Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,634 members, 7,809,370 topics. Date: Friday, 26 April 2024 at 08:25 AM

Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up - Culture (6) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up (59051 Views)

Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? / Some Interesting Nigerian Proverbs With Pictures / Proverbs From The Streets Of Warri (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply) (Go Down)

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by kennethromanus: 2:49pm On Oct 06, 2018
The person wey d gods want to kill..e go first make dat person mad..

The day wey monkey go die,.. all d branches go dey slippery..

pikin wey him mama dey sell daddawa(local maggi),.. Na him dey know fly wey get one eye..

forget about wetin dem write for motor body enter motor,..my brother even ambulance?..

1 Like

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by labelle123(f): 2:50pm On Oct 06, 2018
No condition is permanent no be for breast wey don't fall




Dey no say make pikin no get big, teeth but make him equally get big lips use cover am

1 Like

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by enonche85(m): 3:04pm On Oct 06, 2018
Na "No" dey cause problem.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by NotNairalandi(m): 3:08pm On Oct 06, 2018
grin
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Jgovt(m): 3:17pm On Oct 06, 2018
Nor be eye wey you take chop Eba you take dy share meat o

Respect who get but fear who Neva collect o

Monkey smart monkey smart na cox tree near tree

Belly nor be show glass

I fear police nor mean say I go fear the of ordinary uniform o

My own nor be our own o

1 Like 1 Share

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by flange: 3:19pm On Oct 06, 2018
Dem no Dey do good dey cry for backyard

Person wey shit Dey forget but the person wey pack am no Dey forget

1 Like

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by mtngloetiartel: 3:19pm On Oct 06, 2018
linearity:
make I park here, come check my brakes.
meaning i come read comments
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by nNEOo(m): 3:36pm On Oct 06, 2018
OdikwaRisky:

Akara and moin moin get the same parent na wetin dey pass tru make dem diffrent





One passed through water , the other, through fire....

Nice
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by dagreat4(f): 3:38pm On Oct 06, 2018
Na from clap dance de start

You no need to stay person house till Dem begin cook yam head give u before you go no say time to go Don reach

He goat frown no go make person wet want buy am no price am

E n Gud e no gud but e de epp.

Okro no de tall pass d owner.

Water yam na yam.

I get am before no b property.

Fly wet no de hear word na him de follow dead body enter grave
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by dagreat4(f): 3:39pm On Oct 06, 2018
Na from clap dance de start

You no need to stay person house till Dem begin cook yam head give u before you go no say time to go Don reach

He goat frown no go make person wet want buy am no price am

E n Gud e no gud but e de epp.

Okro no de tall pass d owner.

Water yam na yam.

I get am before no b property.

Fly wey no de hear word na him de follow dead body enter grave .

1 Like

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by kindnyce(m): 3:43pm On Oct 06, 2018
As Goat Stand for market, na so dem dey take price am!

1 Like

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by 24enjay(m): 3:53pm On Oct 06, 2018
Na my house I dey na him dey always start statement for police station

5 Likes

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by WIZDOM081(m): 3:59pm On Oct 06, 2018
I get am before no dey part of property
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Festy4u(m): 4:06pm On Oct 06, 2018
Instead of full cow to loss make you cut the tail!
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by badcompany: 4:10pm On Oct 06, 2018
Trigger be like Mercy Johnson breast, e no hard to squeeze.
Pikin we say e mama no go rest, na orphanage fit am.
wahala be like bicycle, e no hard to start.
monkey smart, na cos tree near tree.

1 Like 1 Share

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Azam101: 4:34pm On Oct 06, 2018
Man no dey drink ogogoro smile.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by WOCKHARDI(m): 4:34pm On Oct 06, 2018
Soldier come, soldier go, barrack tanda.
On parade, nothing concern center rank with "Open order".

Mad man say him get many things to do plus the madness wey him go mad. grin
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by seagulsntrawler: 5:02pm On Oct 06, 2018
Hilarious,
Pikin wey carry bald head come this life, na headache go worry am die
Monkey sabi jump from tree to tree but na the one wey near pass he fit take do amgringringrin

1 Like

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by WarriFirstBorn(m): 5:08pm On Oct 06, 2018
E go better, e go better, na igbo man take stay Lagos tey.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Oju4190: 5:09pm On Oct 06, 2018
U won learn lefty for old age
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Cindy08: 5:11pm On Oct 06, 2018
Kakie no be leather
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by azpekuliar: 5:27pm On Oct 06, 2018
Na d day U kill mad man u go know say e get family.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by akezn: 5:31pm On Oct 06, 2018
woman when dey find pikin no dey wear pant sleep.

feel at home, feel at home na im visitor take dey spoil remote.

Person when no dey hear English dey hear come chop.

Do you know who I am, do u know who I am na im holdup take dey start.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Nobody: 6:01pm On Oct 06, 2018
Lordbucci2:
Person wey dey force shit, no dey laff...
Lol grin kolo like you, see where your mind go. Warri, o na dey represent everywhere. Make I still drop mine. Man must wack, at all at all nihim bad.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Nobody: 6:04pm On Oct 06, 2018
morningstar55:
Make i chop their money small...na so olosho take start

It's a small world no mean say you fit trekk am

No be today yansh get centre parting grin grin

Person wey dey sell sheet no gree say sheet dey smell

Dem no dey tell blind man say rain dey fall

Dem dey count meat kpomo self dey raise hand

Sidon look na dog name grin
grin grin grin grin grin grin the first one making me laugh my ass out.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Mcreloaded(m): 6:06pm On Oct 06, 2018
Because cowmeat dey hungry me I go come see cow come dey call am brother
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by dcncorniels: 6:07pm On Oct 06, 2018
dog wen wan lost no dey hear d owna wistle


cut meat, cut meat, na for cow body


sheep wey dey follow dog waka go chop poo


eye wey open na it sand dey pour
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by cheftea: 6:31pm On Oct 06, 2018
Cut meat cut meat all na for cow body

Atall atall na winch

No be who run first dey win race

If u grow finish u go wait for ur mate

The world small no mean say dangote dy your backyard

If u finish run u go jam am tomorrow

No be who read pass they pass exam

Tomorrow bright no mean say if u see apain way u no go follow

Good child good child no mean say person good

The more u dy look the less u dy see

Pikin way no sabi fight no dy look for trouble

Wetin person way old see if u like climb palm tree u no go see am.



Abeg all na wash wetin work for me fit fall ur hand.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by Nobody: 6:31pm On Oct 06, 2018
The youth wey think pvc na im salvation na buhari go remind say na plastic #modified
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by eme1n(m): 7:09pm On Oct 06, 2018
Water wey touch prick must surely touch blokos!

1 Like 1 Share

Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by rachels: 7:12pm On Oct 06, 2018
I don die oh, person were die no dey talk. they no dey tell spoon say dey Soup dey hot.
Re: Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up by mcmukoko12(m): 7:27pm On Oct 06, 2018
After the man don marry him wife, he discover say him lekwele or working stick no function again.

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply)

Olu Of Warri Hangs Out With FIFA Officials At Qatar (pics) / Sanu Nku Jamaa [Hausa-speaking thread] / Naming In Urhobo Culture: Meanings And Significance

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 23
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.