with that kind knife? Wike in menstrual pains after Yerima disgrace now G5 expulsion. Wike in the mud in the pig sty. fergie001: |
Na so e suppose dey. Even if na im wife run go here Papa house, popsy go tell am to return back to her husband's house immediately. Nothing concern am, especially the issue for return brideprice, u don buy u don buy, no refunds. On the other hand, Adeboye was right though, you know if im no pay im wife that salary, how she go take pay tithes make Adeboye see food chop? brain54: |
You are a drug dealer, hand go touch you soon. We go show you your own conviction, no worry. thesicilian: |
No mind dem, Buba Marwa go catch them very soon. I don't like APC but you see Buba Marwa, he is the only person who can make me like APC because since 2015, he has been performing excellently well. Even Senior Policemen like Kyari have been arrested and arraigned for drug trafficking and even the DEA, Interpol and Europol are liaising with NDLEA, something which was unheard of before Buba Marwa. Nigeria is now a trusted country in the fight against drug trafficking. Take for instance the woman who was setup with drugs in her luggage when she went for Hajj in Saudi Arabia, she was arrested in Saudi Arabia and Saudi authorities believed she might have been setup and they contacted NDLEA who carried out an investigation in Nigeria and arrested many porters, immigration and Customs officials at Aminu Kano Airport who tampered with the bags, even the cartel leader in Nigeria was arrested along with the person who was supposed to receive the drugs in Saudi Arabia. Anybody wey say Buba Marwa no dey work na drug dealer, Buba Marwa dey put serious ijebu sand inside their garri. Buba Marwa for President 2031. erad: |
As a polygamist, I will not take too much of your time. In African marriages, " Your money is her money and her money is her money". All my children now dey boarding school and university but the feeding money wey I dey give when all my children dey house, na im I dey still give when them dey school. If you say I be mugu, I go own am with my full chest. Nothing pass peace of mind, double your hustle and you go enjoy your marriage. Happy Sunday. grandiose4ever: |
Why you dey waste ur time my brother? Each to his own. If there is no benefit in marriage, no wahala. E meansay na single parent upbringing im get. Wait till im break leg or sick one sicknesd wey im no go fit walk reach toilet to shit or open shower, cook, wash plate, clean house, wash clothes, or simply help me pass me my phone na then "Had I known" go come in and dem go start find emergency wife for am with pressure. No dey join talk with children, na waste of time and data, they will never learn until they write exams and fail, then they go start attend lectures. Happy Sunday pansophist: |
Following your logic, who do you think between ADC and APC would benefit more from the PDP having no candidate in 2027? B4 u answer, know that I am not talking about individuals but atleast PDP 6 million votes in 2023 or atleast 3 million votes in 2027 despite the defections. In 2027, anything short of an Atikuobi ticket in ADC will mean Tinubu will win reelection with less than 5 million votes. Shantyken: |
So, if we follow this your logic, Xi Jinping na illiterate abi? Putin too? Messi nko? Let me shock you, Arabic language is much more older than English language. Your definition of illiteracy is wrong and very limited. Remind me which year the Bible was translated to English? So the whole world no read Bible before that time, the whole world na illiterates bin full am that time. I don't know if Ibo, Hausa and Yoruba are still being taught in schools in Nigeria today. If you can read and write in Ibo, Hausa, Yoruba, Fulani, Efik or any other indigenous language in Nigeria, you are not an illiterate. Know this and know peace. ariesbull: |
So after everything Yerima teach your lord Wike, u no learn? Na wa ooo. There is nothing like former or retired. Let me quote the young officer, Lt AM Yerima verbatim, “Sir, I request to enlighten you, there is no such thing as a former Vice Admiral, a Vice Admiral is a Vice Admiral…” stuffs2002: |
U don wake up? I dey see you on the other threads, me and you na the same dealer wey dey buy from na say I dey smoke my own with Rizla while na carton paper u dey use smoke your own. stuffs2002: |
Talking about poverty, I can testify say Gombe and especially Jigawa State na legendary. I buy suya 5k and sprite sit down dey chop, I no even know say almajiri dem don gather for 1 section dey observe me, every slice wey I pick from paper to my mouth these children dey follow the movement likesay na their mouth I dey take chop the meat. I was so embarrassed, na so my friend dey laugh me dey tell me say na normal thing. I just vex call that mallam wey dey sell suya, tell am say make e give those children suya for 5k but tell dem to leave dis area. B4 you could say Peter Obi, those children don finish that suya, still dey look me again as I dey take my time dey chop. I just vex, carry my suya enter motor wind up put AC chop my suya in peace. I swear to God, if nothing is done about those millions of hungry, uneducated children up North, if Trump like make e bring Angel Gabriel or Angel of Death, terrorism and banditry no go ever finish, applicants for banditry and future terrorists plenty pass sand for Bar beach. While my pikin dem dey school, these one dey street dey beg, dey find who go give dem wetin dem go chop. I mean children ooo, leaders of tomorrow ooo. Either they lead in government or they lead in banditry and terrorism. The choice is not theirs, it's ours as a nation. I also want use this opportunity to apologise to GEJ, wey leave road for Otuoke go build schools for these children wey dem don abandon. He saw what we Nigerians did not see then. All insults are welcome. |
Bros, u get energy and data to waste on people wey fit temporarily deny their own mama because of a few grains of agbado Sangoamadioha1: |
No, the intention is not to sack or suspend Wike. The intent is to pluck out 1by1 all his feathers, remove all his teeth, then give am chewing stick. Let him resign by himself and join APC openly, na there APC problem go start between new takers and old takers inside APC. If Wike go court, which is likely as im get Justice supermarket wey im dey sell judgement from im wife, Lifu, Liman, Omotosho etc and they nullify the convention because no be even next year Supreme court go rule on this matter, if incase PDP no get candidate for 2027, na ADC go gain because na dem go inherit PDP structure. BTW, APC no want Wike for their camp. No 4get say Wike alliance na with Tinubu, not with APC. Orlandoo: |
The one wey choke me na social media jokes - Wike was chasing me in my dream, but when I yelled ‘Yerima!’ he disappeared!” Racoon: |
Not only that, help me inform this racist that Africa is the only continent in FIFA that has 54 members, I mean 54 votes on whom becomes President of FIFA and where the World Cup should hold. Just imagine if Africans are united in their votes at FIFA. If he wants to increase European slots at the world cup - he should be asking FIFA how come the United Kingdom in Europe has 4 members associations namely, Wales, England, Scotland and N.Ireland. franchasofficia: |
Comments abi curses? His primary concern should be the victims he is duping Imagine the He's a thief been equally stolen from |
No loud am abeg, person wey never start gas cylinder refill business, na im wan open filling station em sorry refinery. Ok ooo, see urchins up and down the thread licking propaganda ice cream. If Shettima mess now, dem go tell u say im mess dey smell like Paco Rabanne. doctimi: |
Nothing pay pass OS during inflation, I repeat nothing. |
There is also Justice Liman na dem 3 be cashiers for "Wike Judge Supermarket" but Admiral Gambo pass dem, any order wey dem go give for that land, these Justices go surely leave court come enforce that order with their own hands in the presence of Lt. Yerima. hatchy: |
No dey blow hot air for nairaland here, answers dey street live and direct. If you see any military man in uniform for road, just block im path, then begin ask am wetin Irabor or Buratai talk when soldiers went to attack UNIBEN students because of ATM conflict? Above all, no 4get to ask the soldier whether im thinksay the military uniform is a greater symbol of state than the police uniform. Dey like 72 virgins dey surely hungry you. aribisala0: |
So when Wike dey grab land give im friends and children, rule of law no lost? The Nigerian people no lost? Democracy no lost abi? I would have loved to call you a F L but you are indeed a very BIG F L.Yours sincerely. mascot87: |
Have you now seen the bulldozers? https://www.nairaland.com/8560855/fcda-withdraws-bulldozer-disputed-land SlavaUkraini: |
This guy fit don use dem +up or open spare parts shop. Citizens of the Royal Niger company cannot be trusted worldwide even lesser at home. @the bolded, B4 u judge me, knowsay person wey get mind post this kind thing no be ordinary person. |
I swear, you don see Nigerians finish ![]() Samantha125: |
Fyi, I am a military lawyer and I would be glad to defend Yerima anytime anyday twice on a Saturday in any military tribunal according to military law. I have already apologised to you abeg die me with your mentions. BondRiv: |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 27 28 29 30 31 32 33 34 35 (of 70 pages)
👇