Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,153 members, 7,818,485 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 05:08 PM

Osaze Dey Voke For Kesh-i (osaze's Tweets In Pidgin By -ng.supersport.mobi) - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Osaze Dey Voke For Kesh-i (osaze's Tweets In Pidgin By -ng.supersport.mobi) (737 Views)

Woman Defrauds Osaze Of £70000 / Osaze Warns Keshi To Watch His Back / Osaze's Congratulatory Message To The Super Eagles (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Osaze Dey Voke For Kesh-i (osaze's Tweets In Pidgin By -ng.supersport.mobi) by Livermeka: 7:14pm On Dec 23, 2012
Osaze dey voke for Keshi

Wes Bron strika; Osaze Odemwingie don dey voke for Naija coachi, Stephen Keshi, sake of say Keshi no gree wan carri am go Nations Cup for South Africa nes year.
Osaze (hinsef don krakpo. De bros don reash 32yrs) bin rite all de raking on top twitter (@OdemwingieP na im be hin twitter name) on Sunday.

No be only Keshi Osaze voke for sef; he follow rake for NFF, former Naija coachi dem, Samson Siasia and Lars Lagerback, Eagus skippo dem and we wey dey give una dis tori sef. (e remain small maje he voke for una wey dey hia dis tori)

De playa, on top twitter (na around 12 dis aftanoon he start), tok say coachi dey do like Alibaba (he tok say coachi na comidian) dey lie, lie and as he no gree carri am go Nations Cup.

Osaze; he don bin tap beta ball for Bendel Insurance bifor (Up Bede!), even voke for some guymen wey bin dey yarn am on top twitter say make he march brake small.

"I bin sabi say dem no go gree carri me go Nations Cup. In fact, I bin sabi say Keshi and NFF no go fit get mind yarn me demsef. Dem no be beta pipu!"

"Keshi no fit tok say I no dey tap beta ball. Hin dey lie. He tok say I still dey hin mind. Coachi, you no dey my mind o!", he come laff sef.

"All dose guymen wey wan put mout fir dis matta, make dem mind diasef. Wen 2 men dey yarn, 3rd man no get mout. So Ikpeba and de res, make una yarn me una own face to face"

"All dis tin be like Nite of a tousan laff, and dem jus dey lie, lie give our sopportas dem"

"NFF tok, tok yarn MTN say I too dey pose? Me dey pose? Why our contri presido tok say he go close NFF for 2yrs?"

"Why Lagerback no carri go afta World Cup for 2010? Na becos he wan chop our pepper, waka and dem bin sabi"

"Naija pipu bin tok say na ne play pass for de while year, wen we dey play to go World Cup, but na looku-looku I do wen World Cup start and una no wan make I halla?"

"Becos I no follow yarn say Siasia don redi for Eagus afta we win Silver for Olympic, de guyman wait till dem gi am de work, come comot me?"

"Ok make we bone de small pikin yarn about jersey. Wes Bron bin tok say make I come helep dem play ogbonge match and Siasia no gree me becos of play-play match?"

"E make sense? De play-play match na for big stadyum wey 80 tousan pipu fit enta but na only 2 tousan pipu look am. Dat one na beta match?!"

"Dem no fit spoil my name o! Na im make me ass mysef--we no get beta skippo and NFF wey get sense? And settle de matta? Na wa o."

"Meanwilly, dem no come hail (Vincent) Enyeama wey be our numa one goalie for ogbonge match becos he halla about airoplane or one kin small tun like dat? Na crase."

"Dem fit tok say I no get respet but Eagus no bin get beta skippo since. All man dey tink only hin own."

"Den SWAN (pipo wey dey yarn una tori) rite NFF say make dem warn me. (Make una no vex about dat one. No be so I bin mean am). But make una sef yarn una men say make dem no dey lie-lie."

"One elda bin yarn me, afta de fess voke, say na sofli, sofli dem dey cash monkey. I no gree. I don tok my own."

"Na becos of soppota dem make dey rake like dis. Make dem know wetin dey hapin and make dem sabi say I no dey pose."

"Afta Nations Cup for Ghana our suppotas belle bin sweet and Siasia yarn me say he go carri me go Olympics."

"Dem drive Berti Vogts comot den Amodu come enta! For our fess match I no even run small sef", na im Osaze tok as he dey voke.

Osaze come follow tok say as he bin dey voje for on top twitter, one NFF oga bin call am to cuss am.

He come finish hin voking, tok say he fit waka comot for twitter sef.

"NFF persin jus hail me. Na to cuss me. I yarn am say I do sing nashonal antem, e don reash 10yrs and as dem dey do me no pure."

"Ba so dis matta finish. Tori don finish. No more tok about Eagus again. I don tok my mind finish. If e too mush I fit eaka comot for dis twitter sef", na im Osaze take end de matta
Re: Osaze Dey Voke For Kesh-i (osaze's Tweets In Pidgin By -ng.supersport.mobi) by ayusco: 7:35pm On Dec 23, 2012
grin :Dloooooooooooooooooool
Re: Osaze Dey Voke For Kesh-i (osaze's Tweets In Pidgin By -ng.supersport.mobi) by Chokolee(m): 8:03pm On Dec 23, 2012
Hahahahahahaha....No be small voke ooo, this is amplombous! Front page abeg!

(1) (Reply)

Ivory Coast Player Challenges Super Eagles On Twitter!!!!!!!!!!!!! C / Since White People Hate Lebron Should All Black Guys Support Miami / Flying Eagles Get Uruguay Test At Fifa U 20 Championship Knouckout Stage

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 25
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.