Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,624 members, 7,809,321 topics. Date: Friday, 26 April 2024 at 07:47 AM

Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) - Literature (3) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) (61757 Views)

Water Strike- A Comedy (18+) / FRESH Toto(adventure Of Prick Master And Miss Young Toto? / Innocent Ilo Wins 2020 Commonwealth Short-story For African Region (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (22) (Reply) (Go Down)

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:16am On Aug 15, 2018
Watch out for episode 17
coming soon live on WWE raw vs smack down!!!
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Sensitivity1254: 8:10am On Aug 15, 2018
He no ban SARS o. He only ordered that their operation structure be overhauled. But the Transmission to Transition IGP just renamed SARS FSARS


okafor200:
Abeg una been don hear the latest news now make dey trend online?

Say osinbanjo don ban sars from operating for this our country

ahhhhhh the tin sweet me no be lie
chaiiiiii wetin those sars people
don do many guys ehhhh

u go pity for dem
now we fit waka in peace and we no go dey fear again
thank God for osibanjo

abeg make una tell buhari make travel out of the country
abeg tell am make him no bother to come back again
we no need am
we dey ok with osinbanjo
if the news been sweet u ehh
abeg drop ur comments

chaiiii bye bye for sars men

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 11:16am On Aug 15, 2018
Episode 17(WWE SMACK DOWN VS RAW LIVE ON HD)

OBOY RUMOURS HOTEL DON ENTER ONE CHANCE O

as e take be ehhh
people won laugh scatter chair for here o
mogbe! O! baba don faint

but we been con dey see say ambulance don rush dey carry baba dey run go hospital

ahhhh one man con shout
why dem no leave am make him kukuma die from the faint

chaiiii people hate baba o

as tins con take dey happen for here everybody just dey laugh dey happy

omo na so one bros run declare free food and drinks for everybody

ahhh see enjoyment
we just dey pray the next news make we go hear na say baba don die

chaii here go turn to christmas celebration
the whole nigeria go declare free public holiday
so make everybody dey happy

naso we here breaking news

A DOCTOR IS BEEN CHARGED TO COURT FOR ATEMPTED MURDER

people con dey wonder wetin happen
naso we hear say as baba faint
nahim one of the doctors make dey treat baba for the hospital vex run go dey press baba neck

dey shout say him go kill am today
oboy na by the help of other doctors and nurse nahim make dem free baba from the guy strong hand

chaiii see o even doctors self dey vex o
chaiii this one na smack down vs raw?

But wetin con dey surprise us be say dem charge the doctor go court

me con reason am say e be like say this doctor dey support PDP

the doctor won help dem kill am so dem fit easily win for the next upcoming election for 2019

chaiii so PDP VS APC don turn
SMACK DOWN VS RAW

but how we go take watch this fight for HD LIVE?

as i dey reason am
naso we see waiter dem carry book and biro go meet that man make order free food and drinks for everybody

dem con tell am oga abeg no vex
but the tin be say that incident make happen between we and small doctor
we no won repeat the same mistake again

chaiii u remember wen small doctor go stupidly declare free drinks for show where people make come pass 1 million people,
now small doctor don run no body see him back
wen he hear say one bottle gon na 18k naira upwards

chaiiii naso rumours hotel take loose 240 million for all the free drinks dem share give people

oboy dem no waist time collect money sharp sharp from this man hand o

but the money na 600k

but as e take be for here ehhh guys dem dey flex
at least thank God say person surely go help us kill baba physically and aggresively

naso we con later hear for news
say dem don fly baba out of the country with immediate effect

chaiii see bad luck o
why dem no just end this man life once and for all self

ahhhh see narrow excape
ok no wahala

as tins con dey bubble
and dj dey play music
oboy naso people con dey dance
omo small party don start o

chaiii all because say dem for nearly help us kill baba

before we know
rumours hotel custormercareline con dey ring!

Chaiii who be that mad man make dey call self?

as the girl pick am we hear shout for the phone

na thunder go fire all of una make dey rumours hotel

so na una go add fire may make the man make dey interview baba use am vex give baba slap abi?

Ok no wahala i dey come for all of una

ahhhhh as people con hear am naso dem para the more

see come o who be this mad man or whatever u call ur self
ur papa left yansh there
na we u dey threaten here for rumours?
Abi u won die before ur time?
No go try us o
or else u go lick chicken yansh

chaiii everybody con dey laugh
make we no send am jor
abeg cut that useless foolish caller

as dem won cut the call ehhh
naso the person shout u know i be?
I be the INSPECTOR GENERAL FOR THE WHOLE NIGERIAN ARMY

ahhhhhh as we hear am ehhh
see run chaiiiii rumours hotel scatter everybody bob

see race
u say wetin inspector wetin

nobody stay to ask the man 2 times who him be
oboy before 1 minutes rumours hotel empty
even bouncers dem na dem first run go outside

ahhhh who won die?
The man con dey still dey say hello hello
hello

nobody dey to dey answer am na, everybody don find their levels run

chaiii naso we dey fear reach?
Ahhhhh the way people take run ehhhh surprise me o

the way one babe take fly our table ehhh everybody fear

the babe jump like frog
naso the next tin ehhh we see
the babe don cross express dey run dey go house

ahhhhh everybody follow am see running
u won wait make the GENERAL GIVE ORDER FOR ARMY BARRACKS MAKE DEM COME PACK EVERYBODY FOR RUMOURS HOTEL?

who won wait?
Who get mind to face ARMY?

Oboy rumours hotel dry under 2 minutes no single sound again inside

chaiiiiii 2face baba don enter one chance o

ahhh the way dem go take question am ehhh
na that time him go know say
JESUS IS LORD

but u know say na half kilo my guy nahim go bring that rumours hotel custormercare line come
so make people use am take call the interview their hotline

ahhhhh
life go tire 2face this time o
chaiiiii abeg make we dey pray for 2face baba so him go fit survive this one alive

if not naso we go hear say this is the end of rumours hotel festac lagos

chaiii dem fit vex shut down the hotel

watch out for episode 18
coming soon live on hd
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:41pm On Aug 15, 2018
Episode 18(LIVE ON HD)



chaiii 2face don suffer
before we know ehhh the news don reach 2face ear

ahhhh baba shout i don die o
wetin i go do o
nairalanders abeg make una advice me o
ahh this people don put me for one chance o

naso one 2face guy con tell am say baba no fear no be u been dey sing say notin dey happen?

2face con answer am abeg o now ehh sometin don dey happen o

chaiii rumours hotel don dry nobody dey there again
and this baba wahala make dem push me enter so me i go fit survive am?

ahhh who go save me o?

2face guy con tell am say no fear
make we go meet one cele prophet

him go fit help u
naso the guy carry 2baba dey go meet one strong prophet

as dem reach the place
the prophet just dey laugh like mad man

ahhhh 2face surprise why this man dey laugh like this na wetin happen?

Hmmmmm 2face i know why u came here to meet me today
i have seen all ur problems before u even stepped ur legs into this place

no worry i go cure all ur proplems just relax
na me dem dey call the mighty one
the ever strongest prophet in the whole nigeria
no fear again i dey ur side

2face con say thank u baba
thank u very much
i appreciate

the prophet con say make 2face lie down him won do small sacrifice for am say nigerian government dem go forget the matter

sharp sharp 2face lie down
naso the man enter inside
as him come outside ehhh him carry 2 big long bamboo cane

as him show face ehhh
2face run go outside dey shout
ewole! O! Ahhh this man won kill me o?

Say me i no do again o

na that 2face guy nahim rush go hold 2face for outside con dey tell am say na ur only hope of say nigerian government go forget and die this matter be this o

or else if u want make dem sue u go federal court
u no say ur own don done be that

u better accept this man sacrifice anyhow e go be o
u be man na be strong notin dey happen

hmmmm 2face con think am
con say i go try am since na my last hope be this no wahala

naso 2face con rush go inside again con tell the prophet say him don ready

the prophet con tell am oya lie down flat and face the ground and close ur eyes

sharp sharp naso 2face obey am

before we know ehhh the man pour water for 2face back as him lie down so

chaiiii wetin be this

naso the prophet start to dey shout some incantations

odumego ojukwu
ukwu nnwa owerri
super bakasi yansh
ashanti kotoko of ghana
fifa world cup
cronaldo don go juventus
madrid go smell fowl yansh this season
mikel don go marry white woman
ighalo don make us comot for world cup
the super yansh of bibi294
half kilo ur father go die!
egabnsadghds
ggahjhjjjskkssrr
raeararraarararrarararar
brasmkiiiiisytrsraeraroooooobbo
bavasyshgfsyyyyyy
ghsggshhsysyyyyyyyy
yahoozeeeeeeeeeeeee

the prophet just dey talk rubish
which kind incantations be all this one self?

Wetin consine us with say ronaldo don go juventus

Ahhhhh see flogging
gbosa! For 2face back

baba shout chaiiii abeg o
say him no do again

dem wipe baba another one
2face shout
filomina
as i know me now
that was a fuckingggggg mistake

chaiii the cane won run 2baba mad

ahhhh the third stroke enter chaiiiii
baba shout come o na heaven i dey abi na hell

ahhh the prophet flog 2baba craze
chaiii
the flogging ehhh tear all 2baba cloth
see as baba con naked dey shout all him back don red dey bleed

ahhh this prophet sabi flog o
dem train dem to dey flog like this?
2baba con dey cry
ahhhhh my own don done today o
chaiiiii na thunder go fire all of una make follow call that interview

see wetin una don push me enter
naso the prophet flog 2baba 24 hot strokes of better bamboo cane

2baba no fit stand up again o
nahim guy con carry am say dem won dey go

the cele prophet con tell dem say dem go see peace
him don flog that badluck comot for 2face life

notin like government issues again
make dem no fear

as the guy carry 2face come outside from the prophet house

naso 2face phone ring!
2baba no fit even talk hello self baba don weak

the only tin make 2baba hear be say u are wanted in the nigerian army barracks ojo cantonment

immediately 2baba faint
ahhhh naso him guy rush am dey go hospital
chaiiii is this the end of 2baba

upon say that prophet don flog craze comot for 2baba head still yet he is wanted by force by fire for army cantonment for questioning

chaiii 2baba own don really done o

abeg make una dey pray for 2baba o
because the way i been dey see am ehhh baba never even see anytin self

chaiii naso me and my guy half kilo con go lodge for one hotel make dem dey call new planet close to okokomaiko side

ahhhh but our mind no still rest o
wat if dem con declare my guy half kilo wanted?
Chaiii wetin we go con do na?
Oboy na to relocate go cotonue nahim we go do next o

abeg Make we dey pray for 2face o

baba life dey in danger o
but as e take be ehhh
notin dey happen shey be na wetin 2face dey always sing abi?

But now ehhh e be like say sometin don dey happen o

watch out for episode 19 coming soon!
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 1:40pm On Aug 15, 2018
All my tori readers i won say very big welcome to una
me i no dey complain abt anytin like comments again o
as e take be ehh
una fit come here read as una want no problem

but as tins take be for here make we just dey jolly dey happy

man life na only once make we no go use daily stress die young o

we need jokes make go fit dey make us laugh na

anyhow e go be i still dey here for una
one love my people
baba olowo the long prick say so

even guest dem una welcome o
abeg make una take seat for front row hahhahahahahaaaaaaahhhhhaaaa a grin

1 Like

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by adefajosekayo(m): 5:11pm On Aug 15, 2018
brodally you skente
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 5:46pm On Aug 15, 2018
adefajosekayo:
brodally you skente

thank u broderlly
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 6:13pm On Aug 15, 2018
I fit still drop episode 19 maybe this night sha
but anyhow e go be i go let una know
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:59am On Aug 16, 2018
Abeg all my tori readers dem, please o i apologies for yesterday night
after wen me go watch madrid vs athlectico
and me i con go support madrid
chaiiii the tin vex me no be small as dem con loose

as e con take be ehhh
i no con get the moral to compose episode 19 again

anyhow e go be sha i go still drop am today
ahhhh i halla madrid wen be say c ronaldo no dey again
chaiiii very bad market
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Danavast(m): 5:27pm On Aug 16, 2018
keep it up bro
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 6:07pm On Aug 16, 2018
Episode 19(oboy see as i take exchange pikin with condom)



as e take be for this our way ehh
2face now dey hospital

now dem the army cantonment make order say make 2face come their barracks immediately con dey hear news say 2baba don faint and him dey hospital for treatment

naso dem the army dem send some of their higher rank staffs
make dem go meet 2face for hospital go tell am say na just play dem dey follow am play o

as the news reach 2face ear
ahhh 2baba shout chaiii which kind play be this one na?

Ahh see as una don make my heart cut o
sotey i been dey reason to go commit suicide self

chaiiii see 2baba self dey fear like mad man o

before a week self the matter don die no body remember am again
naso rumours hotel take resume their business again everybody start to dey come back as usual notin dey happen

but where me and my guy dey na for new planet hotel okokomaiko side
so we no fit just rush dey come back rumours hotel

but anyhow sha this hotel make sense die

babes dem still full here
guys dem dey high
music dey go on

naso me and my guy half kilo like so we con reason some babes for there

we don agree for the amount make we been go pay dem
na to just enter room go finish work nahim remain

naso me i rush go outside say i won go buy condom

as i come outside
i con see one small boy make just hang around for there

naso i call am o
come help me buy something
for that aboki shop

nahim the pikin ask me bros abeg wetin be that?

Help me buy condom for that shop

the pikin ask me how many?

I tell am 9 packet

ahhh the pikin shout na for one girl?

Yes na
abi u no know say na fire down me i dey so

me dey vex like this now
so help me run buy am make i finish this babe

today na today

as i con bring out 1000 naira give the pikin

sharp sharp the pikin run dey go buy am

me con sidon one side dey wait

but as e con take be ehhh i don wait like 5 minutes i been no see the pikin

ahh me con dey wonder wetin dey happen na

but i still bone dey wait am

oboy na so i wait o reach 30 minutes

chaiii this one don turn another tin o

naso i waka go front go find the pikin

as i dey go one guy con call me come say
guy i been see u dey give one small boy money make him help u go buy sometin

i con tell am say yes o but i dey find the pikin now

naso the guy tell me say as e take be ehhh make i just forget the money

i con ask am why na?
Baba laugh chaiiiii
pikin where be say hungry won kill
make dem dey always come here dey beg for money make dem go use go chop food nahim i carry free money give so

chaiii i don die
which kind mistake be this one na
ahhh na like this here take be?

Oboy see awoof money make i carry dash this pikin o

chaiii if i catch that pikin ehh wetin i go use him eye see ehhh

as i been dey reason the pikin dey vex chaiii wetin be this

oboy naso one other small pikin come meet me for i stand dey reason

con tell me say make i send am na go buy the tin for me
say him go rush go buy am now now come

me don know say na e go be all this begging boys dem
e be like say the other pikin make
carry my money run
go don tell am say me i be mugu for the area

make him self con chop me na

ahhh i con reason am
i no get money for hand here again o

but me i wise
naso i tell am u know wetin just follow me go that aboki shop


the pikin con follow me go

naso i tell the aboki
give me 9 packet of condom there
u know wetin?
me no hold money for here
but this pikin make stand here so i go use am do collateral so if i enter inside new planet

me go go bring the money con give u sharp sharp

as the aboki rush give me the 9 packet of condom gba!

I con tell the pikin stay here i dey go bring money come and i go find u sometin

the pikin shine teeth say bros thank u o!

As i enter new planet oboy i forget the pikin there o

chaiii so dem won use my brain abi?

Me na wise man na

by the time dat aboki beat craze comot for that pikin head ehh
e go go call him second come

oboy see as i take exchange the pikin with condom o

chaiii laugh won kill me!cheesy

Anyway na way o since dem won play my intelligence

as i fall in new planet hotel
me i forget the matter self

i rush go enter dey blow dem the babes dem
me no even send the pikin with the aboki self

abi dem won find me enter new planet
abi dem no know how here take big reach?

Oboy i blow the babes dem reach 3 hours

naso me i relax dey sleep self
as i still dey sleep my phone con ring

na who be this? I ask
My guy oboy enter con shout for phone wetin happen na where i dey na?

say my anty been dey ask of me na

chaiii i con tell am say me i dey new planet like this
before this week runs out i go show face for there

the next tin make i hear na
youngzubi dey still disturb that my anty daughter mercy

ahh but this time ehh baba don blow o

him now dey carry better ride dey come check out the girl

but anyhow e go be make i come back so make we gather youngzubi beat craze comot for him head

watch out for episode 20
(youngzubi don blow o)
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 6:23pm On Aug 16, 2018
Danavast:
keep it up bro

ahhh thank u brother
now i know say una dey really appreciate my efforts
abeg this tin no really easy o

if u won know say this tin no really easy abeg just try compose like 5 episodes in a day

my brother i tell u say ur brain will never be the same again

chaiii the kind headache make go dey worry u ehhh no go be here

anyhow sha me go still dey try to dey drop more episodes for una

a very big thank u to everybody
its still ur boy baba olowo the long prickcheesy
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by adefajosekayo(m): 6:51pm On Aug 16, 2018
baba me pidgin movement on point this one sweet pass english tori
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:56pm On Aug 16, 2018
adefajosekayo:
baba me pidgin movement on point this one sweet pass english tori

naso my nigga
we dey for the same movement
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:38am On Aug 17, 2018
Watch out for episode 20
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 2:18pm On Aug 17, 2018
Episode 20(youngzubi don blow o)


chaiii see as life take be for myside?

Ahhh so youngzubi don finally blow o

i been think say e go be that fight make me and youngzubi been fight that time

make davido and 2face bet 10million each nahim make youngzubi hammer so

oya na we go later see who be the baba for the area na

as me been dey reason am

chaiii wetin i see next surprise me

as i come out side for the compound of new planet hotel

naso i con dey hear guys dey shout dey hail person

baba u too much
u be big shoe
notin do u

baba o,baba o,baba o

ahh me con dey wonder who go be this one o

as i reach there oboy
na youngzubi dem dey hail o
chaiii baba just acquire one bad ride so

bugati veron 2018 model

ahhh mad won catch me

me i no know wen i run for where i dey go hug am

as i rush go hug am youngzubi been won fall my hand o

but as a guy make him be na
e just rush hug me back

as e be say everybody self dey watch us dey happy

so no room for falling hand

chaii me i shout baba God make bless u go bless me too

youngzubi con shout amen o my brother
ur blessing dey on the way
no fear

me i con reply am say no be
no fear
my own version of this na fear not

me as i dey here so me i get mind die baba
abeg just show me the way
me no mind
because anyway na way o

ahhh naso youngzubi start to dey laugh hard
hahahahhahahhaaacheesy

con tell me say guy u funny ocheesy

so anyway na way abicheesy
chaiii naso o
ahh u will surely get there broderly

i tell am amen o
but me no go always dey say amen everyday like say na food

me i need to dey also work towards am na

no be by claiming amen
but na by to achieve am o
wetin be the reason foreign white people dey achieve pass nigerians?
Upon say no be everybody there dey go church go shout amen

but nigeria here na almost the whole population here dey go church
but still yet wetin con make us be one of the poorest economy in the whole world?

Youngzubi laughcheesy
guy u get point there na true talk u talk o

but as e take be ehh
make i forget am
say make we just flex small
then later we go discuss

make him see how e go be
so him go fit link me up for the business say me self go blow in no time at all

ahhh my mind sweet o
so finally me self go soon hammer better money like youngzubi

chaiii me i no fit wait again o

naso youngzubi shout free drinks for everybody here

ahhh see as guys dey collect drinks dey high

baba use 2 better champaine worth 200k naira each take watch the ride

baba spend 400k naira just to watch the ride
chaii see money o

ahhh youngzubi don blow
baba now na big boy
babes dem just dey round am dey hug am up and down

ohh my sweet heart i really love u so much

imagine babes make youngzubi never see for him life before o dey tell am say dem love am

oboy notin money no fit do o

naso youngzubi para
spray 500,000 naira up
chaiiii see as people dey fight for money

expecially dem those babes ohh

as him see say that one no reach dem

youngzubi spray another one
this time na 1,000,000 naira

ahh people mental
wetin be this

ahhh me i no know wether make i dey happy abi make i just dey cry

see guy make e be say we think say e no fit blow for life
now baba don get 2018 bugatti veron latest model

now we been hear say youngzubi buy house 250 million self join am

chaiii see too much money

me self go hustle reach that level o
but how e won take happen na?
Which way dey for me na?

See babes dem just surround yongzubi
dey massage baba dey kiss am like say na their boyfriend o

as everywhere dey hot so
naso we hear one babe shout for the other babe

please excuse me why are u holding on to youngzubi like that?
As if u only want him for urself?

Naso the other babe con reply am
hmmm the last time i checked i thought u have a boyfriend?


Chaiiii laugh won kill me cheesy
ahhh see two babes make dem get boyfriends come here dey drag for youngzubi o

before we know ehh
one babe give the other one hot slap gbosa!

Chaiii wetin be this
ahhh mogbe see fight

oboy see as people dey saperate dem
but dem no gree o
see as dem just won naked theirself for new planet hotel because of youngzubi

youngzubi just dey laugh like mad man

na wen one ugly bouncer show face ehhh

him no even saperate dem
the bouncer just stand dey look dem

as the two babes dem sight the bouncer self
oboy no body tell dem make dem saperate them selfs o

chaiii see as that bouncer ugly face take fear dem reach

anyhow sha guys no even send dem selfs
everybody dey high
dj con dey play this kiss daniel latest music
baba o


ahhh see money talking

naso we see the man make get new planet hotel come outside come greet youngzubi

dey hail am baba
u be the man

youngzubi con reply am
dele na my boy
dele na my boy

if u come my house u go see my toys

ahhh everybody shout youngzubi na you be the man now

oboy me i never see person make shut down new planet hotel before

oboy youngzubi shut down new planet with drinks
sotey dem need go outside go carry drinks dey come inside

watch out for episode 21

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:46pm On Aug 18, 2018
Happy weekend to everyone
watch out for episode 21
very soon
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 8:34pm On Aug 20, 2018
Sorry for the delay for droping episode 21
really got light isues here o

abeg make una no vex o
its been a while now
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 6:19am On Aug 22, 2018
Bugatti veron 2018 latest model
incase u go need am
abeg go ask youngzubi how much him buy e own

happy sallah to all my niggas
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:52am On Aug 22, 2018
Episode 21( finally official youngzubi don blowcheesy)

abeg all my tori readers abeg make una no vex for the late episode 21, my area been get serious light issues here and my phone been dey down since

any how sha we still dey for new planet hotel here dey enjoy our guy youngzubi make just blow
baba hammer better money!

now here dey bubble
people just dey happy for baba youngzubi

as i dey reason as i go take go apologies to all my tori readers for nairaland
naso one guy just tap me

guy wetin happen na?

I con tell am say which one be wetin happen?

The guy con say but i think say u been follow youngzubi talk say una go discuss small business matter before him go?

Naso i tell the guy ehhhhh
wetin con consine u for the matter?

Ahh the guy shout
youngzubi don move o

i say move as how?

Naso the guy yan me say youngzubi don bob
baba don go house

chaiii me i shout i don die
wetin be this?

Naso the guy reply me
na mallam u dey tell o?
I dey come

the guy leave me waka comot

chaiii so youngzubi don comot and me no know
how manage na?

Ahhh the tin pain me

as we still dey new planet hotel

naso one guy con dey shout

happy sallah! happy sallah!
happy sallah! happy sallah!

Before i know ehhh
half kilo my guy con shout

na thunder go fire u fire happy sallah!

Chaiii laugh won kill mecheesy

ur father prick there
idiot

ahhh me won laugh kill my self
i con dey reason am wetin make half kilo dey para like this na

half kilo con still continue to dey yab the guy make dey shout happy sallah!

take am again there ur papa yansh

u just dey na to dey shout happy sallah nahim u sabi do like say u be ram

u no fit just declare free drinks for ur guys dem as youngzubi take do?

Abi u be mad man for here?

Chaiii the guy make half kilo dey yab con para

this guy dey mad?
wetin consine u with my happy sallah!
Make i dey shout o?

How the happy sallah take affect u na?

Half kilo con yan the guy
e be like say ur mama get bone leg abi?

Here be like ball house where u fit just come dey shout anytin make u like abi?

E be like say u get mental problem abi?

But anyhow sha na thunder go fire u for there
i go still talk am again
ur father yansh for there

chaiii see fight
oboy see as people dey saperate dem o

ahhh halfkilo dey vex
me self dey follow saperate dem o because i know say if dem leave halfkilo with the guy one on one ehhh
halfkilo go carry only one teeth go house

anyhow sha we con saperate dem

naso halfkilo para give the guy
if to say na rumours hotel u dey ehh
dem for don carry u go trowey comot from fence go outside

chaiii laugh won kill mecheesy

one other short guy con say
na lie jor
why dem go carry a whole person trowey comot from fence say wetin happen

dem no go even open gate before dem trowey the person?
Na lie jor

ahhh before we know ehhh
halfkilo sound craze comot for the short guy head gbosa!

Chaiii see another fight o!
Oboy new planet scattercheesy

wetin be this

guys dem don high
now na to dey show power

but why e con be say na my guy halfkilo dey start all this wahala self?

Me i be gentle guy o
me no like fight but as e take be ehhh
i need stand for am
after all youngzubi don fall my hand and me i dey para like this

oboy see fight o
halfkilo my guy dey exchange blow with the short guy

before we know ehh
halfkilo see himself for outside gate of new planet hotel gbosa!

Ahhh wetin happen?

Where my guy go?

People con dey wonder wetin happen

naso the short guy con dey shout u know who i be

emi omo bale pikin
jazzman

ahhh abi the guy don jazz my guy halfkilo

as we con dey reason am
naso we dey hear shout for outside new planet hotel

ahhh wetin happen again o
as we rush come outside oboy we see my guy halfkilo dey fight with one other tall guy again o

ahhh wetin be this na?
Naso one woman just start to dey explain wetin happen o

say the tall guy na okada man o make just dey drive e own dey go o

naso my guy halfkilo run give the man spear on top him bike gbosa like say dem get wahala before?

Oboy naso fight start o
ahhh wetin be this?

As we con dey saperate dem o
that other short guy make been fight halfkilo before

con dey laugh
hahaaaaahahhahahahahahaacheesy
mad man u go fight tire today
me i don jazz u like this o

shey be na me u won fight abi?

Oboy see as outside of the hotel
people full just dey saperate fight

as dem still dey talk wetin happen
naso one mad man just dey pass e own dey go o

naso my guy halkilo rush the mad man give am better spear for bele like say na WWE RAW VS SMACK DOWN

chaiii laugh won kill mecheesy
wetin be this

oboy see another fight o
ahhh
omo the mad man no gree o

oboy see as people dey saperate dem
chaiii see fight

na wen dem dey fight
nahim we con know say that mad man no really be mad o!

Na normal person make just dey claim mad man for the area since for how many years

chaiii the truth of the mad man come outside that day o

oboy see wahala
mad man business don spoil o
laugh won kill mecheesy


watch out for episode 22
coming soon live on Hdcheesy
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 8:16am On Aug 22, 2018
Oboy see as my guy halfkilo don spoil person business make dey claim mad man for the area since

the mad man na normal person o
but due to say baba no get work
him have to divert enter mad man business o

now my guy halfkilo don spoil him work for am
how e go take explain this one to everybody o

chaii episode 22 coming soon
una go laugh tire
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 1:55pm On Aug 22, 2018
Episode 22 (halfkilo my guy don really mad o)



as e take be for here ehhh
me i confuse o why my guy halfkilo just dey fight anybody make him see na

chaiii as we dey saperate him and the mad man

naso one guy shout
come o na mad man u dey follow fight so?

Oboy the mad man answer the guy o

na ur papa be mad man there
i be like person make mad for ur eye?
Abi u dey craze?

Ahhh everybody shock chaiii
wetin be this

so u no be mad man before abi?

Oboy people make been dey saperate dem before
naso dem catch the mad man ehhh

dem rush beat craze comot for him head

chaiii me i confuse

why na?

Oboy see beating
so na u be that mad man make dey rape people for the area abi?

oboy as dem dey beat craze comot for the mad man
naso my guy halfkilo run with full speed enter street

ahhh the mad man make people dey beat con shout abeg o me i no be mad man o

see that guy make run so
nahim be the mad man o

before i know ehh
naso dem leave the mad man o
start to dey pursue my guy halfkilo

ahhh see as people dey pursue halfkilo my guy for back

even the mad man self go find rope dey pursue my guy make dem tire am with the rope

as dem dey pursue am
naso my guy halfkilo run divert enter one mosque where some muslim people dey pray to celebrate their sallah

oboy as halfkilo rush enter gba!
the next tin make we see na matured men dem dey fly come outside from window ewole!
See race!

chaiii laugh won kill mecheesy

oboy mosque scatter

chaiii see race

one alhaji fly from window enter gotta gbosa!

One tin make surprise me pass na their women

omo na dem the women get speed pass o

the way mosque take scatter ehhh fear the alfha make dey there

oboy alfha pick race fly comot from window

as the alpha dey run dey shout
naso my guy halfkilo pursue am like mad man

ahhh omo na that day i know say alfha dem get speed o

halfkilo no see the alfha back
alfha bob enter street

as alpha run come outside
oboy see comotion for the street o

naso people carry rope pursue the alfha dem think say the alfha don mad

as dem won catch am say make dem tire am rope

oboy like so dem look their back
ahhh mogbe! Dem shout
na my guy half kilo dey run dey come their side with full speed
ahhhhhhhhhh

oboy no body wait o
dem leave the alpha pick race
as one guy just run enter the next street ehhh

naso we hear gbosa!
Ahhh people shout

omo we no believe say okada don jam the guy

laugh won kill mecheesy

chaiii wetin dey happen here

halfkilo my guy still dey pursue the alfha with full speed dey go anywhere baba run go

ahhh see as large crowd dey follow them for back

abeg make una help us hold am o
abeg o the alfha get typhoid for body o
that alfha no well o
na sick man him be o

but i con dey reason am
so the alpha no even well self
but how manage him con get this kind speed dey run like antelop

oboy before we know ehh
alfha and halfkilo run pass one police check point

chaiii see as police dem trowey gun
wen dem sight crowd make dey run towards their direction

see as police abandon their checking point pick better race

both the once where go jam person make dey drive bicycle dey go him own o

chaii see confusion for the area

me i won laugh kill my selfcheesy
even people make dey pursue dem everybody just dey laughcheesy

but dem still dey pursue halfkilo and that alfha

chaiii wetin be this

the alfha dey shout
help me o!
help me o!
I don die today o!

Before we know ehhh
my guy halfkilo fly give the alfha better spear for back gbosa!

Ahhh the alfha fly enter person shop make dey sell mama put beans and bread

the alfha fly enter scatter both people make dey chop their beans and bread

we no wait a seconds as the alfha fly enter

oboy see as matured men make been dey inside dey chop before run come outside with full speed everybody ewole o!

See race from different angles

chaiii both the ones make thief person bike take run

no body just understand wetin dey happen self

chaiiii laugh won kill mecheesy

wetin be this

ahhh na wen we enter the mama put shop
naso we see the alfha don faint

ahhh as we won carry the alfha up

oboy the speed make the alfha take wake up ehhh fear everybody o

the alfha stand up ehhh pick race fly come outside gbosa!

Everybody make been dey wait outside dem pick better race!

chaiii the way the alfha take rush come outside ehhh fear people o

see as crowd dem divert go different directions

na who go run pass na wetin we go call this one o

the way one woman take leave her 3 years old pikin pick race self funny me o

chaiii one man make been dey preach for street with microphone

oboy we no see the man again o
but we only see him microphone and loudspeaker for ground

baba bob pick race

chaiii the alfha run fly person fence enter compoud where be say na 5 bull dogs dem get
dem dey roam about for broad day light

ahhh the tin surprise us as dem the bull dog no see alfha catch

baba get speed die
chaiii the owner of the bull dogs con dey shame for him dogs dem

watch out for episode 23
coming soon live on Hdcheesy

1 Like

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 2:19pm On Aug 22, 2018
Abeg o happy sallah to all my running muslim friends

halfkilo fall on u!
Na to pick race remain o!

Episode 23 comimg soon

1 Like 1 Share

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 5:54pm On Aug 22, 2018
I fit still maybe drop episode 23 this night o

but if una want am this night make una let me know by saying
baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Nobody: 8:04am On Aug 23, 2018
okafor200:
Abeg all my tori readers dem, please o i apologies for yesterday night
after wen me go watch madrid vs athlectico
and me i con go support madrid
chaiiii the tin vex me no be small as dem con loose

as e con take be ehhh
i no con get the moral to compose episode 19 again

anyhow e go be sha i go still drop am today
ahhhh i halla madrid wen be say c ronaldo no dey again
chaiiii very bad market
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Nobody: 8:06am On Aug 23, 2018
okafor200:
Abeg all my tori readers dem, please o i apologies for yesterday night
after wen me go watch madrid vs athlectico
and me i con go support madrid
chaiiii the tin vex me no be small as dem con loose

as e con take be ehhh
i no con get the moral to compose episode 19 agai

anyhow e go be sha i go still drop am today
ahhhh i halla madrid wen be say c ronaldo no dey again
chaiiii very bad market
you dey support madrid? on ur own you dey. cr7 don leave the team. t
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 10:44pm On Aug 23, 2018
Episode 23 coming soon
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:02pm On Aug 24, 2018
Happy sallah celebrations to everybody here

i hope say una dey catch better fun
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Nobody: 3:34pm On Aug 24, 2018
Keep it up, just be Good with Your pidgin !!!, Youngzubi have already told you what to do...
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by pradoic(m): 5:37pm On Aug 24, 2018
long prick where u enter
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:56am On Aug 26, 2018
pradoic:
long prick where u enter

my nigga me i dey o
but na sallah tins we still dey flex here o
anyhow sha me go soon find time update una more sweet episodes
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 8:32am On Aug 26, 2018
I been dey reason say today na sunday morning

but i dey my house here they play tory lanez audio track shooters

ahhhh this song dey give me big joy chaiii
me i really love this song
its for all my niggas in the house

abeg u fit go search for the song for google.com and download am

tory lanez ) shooters

u go feel the vibes of the music

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (22) (Reply)

Rhoda / African Nerd / Out Of The Blue

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 141
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.