Franvincoop's Posts
Nairaland Forum › Franvincoop's Profile › Franvincoop's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 53 54 55 56 57 58 59 60 61 (of 61 pages)
Hygiene kee u there lol. It's better to die from typhoid and dysentery than to die of hunger. ehikwe22: |
He is a former ballon d'or winner, no be issue of black man. All thing for una na either racism or tribalism. If to say anybody deserve that award for Real Madrid na Dani Carvajal and not even Vinicius. Since that Euros best player award to Rodri, I be don knowsay na either him or Carvajal. Fact check me, go and verify or go to court. BadBradley: |
Chiamaka Rodri Onwubiko Okoroawusa: |
Dat person wey u dey quote don tell you the truth but u no wan just believe am because you love Lookman. Lookman na average player, I repeat average player. If you doubt am, answer dis question as attacker wey him be, wey don play for epl, bundesliga and now serie A. im don ever 15 league goals a season? For say him be Nigerian no mean say u go forget truth. If according to you, Lookman na outstanding player, wetin we go call Haaland, Palmer, Foden, Salah, Kane, Lewandowski, Messi, Mbappe, Vini, etc people wey di deliver 20+ goals per season? yomi531: |
The person wey hand Rodri that trophy "George Weah" too na white man im be? Cuz him too get ballon d'or. Or for 1995, white competitors no b dey? Some of una here been dey still wear pampers for 1995 but na una dey scream racism everywhere likesay una don ever see racism. Ask elders for dis forum dem go tell u. Racism don cool down, so make u too cool down. ModestManager: |
Ronaldinho is black, go use dettol wash your eyes, u go see say no be white im be. ModestManager: |
You wey no dey smoke, u sure say u get brain or na your love for a footballer wey no achieve anything dey enter your eyes. Okocha no get levels at all. Ok, how many ballon d'or okocha get, I mean african own? How many trophies him don win for him career? Afcon him no get, na only Olympics him get ohh. Make I clear you, Etoo get consecutive champion leagues with two different clubs, im get 3 champions league medal in total, 3rd in ballon dor ranking in 2005 after Ronaldinho and Lampard, 4 time african player of the year, the only player in the world to have ever won two continental trebles, highest goal scorer in afcon history, Olympic gold medal, 3 la liga titles, the 2nd player ever in history to score in 2 champions league finals, 2 afcon titles. Tell me Okocha no even be competent for become etoo e water boy. Same with folks like Drogba, yaya toure, Salah, mane and even Lookman, osimhen, boniface... Okocha no suppose talk when Mikel Obi dey talk regarding football. Who the hell is Bolton Wanderers? Even for that their time, wetin dem achieve. Conclusion, Okocha no get levels. Nothing dey inside im trophy cabinet, nothing apart from Gold Olympics 1994 and silver afcon 2000. Post football wetin okocha don do if not advertise for nairabet? Even Club president for Eyimba, dem no fit dash Okocha? him no dey see say Weah don become Senator and now ex-President. Him no dey see say Etoo now na Cameroon Federation President and soon to be President of the country when Biya go disappear? Okocha no get levels, infact im no even sabi speak English for TV, dey talk like person wey get tongue tied. I repeat Okocha no get any levels. PS. I no be Yoruba or Fulani so no bring tribalism come my side. I talk am as I di see am. You can either fact check me, go and verify or go to court. All insults are welcome except the one wey go accuse me of being a muslim or Christian. I spit on all organised religions ehikwe22: |
Zoo police have arrested a special Biafran monkey[b][/b] NOETHNICITY: |
Wetin I dey take Muslims and Christians do? If I had my way, we just deport una to Rome abi na Jerusalem and the others to Mecca. There is no difference BTW a Muslim and a Christian, all una believe in Heaven/Hell wey no di exist, una believe in Satan wey no di exist, una believe in karma wey no di exist, Tower of babel meanwhile we don build ISS. Una believe in books written by someone who was on colos, una di kill one another for a foreign, racist, genocidal bloodsucking God wey no send una Papa message. I'd rather worship Bobrisky as a God than being a Christian or Muslim. I spit on all organised religions. Nwaikpe: |
Many things will change. He will now have direct access to his father's estate as nobody even his grandfather will not be able to contest anything with his guardian who is his mother. Also, he may get sponsorship/help now or in future from his father's friends, fans, well wishers and business associates. On the other hand, what if the DNA test proves Mohbad did not father the boy? We would have an usurper sitting on the throne, which will be great injustice especially to the late Mohbad himself. Mohbad's father as quick footed as he has shown, will sue for refund of every kobo that woman has ever received in the name of Mohbad. Only the DNA test result can prove her (suspected) infidelity beyond all doubt. If the test is positive for Mohbad, then the infidelity accusations are hearsay and baseless and Mohbad Papa and VDM must collect Diddy oil from Nigerians, but a negative test result giving the publicity of her prior refusal to take the test will cause her to disappear, leave social media and maybe contemplate suicide cuz millions of Nigerians are awaiting those results pass INEC 3a.m announcement. Good day to you Mindlog: |
Firstly, you are not righteousness or are you righteousness? Secondly, I am not a Muslim so insult Koran or Allah or Mohammed or Muslims anyhow u want, e no go affect me at all. Thirdly, your Bible is not better than the Koran cuz na Abraham be una Papa. But wait ohh, I remember now say according to your bible, you Christian folks are products of incest. Cuz after Adam and Eve, came Cain and Abel. Are you aware say Cain dey knack his sister steady and you are a direct result of the doggy wey Cain give Aclima ontop Abel e grave? Quote me again, I go use that your bible clean your nyash here, u feel say I be Muslim abi? Death to all organised religions. Nwaikpe: |
My friend, you are wrong here. They are not distinct, infact they are siamese twins. It's due to confirmed/suspected infidelity that paternity must be proven. Na the paternity test results be the undisputed proof of infidelity. Mindlog: |
@Righteousness, abeg where are you? U claim they are God's own country and God's own soldiers, oya tell us as im don commit suicide now, whether na heaven or na hell im go enter cuz I mesef dey confused. God's own soldier fighting for God, then commit suicide and dem no gree am enter heaven, na im b say no be God work him dey do abi? Pls help me better understand cuz if na Palestinian im be u for don start ask whether virgins go still remain for am or not Righthussle: |
Na dem dey run "rat race" as "church rats" wey dem be. Normally u no suppose bring minimum wage into this thread. Na 300 to 500k dem dey talk abt. Minimum wage wey no fit buy bag of rice?, where money to use buy oil, gas, tomato, spices to take cook the rice go come from? Bamss1: |
But u suppose know say dem play for Wednesday with goals galore so goals no go beaucoup today bluefilm: |
Police vehicle kill u there. Identify yourself!!!!! and state your mission. For dis gate wey I dey so, I no send your Papa or IGP message. From Oyo to Osun, ur As uniform man wey i be, i hate police pass Bobrisky, if na me I for just waste una tag una kidnappers. I for waste una like how army been waste three of una when una go kidnap Wadume in the name of arresting him. All d way!!!!!!! Ahuja!!!!!! IamANigerianMan: |
Police from Oyo travel go Osun to go arrest person, police no dey Osun? Or shebi I no read am well? So when they arrest the person dem go transport am from Osun to Oyo go lock am up for their station for Oyo abi? Fellow nigerians, no be kidnapping be that? One day one day Police from Borno go travel to Anambra come arrest person. Najeriya we hail thee, no lie ehh those our heroes past really labour in vain |
Wetin I dey reason na wetin I fit tell this man make him sell me the mama of the dogs as e don born 12, make we run the mama pepper soup with Plantain take hold body for ARSLIV on Sunday. Ohhh what a day!!!!! |
Leicester City Chairman Iran President and FM Atleast 3 in the last 6 months in the USA Anything copter or anything wey get rotors, forget am na die you dey even if na brand new na still die you dey. Na why most of the people wey get private jets no get copter cuz deep down they know say na flying coffin santaclaws: |
Bros, dont pretend like u dont know her or have u 4gotten? na the same lady give Eve apple naw.... BABANGBALI: |
Mr. Man, all those American whatever you mentioned are made in China and shipped to the USA. I repeat all of them cars, iphones, whatever. Between China and USA na who di import from each other pass, go and verify as they say... OChimex: |
Na you go surely manufacture am? Where u go see AK47 for 250K buy? Even for 3 million for dis economy u no fit get am. Check am bros, if AK47 na 250K ehh you no for di see any bandits or herdsmen carrying dane guns like those ones Ribadu burnt. AK47 no di rust nor rotten, u fit bury am come back after 20 years dig am back then oil am, e go fire like brand new. Kalashnikov na forever gun finallybusy: |
50k kwa ![]() See 1 single AK 47 bullet na 27k, I mean just one bullet, na black market price I di give u so. When I mean black market, I mean the price wey uniform pple di sell to bandits/thieves. No ask me how I know, just knowsay I know pple wey don sell their own. If u hear shooting, just di count 27k by the number of gunshots. Na scam dey scam dis guy sef or he come buy cheap to go sell. 1 AK 47 na around 4 million naira black market price in Nigeria but the pple wey dem buy am pass na those Cameroon rebels wey dey fight their government. Dem dey buy 1 AK47 around 8 million naira and 1 bullet around 40k based on current cfa exchange rate. If dem put you in charge of armoury for any force for dis country, just know say u done rich be that. Everybody dey sell, soldiers, policemen, immigration, customs, ndlea, efcc, safety corps, I mean everybody. Fuckallmods: |
Just the devaluation alone na how many percent? Oya calculator, calculate tell us. Kobicove: |
U can be seeing 6 and I am seeing 9. Another man's terrorist is another man's freedom fighter. The greatest gift the enemy and occupation can give me is to assassinate me,”. “I prefer to die a martyr than die a meaningless death.” Yahya Sinwar [quote author=Righteousness2 post=132547662][/quote] |
Put those leaves inside 1L bottle and fill up with cheap whisky, crush bitter kola put inside, then add small 4-20 then close and keep in a dark place for 21 days. After 21 days or more open and take 1/4 glass every 10-30 minutes before u wan knack, u go thank me later. The name for this mixture na combine + dogoyaro. But if malaria try dey your body, your name na sweat but if you no get malaria, your name na knacking. |
Israel cannot claim the right of self-defense against a threat that emanates from a territory it occupies, from a territory that is under belligerent occupation. The fierce Hamas 7/10 attack was no more brutal than 75 years of denial of the right of return to Palestinian refugees, or 57 years of Israeli occupation, or the 17-year siege of the Gaza Strip. |
Na dis guy be that aboki wey dem mention for this story, if not how e a whole corps member go take wan derail this thread with "corpse" eventhough we knowsay na NYSC service im wan talk about. I don talk am say illiteracy is better, far better than half education. Regarding the topic, make we first find out if the girl na Christian or Muslim cuz dis wan wey aboki dey inside and the girl say dem pack her and her belongings give aboki, who here knows whether aboki don pay bride price? I don attend wedding/betrothal wey dem hand 8 years old girl to 67 years old man and everybody dey clap dey jolly dey happy. Thunder go fire anybody wey go ask me if I be dey happy for the wedding or not, dats Nigeria for you, take it or japa. No ask me go ask Lugard. SaoPaullo: |
I can design a biogas plant for your project, which will use all the wastewater from the cassava/garri process and the dung of the goats to generate gas on site which you can use for cooking and running a generator for electricity plus the same plant will provide you with quality fertiliser for your farming all year round. This will cost less than a million naira. adonainana: |
Yes, but CNG is a whole lot less risky than that gas cylinder in your kitchen right now and less flammable than it. I have been using it since 2017, no be today we dey use am. See CNG is lighter than air, if it leaks it will just evaporate above as air will disperse it immediately and the whole gas leak will disappear in an instant and secondly sparks cannot cause it to ignite it will need a full flame near it to ignite. LNG is the same gas which had been Liquified well below zero degree that is why your gas cylinder is always dead cold, if it leaks, it is heavier than air and will displace air to rise above it while it will pool on the ground roaming around for its(the gas)temperature to increase and make it lighter than air before it disperses, only God knows how long that will take if you are a chosen or not but you will be having a dangerous situation on your hand cuz if someone as much as flips on a switch, y'all burn in hell. Capiche? No offence meant and not wishing any bad thing to your family. professore: |
I will be making a thread here on nairaland about biogas and biogas plants very soon. I will let you know when I do. Emco1: |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 53 54 55 56 57 58 59 60 61 (of 61 pages)


