Jehoha696's Posts
Nairaland Forum › Jehoha696's Profile › Jehoha696's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 21 pages)
Twenty years from now there pikin go watch the video for naijauncensor .....Then my kids will ask dem questions,till then I reserve my comment. |
Worst reality TV show (maybe now)... The stuff juz get boring on a dialy basis,bbnaija school of future celebrity olosho's ...imagine within one week two separate pple don dey kiss and smooch for public, and the koko be say diz pple know say camera dey with dem..anyway naw there life,e no concern me (THEN,NOW ND IN FUTURE) |
Worst reality TV show (maybe now)... The stuff juz get boring on a dialy basis,bbnaija school of future celebrity olosho's ...imagine within one week two separate pple don dey kiss and smooch for public, and the koko be say diz pple know say camera dey with dem..anyway naw there life |
Baba dey find watin him go use trend....anyway its been long we heard about him on the internet/media how va with him wwe style of deliverance ?? |
Una juz gather dey drink panadol for headache wey no affect una....,But based on subject mata,I prefer Mr Eazi's style of wedding..,very gentle with class,just selected few ...Like my wedding reception was done at top5place events hall at VI with only 80 invited guests exclude her maid (aso ebi) and my guys (men on suit) live band (12) DJ ((4) decorator and vendors (12) security (6) ....very peaceful where me gathered & feed crowd was at the Thanksgiving service/ceremony almost everybody for golden estate.... Anyway d main koko naw after the wedding WHAT NEXT |
Are there no security men around, I toth after close of work, security men do take a routine patrol around car park,some even flash light inside cars,naw so my company security take catch my P.A with with one of the company driver knackin inside company private car.....anyway the mata went well,my boi collect #50k dere jus for the mata not to cast,but the idiot later cast give me,cus I been wan parole the babe same week. |
Naw one oga @ the top go don collide with "men" to sell the house and chop government money as usual, now mata don cast,dem no fit defend mata for court cuz "Men" don gather share money chop and disembark... The koko be say hope Alibaba 220m Neva enta "devil's account" like this sha |
Fact check and know..., but for show Twitter wouldn't take down that post,all the dey have done and could Eva done,has already been done by contacting sowore,nothing more,so Tinubu can lie like this,anyway naw for Brazil him go fit throw dat type of lamba not in White house,no place in USA or even London.... the questn is how did we get here |
Finally after dating for how many secs,mins,hours,days,weeks,months & years....hope no be after marriage we go begin hear stories,as una dey manage since,make una kwatinue like that ooo |
If I wan REST,I no dey travel out,naw to comot from office,go house go take enuf rest,with all diz things going on in the nation,the president still has time to travel,it's eida Baba is not seeing it on TV or paper,or he's yet to hear about it,but why nor of our leaders dey gree stay for the country,any small break naw to fly out,ND later dey tell us to patronize our own,support NIGERIA MADE(home made) how will that be possible.... "President Tinubu remains in full control of state matters despite being on a short vacation, " WHICH KIND LIE BE THIS.... Ni to ri oluwa |
Picture the scene where diz men have already sight dem before hand,or somehow gave out the exact coordinated movement of the BUA workers to the gunmen & dey decided to lay ambush,firing from all angles,since naw ambush aje e go take dem security guys unware nd limited time nd space to fire back,so with diz type of encounter me no blame the security agency,but on tracking & rescuing the expatriates diz one naw 1/10 ....cus Otilor ...The gun men known already before hand dat dey will be there,I just wish we enforce more on our security and assume doz men mount on bullet proof helmet and jacket,e for no too be lyk diz (MAYB)...ALL THE SAME,MAY DEY ALL REST IN PEACE ND GOD GRANT THE FAMILIES OF THE BEREAVED MIND TO BEAR THE LOSS. |
Bend rules to suit dem...#rulebender,just dey bend anoda family go come,u go still bend and unbend till nothing dey again to bend, by then u no go get any principle again,by then anything goes. |
Naija e no dey hard una,any mis act for road naw lynching go follow,u do anyhow,tire,fuel and fire don associate with your skin. |
The hippos jus dey form jardon for there,thank God say no b naija by now,we for don dey perceive aroma of bush meat pepper soup for the hood. |
I already know Tinubu isn't a lagosian,alot of high profile office holders unda LASG are eida from Ogun,Ogun or Ondo state..., Even lagosians no get hold of Lagos, anyway it's well |
Some things dey happen behind the scenes and back of curtains, if you know,you know,but if you don't know,no qualms |
See academic achievements and work achievements.... 8ter person go say school naw scam,I think the promotion was done on merit sha,but being work in Lagos a state ruled by the president protégé, what ya expect,...Tinubu sabi settle pple wey dey loyal to am....Maybe one day that nurtw boss go turn minister of ****** or dem open one new office,ministry or portfolio for am |
Which naw Columbia,country wey the highest and strongest drug cartel dey decide fate for...,I just pity the player cus if the ref get link to any drug cartel, dem fit gather revenge in her behalf |
Cruise..., Nothing wey government goan throw to us wey we no go fit Dodge... Naija best comedy station for heaven |
THIS IS SUPER STORY.....What else we saying no wonder some pple no want make Naija divide..aje naw north get this Naija from land mass,even all the mineral wey dem dey mine out FG just gave dem upper hand,naw dem dey decide,even in politics,if the northern elites no want you for aso rock,who re you to get there. |
Ganjafama:Based on script... |
19years old, what's her mandate...hope she will be open to it sha,abi naw juz figure head, ceremonial councillor....Anyway I still wish her all the best,if naw the pple really vote her in(thumbs up) but if naw same padi padi government select her IN...,the me reserve my comment |
Some gentle the yahoo no fit pack bifra solders to go rescue Simeon from Finland,so dem no fit go declare SIT AT HOME for Finland,was thinking by now gentle the yahoo & him boiz go don enta finland to go give Finland security forces woto woto |
Abeg which peace kaduna state get,same state wey dey pay bills and taxes to bandits?... If el-rufia enta power belong me insecurity will be worst,bandits will have upper hand |
On wrestling I don't fancy him,I prefer watching my ex gf cry than watch him on wrestling,but on action packed movies,I can stay glued watching him than collecting HEADIES from my ex gf inside my room |
Baby mama dey find validation..., must he visit,re dey in same region or state,during the Rwanda/Uganda clash my dad was drafted to join the UN peace keeping force, I didn't see my dad for close to two years,but dad was sending cash steady to my mom to takia of us.If Reno is sending cash to takia of the gal,then madam no cum dey find online soldiers wey go cho cho cho for una family mata |
Women then were real....,now naw gen Z with zero brain full the market, someone said women with grace nd bright star no reach 1% for diz kwatry,cuz yahoo boiz DON collect majority of deir stars take lodge for hotel and buy cars,while drugs and early morning drugs DON cast dere womb |
Peacecore:You wey go school before law enforcement agency will make open report of preliminary investigation some things must have been eida done or carried out. 1.securing d scene 2.identify and interview witness 3.Collecting evidence 4.. Making & collecting observation. (This is c'mon something we learn in sch) And police didn't do any of such,from what me heard,So can you explain to me in a lay man language/understanding how did the police come out with such accusations,since u went to school and I didn't cuz according to you,I said "school naw scam" more reason me didn't attend |
Shebi police say the matter still dey under investigation, so how then did dey conclude that it was el rufia thugs that attacked him...,dey just wan use style ban freedom of association... We Neva can tell,but it might be doings of the ruling party in da state |
Dino wan dey form set....anyway as it things now,no country is actually corruption free...but wen it comes to Naija,we carry A1 with GP of 9.9 for election corruption and financial corruption |

