Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,455 members, 7,808,627 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 02:28 PM

Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi (315413 Views)

Life Of A Rugged Guy +21 / Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi / I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (51) (Reply) (Go Down)

Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 5:50pm On Jul 07, 2018
for learners i mean those of una wey neva nack woman,Chai nawa for una ooo



no go think say na me sin pass becos i dey yan(talk) you base on self research and em Chai i don forget this beta grama wey my school teacher dey always talk,i swear na that English be the only beta tin wey i learn from schoolapart from sey we fit carry hiv through s-x …Lolz check well oo nobi my handy writting


my name na spana. no go think why dat one na my namesy just cool down like kulikulias when the tori land you sef go stand catch d whole fall


na God be say i still dey alive to write this story asin the wey i take start to dey f--k f--k like dog the tinno even gree me understandnothing wey i nefa put my p---k inside and pafuka……Chai God dey ooo



upcoming tori.. coming soon like Jesus Christ just kukuma come and carry you sit …sit dawn before the whole place full….register ya name and answer presently seated tasuu allll!!!?

13 Likes 4 Shares

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Ann2012(f): 6:00pm On Jul 07, 2018
grin grin grin
Presently present

2 Likes

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by nastynic(m): 6:04pm On Jul 07, 2018
Ann Shift Abeg...



Present Bruh
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by purity247(m): 8:13pm On Jul 07, 2018
this is your captain speaking please fasten your seat belt we are about to land at peoples republic of youngzubi the country of endless story update waoo please i need the VIP i no dey fight for front seat journey from soloho to here is not easy

3 Likes

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 3:38pm On Jul 08, 2018
Be warned!!!!!!!!



This work is 100% owned and written by youngzubi the author




No part of this work should be copied in any form to any platform whether in a text book or to a site without the prior permission of the writer

Any interested person(s) should contact the writer in any of this platform below


Email:youngzubi@gmail.com



to obtain copyrighT©2018

Do it right! get it right

if u do otherwise then whatever u see its your fault!

Episode........ 1

SUNDAY GBEDU!



All the way from warri to lagos
***************************






Fire!! Fire!!! Fire!!!!! oo egbami o!! egbamiiii!!!!! aahhh!!!, yea thats the only sound i could hear, it sounds so motivating but she's getting on my nerves alrady......

Wo i go tear you dirty slap o!,
open ya leg well nah,abi i no pay you?,naso so shout you just dey use scatter everywhere since"i said to hush the ashawo girl
"abeg comot hand make i enter deeper jare"



"Chai i don dey samah this ashawo girl since 3 o clock pm and time dey talk 5 pm now,i still never satisfy sef.

" the ashawo girl don faint three times now but i no even care,all my concern na to f--k till i satisfy.

"after i drink one herbal medicine like that wey my aboki friend wey travel go north come back give me,naso my pennies just stand kakgraka like electric pool sotey e come dey pain me like mad..

i don call my babe and reason her sey make she run come my house sharp sharp, but gawd punish me join,my babe talk say she no dey town, she don go her mama side for lagos island,Chai i use vex smash my phone go jam wall.



"i don use my hand rob my hard dick tire mtcheew! the thing sef dey add more wahala to the whole gbese!!..

"i just dey waka round the whole room sweating like Christmas goat..

Na gawd save me sey spata one of my friend come visit mah side,as the idiot waka enter house naso him wor wor eye jam my standing dick,o boy the guy laugh and laugh sotey him lay down for ground, i no even mind em i just stand dey look....


spata finish with him stupid laugh come do like better human being as him quickly run go one hotel wey dey for my area wey dem dey call blue-carnival na there him go carry one lekpa ashawo girl come give me


as the ashawo shake yansh waka enter my house with chum gum in her mouth wey dey make one kind kpa!! kpa!! sound

Chai my brothers make una fear ashawo girls,them wicked like mad becos as she enter my house come notice say my dick don stand long due to medicine wey i take naso she charge me like say na gold she carry


abeg i no get time to waste at all!! ,as i dey here so!, plenty customer dey ground wey need service so your money na 50k if you no fit pay just talk make i kukuma find my way...she said with that stupid chum gum still making kpa!! kpa!! sound

onto say my life dey ground i no bother to price am i just pursue spata go outside close the door then carry the ashawo girl enter my room as i open my drawer and count 40k give her as advance before i go padlock door a trowey key enter dustbin today na today

the girl climb bed as she comot all her clothes,i look the girl with her slim small stature like 17 years old pikin,hmm she never know watin dey ground
nah her vagina i dey pity becos my hmmm let me not talk now


she seat down for bed dey look me as i comot my boxer,waaa!! my long and huge dick sprang out shaking like a spring with pre-cum dropping..



jesssssuuuuuu!!!!!!!! watin be that ...she ask with her eyes and mouth wide open



na my spana nah,i reply with a wide grin


abegii abegiii take your money i no do again,how this thing go fit enter my sobinto?


watin?? ogbeni lay down back jareee!! ..see eh i don already lock door tight so just relax you're going no wiaaa !!!!!



i draw near go meet am for bed but she run go meet wall..ok



i go meet her for wall naso she run go down...taaa!! no be me this one go take do hide and seekk

come hia i said as i pursue her, we begin run up and down. sotey the thing come dey vex me becos my hard dick don dey increase in size


gawwm!!!! i dive and catch her she struggle to free her sef for wiaaa,i kukuma bend her yansh as i force my dick enter her from behind




aaaahhhhhhhh!!!!!!!!!!! egbammiiiiiiii ooooo!!! she scream,but that one na genesis



i try push in small again but e no gree enter reach half sef......

kpaaa kpaaa kpaaa kpaa !!!!!! naso i continue dey nack her,o boy the olosho sweet sha Chai!!! i just carry head up dey look ceiling as i enjoy the sweet sensation

i Bleep her for good 3 hours without stop na position i dey just dey change...


the girl won scream down my house but i nor kiaa all i want na to satisfy my sef and again Bleep out my 50k from her toto


she cry,faint,struggle for wiaaa i nor even move



till around 5:15pm i pull put to rest small before i continue


firee!!!!!! firee!!! the olosho girl scream as she jump outside through my window necked no clothe at all



chaiii this girl run,ha why i forget to luck my window naw,no she no fit escape i said as i run go outside necked too without any clothe


i reach my backyard with my long dick dangling



fire!! fire! fire !!!!! naso the girl seat down for sokaway dey use packer dey fan breeze for her toto


i for won rush her oo but people begin dey run com out side becos na face me i face you compound


o boy i reverse sharpaly before dem go see me...


as i reach inside wear my boxer naso i look out side,one woman don run carry her rapper cover the ashawo girl becos some children don dey piss something for dia nicker due to the girl wide open pussy and breast

chiaa Bleep up.... i still dey talk when person hit me




spana!!!!! wake up we don reach lagos ooo my friend spata wake me for bus




i look my trousers as i wake,my guys i no fit lie una my boxer don wet finish like say dem pour me pure water



ha! as i sit down inside the fine bus wey carry us from warri to lagos,i don look outside sotey my eyes com dey pain me like say dem pure pepper water enter my eyes

so i kukuma say make i sleep small na this one go make am third time wey i dey sleep inside this bus

i came down from the bus as i look around wowu lagos hiaa ah com una girls go hearram una go see wieeee!!!!!!




to be continued.....

18 Likes 2 Shares

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by pacifust058(m): 7:14pm On Jul 08, 2018
Update o abeg

1 Like

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 8:01pm On Jul 08, 2018
na only one thing go make this story end like this for this una trend abi thread i nor no

but if una no fit comment after reading ....then make una forget am becos me sef get plenty work for hand,i no go find time write finish una go read without saying kpeekim ... no e dey vex me reach bone

5 Likes

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Centino: 8:24pm On Jul 08, 2018
Youngzubi:
na only one thing go make this story end like this for this una trend abi thread i nor no

but if una no fit comment after reading ....then make una forget am becos me sef get plenty work for hand,i no go find time write finish una go read without saying kpeekim ... no e dey vex me reach bone

I understand my man. E dey tire person. My advice be say, if you get story to tell, tell am. If you get message to pass, pass am. So long as dem dey come view, one day dem go see something wey go push their hand to comment. Be confident in yourself and your craft. Meanwhile I sight you for my thread today and you no talk kpeekim grin

11 Likes 1 Share

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 8:35pm On Jul 08, 2018
Centino:


I understand my man. E dey tire person. My advice be say, if you get story to tell, tell am. If you get message to pass, pass am. So long as dem dey come view, one day dem go see something wey go push their hand to comment. Be confident in yourself and your craft. Meanwhile I sight you for my thread today and you no talk kpeekim grin


hahahaha!!!!!! my guy my guy... Chai u don weak me ooo

no vex as i read finish Ehe na to just write i won do before my ink finish....no vex na naw i just run go buy anoda ink put the phone




tankuu for the advise,am really glad man!

4 Likes

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Ann2012(f): 9:22pm On Jul 08, 2018
Well done youngzubi

You wan use ur spana scatter d girl sobinto ( this part got me laughing) grin

Abeg update biko

1 Like

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by ceecane2(m): 5:45am On Jul 09, 2018
Following keenly
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Silver1996(m): 9:41am On Jul 09, 2018
Youngzubi i sight you here... Abeg continue....
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Nobody: 10:46am On Jul 09, 2018
Centino:


I understand my man. E dey tire person. My advice be say, if you get story to tell, tell am. If you get message to pass, pass am. So long as dem dey come view, one day dem go see something wey go push their hand to comment. Be confident in yourself and your craft. Meanwhile I sight you for my thread today and you no talk kpeekim grin

Mr Centino i sight u
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by WHIZKIDEFE(m): 8:58pm On Jul 09, 2018
Youngzubi:
na only one thing go make this story end like this for this una trend abi thread i nor no

but if una no fit comment after reading ....then make una forget am becos me sef get plenty work for hand,i no go find time write finish una go read without saying kpeekim ... no e dey vex me reach bone
My guy, nor reason the comments o, just like Oga Centino talk, just dey do your tin dey go. Na so e do me when I start until Don Meneski con give me voltage to carry on.

If nobody motivate you, motivate yourself. I know as e dey go. comments dey road dey com, do your tin. I dey your back..

1 Like 1 Share

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by TheLoser: 10:05pm On Jul 09, 2018
Lol
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 10:16pm On Jul 09, 2018
WHIZKIDEFE:
My guy, nor reason the comments o, just like Oga Centino talk, just dey do your tin dey go. Na so e do me when I start until Don Meneski con give me voltage to carry on.

If nobody motivate you, motivate yourself. I know as e dey go. comments dey road dey com, do your tin. I dey your back..


i dey feel u my guy

i dey happy say some of una undastad my palava

the thing no easy if anybody tink say e easy then make him go tell calaber guy say make him pronounce parallelogram


thanks my G @ WHIZKIDEFE

2 Likes

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 12:51pm On Jul 10, 2018
Episode...........2



GBEDU!


Welcome to Lagos
________________________
Welcome to my home
____________________________





The agent man wey help me find house wen I still dey for warri nahim use moto come carry use from park go our new house...


As we enter road I begin dey reason how life go take be now as I don leave my home for warri come Lagos to fin greener pasture..abi nobi so oyinbo dey talk am


Onto say I no dey like share house with peson especially mumu peson like spata chai the guy behavior no deferent from goat own,i don yan the agent man earlier sey make im find our house separately for different area......na me talk am




The drive from park no far as we enter one fine street like that see as every wia fine like say na estate chai nahim make me like Lagos,no go reason am say na my first time for Lagos be this,lai lai I be Lagos guy o!

I get one broda like that wey we two resemble our sef well well like say we be twice....I tell una say I no finsh school

Na for im place I dey come stay dey hustle some times before him come get one kind wahala like that with some cult guys,chai they almost butcher am oo! Na gawd save am as him escape come fly aweh(Malaysia) na there him base now


The agent man stop him moto for one big gate like that nahim he come reason me say make I come down say na my own area be that
Chai I fly com down as I carry beta smile plaster for face omo I rush go boot na there I hijack my loads
then together with spata and the agent man we waka enter the compound



Na two building dey inside the compound one na storey building one na bungalow as I sight the fin mansion omo my julliness increase but dem come fall my hand as e come be inside the bungalow my apartment dey,e fin too sha


Spata and the agent later comot go spata own apartment as me I begin work,no be small thing o!
I work sotey my body come be like robot


Later that day I comot go buy plasma TV,fridge,chairs and bed
At the end of the day all my body just weak like rag join the hunger wey dey waya me ,na so I come dey remember my ma'le fufu and egusi soup chai! See as spit don dey drop comot for my mouth already....


I stand up comot my clothes as I rush enter bathing room use shower baff before I waka come out and carry phone call spata
Omo my guy don already dey road dey come my side

I drop phone wear my boxer as I wear penciled Jean and body hug polo
I look my sef for mirrow as I carry pink lipstick shine my already pink lips dat one na to just make am more gbeducious

For those of una wey dey try reason my age and how I take be..ok

I dey light in complesor,tall with well built body heavy chezt and six packs na watin excersis carry dash me

Since my mama born me na girls dey always toast me,if i.comot clothes eh no girl wey see my body stucture wey no dey fall,fine face with killer lips .....oyaaa!!!


I carry comb,comb my afro hair style,carry my wallet naso I look mysef well again chai!! Freshy!! Dats how we roll

I carry padlock password my door wella becos I still like my TV and fridge

I enter compound as everbody just dey look me like say I be buhari,na dia I sight one woman abi lady I no nor but the size of her yansh no dey hia ooo,if una join all the woman wey dey una village yansh together e no go reach quarter

the woman just bend down for one tap dey wash cloth chai my spana shout,I just ignor am dey pass onto say I still be new comer bUT not a leaner.......well coded


As I step outside naso okada carry spata drop for my front...


Spata the great okpata....chop an clean mouth one!!!


You still get strength to dey shout abi ......spata yan onto say hunger dey waya am

Oya no need to come down shift make I join you nah

I seat down for spata back


Spata ask the okada man to carry us go any beta bar nahim the okada man reason am say na one big hotel like that but their things too dey cost ,,him name na blue-carnival..



As I hear the name blue-carnival naso I remember my dream,,yes na thesame name abi I don dey see things for my dream ....ha! if naso then na to open church and start business be dat oo!!


The okada man later stop us for one big hotel like that nahim we come down and pay him.....viaa he zoom off....



We reach the gate naso one big giant guy abi bouncer waka comot

Spata run go stand for my back


Spata watin happen na
Comot for my back


Weldon how can I help una??....giant yan,Chai no smile at all,i nor sure say this one go fit sabi laugh




Weldon bros na to drink and relax we come do na
,i manage yan after minutes of thorough scanning


Ehn!, but donlope slippers is not allowed for hia ,the giant guy yan


Watin? I vex for am ....as I look my leg to comfirm but na fin can I wear nah!!


Nobi you na your friend wey dey back
,he yan


I look spata leg chaii na bathing room slippers the idiot wear come hia
,omo the tin just weak me



Oooo!!! Spata watin dey worry you na wich kin thing be this ?,i para



Gbammmmmm!!!!!!! The bouncer slam him gate for our face.......



Abeg no dey shout for my head jare abi peson no dey make mistake again,abeg fold ya mouth put for pocket jare.....spata




I still dey think watin I go do wen
I sight spata crossing the road with one fine Pam wey him just thief


The idiot com dey shin teeth as him drop am for ground and wear am





Chai spata na proffessional criminal the guy dey hold high degree in the field of thiefology


Gbomm! Gbomm!! Gbomm!! Spata jam nok for the hotel gate


The bouncer bounce com out as him look spata leg na dat time I no say the idiotic bouncer get teeth sef becos him jus dey smile as him open gate wide for us to waka inside





We enter their bar as we find better place seat down omo runs girl full ground dem plenty like fly,different types shapes and sizes chai life come dey sweet me as spana begin nod inside my boxers



We chop finish as we begin drink chai we no even ask price as we just dey order wine beer we drink sotey bottles full table and ground



I don drunk oo but I begin notice some group of huge guys dem dey point my side dey look me like say dem won recognize me...





Watiiiiinnnnnnnnnnnnn!!!!!! Watttttt!!!! Spata scream!!! As him look the bill wey one waiter come give am


150,000naira na watin him screamm as I open mouth,gbese le oo!!!!!!!!!



To be Continued

12 Likes 4 Shares

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by germaphobe(m): 11:49pm On Jul 10, 2018
Kwantinue my broda, i dey ur back
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Ann2012(f): 5:41am On Jul 11, 2018
;DWell done Youngzubi
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Silver1996(m): 6:42am On Jul 11, 2018
Brother continue
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by pacifust058(m): 8:48am On Jul 11, 2018
Ogbeni, na yawa be this o
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 9:27am On Jul 11, 2018
germaphobe:
Kwantinue my broda, i dey ur back


Naso broda

Youngzubi appreciates
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 11:21am On Jul 11, 2018
Ann2012:
;DWell done Youngzubi

U well come ann2012
I don sight u since ur face clear jare
Thank u

1 Like

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 11:23am On Jul 11, 2018
Silver1996:
Brother continue

Brotherly I sight u man Thanks for the encouragement
U be sure peson for keeping ya promise #stood by me
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 11:24am On Jul 11, 2018
pacifust058:
Ogbeni, na yawa be this o



Next update says it all my guy
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by pradoic(m): 9:04am On Jul 12, 2018
better tori

guy keep it up ooo

if i tell u say i nodey enjoy this ur ritup nahim be say i dey lai asin better lai

continue. pradoic is hia

Mr spana grin
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by pradoic(m): 9:09am On Jul 12, 2018
oya make i help u call register




mecusbosco(33), buqy (35 ),






sucess001 (36 ), esey(68 ), Seanpoe, toragema (35 ), salmaz, Oladhayor , Orokita , omonla10 ( 36), utioh (29), bennyjay1 (27), obinon , kenny160 (40 ), shomatth( 31), oluaries01 ( 35), lillyontop (38), seraphine , unuane1 , muyikutkene (31), Sholyzee, Olekumaster (27), kaaTheo (28), Wadasco (21 ), Eddy2cute (29), ineco ( 32), pixey, ictmikky, Modelling (30 ), lekanwj, teekem (28), rocasmilatos, ifeolamide00 (23 ), xmobaba(29), Babcee (32), Nonsoco80 ( 38), defutureleader(34 ), Kreemsy(34 ), Lallaopeyemi(35 ), kubbiebrownie, Alexk2 ( 33), Thiannah , owoeyeadeyinka, bk48( 46), alawe95 , Elkrypto(32), kazeytee( 33), ZAYNUL , blaqtom (32), Leoneo (22 ), highmood (32), horleykay , Widall(30), omat20 (27 ), maestrojay, Hasawa( 22), ecksplizit, Nathdoug (27), DGr8GOD (34), rawlineo2000 , Crownofwealth (32), McOsheBaba (29), Rasengan02 , adefreshguy (30), EmmGee (22), esaias1 ( 23), Laryne, MizterAccurate (20), Mofetemi (30 ), Braze9 (32 ), HeavenShield(33), Donswatter (22), rayornb ( 28), kizolo (26 ), Faithhealsall (23 ), Litesanti(26), Fredry , metaphysics, simplemtray, chymi, dilezy , iykedonly1 (24 ), Godiswise( 29), dezyner( 30), WealthPhillips (28 ), Tallestbae , leahmah, dhannyson(23 ), coco1992 (26 ), adeskee (28), efe0 (23), COURVOISier( 58), arcttayo(27 ), TheGuyInPower (23 ), dessywayne( 21), akphilip99 (23 ), HOLYDICK(27), neyoflexzyl (33), Chrismarvel ( 20), eabby (34 ), jamesfadairo, Mynet11 , kurlar101 ( 38), ciggy000 , Saintbusco1 (28 ), onyekanma2006 , SIRTAYLOR (23), Mroduks (23), diayne, LisaAnne , KingDixon , charleyreal( 26), TonyPrinczsmith( 22), edgeP ( 41), Daravin ( 30), kolawolevictor(17 ), wedco666 (27), maureen12 (22 ), heart12 , Adenat( 26), anniepom (28 ), watutsi( 22), solutionmi, Filly3 , kolewealth (25), soundprince111 , dboss12 (26 ), Davidbadest (21), donobilo( 31), cheery1472 (26), Samaryaiba856 ( 26)
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 4:14pm On Jul 12, 2018
Episode……………..3
GBEDU!!!!!!
___________________
E SURE FOR ME
_____________________________
MEET MY NEIGHBOR
___________________________________





As I hear 150k, e come be like say na my account balance spata dey tell me,nahim I grab the bill comot for him hand, as I look am my drunkness clear fiaa for my eye
I come carry table water use wash my face wella dat one na to be sure say watin I dey see for the bill na true



Spata nah how much you talk say dem write inside this bill??…….na me ask



Na 150k nah……….spata yan


I swear to tear you slap jus dey hungry my hand,infact your village people don succed in geting you o!,dem jus dey use your brain dey test their new winchcraft……na watin I tell spata be dat

Because na 15k dem write for the bill, wia him go carry extra zero come join I no nor,mtcheew I don already tell una say na goat spata be ,dont worry I go yan una about him later nobi now,make I quickly go settle our bill becos night don land already



I waka go meet one attendant,nah dia I pay the 15000 naira,I for like make i carry one better babe dey go house o! But onto say I don tire for the day nahim make me reason that one as later things




Omo na drag I drag spata go house o!,the idiot don dey sleep naso him just dey talk rubbish as we dey go



We manage reach house naso I drop spata for ground comot my shoe and climb my fine new bed chai the bed soft well well ….no go think rubbish oo


PIifffff!!!!!! naso I sleep till next morning…





#########################


Saturday morning





I wake up for the following morning,look every wia but I no see spata,so I just do my normal morning exercise na watin I dey always do to keep fit.


I enter bathing room na dia I brush teeth and baff
The whole compound don already busy with children noise every wia onto say na Saturday no work no school



Ko! Ko! Ko!!!!


Peson knok for my door…….



Na only for naija peson go dey knok your door with hand and go still use him mouth dey shout ko ko ko join


Who dey diaa!!……I ask

Its me your neighbor……na man voice


Chai fvck up I been dey pray say make my neighbor be woman…


I near door as I open am…..


Goodmorning bro,I guess you are the new tenant right….the peson ask



Na who be this one wey come dey use grama to dey spoil my better morning eh??..na for my mind I dey reason dat one o!


The guy na very handsome guy too just my stature…….


Yes na, nah me how things na?….I ask am as we shake hand


Am good bro,Am sentino by name,a banker but I wont be going to work this morning becos am in the afternoon shift…….


Ehen! Ha you be rich guy na……na me be spana the letest rugged guy in town,tho I never get work onto say I just land but with time I go engage na!


Did you just say spana,hey dude thats a funny name you gat there……


Yes you free to begin laff if e funny
But guy I no dey like people wey dey speak too much English oo!


Oh oh! I see ,ok na I go see u leta in the day nah.i just say make I come greet you …..sentino said as him waka go


Me sef I waka go back enter kitchen,na that time I come remember say I never buy any food stuff put for house,chai I quickly carry my ATM card,lock my door naso i waka straight to bank


As I enter compound omo come see fine fine girls,me I nor dey look man na woman I dey always look….
Some of them dey greet me onto say I be new tenant while me I dey greet some onto say I go like introduce them to spana



i later waka enter street thank gawd sey bank no far from my house as e dey just across the road


i don almost reach main road o! Nahim I come see three aboki wey dey shine shoe chai una need to see argument


Aboki 1: walahyii I go schooo kwo na fur primly sikiss me I finish am….


Aboki 2 : furgate tha one I no say I no go zukul but me I zabi buuk pass you walayii


The third one just stand dey nack him box kpoi ! Kpoi ! Kpoi!! ,e be like say that one no dey speak broken at all becos him just. stand dial dey shine teeth…..


Aboki 1 : oya if u sabi book pass me wey go schoo watin dem dey kwall monkey for English


Aboki 2 : hahaha!!!! Hayii hayiii!!!! Walayi you dey maky me laff well well kwoo!!
monkey fur English na chimpiezy nah who no no dat one….


Aboki 1 :kai wo mana ...na gawd safe you say you get am , I fur laff you tire!!!!


Chai laugh no gree me laff wia I stand,I just kukuma cross road waka dey go bank…….


i don almost reach bank before I sight one fine Lexus like that wey park for front,one woman about 46+ waka come down as she carry her purse enter bank,but no be she i dey look,No e get one beautiful damsel wey seat down for passenger front seat omo the girl fine diee!!!



I just stand dey reason how I go take approach her befor her ma’le go come back

tho she suppose don reach 25 yrs old the way I take see her

but As a smart rugged guy wey I be,I nor say this one go sure for me so I gather mind waka go meet am


As I reach her side omo her beauty come increase no artificial makeup at all,but the problem come be how I go fit get her attention becos she put ear piece for ear close her eyes come dey sing you are my African queen by tuface idibia


Chai come see sweet voice ,infact I go make this one my girlfriend becos she complete pa!!


I try everything wey I fit do ,but this babe no gree open eyes e be like say the song dey enter her brain


I just vex tap am………
She shock as she quickly open eyes comot the ear piece sharpaly


Wow see beauty my heart mealt instanta,so I just smile ,my smile na electric shock to girls oo


Omo the way I take hear her accent she be ajebuta oo ,abeg una go permite me make I speak English small


Me: hi

She:hello….


Me: with my Charmin smile still on my face,it seems you love that song so much cos I been greeting you for a while now,am beginning to imagine what sort of song would make such a pretty girl like you to be soo carried away


Oh!! My gawd please forgive my mannars,I was actually practicing,I have a show to perform in this evening,so i was actually practicing ….she said giggling



Comfirm comfirm comfirm!, since e be say she like music and she dey perform too...e don settle na,the thing na to just apply law 919 coded,it mean say mesef I go pretend and lie for am say I be musician too so e go dey easier for me to toast her


Na so I come gather all the better lie from east north west and south tell am say me sef I be multinational instrumentalist,sey I fit play any kind of musical instrument………..

una need to see as the girl just happy she come open door com outside full

Wow you mean you can play music instruments very.well…..she ask


not just very well am a professional an expert for that……….I sweet mouth join


Wowwwww!!!!! Please can i have your contact please I would like you to come to my show this evening,even the state governor will be there,its a very big show please promise me you will be there…..she pleaded


Oh! Boy I tell una say I go make am for Lagos I tell una say I be baba for the girls chai if I fit make this one my babe e mean say I don turn rich man be that……

So we exchanged contact after I promised her that I will come to her show


Chai I rush enter bank go cash 30k nahim I use go buy food items put for house

Later in the day after I don chop sleep,watch TV sotey I come tire nahim I go carry wall clock hold for hand dey look time ……
Ooooo!!! make four nack nah




3;30 pkam I rush enter bathing room go baff after that nahim I come remember say I nor get any suit at all
Better idea enter my head so I quickly run go sentino house since him be banker e mean say suit go full every wia…
But as I nok na one fine babe like that wey wear bom short open door I guess na sentino girlfriend

chai the girl over make sense i Iook am sotey I come forget watin carry me come
She just close door as I no talk anything na look I just dey look am

Sentino later tie rapper come outside na den I comfirm say my bros dey do assignment


Bros thank gawd say you neffa go work oo….I greet


Abi na I for won go but my babe Maya just land from her mupsi side from katakata , so I decided to waya small nah!!


baddoo I dey feel you bros abeg you fit borrow me any of your well ironed suit
abeg e get one interview like that wey just surface

Chai sentino na sure guy as him carry one better suit gimme……

3:45 I don already dey road,e no tey before I reach the big gigantic hall wia the show hold omo no be small show be that oooo
Come see big big men car full every wia Chia to buy car come dey hungry me but na keke I take come sha
I enter hall after the bouncer grant me entrance when I show them the iv card wey the babe don gimme earlier
Every wia don full gbimm as I enter,every wia just dey smell rich rich

I stand dey look befor I sight her coming to wia I dey stand with better smile for her face…
She hug me as she reach wia I stand omo this babe too make sense pass Maya sef ..Chai e go sure for me oooo

She carry me go wia her Parents seat down
Nahim she come introduce me as her very good friend say I be multinational instrumentalist
Chai my head come dey swell as I shake hand with both him ma’le and pa'le dem

Him papa na rich man oo because na two bouncer and two soldier dey stand for him back as body guard…

The girl later carry me go another sit na for dia we sit down dey gist before the stupid MC come call her up for stage say make she come perform
She excuse her self as she waka go stage omo come see clapping

She carry microphone,,,,thank u thank u everybody am glad you all came this show ...this evenin i wont be perfoming alone ,there is a very good friend of mine who is an instrumentalist ,both of us will be doing it together to night I will do the singing while he would be playing the keyboard


Please ladies and gentle men help me to welcome YOUNGZUBI !!!!!!!!!!!!!

chai shiit catch me wia I sit down omo I don enter am today

I tell the girl say my name na youngzubi earlier base on say spana go dey local

People begin clap mesef I follow them dey clap infact na my own loud pass

She wait wait and wait for wia I nor even stand up
Nahim she come use her hand come drag me go stage

Omo I go seatdown for wia the key board dey nahim the girl come whisper for my ear say her voice dey for F key

Chai cold sweat catch me as I sitdown dey look the keyboard dey wonder why the white keys come long pass the black keys,how i won take see F keys for this plenty keys wey full every wia i wonder oo

Zubi start now …..she shout

Chai I don die oo!!for my life I never touch keyboard before but I gather mind press one key

Piaaaa!!!!!!!!,the whole speaker shout chai hot we we catch me instanta

I press black one

Poowwwww!!!!!!!!



Zubi be serious now stop playing with the key board….she talk


I come gather mind us all strength take press the whole keys both white and black together..
Chai una no go like hear the sound wey the thing make as my village people shout issa awa work oo!! for my head

the girl vex trowey mic and run go down the stage
Omo fear catch me infact I begin dey drop we we for sentino trouser as I sight the girl papa soldier as them dey climb stage come meet me with vex……


Na watin I go do oooo!!!!! Gbese le oo!

9 Likes

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by saraphina(f): 6:51pm On Jul 12, 2018
you go do frog jump tire......

1 Like 2 Shares

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (51) (Reply)

1985.... 1987.... 2014--[a Crime Story] / "Ocean Of Secrets" A Story By Millieademi / An Evening With Eva (2013 Triple Award Winner in Crime. Thriller. Action.)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 117
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.