Freebloke's Posts
Nairaland Forum › Freebloke's Profile › Freebloke's Posts
luluosas: For your information, GLO Bumpa prepaid plan is the most useless plan on earth right now. Can you imagine they are charging N30/min (50k/sec) on this useless plan.mmmmm...another invented sweet mouth scam by GLO. Glo is loosing it! I pity people Wey dey fall for glo wayo. |
franksam2009: u glo guys should allow us to use our bis plan on android na, dats all we wnt, if u cant do dat jst sharap nd get d Bleep outta here ![]() |
luluosas: They wiped my own. They must return it by the grace of God.bros, I just no understand dis glo network @all @all... seriously,if no bi sey de line na my official line I for don use acid woundjure de useless sim tey tey. na so so scam tins glo dey inside. |
Glo na one useless network wey no get any solution for any of dia numerous scams..... My free MBs Wey dem dey give me just dey pile up but dem no gree me use am...wipe am off dem no gree.... I just dey see de useless tin dey pile up without being able to make use of it. ![]() |
luluosas: My brother how you feel. But for now, it is only people working with Glo that can assist you, but should I figure out something, I will let you know please. Thank you.Bros, thanks jaré... |
luluosas: I am asking because mine has been working with gloflat APN until I exhausted my free MB three days ago. Please, kindly get across to customer care. Thank you.bros,even dia customer care agents na dem fffucck up pass...either dem no know any ssshitt about how to resolve the issue or dem just deliberately quench the tin for my line. l don call dem soté na halla I come dey halla with one lady like d@. na different tin dem go dey tell me. the one Wey dey vex me pass bi sey wen I send ""PAYU"" to "127" dem go reply me say "dear customer the plan you are trying to purchase is not compatible with your current data plan"..... I don call dem make dem help me check wether anything dey wrong with my line and dem say nothing do my line also no any data subscription dey on the line...... so, my question na which data subscription no dey compatible with which one and na who subscribe am?? BLOODY SCAMMERS! |
luluosas: What APN are you using please? Thank you.bros,dis one no be APN mata @ all... the tin bin dey browse with gloflat when them first introduce the tin after some time dem come quench am for my line.... I don use glowap,glosecure,gloflat and any other apn Wey the useless network get and all na zero... I don change 3 different fones (HTC,lumia and LG) for the sim and all na still zero... Glo na first class SCAMMER! |
aieromon: I'm experiencing the same thing here.bros,as in ehn....last 2 weeks na 1gig+ just waste laik d@...presently I don gather reach 500mb+ but I nor fit use am. how I go take dey see free mb Wey I nor fit use...Glo na first grade scammer...make dem kukuma scrap de useless tin. |
I Fit Not shouted for Glo ooo! if i switch to Gbam i go browse wella with de free 5mb without issues but if switch back to bounce i Fit not fit browseing again with dia useless Free data. if I send Payu to 127 dem go dey tell mi sey de data Plan i'm tryn to purchase is not compatible with my current data plan....na which data plan bi dat one Wey I no subscribe for? i Don Call dia cc taya and e bi laik sey all de cc agents na dddunce cos dem go dey tell mi sey na my fone model or one tin one tin . I don put the de sim for 3 different fone na same tory. this thing bi dey work before dem stop am. abi na because I dey recharge wella and dey get enuff free data....? Glo na real ssh!tt network. na only glo get 3 abi na 4 different apn.... |
I dey always wonda y all dis our tif tif politifcians no dey delete so early laik dis nah,naija for don dey beta small small instead na pipo Wey sey hustle hard for dia pay sey delete.... RIP BRO... |
ashmanpolo: Hmm my twin blooderI see you... ![]() |
luluosas: Well, it is the say gloflat APN I am using. By the way, try this method, it may solve your problem.Oga Lulu,thanks for your concerns. I have being busy dats why I'm replying late. b4 now I don try all dis methods,put the sim for my other fone na same thing I dey see.... I'm not bothered about dia useless data bonus cos I have other options. they should be able to give dia customers what dey advertised. |
overdrive: E be like say na d same keke we enter,I have 270mb and have tried d whole settings whosai infact I don tire if not for having d cheapest caall rate I wouldn't have been recharging that glo. @luluosas thank u I later dial #122# and saw where my mb dey hide abeg help us tell them to allow us use d mb.I use samsung galaxy s. Thank ubros, I fit not shouted o... na because dat glo line na my "public" and official line na him make me still dey recharge am if not, I for don troway am since. glo no fit maintain any beta plan dem introduce,na only to use such plan to woo customers after dat,you are on your own... |
luluosas: Which APN are you using please?gloflat... the wahala bi sey if I send "payu" to 127 dem go tell mi sey dey plan I'm trying to purchase is not compatible with my current data plan... I no get any data plan on dat sim,I don even call customer care make dem help me check if any data plan dey dat line and dem confirm sey nothing like dat for de line... I change to glosecure no show,glo wap no show... well,I just forget dem cos I dey use my etisalat data bundle dey browse. |
luluosas: But I am still browsing on my Bounce free data bonus.Oga Lulu, me no understand dis kain tin o ![]() |
E bi like sey dem swear for GLOBACOM make dem no dey dey consistent with dia plans... ![]() |
luluosas: But, na the same Bounce free data bonus me I dey use na.your own beta o. |
luluosas: But, you know say Glo better pass other network providers in terms of data allocation.all na same same.... glo go give you with one hand and collect am back with the other hand...I get close to 2gig for my fone under bounce but to use am browse na shege! I don send "payu" taya,change apn taya,call customer care taya,twit taya...all na wash. |
luluosas: Glo dey fall hand, how?if dem complete am 1gig na crime? abi de company go fold up? |
petaling: Is a good development but it should have been 2k for 1GB. MTN night plan is still unbeatable 2.5k for 3GB night and 1.5GB bonus for 24/7true talk! 2k for 1gig or 1.5gig for beta pass. GLOBACOM too dey fall hand! ![]() |
6th ![]() |
simple tin! na "Naturalised State" .... |
na wen dem go release pvssykat... ![]() ![]() |
present sire! naija home base na him mi bi... ![]() |
No.Talk.Again o.... no blame dem jaré,na "Ram-ses" in human form dey "working" dia o. so dem "has" to show dia brodas in "holympic" "cum-pit-ition" |
trae_z: 1) Kpele, take am easy e go betterGbam!!! |
luluosas: Honestly, I don't know what is actually wrong with the Glo Bounce free data bonus. The MB dey consume and dry quick quick like petrol in fire.no mind dis yeyeshious glo pipo...dem just wan use dia fake 30mb woo pipo to dia network. dem know sey Airtel 2good premiere package beat dia bounce tariff hands down so dem come up with dis fake 30mb.... thanks to Airtel, I no send dem. |
mai yown no flenti... Ialomo Igarri Igrandnaught Isuga... and all is well. |
well....i always take "aka-sarah" "missed" with "cellidione" after chopping kola naughtz... de tin dey helep kip mai toothz klin.. Amen. |
goshen26: i want to port!porting to GH....... to read anything about 9ja Nowadays dey vex me because na so so bad bad news you go dey read about and freshly polluted air person go dey inhale. ![]() |






