Franvincoop's Posts
Nairaland Forum › Franvincoop's Profile › Franvincoop's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 57 58 59 60 61 62 63 64 65 (of 70 pages)
Monday wey no fit spell Tuesday aka Its confusing me, don dey interpret law for Supreme Court. Wetin concern me sef? Na Edo people I dey pity for. |
Kemi Badenoch, pls where are you? |
You dey argue with Jacqueline.questle aka Botragelad? Guy u get data to waste a swear. Note say Im never yet post Houthi missile wey reach Tel Aviv yet, or according to him na surely another friendly fire. God1000: |
Na so. You be low key and low budget armed robber and kidnapper. Na me talk am. rentAcock: |
Bro, breathe in. You wan argue say Nigerians are not cursed? I fit give you 10 million reasons per second why Nigerians are so fvcking cursed. Ever heard of a rice stampede in those demographics u are mentioning? Bros calm down abeg. grandstar: |
I no know why dem no remove im two front teeth sef, mtchew |
Abeg, u fit help me ask Omokri, if na rice stampede be happen for South Korea, Israel, the U.S. and multiple European countries? Una don create new one, rice stampede, very soon we go get bread stampede and agbado stampede, it's just a matter of time. Just go Google type " rice stampede" All the results na about Riceria abi na Nigeria. LivingSage: |
Im belle big like Police band, make dem less im belle asap, na cable theft dey fund that im belle. illicit: |
All I know be say, if dis motor reach Sokoto. Dem go kidnap both the car and the occupants. |
Only 36? Take dem enter Okija shrine, it's nearby. Make ezemmo perform some abracadabra, they will wake up as someone has suggested above that they might be sleeping. Ibadan 35, Okija 36, we dey wait IREV for Abuja final scores. I no get fxcking RIP to spare, this kind death no deserve RIP. Elections have consequences, make una continue di vote wrongly. Naija don enter level wey dem dey announce for radio say dem wan share bread, share rice and pple dey come like say na free Portable concert. Over mere rice. Grains of rice...... What hunger cannot do, does not exist. Jesus Christ abeg na now Naija badly need dat miracle of 5 loaves of bread and 12 fishes abi na 12 loaves of bread and 5 fishes. Or rather make manna fall cuz as e dey now Nigerians fit vote for Satan for a plate of imported rice. Just imagine say u reach the land of the dead and dem ask u wetin bring you? When u finish answer, dem go just add rice for your last name like Declan Rice. |
Only 53 EB5 visas were issued to Nigerians for 2023 year. Only 53? Get it. Meanwhile 7300 US visas were issued to Nigerians in the same year. Those 53 EB5 visa people na just nationality and residence for their children dem buy through the EB5 visa and most of them are politically exposed persons PEP. Mind you, their source of wealth and their oil well wey enable dem to apply and get the EB5 visa na naija e dey. Thank God you know they live in Nigeria and their kids are abroad. So na Japa be that? Is that your definition of japa? If Dangote go collect EB5 visa, abi u go talksay Dangote don japa? The only reason you will be denied visa to paradise is if you are not rich. Rich people no dey japa. EB5 visa na just security for their children. Who dem go leave their oil well or business for? To go work wetin for US again? Wetin US go fit give them in terms of wealth wey Naija no fit give them. It is easier to make a million dollars in Nigeria than to make it in the US, take it or leave it. RodgersAkpafu: |
The bolded is true. For your mind now, Omotola na rich person. Those yeyebrities like Mr. Patrick na rich pple abi? You can not become rich by earning salary. Those rich men you know were not rich, the person who was rich was the one paying them that salary. No rich man wey get factory wey dey manufacture anything for dis Naija go leave am, go wipe nyash or shove snow. It's easier for a Nigerian to make a million dollars in Nigeria than in the USA. Japa if you wish, na your choice. RodgersAkpafu: |
Na the 3k usd per month job for US na im easy sis? Its easier for a Nigerian to make a million dollars in Nigeria than in the USA. ndidibabe: |
3K USD can not take you to the USA. 3K USD can not start a business in the US, except say u wan dey grill hotdogs abi na sausage for roadside. But 5 million naira go rent u shop, stock am up, still employ person sef for Nigeria. If you use 3k USD plant only Plantain for dis naija, at harvest time u go get money wey go pass that person wey dey earn 3k usd per month x 12 months for yankee, make we no talk abt Yankee rents and bills and tax. Na Plantain I talk oh, no be cash crop I dey talk abt. If you try cash crop like cocoa with 3k usd, you are setup for life after 3 years. I mean for life, even your children go dey hail u when u don die cuz of cocoa farm aka goldmine wey u leave for them. Person wey get cocoa farm dey Japa go Yankee na for honeymoon or visit. No be to go hustle again. 1kg cocoa now for Nigeria na between 10k to 12k naira. I mean 1 kilogram of cocoa beans. ndidibabe: |
OP, abeg I no understand something. Who is 44 years old and who is 26 years old from the photos? Cuz abi na eye dey pain me or I no dey see well again? [quote author=LegendHero post=133379371]Source: https://x.com/rsa_cjs/status/1870100787977752765?s=46[/quote] |
Person wey na thief money dem take pay im mama bride price, im maternity fees, im school fees and na thief money make am Rep member today no even get to talk abt thief, cuz na thief im be. He who comes to equity should come with clean hands. Na 423 billion im papa thief for Kaduna. 423,000,000,000 Naira. I dey see pple dey hail am cuz e don beat drum small, rouse their emotion and dem don get erection. Gullible Nigerians. Make dem dey use una brain dey play golf over forks and spoons, meanwhile prayers have been sent to their mailboxes for the happy holidays. |
Abeg who fit Google the name of the person wey bring this tradition for kneel down for woman? That inventor really do men strong thing cuz I can't find the inventor in the Bible or Koran. Na who really invent this thing? Na Galileo or Vespucci or na Drake? |
Na una sabi. Wetin I dey think na how I fit get one of those dogs, make I take am cook better pepper soup use watch EPL 2morrow. |
Which japa una dey talk again wey concern exchange rate? Those ones wey dey use leggededbenz through Libya no be Japa be that? Somebody mention 25 million sef. If you get 5 million+ for this naija and you decide to japa, then you no get sense, not to talk of 25 million. Just use the money plant Plantain or cassava and thank me later. E don tey I never see that kind thread for nairaland like " I have 1 million, please suggest a business for me". Naija na wah, pple wey get idea no get money, pple wey get money wan japa. |
@God1000 I like you cuz ur threads are balanced 2day you show us Ukraine attacks and tomorrow you show us Russian attacks. Today you show us Israel and the tomorrow you show us Hamas/Hezbollah/Houthis. I mean we are getting the crude balanced picture of attack and defense. Terrorism by both sides. Kudos to you. Not too long ago, I thought you were biased and boy o boy u did prove me wrong. Don't be like Jacqueline.questle aka Botragelad who will only show us Israel bombing hospitals but will not inform us of when Israel is under attack. He will show us Ukraine/Nato ATCAMS , Storm shadow and drones bombing Russia but he will not notify us that Putin just promised a PlayStation 6 multi-missile game with Ukraine which has just started. I can see him viewing this thread right now. Jacqueline.questle aka Botragelad aka Am Israel chai should be given an honour by the Jewish state. That guy love Israel like die and I love and hate the guy at the same time. God1000: |
After all read here, I propose that @Okoroemeka refund that guy 50% make both parties accept loss and settle amicably make dem close down this thread. What do you think? @Okoroemeka, please stop selling seeds as it will ruin your reputation and stain your white agbada. I have read all your pepper and garden egg writeups from Genesis to Revelation and you sef times without number have talked abt difficulties in seed preservation, grading and final germination on both local, EU/USA and the Cameroon variety. @Xpol Truth be told, pepper seed germination dey like 1xbet. I am a pepper and ginger farmer too so I know what I am talking about. One time we bought 2 cans of 50 g Avenir F1 Technisem original from the company with expiry date 2 years+, 1 can sprout more than 85%, the other can no reach even 10%. We followed all the best practices, there were no ants, no reptiles, nothing but the 2nd can germination was very very disappointing. We no go Technisem make dem refund us, we cut our losses and moved on. So if you can accept my proposal that @Okoroemeka refunds you 50% of what you spent and let's move on like gentlemen and you delete this thread. What say you? @Okoroemeka, Pls stop selling seeds as some will come back to bite you in the ass. The road to hell is paved with good intentions and 99 good plus 1 bad is equal to 100 bad. Sell only seedlings or sign an agreement with any seed buyer that he will pay your money 100% before shipping and you will not be responsible if it germinates or not to avoid stories that touch the heart like this one. |
Na Odili start perpetual injunctions for dis Nigeria no be for 2020 e start. BuharisBoy: |
Within the last 24 hours, we've had Oluchi - Oluwole - Isong. SE - SW - SS I swear, Nigeria is well represented in saner climes, make I no loud am. |
Congrats to you Zackmann. Dear nairalanders, Note from the bolded below, say this Zackmann (no fault of his) was born into privilege and the source of of his golden spoon existence and the buying of bottle water @ 5$ is rooted in Nigeria. E don first talksay im be Yankee by birth. So when im dey tori u advice abt japa + gratitude make u wise up, cuz dis one no know Libya desert, im no know Cyprus nor Mexico route, im never ever pay house rent as im popsy/mumcy be don buy house since 19from for Yankee. im dey tell u make u japa but im dey reverse japa. Wonderfulkistan. It's easier to make a million dollars in Nigeria than in the USA. If u no believe am, na your mindset dey limit you no be me nor your village people nor PDP nor APC nor LP nor Church nor Mosque, ONLY YOU. People don fry akara build duplex. If you can't build it for yourself, build it for your children, even Zackmann popsy go mad say im pikin buy bottle water 5$, the life he is living even im papa no enjoy am 1/4. If you wan japa, no wahala but japa wisely and legally, whole u are there avoid fraud and drugs and be ready 2 work/skool like a donkey for a long time. Also know say japa no get format and everybody pommo no dey soft at the same time but above all avoid your fellow Nigerians. I dey see Kazakhstan and Uzbekistan update of late for nairaland, if u try am your name na die. Cheers Zackmann zackmann: |
Why are you calling for a coup? Did Tpain become President through a military takeover? I am not supporting the excesses of the government at a time its supposed to reduce its expenditure. But truth be told, were u not alive when Billions were allocated for national prayers? How much was the cost of Diezani transparent bra? Did you call for a coup then? Elections have consequences. NaijaSumi: |
Dear Caterpillar operator, Next time when dem send you to demolish house, ask if na army man get the house, e get why. Just imagine as dem point u dat gun, then accidental discharge. Wike no send u or your papa. Na OYO u dey. I don talk my own. |
You cant register yesterday and be begging today, i can't help u even with data. Use your original nairaland account if you need help. Make e no be say, u no wan use your original account cuz you were standing on Tpain manhood with "it will favour me and my family ohh. Just knowsay help go come no matter your political affiliation or tribe. Good luck. Staying393: |
Hopesay when Christians go put their own, we no go hear Deborah 2.0? Remember Charlie Hebdo? I expect a serious Christian counterattack, InterMilan Mourinho style. etrouble: |
Can someone tell me why the Okafor of Lagos is crying? |
Guy u dey make me laugh seriously. Dat breasts and kpekus belong to mortuary attendant now. I dey laugh cuz I remember like 10 years ago when my one of my guys wey na mortuary attendant for Lagos be tell me say im dey wait for Genevieve and Rita Dominic for im mortuary, say im must collect im share. AmalaAtiEwedu: |
Only 421 million$? If na for Nigeria, im go use that 21 million$ ontop settle EFCC lawyer make im rubbish the case, then Judge go throw out the case for lack of merit, technicalities or wrong procedures after e don chop im share by granting bail. Infact, dem never yet born the Senator wey fit even propose death penalty for corruption in Nigeria? Just to propose am ohh. Ladies and gentlemen, the Senator above mentioned was aborted somewhere in Taraba state in 2015. |
Lack of Force of your argument. I thought we were having a civil discussion on the ballon d'or but since you failed to convince me or yourself with the superiority of your argument, you started hitting below the belt and talking about anger, traps and alternate accounts. Why would I be having alternate accounts on nairaland for Bleep sake to write to you? Do you think you are that important? You have a very fake sense of self worth and self deception is the worst kind of deception. I thought you were human but u fall my hand. Don't include me in your nairaland battles with whoever. If you don't believe in my points abt the ballon d'or good and fine. I'll teach u another thing today, you can never win by the argument of force but rather by the force of your argument. naptu2: |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 57 58 59 60 61 62 63 64 65 (of 70 pages)

It's way too obvious that franvincoop's only purpose is to try and provoke me and he has failed.