₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,324,986 members, 8,419,833 topics. Date: Thursday, 04 June 2026 at 12:51 AM

Toggle theme

Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up - Culture - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralCultureSome Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up (70193 Views)

1 2 3 4 5 6 7 8 Reply (Go Down)

Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Hujosi(op): 5:18pm On Oct 05, 2018
Nyash no get teeth but e dey cut shìt.

Person wey de sell egg, no dey start fight for market

Shame nor dey catch craze man, na him people shame dey catch..

Pikin wey play with him mama bress, no fit play with him papa blockos

This life na per head.

Farm for your farm.

Pregnant woman no fit pass under bench

Pikin wey wan chop party rice, no supposed to dey fear dance.

Lean on me no mean say make you push me enter wall

I no get patience no be when mosquito land on your scrotum

Hunger dey take long time but to belleful no dey take minutes

Woman wey dey find pikin,no dey wear pant sleep.



Add yours..
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by linearity: 5:24pm On Oct 05, 2018
make I park here, come check my brakes.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by basmur(m): 5:32pm On Oct 05, 2018
pikin wey say him mama no go sleep, him sef no go close eye
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Supreme01: 5:34pm On Oct 05, 2018
flies were no hear word the follow death body enter grave.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Rubbiish(m): 5:42pm On Oct 05, 2018
Lol...Quite funny d first & last one
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by fk001(m): 5:49pm On Oct 05, 2018
Hilarious



Breeze don blow fowl yansh grin
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by jayokoye: 6:06pm On Oct 05, 2018
Everything up there is funny cheesy especially the last one cool




Hujosi check your mail bro
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Lordbucci2: 7:06pm On Oct 05, 2018
Person wey dey force shit, no dey laff...
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by mezarddinny: 7:30pm On Oct 05, 2018
Supreme01:
flies were no hear word the follow death body enter grave.
wtf is this bro angry
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by acenazt: 7:33pm On Oct 05, 2018
Pikin no dey measure blockos with him papa.

Naked man no fit put hand for pocket.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Nobody:
Make i chop their money small...na so olosho take start

It's a small world no mean say you fit trekk am

No be today yansh get centre parting grin grin

Person wey dey sell sheet no gree say sheet dey smell

Dem no dey tell blind man say rain dey fall

Dem dey count meat kpomo self dey raise hand

Sidon look na dog name grin
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by jojothegreat(m):
E don tey wey ynash dey Back.

Road bend no mean say we go Bend waka.

Big belle no mean big man.

No food for lazy man,no be for pikin wey him mama dey sell food.

Air condition na just fan wey get phd.

Them say make sickness stand up,kraw kraw sef dey smile.

No matter how room dark,man go still locate woman bress.

Custard Na just akamu wey school for abroad!

To craze no hard,na the trekking be wahala.

Person wey too tey for party,dey follow wash plate.

You no need cutlery to chop slap

If mad man done bite you once,next time wey u see machanic you go take off!

Pikin wey won follow him papa solve family problems, bald head go shame am!
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by JonnyConnection: 8:56pm On Oct 05, 2018
lipsrsealed
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Waffarianman(m): 9:02pm On Oct 05, 2018
Who Dey Shake Coconut Nai E Head E Dey Shake. Lol
Dog No Get Head Wen Take Dey Carry Load, Na Who Get Load Dey Carry E Load. Lol
Dog Wen Dey Shaze Elephant Na Emsef E Dey Worry. Lol
Na Who Dey Pursuit Foul Nai Dey Fall, all our enemies go fall behind us. Lol
Na Who Arranged wood nai go carry E wood. Lol

More Loading
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by ahnie: 9:08pm On Oct 05, 2018
As goat take stand for market Na so customers take de price am.




Atall atall Na im bad past!
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by lapazi(m): 10:19pm On Oct 05, 2018
Chop alone and die alone!!!

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Nobody: 10:24pm On Oct 05, 2018
Na because house collapse na him make fowl fit climb roof grin
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by pansophist(m):
I run for lion no mean say I go run from him shhit

Snake pikin go always long

Na condition make crayfish bend

Na the same water wey fish de swim dem de use cook am

Mad man wey no de hear word de understand beating
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Nobody: 10:31pm On Oct 05, 2018
lapazi:
Chop alone and die alone!!!
Madman grin and you had to use Ambodes picture to prove your point grin

Werey
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Olifiz(m): 11:08pm On Oct 05, 2018
morningstar55:
Make i chop their money small...na so olosho take start

It's a small world no mean say you fit trekk am

No be today yansh get centre parting grin grin

Person wey dey sell sheet no gree say sheet dey smell

Dem no dey tell blind man say rain dey fall

Dem dey count meat kpomo self dey raise hand

Sidon look na dog name grin
Who is this guy lol
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Lordbucci2: 11:52pm On Oct 05, 2018
Person wey dey force shit no dey laff
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Lordbucci2: 11:54pm On Oct 05, 2018
Who dey mat no dey fear fall..
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by emmiesky(m): 12:33am On Oct 06, 2018
Pikin wey no know him mama boyfriend, na him dey call am uncle

Stone wey roll, na person push am.

Half bread is better than puff-puff
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by hpymoment(f): 1:24am On Oct 06, 2018
morningstar55:
Make i chop their money small...na so olosho take start

It's a small world no mean say you fit trekk am

No be today yansh get centre parting grin grin

Person wey dey sell sheet no gree say sheet dey smell

Dem no dey tell blind man say rain dey fall

Dem dey count meat kpomo self dey raise hand

Sidon look na dog name grin
I love this
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Nobody: 1:32am On Oct 06, 2018
jojothegreat:
E don tey wey ynash dey Back.

Road bend no mean say we go Bend waka.

Big belle no mean big man.

No matter how room dark,man go still locate woman bress.

Custard Na just akamu wey school for abroad!

To craze no hard,na the trekking be wahala.

Person wey too tey for party,dey follow wash plate.

You no need cutlery to chop slap

If mad man done bite you once,next time wey u see machanic you go take off!

Pikin wey won follow him papa solve family problems, bald head go shame am!
This is funny
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Nobody: 3:27am On Oct 06, 2018
No be today yansh dey for back

Escort me, escort me Na so slave trade start

Make we leave matter for Matthias

If you think say you get strong head, go head-butt cement

Man wey naked no dey put hand for pocket

Make chicken run from Lagos go Abuja e go still end up for pot of soup

Today’s newspaper be tomorrow’s suya wrapper


Cow wey dey in a hurry to go America go come back as corn beef

Akara and moin moin get the same parent na wetin dey pass tru make dem diffrent

NO matterhow dark room wan be, man go still locate woman breast.

Wetin concern agbero with overload?

If life dey show you pepper my guy make pepper soup

If person too tey for party e go follow dem wash plate

No matter how hot your tempa be,e no fit boil beans.

Every mallam with em own kettle, every aboki with em own radio.

Fly wey no get special adviser na im dey folow dead bodi enta grave

Today cassava fit be tomorrow garri
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by odogwunaija(m): 4:03am On Oct 06, 2018
Toto water small but e dey baff prick

Fuckup no be soup, e no dey sour

Feel at home na em dey mk person spoil remote

Person wey read na em try pass but person wen pass na em sabi book.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by xtivin2: 5:25am On Oct 06, 2018
Na small shi_t dey stain pant grin grin grin
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by cliper230(m): 10:29am On Oct 06, 2018
Who wan die no dey get sense
1 2 3 4 5 6 7 8 Reply

Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know?Some Interesting Nigerian Proverbs With PicturesProverbs From The Streets Of Warri234

Masquerade, Ajeron, Cleanses Ajegunle Of Coronavirus (Photos)I Am 'Osu', My Girlfriend's Parents Rejected Me Because Of That - Man RevealsAny Man Who Sleeps With Ooni's Ex-Queen Will Die If Not Cleansed - Ifa Priest