Sistajay's Posts
Nairaland Forum › Sistajay's Profile › Sistajay's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 68 69 70 71 72 (of 72 pages)
Abeg my brother make you move along and forget de girl, the girl parents don sey no. Wetin you fit do eh? I only hope your girl don't end up like me o, my parents still dey wait for man to come take me off their hands. |
Men sabi lie even though they know sey you know na lie dey talk and some na compulsive lair dey go cover one lie with another lie. For us women when we talk our own lie we are so convincing, you no go know sey na lie we dey talk. |
My sista how your man fit talk marriage wen im no get work, house. For now na only love im get to give you and dat no go pay for de rent and all de other things in life. Some people fit meet today and marry tomorrow, e depends on the couples. No forget your biological clock dey tick everyday o, na only you fit decide wetin you wan do for here. |
@ Faketan Why you no start new post to find where the northerns dey? you know sey Nairaland is open to all. |
Change go come one day, make una no give up HOPE. Plenty hard work, sweat, tears, blood and prayers go make Naija beta one day. |
If you no dey happy for your own skin by all means change it. De problem started with most of our naija men wanting light skin women. For me sha black is beautiful. |
Which one concern us if our black sistas dey follow oyinbo man. Man na man what ever color im be. |
Abeg make you no come start holy war for here o by asking which one dey more powerful the Bible or the Qur'an. The christian man go talk say na the Bible dey more powerful and the moslem man go talk say the Qur'an dey more powerful. If you set fire to either one of de holy books dey go BURN because na paper dey take make them. |
Na for broken english we dey say "next tomorrow" but for proper english na "the day after tomorrow" |
Na wa oo are we back to school? |
Tell me what has bald head got to do with marriage. For most women they find bald head guys very sexy. |