Morientez's Posts
Nairaland Forum › Morientez's Profile › Morientez's Posts
1 2 (of 2 pages)
1*No fall in love.. just do how e dey be things.. hookup 2*Just know one or two senior men.. get why 3*Get small street ruggility. 4*Verify before you rent apartment..most rooms na grave yard..to avoid make person press you neck 4nite. 5*aviod nite movement wey no involve your unit. 6*try hustle ohh hard, cause thing expensive die for pH. 7*aviod compound or flat neighbor Bleep...if you want run shit go far small..barneys prerere with standing breasts.. |
Most gals we they date na wetn? |
See am sit don like say na town hall meeting dem dey do.. ![]() |
Yes they do,but it's mostly married men or guys that re in a serious relationship...you know the saying stolen water is sweet.. |
She said in quote ( I don't do boyz) I shunned her and was rolling with others hot girls ..then surprising she later said she doesn't mean most of what said.. Me i know too get dat luxury to entertain such capping.. |
I don't think she finds you instresting...a girl that fancies you wouldn't have the audacity to bill.. Fear go dey catch her make she no talk wetn go make you run.. |
It's quite sadden what our ladies are turning into.. Na so last year july i met one fine fair lady ...it was raining heavily that morning , after the rain everywhere was just flooded. So met this damsel coming out from the same estate were i leaved , as per bad guy i approached her .funny enough both of us are heading the same direction..so i paid for cab both of us.. See were wahala come start the barney ask me what do i do for a living ? na so i knack her lamba say i dey work as sales personel for one shop like dat ohh.. na so her facial expression change.. So as i don dey reach my destination i asked for are phne no. She do gra gra come later pity me give me the number base on say i don pay her t.p..told her i will call later in nite tho.. Dat same nite i called her introduced myself to her.. She come being give me attitude dat she was tired n feeling sleepy bang phone for my ear... So i later decided to call her the following day.. just toknow sup with her... the mumu don block her papa say na me she block... her lost though.. Saw her last week she come see the calibers of men wey i cluster with..she being form familiarity... I know look her face me wey own my own business ,i know blame her though i look very young.. |
U.b.a removed 60k from my account.. debit i no even see..went to print statement nothing came up.. Please for your sanity aviod these banks.. U.b.a Access bank G.t.b |
Berbertov .. because of my sluggish style of play.. when i relocated to another state they started calling me david silva.. mehn i was beauty to watch playing soccer.. leave say nigeria corrupt person for know where him dey now. |
Aboy is not ordinary ohh.. know rush go comot am oh.. |
Dat man dey sure say na him pikin be dat? I get why i dey ask ohh... |
I will not take it, because i know that she will not give me. |
I see shege for boy ...you will wakeup some morning madam will tell you there's no food in the house, weas her children are having bread and egg for breakfast.. the worst is that when you get to the shop there's 40ft container already waiting for you to offload with empty stomach. Abi na the one wey madam want set me up say i beat her up when oga travelled for a buisness trip.. Abi na the one wey e reach time for my settlement oga say me n him go do combine buisness for one year, say na my profit for the combined buisness nia him go use settle me weas our agreement was 6 years why i don stay 7years .. Abi na wen him want set me up with money.. Abi na wen him use goods of 300k start combined buisness wey dem dey use like 2million start. Abi na when e reach settlement wey him check stock.. stock complete come balance account I come they make gain of 3m him shock.. Him tell my mama say na 300k worth of goods plus shop rent 300k na him go take settle me ...or him give me cheque of 6ook if I no want the goods.. tears comot for my mama eyes.. she tell am say person wey serve you for eight good years na 600k you give make am him take start life... say if i comot shop rent money how much go remain... So mama ask which one i go take, i had to opt for 3ook worth of plus shop rent base on say i don build contact.... Wetn dey dis life be say wetn God don talk say person go be him go be ..once you no drift from the plan of God in your life. I morientez! my life is miracle.. ![]() |
tonexman18:nawao him dey use fork they pick rice like fowl ...him go eat the food like 3days before him go bellefull |
It will in premium tears.. am a victim |
Lastmankc:Baba i no see her pant oh talk more of to shagg...she play me virginity tape and base on sayi see her as gal wey i get future with niam make i know too disturb her... Thing pain me ohh make i no lie |
avrilwisedata:My brother i was doing it base on serious relationship stuff ... i was seeing her someone i had a future with,but the idiot wanted to explore... For now am done with anything serious relationship.. (na how e dey be) na i dey do now.. |
avrilwisedata:I saw her the other day she was looking haggard n pale ,her hair was unkept but i Careless i no send her again .....she hardly upload her whatsapp status this dayz cause nwa diro zi sharp like those times i dey provide virtually all her needs.. |
My ex always gives stupid excuses of not been chanced ,always forming busy with school stuff...she only do come to my shop for food n money...each time i tell her to come over to my place so we could spend the weekend together cus am always busy during weekdays ,because of the nature of my bizness... The idiot go tell me say she dey cook Sunday rice ,say her pman no dey allow her comot on Sunday s apart from going to church.. ..na so one day like dat i caught her in my street with one manchie walking romantically inside the guys compound.. I echoed her name she turned around and was shuttering with words..I ask her so you dey go out finishe?7 ...you come dey lie say your pman no dey allow you go out weas you dey gum body with this nigga.. Nia she lie give me say she tell pman say she want go for all night revision for her course mate house cus her 1st semester exam.. I don comot hand for anything wey undergraduate.. |
Osashalom:the one wey pain me most be say at times she go dey lap me with her course mates wey be gals.. imagine how much go comot for guy man pocket,but the idiot no dey appreciate am.. |
Osashalom:na so my current ex dey do.. she go come my shop the they order wetn dem no go fit cook for house , come dey expect me to go use my hand buy am with still my money.. Na so i para for her want day ask her weda dm dey cook dis kind expensive food for their house she say no. |
Pot belly (ofo beer).. it's beats my imagination why a young gal in her early 20s will be comfortable carrying big belle around..wetn go come happen when she don Born like one or two pikin, chinekena.. Billing....i know say country hard but some gals dey fall hands..you just know a gal just now these next second you go dey hear ..am hungry, can u do a favor, can you sub for me, my rent is due..haba how you take dey cope all these while before I jam you.. Hygiene... Some gals can form posh like beyansi but you see were dem leave ehn...dirty clothes litter ed all over their room,dirty pants hanging like wallpaper waiting for their appointed time to be washed.. wearing pant ontop of pant with tight and boxers all in one waist, walking under the sun then sweating like goat.. When they sit close to you in a public transport na so so rotten fish smell go grace your nose.. |
kense88: how i want take know weda hm dey smoke weed.. his an adult |
Dad was fond of yabbing momsy dat he use to see her dead grandmother inside the soup dat do cook for him.. Says the soup looks watery n transparent..dat someone can mistake it for a make up mirror.. One day he killed a multi colored snake n used it to prepare pepper soup.. when he was done,he called us including Momsy to come n have taste of he cooking skill.. Mom gave us Stern warning not to taste he food. So he ate it alone after some hours he eyes kept blinking nonstop for 2dayz.. |
I pick am for ground ![]() |
Cooked new okro soup na so babe begin talk say she dey eat well well each time she see okro soup.. Like play like play she do 5cups of garri, eat am finish |
70k |
Diz one na small tin here for PH.. When dem dey lounge you go see dem with nose ring, ankle chains, multiple ear piercing, putting on bikerz shot(under wear) exposing there camel toe, putting on topz without bra.. Putting on gown without pantz, na so yanzh go dey kpaka kpaka... But wen skul close na mountain of fire gown dm go wear thy go house.. Leave oh.. my eyes dey see tinz on daily basis oh here but i dey comport myself make pikn no go village.. Wetn i go tell my mama.. say na umuzi zegemi Nia run me down.. God for bid |
Can you push paracetamalt? Can you push paracetamalt? |
You no add were the barney dey bill guy man urgent 2k You no add were the barney dey bill guy man urgent 2k |
The problem is that most of them don't have a.c in their house.. So when they opportune to meet a guy with car, it's seems like they have archive something big in life .. |
The one wey dey pain me pass na the numerous abortion wey dem dey do.. Na only God knows the kind woman dey person go marry. |
1 2 (of 2 pages)


