Morientez's Posts
Nairaland Forum › Morientez's Profile › Morientez's Posts
1 2 (of 2 pages)
Na normal thing for PH Na.. If u know join ogoni or seaddog you no go too dey get contracts or big political post |
Ikwerelastborn:guy i know want take chances abeg.. And beside ph niggaz e know dey hard dem to cut person head.. I know want my head to turn to ishi ewu in somebody pot. |
rollandben:guy i later asked her.. Say she don divorce with her husband.. Then i make some underground inquiries found out she was lying. |
Second scenario was in ph.. Was standing in front of my shop when i sighted this fine ebony slim curvee gal.. Called her.. She came immediately (trust ph gals them too like money).. No much talk took her number.. then we begin to vibe immediately.. Trust ph gals na.. Was with her one day when i got a call from an unknown nigga claiming i was sleeping with his wife.. Treating to cut off ma head... Trust me now e know dey hard me to japa. |
Mine was on two occasions.. first was at omoku Rivers state.. saw her on sunny afternoon so I decided to try my luck.. Approached her collected her capa code (phone number).. told her will call later in the day, then i left.. Got home dat same day then i decided to call her.. Called her and we got talking and I get to find out dat she was a student of college of education there in omoku.. During our discussion i notice something fishy on the background.. Was hearing ynaring.. Ynaring.. Uwaaa.. Uwaaa.. (baby cry) na so I japa oh |
See guy man make i clear you.. 98 percent of these modern day ladies no go look your side if no dey comfortable as man.. Been there trust me, when i served my oga as in (nwa Oboy) dem know dey look my face talk more of to exchange words with me.. But immediately dem settle me, i know come dey stay for sun again, dey chop up, levels come dey change small.. Nia dey come dey form line dey form wife material for me... Even for church dey go be pls bro.. Mori we you like to join the band, choir, diz cell. Bla Bla.. |
[quote author=dairykidd post=100543193]Hope u used condoms to knack oooo.. because from ur write up that girl na ashawo no be even runz babe.. Okpo! Abobi sex no dey too move me like dat.. Though she offered me puna bt my instinct told me to decline her offer ... Her friend later told me had it been dat i sex with her, she wudav hanged pregnance on my head (fake Belle) then now Bill me.. Say na so she dey do other men.. Local man buy fowl go do Thanks giving for church.. |
Met one here in ph, fine slim yellowish Akwa ibom babe.. Like going through my phone always bt will never allow me to touch herz nt talk more of going through it.. Always requesting for gift each time she came visiting.. Flirting with different men.. And went ask her watsup, she say na my brother be dat, always on call 2/4/7.. The one dat got angered was went i insist on knowing were she stays cause she was pestering me about her house rent.. Got there and i found out dat she was staying in a batcha (wooden house) with three gals.. Av to japa oh... Me wey be first born wey carry responsibility na want come kill me before my time |
![]() dancok:Baba Na last year oh.. Wetn make i go answer her be say the barney go well (you know all dz ajebo galz na.. Her skin dey like Wetn Dm do screeding... think say she go give me number |
Was coming back from work when I sited this babe holding a black baco nylon bag..and better hungry dey wire me den. Na so babe call me fine boy.. Nia i Mumu go answer her, she said i Sud help her and carry her big baco bag. I asked her wat is inside.? .she said ice block ,when i heard ice block na my instinct tell me to japa but i know hear. I asked how far is the distance? she said just here (@junction) dn from there she board taxi to estate.. Her destination (mind u i also stay in dat estate oh).. I said no qualms let's go. We movee.. I gym the bag of ice block.. (heee! bag dey heavy like G. P tank) i manage carry am na so we Waka pass reach junction pass junction enter Aba, to Nnewi to Lagos.. B4 the Mumu come see taxi a drop.. Wen i wanted to join her Since both of re going same estate.. the idiot said i Sud come down Dat she wants to drop something to her cousin before going home.. I just weak come down with vex.. idiot no even tell me tank you. |
Hmmm a plate of ice cream 4100"? Money way i go take cook beta pot soup.. Nia you take lick sugar wey dem put for ice block.. |
Mine was during my apprenticeship days.. My oga supplied ceiling for one chief like dat. And i was asked to go and collect the balance at the chief 's house.. got dressed up, spray perfume (the man get fine daughters.. say make know weda I fit try my luck..) Got to chief' s compound, knock on the gate no reply (everywhere silence like grave yard.. mind you dogs no gree bark oh..) Na so i open gate oh begin shout chief, chief, before I say jack Hmmm Na one big dog Nia rush me oh.. Na so I dogged oh.. Got a little scratch on my jeans trouser tho. I face dog face to face. she was barking at me but i stood my ground.. She kept charging at me but i stood firm, she called for backup (na dat time I know say Na two dogs dey the compound). Second dog just ran straight to me without asking her sister Wetn dey sup.. Na so i take cover.. God like me sha, When i was kid there is tale about dogs hate sand been thrown at them.. Ma broda na so i pack sand pour them to my greatest surprise, nothing sup oh them dodge the sand and I became scared immediately... When they noticed i was sacred.. Chased me Na japa tins i ran for my dear life they chased me from the street to main busy road... That was my saving grace.. Had to go too a near bar to drink malt i didn't plan for, and also use dat time to wait for the mother fu**ker.. Later saw his car drove past the street.. Had to call him on the phone dat i was nearby he said i should come to his compound.. I went and told him all dat happened.. Idiot said dat his dogs were friendly dat he surprised dat they attacked me.. Wife n daughters went to church. |
Avoid married men at all cost. |
Mm |
Alcatel a50
|
Ma broda de matter serious dt day oh..after she killed the rat,na xo she bngn prayer nd kabbashing she say dm want mk hm pikin impotent oh.. |
Mine be say..e get one yard lyk dat wey we park enter newly bk den,and dat yard get as e be.. mysterious tinz 2dey happen there. One hot nite lyk dat, na xo i say mk i relax oh..mean y i dy lyk 2 lie dwn wit only ma boxerz xo dat ekuku(air) dy enter my ikemba..lol na xo i bngn sleep oh b4 i dy kwn wetn dy happen na xo i bngn 2dey feel movement 4ma right leg oh.. Pian pian pian b4 i dey kwn wetn happen e don move up 2ma ikemba kum bite me 4 ma smtn oh..ma pipu na xo bngn shout ooo..dn use ma hand 2hold ma smtn wit d tin wey bite me join. Nia mumsy hear ma shout burst out lyk jet li..nia she bngn para oh dy ask me y hold hnd 4 ma groin area?nia i tell her say smtn bite me 4my ikemba nd i kwn no wetn b dat, nd i still hold d smtn. She say mk i remove ma boxerz hold am wit d tin wey bite me.. say mk i kwn ever leave d tin oo .. Naxo i do she talk oh,remove boxerz put 4 floor kouple wit tin wey bite me join.b4 i go jak robbinson da woman don use motor pistol smash both ma hand nd wetn dey inside d boxer. Ma pipu guess wetn bite me oh..na nkapi(oke belgium) |
1 2 (of 2 pages)
