Freebloke's Posts
Nairaland Forum › Freebloke's Profile › Freebloke's Posts
pinkguy: Just member 3million some faction leader 7m with house i hope u no be boko haram memberbros,thank u o...wen fg begin to sell form i go sharply buy mai yown so d@ i go fit follow dem enroll.mi no bi boko boi 'officially' but biznes tins nah,man go hustle nah. 3milla/monthly,bros no bi sshange bi d@ o. |
Enangson: I have been shaking my head for like 2hours now.2hours ke? Onto wot,bros?! D head nor dey pain u? Anyways,sofri sofri make de head nor fall comot from ur neck. |
pinkguy: I heard that boko haram member will get 3m naria may be for killing christianbros,abegi dis 3milla na for individual/monthly abi na all sshoin?! E go make beta sense if na individual go get 3milla monthly.bros,ssheck am nah,if peson com get d@ kain pay for 1 year....o'l boi, serious hama be d@ o. |
abegi o,mey unu nor vex o,shey unu know weda dem don work out how mussh dem go dey pay dis boko boiz for 'arm-nesting' ?! If de pay make sense mi fit claim boko boi since i miss out for de time of mend. |
KINGwax: Is SA using a motocycle?yes o! And 9ja wan use bicycle overtake am. |
mazado: Haba OP, you appear very aggressive and personally involved with this SURE-P thing. You seem to resent anyone daring to express a view contrary to your post. You insult and demean almost anyone who disagrees with you. It should not be like that. You brought this issue to public space and called for views, yet you do not show civility or respect to others. It's as if you want to force everyone to accept your argument. Again, people do not have to travel all over Nigeria to experience the SURE-P, if it is working as you mentioned, and since it is state to state, then Nigerians will definitely feel the impact wherever they are. The projects will find them in their states whether they like it or not.haaa!!! U dey look for trouble o! I no dey dia o! Anyways,wait make "dem" come read ur post first make u den see fire for fire... U no know sey u be buhari and tinubu thug...u opposition guy...hehe. |
luluosas: You wan use laff kill person ne?oga lulu,life is good...na de one i sabi na him i dey do o.mi jos dey cassh fun for nairaland.sometimes wen i read de way wey some pipo go take dey comment with vexynashun and angreement,for ur pc or fone u go fit see smoke dey comot for dia ears and nose...u go com wonda!when i read dat kain comment i go jos mix my alomo and ogidiga 2geda,sip am den smile. Some mothers do av dem... ![]() |
Edoboy1: u go gud wel wel for pdgin english news......submit ur cv for any NTA nearest to you.bros eh, nobi my fot nah.na de skool wey i go do mi lai dis...(IKPOKIRI GRAMMER SKOOL,IKPO). Anyways sha,i go try send my cv to ur letter box for nipost office so dat u go fit helep a broda in nid...abi u get hemail address make i put am dia? ![]() |
rman: No operator will allow you call another network with bonus airtime.bros,for 'eti-salad' network u go use the promo airtime kol any other network,abi na juju dem dey use do am?! Nobi same 9ja dem deyy?? |
mtcheew...dis one na promo?? make dem go siddon jare,glo no dey fail 2 fall my hand @ all.even sef why person no go fit use the promo airtime kol anoda network,yeye pipo.oga lulu don talk am finish. |
wait o! All dis die die wey dey hapin so,na piples dey die so abi na shickens?...even shickens no dey die lai dis nah.if dem come sluta pipos finish na wetin dem go come dey sluta....mayb shickens! |
Weda na buhari dey sponsor,feed,house and marry boko bois wey dey kill peepo and destroy tins,mi dey aks weda d presidency no fit crush dis boko bois and arrest buhari? Evryday na buhari+boko bois...wetin be d work of d presidency sef in tams of proteshun of lifes and propatys of d cityzens....make una dey dia spik big big grama. *make i mix mysef sum ogidiga and koboko * |
Three months ke b4 i fit port ![]() Wetin come be all the galala dance about porting if i go wait 3 months b4 i fit switch network. So if my current network come dey 4uck up for my area and other network stand fit and i need to make emergency calls na him be sey i go wait for three months b4 i fit make my emergency call. Abegiii! Make dem hol dere pot abi na kettle. Mi get all d networks 4 my pocket. |
Its the lords doing.... go yea and multiply |
@ ooman,i no know how old u be and i no go talk sey ya posts no make sense.nobodi sabi am pass but d way u just dey kpara,dey trowey insults for anybody wey no agree wit u,guy e no funny o.u sure sey u well so.guy make u grow up.na learn we dey learn from each oda but if u go about insulting people simple because dem no gree with u,guy how u wan people 2 gree with u wen u don put insult full ground. Weda u be atheist abi na nontheist dat one na ya yown wahala but.....but me think sey u confuse small. Oya! Begin 2 insult me. |
where dem dey ?ehm ehm...i mean dem wey talk sey oga presido don improve power supply.abi dem sef dey fil de heat. Anyways,mi dey get constant power supply,na (MPG) MY PERSONAL GENERATOR dey supply de power. Cos nepa,phcn nor dey exist 4 my area.dere poles and cables wey dey,people go soon dey use dem dey dry cloth. |
mmmmm....i fit not talketh! I just dey wonda y dis baba godey no com do all de talking himself or show himself live and direct... make mankind rest... Anyway,make i go shyt. |
Religious folks...mmmm. christains....mmmm. una go always dey fight amongst unuself...na mi sabi am pass,na mi sabi de bible pass,na mai church beta pass,na 4 my church u go see baba godey live and direct,na 4 my church we go make u put ur hand hinside phcn live transforma and notin go do u,na 4 mai church u go drink ogogoro and get belle...mmm...una no dey dey in agreement. Haba! If all of una come go heaven,na desame arguement na go dey do 4 heaven b dat. Na him be sey baba godey go just vex leave heaven 4 una come live 4 mushin,lagos. |
mtcheew!Ncc no dey remember sey data subscribtion still dey high 4 9ja??!! Na d@ 1 be my yown vex now. |
gunuvi: There are some news you cannot read without an alomo bitters beside you to cool down ur temper.confirm guy!!! ![]() |
ochukoccna: I voted for Jonathan not for PDPhehehe... I wan chop omellete...but no give me egg chop. ![]() |
na god tell aga presido 2 pardon alams... na god boko bois dey kill for... hmmm... We need 2 set up another commit-tea of.....abi na panel of enquiry...to look into and probe these gods,and also invite them to a public debate make dem tell us why dem dey send dia men to give us all dis wahala. Pheew! The heenglish tire me o. |
Una say oga 4 top no dey do anything about dis boko bois... But una forget sey even to dey open mouth everytime dey condemn na work be d@. @least oga 4 top dey work with condemn. ![]() |
mtcheew... Make dem go siddon joor! One 'akara' bomb dem no fit throw. Boko bois dey talk and harm....massob own na to talk and sob. |
well sha, anything wey good for kanda meat suppose dey good for pómó meat. |
jidelekan: Go and steal no moreWRONG!!! Go and steal some more. |
Abeg make dem make d one wey go dey give me correct "baba ijebu" number to hammer big time. ![]() |
Darey_00: Going through comments on this thread,i can see Nigeria's real problem: Ethnicity1 million likes! |
I fitnt stay inside d waiting room..... E dey boreing 4 there. |
Koleman: na im be say i go taste am notin do u. |
Koleman: abeg bros give me the nitty gritty of package make me sef jolino big wahala 4 there.... Me just enter d Gbam tin and dem dey chop my 5naira daily but dey sama me with mb's every day. Use d gloflat apn to braze o,if u use anoda apn ha him b sey ur airtime go just dey waka go messege wey u no send am. |
eliment: 4 those xperiencing challenges, sorry 4 dat maybe they are xperiencin network problem cos 4 me its been sweet sailing ever since, infact i was given more than 1000000mb to xpire in 99 yrs time. You can migrate to another plan and come back to it later i think that should solve the problem.bros,me sef get mb pass u o.i don download tire.but my fear be sey glo fit wake up one day and delete dis kain awuf.me no dey trust dem wella. |


mtcheew!