Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,091 members, 7,814,797 topics. Date: Wednesday, 01 May 2024 at 08:03 PM

Arsenal Mata Na Helele - European Football (EPL, UEFA, La Liga) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / European Football (EPL, UEFA, La Liga) / Arsenal Mata Na Helele (453 Views)

David Silva 'two Or Three Levels' Above Juan Mata And Santi Cazorla / Juan Mata Vs Santi Carzola / Article: Mata's Omission From The Spain Squad Is A Big Mistake (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Arsenal Mata Na Helele by Livermeka: 6:12pm On Dec 13, 2012
Arsenal dem don suffa one of d woss difit for dem Histori as Bradford City wey dey Lig 2 carry dem do yeye ,come win for penariti afta dem bin draw 1-1 for d quata-final on Tuesday.

Gunners dem rekod dis season be d woss wey dem don eva get for Premeir Lig fsnce Arsene Wenger collect di work, but tori get k-leg now as e don bad reach wey be say pesin no fit shout oh!

The kain wowo match wey dem play go vex even dem supporter, and d woss part sef, be say d team wey dem play dey Ingiland dem difision 4.

Arsene Wenger clean shame comot for im face talk say im boys dem try well well say no be dem fault, e come talk say na so game dey, say dem try for d 120 minut wey dem play d game " We bin try, but we lose, we go stand up, dust bodi take prepare for we next match" Wenger bin relate.

Bradford Coachee Phil Parkinson sef jolly no be small, d way im dance garala wey final wisil go pass be careful, im talk say im boys try well well, " d discipline wey we put take defend craze no be small, and as per say na Arsenal, na im sweet belle pass" Parkinson talk.

Na Bradford score fess, Garry Thompson carry beta shot wey enter Arsenal net as d gunners bin no clear ball comot for d 16 minute, Arsenal sef vex come dey pepper Bradford house and na for 88 minute Thomas Vermalean take equalise, for arsenal cari d match enter extra time.

Extra time come be push me, i push you, still d two team no fit add to dem gol, d match come shif enta penarity.

Bradford come win 3-2 for penarity come rob mud for Arsene Wenger face, as dey come zoom enter the semi-final od d competition



© supersport.com

http://ng.supersport.mobi/football/nigeria-naija/news/121212/Arsenal_mata_na_helele
Re: Arsenal Mata Na Helele by azeeza(f): 7:42pm On Dec 13, 2012
e don reach make una commot mouth for this arsenal mata.

(1) (Reply)

Club Or Country, Which Do You Prefer More? / Casillas Picks Ramos Over Ronaldo: Check The Full List Of Voters And Their Vote / Sparta Praha V Chelsea Today @ 7pm

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.