Jehoha696's Posts
Nairaland Forum › Jehoha696's Profile › Jehoha696's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 21 pages)
Deepspirituals:Dude those are used to treat anti biotic not for fungal |
Hahahahahahahahashashahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahah.....shey naw around 9pm for express road u wan tell.police "I know my right.." "You aren't allowed to search my phone" When one OC first give u slap or use gun hit you for waist.... When police put u for counter without connection beta drop something for counter,or else naw from court room to awaiting trial... JUST PRAY MAKE NAIJA DEMON IN BLACK ATTIRE CALLED POLICE REASON YOU THIS YEAR |
One thing I still.can't figure out is a country,a super country like America will just wake up and decide to airstrike another sovereign nation,then exit with deir kidnapped president, and what other countries can do or will do,is nothing more than bark shout, rant and condemned on line,none will ever dare or ask their military to go rescue the kidnapped president, Is america same as our leaders kinda above the law ?? |
All this ones just dey rant..empty vessels making loud noise,make dem put body,when trump was talking about invading Venezuela, y dem no dare Trump, the president has been captured and none of dem can invade america to free the man,even China nor Russian can't .....Make Trump just dey careful so he doesn't gather more foes than allies for the america pple |
David even kill persn legitimate husband cus of pussy, baba wey enjoy peeping someone's wife when she dey baff....IF THOU SHALL NOT FORNICATE DEY TEN COMMANDMENTS THEN I FOLLOW,IF THOU SHALL NOT ENGAGE IN EXTRAMARITAL AFFAIR DEY THERE ALSO THEN AM IN,BUT IF NOT....ABEG "ALLOW ME TO ENJOY MYSELF" |
Some few years back we all toth diz isn't possible, as in a situation where the president of a sovereign nation will send his soldiers to anoda sovereign nation to kidnap its president, as in its number1 citizen ...,But I wan know the full gist shey the presidential guard no fite america forces,them no try defend and protect their commander in chief? Does the end really justifies it,Trump don dey feel lyk superman make baba calm down ooo,Cuz if Tinubu reason am,e no go take our soldiers pass 1min to over run entire US fleet |
Shey all diz numbers indigenes go carry all for brain or save am for contacts...we sabi play play for diz kwatry,anyway one day we shall get their |
Watin our military dey find, validation from civilians or public clap from citizens?.... Round this people up that's your job ,no cum dey run showcase for media unto what naw,shey naw make we know say una dey work or what,imagine full family dey into suicide bombing...,Wahala be lyk watin again |
Is that solution to problems ravaging them,will that put food on their tables, will it help the indigenes pay their Tax...,And what if the SW ask their pple to not buy things from oda tribes nkor,in all dz things naw the ibos go kinda suffer pass,naw them get things plenty for oda States... So lets kill this tribalism spirit and work togeda to promote our cultures, but not via this method |
So Ghana self dey run jungle Justice, but shey d thief think him don escape lyk that,cus how long does he plan to stay up there? |
"WHEN YOU ARE BIG,YOU ARE BIG".... US & intimidation, once u accept aid from america juz always always dance to their beats eida u lyk it or not,Shey no b bulling be diz, anoda president capturing the president of a sovereign state,hmmm... America jus dey wade their power baton anyhow,anyway if its for the good of us all,no lele but make Trump easy sha,not to gather more enemies than allies cus america soldiers don ova die,so make him calm down |
Watin dey work for naija pass corruption ? Nothing reasonable works wella over here,apart from crime such as bandits, kidnapping,terrorist, illegal killing,police intimidation, bribery & corruption... Anyway no b today shit dey happen for live TV,we still remember the saga of "MY OGA @ THE TOP" GOD BLESS NAIJA |
Imagine make that money enta my account when I dey own opay 2.5m with interest of 6months...oti lor ..I go just return the remaining balance to the bank,cus since naw bank dem go charge you with fraud,HQ go declare you wanted,right now 330m naw money,unless u invest Into real estate then japa go Ghana after you gather the money finish,maybe after like 5+years u pay the money back to the bank....... |
Value added Tax inside country wey no get value for human lives?... Tinubu just wan recuperate money wen him use sponsor elections and also gather funds for APC to take lure oda top Nigeria citizen to their fold,and also use am buy the remaining pple wey dem Neva buy..,If only the tax will have value |
Some of una dey cap vertical.....the koko b sai if e reach una turn do as it pleases you,Naija is a kwatry where anything goes,u can do as it pleases it,become the gov'nor make erect first land office complex for ur wife in very LG,arrange first son/dauta office for ur kids then get granny complex and parents office,... THIS IS NAIJA ANYTHING IS POSSIBLE |
And naw person serious "whateva" be the lady,she dey stay for hut but get Facebook account,but I love her wife material swag,she get the yards plenty,I love her type,no b all diz almajiri naija babes wey dey fear c'mon cockroach,dem dey fear dog,but love doggy |
This is a cooked up lamba,but lemme believed it happened to you...,what's stopping you from discussing things with her,and how you knew her friends influenced her billing you,so cus you gave her money and she didn't say thank you,naw crime for your side? Dude,fake alpha goat that's a pure definition of who u are,cus several times have given my babe things,Shima juz smile collect am without thank you,you wanna know y,cuz we have been so much in2 each oda so too much thank you no dey fancy any of us,person wey don spend night for my house, first me wake up,after her quiet time,kissed me,did her morning exercise,bath prepared tea and left my apartment, @tymz we juz walked pass each oda,smile & wink to each oda...,So cuz she collected money from you pocket naw taboo,did u tell her first hand,before I get entangled to any lady,I go first tell u my rules my DO'S & DON'T'S ........ Anyway whichever way naw u use pity mind dey date her, so somehow she don sight u as mugu/maga,but check her activities towards u,if she really love u,or juz a gold digger opportunist,I once dated a gal wen she no get shigba,and wen everywhere stew for her,d babe juz wan spoil me with things, we couldn't marry cux of religion,but till now we still best of besties |
Take away money as in bribery and vote buying,then thuggery (political touts) who threaten people to vote against their wish from Nigeria politics,90-95% of people in seat of power wouldn't be there. Presently we don't have any opposition party Tinubu just dey use Federal power dey tackle dem underground using the formulae "IF YOU CAN'T BEAT US,BETA JOIN US"... when me fear APC government was during Oshiomole & festus Keyamo transition, they both joined dem & became something else,It wouldn't surprise me if Evans or any of doz Bandits join @apcnigeria tomorrow and become state gov'nor,join APC and ur sins will be forgiven/blunt out. Tinubu will win second term,he has the man power and money power. |
Interactions inside classroom nkor,is this really our problem nor solution to all the insecurity going on in diz kwatry,we aren't ready to move forward,so with all the bandits attacks, kidnappings and herdsmen/farmers clash naw watin dey yobe government head be diz OH LURD AREN'T WE FINISH? |
Every state get where neat and where dirty pass detty,even developed countries get ghettos, even Lagos wey dirty like this still get some areas wey neat pass some of una gf panties nd puci,the population of Lagos e such me reach some countries for this planet,but Lagos dirtiness don dey worst pass anything, this days sha,the pple in charge should do something... Big up IMO state and the imolites |
#70k-1000k just to kill pple you don't know,unarmed pple who has never wronged you,you never knew if any of your kinsman is there....Let him be tortured to drop names of leaders ,his colleagues and pple paying him |
I understand his pain, just like when u part ways with a nagging gf...political party wey Obi epp bring to limelite...anyway naw here we dey 2027 naw just next two months |
Which intelligence gathering from DSS...video wen trend for social media,wey the guy dey rant say many go go church but few go come back, like this it seems the gate of hell wining this fite |
For the APC regime naw only deny & debuke dey trend join with kidnapping, bandits and terrorist...., but shey oba of Benin dey lie self..,cus if dey weren't acting based on his instruction, when he was brought to the palace what role did he play |
She no talk where she misplaced the fone,una don sharply epp her conclude say naw naija diz OP u sure the hot weather Neva melt ur brain |
Dey are both battling something, eida diabetes or cancer and not cus dey ate any money, Check Obasanjo,Check IBB and some past and ex heads of states and president..... Abi naw the money even sustain dem till now,anything wey keep dem alive like diz till now,go don swallow poor man |
I juz dey laff,but laff no allow my laff to laff the laff finish video of the place before the bomb,during the bomb and few secs/mins after the RAIN OF FIRE... |
One thing am kinda made to believe after viewing the whole news on USA bombing sokoto be say,how sure are you say d bomb kill anybody,I beleve shey some infantry suppose Mount nearby so after the bombing dem ransack the entire forest to finish the wounded terrorist and those trying to escape..,and shey any video dey to prove say the RAIN OF FIRE really touched dem, abi naw ordinary empty forest Trump soldiers go bomb |
Expanse2020:The koko be say doz guys are gaining from the war,via selling of weapons to both parties (the governments & terrorists) no be everything dem dey discus ontop table,some naw via signs and symbols,while some re labeled as classified. |