Jehoha696's Posts
Nairaland Forum › Jehoha696's Profile › Jehoha696's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 21 pages)
highyo:Read bro its 'Niger" not "Nigeria" |
I blame the government for allowing diz pple to still trend person wey DSS for don give free rent for their housing project |
How this news take concern us...who cares how many kids he planned to have,if the law permits he's free to have 100000))00)))))))00000000000 kids, what positive effects does it have on we Nigerians |
Myth! Myth!! Myth!!! How many dey diz 3rd planet called earth,how many the poster don see self,but the way dem say raw materials dey some northern states,e such me say one fit dey that state,and who knows it might be what Trump is targeting |
I will talk you about the first two go check THE BOOK OF SHADOWS you will see those inscribed there and also THE LESSER KEY OF SOLOMON ...download the full.content online or if u have any full fledged graduate of theology you can ask dem,majority of have come across it |
Who dey use Google map for Nigeria, just ask okoda man esp doz kinda intellectual ones,dem even know the direct route to ryde from Lagos to Isreal without passing any red sea |
You said 8k....Anyway u sure no be birdflu in fowl.clothing dem sell give u,cus the least price me bought was #20k the smallest was #15,wanted to buy turkey cus my dauta was around but wen I hear #80 me shock thank God for my factory fitted absorber so since naw juz I and my dauta & few Allies I just maintain my pocket buy #20k (broiler) carry go...Anoda Xmas still dey come,cus e no dey finish |
Even with diz full evidence the gov'nor will still deny it and get second term in office...Police or no police for those thugs to show up in front of government house, means that someone close to Kwara seat of power gave dem order and tip dem off |
ONE GONE, SEVERAL OTHERS TO GO....,I HOPE NAW DIRECT TO KILLED BY HANGING OR FIRING SQUAD, NO NEED FOR ANY FURTHER POLICE INVESTIGATION |
I just wan ask shey the guy fit sue the oba,if he's innocent cuz me don't really know his crime before such humiliation was meted on him,but the Oba over do,anyway e dey happen anyway,shebi naw for lasgidi an Oba slapped an police man on uniform infront of police station & nothing happen |
HE's using style to beg Tinubu....Person wey no dey any party, Agbero politician wey Tinubu take dash Abuja pple |
Who be diz OP...Have you seen our elites go check our SBS full kit....every force have random pple that "maybe" "decide" to dress like that or anyhow,even in d USA check the sheriff and police department then compare to SWAT which is also under the police...Pple.dress and pose for camera u dey rate dem .... |
Me wey cum dey work for one of the best MOTEL as in OS HQ base for lekki,....watin I go cum do,cuz most times u wake up naw one fresh smallie with pant and bra go hang u first anoda with tube or singlet and mini skirt or bumshot go tasi u....Dey believe say since u are the DJ dey gat near u small so anytime dey need their best song to twerk and attract customers or to dance nd make deir client happy and spray dem more cash,u go deliver u say make I no fall.............Anyway story for another day |
I understand their plight but what have dey done to curtail the massive killings going on the north & middle belt,what have dey contributed to help Nigeria in eliminatin diz terrorists,if nothing then I will advice dey jejely SHUT UP,cus if I enta dem naw xenophobia attacks dem go initiate next |
Hmmmm....watin we go talk now,shey naw she kill herself,or naw religion kill her..,whicheva anythin made by man is still man made in the sight of God...They most have told her blood transfusion is a sin and she doesn't wanna sin against her God,so her faith killed her. Same way dey indoctrinate radical muslims into sucide bombing (Jihad) with hope of sleeping with 7 virgins after death |
floss:So Catholic and JW naw Nigeria church..., Some Pentecostal churches like MFM,deeperlife,redeemed....etc have deir HQ in naija cus it was founded here as in naw for naija dem Start am |
nairalanda1:I know but was currently referring to the present sheik Gumi |
ibedun:So my question to you is :- DID AMERICA CARRY OUT THE BOMBING OR NOT ?? |
EYE SERVICE |
Before naw the receiver go pay,but now naw the sender pay,no lele,but aje some banks go soon bill both d sender and the receiver. This Tinub APC led government don turn to tax master,we go pay tax tire,even heard about cars recycling payment, every soon if u wake up u go pay money give government,..... The problem might not be the payment,but what's the money been used for,money wey agbero(NURTW,RTEAN,TODAL.....) Dey collect steady for road,and still yet the roads looks more like HIGH WAY TO DEATH.... "E GO BETA" |
Until the government and its agent get this man arrested and questioned, then our fite against Islamic terrorist and bandits never start,pple like Shettima and minister of communication and oda northern elites no suppose dey that corridor of power..The government just isn't ready to tackle insecurity cus majority of dem are earning huge cash from it ongoing insecurity directly or indirectly from our ward chairmen,down to local government chairmen,their state governors and oda states elites... |
The us can bomb terrorists camp without coordination from Nigeria, the have the tech,and man power, but I toth Nigeria government said bombs can't penetrate the forest,or shey no b wyning to deceive the terrorists and let dem let deir guard down,I already knew that with all d visitation of several organizations in america,something is up..,Tumbs to those who carried out the attack, if naw naija we for hear say naw displaced pple camp dem bomb,america should continue biko and me mindful of Nigeria government dey let in2 the situation room,maka casting and moles ....Bomb all of dem (Isis,bokoharam,terrorists, bandits,kidnappers,evil corrupt politicians, and doz non state actors for east) |
I know she will rebrand the rice... Money wey government give u to takia of your pple,u use am buy rice,rebrand am then begin share give them, to score cheap during election....GOD KNOW ALL OF UNA |
Naw the wives me pity for,imagine 7 young lads accept to marry him,shey naw juju or naw fvck him take hold dem down, believe me naw poverty make doz women clique to am,and now their sufferings and those of their kids juz start afresh |
Local igbotic and asaba rating I give it to Pete Edochie...then international level I give it to Olu Jacobs, but on a normal playing field A,B,C in no particular order,odaz dey learn where diz pple dem dey...you might disagree with me cus am not really a fan of #nollywood but from the little av watched.......... |
Lagos state government wey no dey use it workers play,this driver juz collect free tourist ticket to visit federal housing project and chop free stony beans there with customized cloth,naw the family wey depend on am,me pity for pass,cus like this without connections and God diz driver mata don cast...minimum 2-5years imprisonment. No pray make police,Vio or Lastma catch u for road,esp lastma and vio those pple..dey feel lyk God |
7 dangers but naw only one me dey see...what gwan to the remaining 6 |
As a Dj I dey normally first ask for swallow,then rice go be after for the road...then back to the MA...,Abeg naw concoction rice with plenty c/fish ontop nd shawa fish or Titus fish make sense pass |
A whole DSP naw biker Ryder to Senate president...watin happen to junior rank personnel.., to dey follow senate president dey sweet am,now Senate presido,don use am arrange science, cum chamber dey drop audio job promise, naw the kids me pity for.... Imagine working as driver for 25years...,hmmm I reserve my comment sha |
E remain busy...I just hope he has some hidden accounts..., cus US go make sure dem draw and suck every last kobo comot...,And naw person role model be diz ooo |
This one juz wan tread, u think America policy markers are like naija ministers/commissioners and politicians...,they av checked and measured both deir advantages and disadvantages..., Trump might eida call it off,I guessed the white huz leader wan test run something |
me shock thank God for my factory fitted absorber so since naw juz I and my dauta & few Allies I just maintain my pocket buy #20k (broiler) carry go...Anoda Xmas still dey come,cus e no dey finish