₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,833 members, 8,447,287 topics. Date: Saturday, 18 July 2026 at 02:55 AM

Toggle theme

Ranoscky's Posts

Nairaland ForumRanoscky's ProfileRanoscky's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 185 186 187 188 189 190 191 192 193 (of 216 pages)

TV/MoviesRe: Your Best Movie Quotes by Ranoscky(m): 4:43pm On Jul 18, 2010
hey! i'm 9inchies tall, i only see d up side! G-force.  (what a funny movie)
RomanceRe: She Says 'choose Between Me And Football' by Ranoscky(m): 4:01pm On Jul 18, 2010
gurls na'em dey cause more damage to dia sef in d name of claiming right time to be with dia man.
just lyk a gurl said "if we deny u guys azz u guys wil go crazy. now u don't wanna spend som quality tym with her" if u no give me azz i go meet person wey go give me. even give me better style pass as u dey give me. afterall we'r not yet married. u dey cras for nyash dia. sad @Op, u did d right thing jare, no b lie u. dis is just friendship and she's acting shaddy. what if u com marry her? na'em be say she go turn u to zombie husband. u'll never watch football unless she ask u to! a gurl is surpose to know when her bf needs a private tym. anytym ma mum is watching her favourit programme on tv u dare not even come and disturb her talkless of changing d station. but if she know's dat we want to watch football match, no matter d programme, she'll xcuss us. same with ma gf. we can talk on phone for 2-3hrs but terms of football all she'll do is ask me when the match will b over, and when i tell her, she'll never disturb/call me again until dat or after dat tym i told her. but @op, i no com understand your gurl way in terms of football. so many gurls dey giv dia bf break when a football match is on but your gurl's shaddy act tire me o. maybe she's doz kinda gurls dat like's acting "the boy is mine, i can do whatever i want." Omo mhen, if na doz type make u free her now dat it's stil early o, b4 it get's too late b'cos if u marry dat type put for house make u know say u don use ur money buy wahala put for house. she go turn u to house boy! do u know dat d only tym i was harsh on ma gf was when nigeria lost to argentina at d just concluded W.C in S.A? but stil, despite d harsh, she was stil tryna console me and was telling it's just a mere football match dat i should not be angry. talkless of make my gf no allow me watch football match. shey na madness? huh
PoliticsRe: Akala Evacuates 120 Beggars From Major Roads by Ranoscky(m): 2:21pm On Jul 18, 2010
@Oloritinu, u make sence die for dat your post jare. @Global-D, u just finish d whole tin up! u guys r perfectly correct!

b4 u know it, after election and every-every, u go hear say 120 beggers don turn to 120 dead body! POLIRITUALS! sad
PoliticsRe: Halliburton Scam: 49 Lawyers Sue Efcc For ‘protecting’ Obasanjo by Ranoscky(m): 1:33pm On Jul 18, 2010
se bai la se maa ma wo?
PoliticsRe: Kidnapped Lulu's Mother In Abia State by Ranoscky(m): 1:19pm On Jul 18, 2010
Lulu where u dey na? undecided go settle doz guys make dem leave your mama for u na? abi u no wan spend money? undecided

*how i wish doz kidnappers no go bring down d demanding offer so dat, dat bas-tard go know how e dey pain 4 body*
RomanceRe: Toasting Lines You Used To Use In The Olden Days by Ranoscky(m): 12:14pm On Jul 18, 2010
I remember toastin a gurl inside a bus when coming back from school back then. cool while the bus was stil far away b4 it get's to my bus-stop and after all the secondary school flow and yanings omo mehn, dis gurl no dey talk well o. undecided so i started saying some funny things dat'll make her laugh (b'cos back den, gurls dey like guys wey dey make dem laff well-well) but stil dis gurl bone. sad when the bus was gettin close to my bus-stop where i'll get down, na dat time dis gurl com start to dey respond fine o sad (but how i go take com down from d bus wey she has only told me her name and she has not yet told me her home address?) undecided omo mhen, i bone ma bus-stop o. i com flow with dis gurl til we reach the last bustop. den, she has told me her home address and direction on how to come. (but how i go take go back now? and i no get xtra money to take another bus comback to ma bustop) b4 i know wetin dey happen, Omo mhen i don dey trek 1hr 30mnt journey back to ma bustop under the HOT sun shocked with better hunger wey dey catch me dat time eh. . . embarassed ah, Omo mhen, I wan vex DIE! huh  FOOL!!! sad
FamilyRe: Whats Ur Opinion On Adoption? by Ranoscky(m): 10:57am On Jul 18, 2010
*took a deep sigh*

I'v read enough on this thread and i'm somehow disapointed on @kobikwelu post.
are u tryna say dat adaption is an evil idea or what?. . .i don't just understand how some peeps reason dis days.
@op, the problem is, whatever the situation maybe, just know that GOD still exist. but since u said u still have faith
in GOD and at the moment, u need an adopted child while waiting for GOD's miracle on when you'll have ur own
biological child, i don't think their's a big deal on it! the problem their is, are u ready to love and take good care of the baby just like ur own biological child?. .why i asked dis question is b'cos, such children are so important to take good of.

The father of ma x-GF married two wives. the first wife was the mother of ma x-GF, while the 2nd wife was the mother of two other children. boy and gurl. but do u believe that i had a very serious quarell with ma GF and stopped going to her home, why? b'cos i don't like the she and her siblings treat doz other two children. and i told her never to talk to me again. tho, later on we both reconcile but, why hate the 2nd wife's children at d 1st place?
CultureRe: How Do You Define A Nigerian? by Ranoscky(m): 9:00am On Jul 18, 2010
E ma tan ra yin!

so long as ur paleh n maleh na naija citizen, if dem like make dem born u for pluto, Ogbeni, u'r a NIGERIAN!!! finito!
FoodRe: Have You Ever "stolen" From The Cooking Pot? by Ranoscky(m): 8:40am On Jul 18, 2010
O'boy, me i no dey slack for dat kyn level at all oh.

I remember 1 december time like dat wey my mum prepare dis stew wey i dey tell u, omo mehn, waa gba. D smell of d stew na DIE. n na different kyn of meat na'em mhale take prepare dis stew wey i dey tell u. we just finished eatin so we com dey for parlour dey watch christmas movie. omo mehn, where i dey, i no concentrate on d movie at all. my mind just dey 4 dat stew, b4 u know it, i just stand up, stroll go room. from dia i walker like rat enter kitchen go mo dis meat wey i dey tell u. E com b say d meat wey i take na very big 1 n if i put'am 4 mouth omo, d tin go choke me 4 throat, so na'em i say make i dey use teeth dey bite'am small-small till e finish. Omo mhen, my 1st bite wey i bite dis meat com spread pepper enter my eye oh. shocked O'boy, d pain too na DIE! i wan shout, i say NO! if i shout na fukk up. na'em be say i don koba mysef be dat, but wetin i go do na, i no fit open eye find water take wash my face and d pain too much i no fit bear'am anymore, Omo, na'em i SHOUT for dis SHOUT wey i dey tell u eh, b4 my siblings with ma mumsy com show, com jam d meat for ma hand. with my christmas cloth sef (white) wey i wear all stain with stew. ah, omo mhen, e better make i koba mysef oh, dan make pepper to blind ma eye oh! later ma peeps com wash ma face with water com change another cloth for me, but later, d beaten wey i recieve from my mumsy eh. . .omo mhen, d beaten no dey here oh! i loose 4 things for dat christmas. (1) i no chop d meat again. (2) pepper enter ma eye. (3) stew stain my fine christmas cloth. and (4) i recieve beaten wey pass beaten from mhale! i no sure weda na d birth of jesus i celebrate dat time sef b'cos, i no get mysef again after den. dat was ma worst christmas expirience as a kid! ***ah, small pikin sha, na wa O!***
FoodRe: Have You Ever "stolen" From The Cooking Pot? by Ranoscky(m): 6:45am On Jul 18, 2010
I steal meat from my cousine house wella no be small. grin  (Ah, doz dayz mehnnnnn. small pikin xpirience!)

u no go blame me b'cos if u sef c d kyn orishi-rishi meat wey dem (ma cousine) dey take cook dia soup eh shocked Omo mehn, NA DIE! u sef go steal, no be lie! and if dem catch u com ask u y u steal d meat? even without shame and in boldness, u go tell dem say make dem no vex say u don try make u no steal d meat but d meat dey tempt u and d tempting is annouying! Omo mehn, anytime wey i go dia com jam dia pot of soup i no dey slack oh, so tey, e get to a stage wey be say i com dey chop'am enter parlour sef with confidence. if dem ask me wetin i dey chop? i go tell dem d 'koko' say na meat and i take'am from pot of soup! so ma cousine mumsy go come even tell her children make dem go make eba for me den warm d soup make i chop! u call it stealing while i call tempting! Omo mehn, na true yan brov, no be storyland. but dat was den sha, small pikin expirience!!!  Ah! but @OP, y u bring up dis topic na? undecided as i dey type dis thing so i don dey miss dat pot of soup again!!! sad
Nairaland GeneralRe: What Motivates You? by Ranoscky(m): 4:57pm On Jul 17, 2010
my lil sister really! i love her to tha bone that i can go an xtra mile just to see her happy!!!
CelebritiesRe: Nigerian Parents Wants Aki & Pawpaw Banned From Nollywood by Ranoscky(m): 4:31pm On Jul 17, 2010
@Edicolove

I don't think that's a reasonable idea for parents blaming aki n pawpaw for the corrption of their children.

they (the parents) should all be jailed for giving birth to children when they know they can't take care of them!
TV/MoviesRe: Ghana Slams $1,000 Fee On Nigerian Actors by Ranoscky(m): 6:20pm On Jul 11, 2010
@sir kay

First of all, i'll say thank u for your word of advice on your previous post. secondly, i think pafuri started it again by saying. . ."That way we could have learned first hand what the 'BAS-TARDS' are doing to damage whatever good name their fatherland still has." Now what has bas-tard gat to do after a peaceful word of advice from u? don't u think such person enjoy's beefing some1?
CareerRe: She Sacked Me because Am A Lesbian by Ranoscky(m): 5:35pm On Jul 11, 2010
^^^ grin grin grin so u mean say U.S na sodom and gomorah? grin
TV/MoviesRe: Who Is The Funniest In Nollywood? by Ranoscky(m): 2:41pm On Jul 11, 2010
*yawns*. . .i no dig dis una topic at all o, e no ginger my swagger at all. but all the same sha, all join!

if u ask me i'll say Osuofia is the man, others are the boys! *leaves the thread for another immediately*
TV/MoviesRe: Ghana Slams $1,000 Fee On Nigerian Actors by Ranoscky(m): 1:29pm On Jul 11, 2010
mba, nolu dia koba asili. e je na lahula, Aturu awusa!
CelebritiesRe: Nigerian Parents Wants Aki & Pawpaw Banned From Nollywood by Ranoscky(m): 10:21am On Jul 11, 2010
mscheeew!!!. . . Flawbish xcusses from Flawbish parents!  

if they know they'r not ready to take good care of their children, then why give birth to them?

now they'r putting the blame on Aki N paw paw as the cause of the corruption to their children. NONSENCE!!! sad
SportsRe: Spain Vs Netherlands: 1 - 0 @ World Cup 2010 Final by Ranoscky(m): 7:45am On Jul 11, 2010
some1 was saying that paul the octupus predicted in favour of the oranges to be tha champions buh i don't think it's true. i think the octupus predicted in favour of the spanish. buh, all the same, weather Holland wins or spain wins, all i know is, Van persie vs Farbregas, Gurnnaz 4 life!!!
CultureRe: What Would You Say Is The Best Thing About Living In Nigeria by Ranoscky(m): 6:53am On Jul 11, 2010
^^^ Feel u brov, i know what u'r goin thru buh, i decide to make dat comment cos of what @mr Anus commented on his post. the only thing i agreed on his post was "nepa" but the other once na "iro." there's no country on this planet that u won't find armed robber's and area boys (touts). in conclusion, he then said he feels fine over there in new york, he's tryna let us know that he's in U.S. ya, good for him buh shey US na heaven? undecided so that was y i said i also feel good, relaxed here in NIGERIAN and I feel so happy to be a flygerian. very, very, very PROUD to be a citizen of the GREEN pasport! and i'll never, i repeat NEVER EVER deny ma country naija for any other country!  to me, naija just be like marraige in front of the alter. weather Nigeria is in good condition or not, better or worse, rich or poor, i'll always REP that country naija to the FULLEST.  Flygerian till INFINITY!!!
RomanceRe: Is It Degrading To 'toast' A Girl? by Ranoscky(m): 12:14pm On Jul 10, 2010
^^^ Oga~madam, how ur own no be na? which 1 u no dey? u be man abi u be woman?

if u be man correct ur mistake for ur profile. thanx!
TV/MoviesRe: Top Ten Movies That Make You Cry by Ranoscky(m): 9:24am On Jul 10, 2010
South africa world cup 2010. Nigeria vs Greece. what an Emotional soccer movie!
TV/MoviesRe: Ghana Slams $1,000 Fee On Nigerian Actors by Ranoscky(m): 9:00am On Jul 10, 2010
^^^ Hotest part of HELL my broda, No be lie u talk!
CultureRe: What Would You Say Is The Best Thing About Living In Nigeria by Ranoscky(m): 8:26am On Jul 10, 2010
Arm robbers, no light, enough area boys, ole dey, HELL YES!!!

I'm stil fine here in Naija!!! Feels good to be a citizen of the GREEN pasport!!! Imma flygerian!
RomanceRe: Just When I Wanted To Propose by Ranoscky(m): 6:29am On Jul 10, 2010
This topic stil dey exist? undecided
PhonesRe: The Most Annoying Phone by Ranoscky(m): 4:33pm On Jul 08, 2010
but wait 1st O! una dey try O! so una dey even check/remember model number of phone wey una dey use?. . .ha, una dey try gan. my own be say, if i see any phone wey fine and i want buy'am, na only that time wey i want buy'am na'em i go remember the model #, immediately i commot from where i buy'am, ma guy, if u ask me for the model #, i go just carry the phone give u make u check'am urself. but another phone wey worry me again na SENDO X! ya wa phone! sad
PhonesRe: The Most Annoying Phone by Ranoscky(m): 4:20pm On Jul 08, 2010
As i remember that useless Alcatel now saf i don dey vex! sad
PhonesRe: The Most Annoying Phone by Ranoscky(m): 4:18pm On Jul 08, 2010
mine was 1 useless but beautiful and portable Alcatel. that phone na odemental to the core that i gat to dash it out to avoid more anger! huh
RomanceRe: Is It Degrading To 'toast' A Girl? by Ranoscky(m): 4:00pm On Jul 08, 2010
@Muggle, how u take see that prayer of a thing? grin grin grin. . .chai! pipu funny die O! grin
PoliticsRe: Pastor Okotie Blasts Jonathan Over Soccer Ban Reversal by Ranoscky(m): 3:54pm On Jul 08, 2010
^^^ True talk brov, no be lie!
Music/RadioRe: Kelly Hansome Presents 'P.i.m p My Room' Show by Ranoscky(m): 2:24pm On Jul 08, 2010
^^^ That was where i reside before i built my own duplex where i reside now! cool
FamilyRe: How Is Your Wife Or Hubby Coping With You Snoring! by Ranoscky(m): 2:20pm On Jul 08, 2010
^^^ very easy! just look for a very strong 'fufu' (akpu) to block the nose and that's the end of the sneezing! 4real!
Music/RadioRe: Kelly Hansome Presents 'P.i.m p My Room' Show by Ranoscky(m): 2:02pm On Jul 08, 2010
How can dey be an igwe if dem no be NWA AFOR? . . .no mind dem jare, dem just dey make noise!
dem say no do no do but E biago ozor, it's another hot one from love-vendor ma room! u get mouth jare, nothing do u!

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 185 186 187 188 189 190 191 192 193 (of 216 pages)