Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,193,954 members, 7,952,841 topics. Date: Thursday, 19 September 2024 at 05:15 AM

Arsene Wenger Don Ready To Do Betta Shopping - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Arsene Wenger Don Ready To Do Betta Shopping (598 Views)

Jose Mourinho Hit Hard On Arsene Wenger Again / Arsene Wenger Finishes Steven Gerrard / 60 Arsene Wenger Favourite Quotes (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Arsene Wenger Don Ready To Do Betta Shopping by Livermeka: 1:04pm On Dec 29, 2012
http://ng.supersport.mobi/football/nigeria-naija/news/121229/Wenger_ready_to_do_betta_shopping


Wenger ready to do betta shopping

Arsene Wenger dey fil say busines go dey boku for dis transfa windo wey go open, but im no go rivil wein dey im mind.
D Arsenal Manaja sef don dey eye plenti plenti playas dem ( na so amebo pipu talk oh, no b supersport.com) for d wiks wey don pass and dem bin ask am for Friday wen im siddon yarn with media pipu, say who dey shw come join d gunnas.

Wenger dey find korrect playa wey fit improf im team and e b like e go allow some playas make dem waka.

" I go dey busy" im confam. " I no even nid to talk playa mata becos una ( na media pipu b dat) dey always find dem for me.

" We go fit enta Champion Lig wit d kain playas wey we get, but we fit add join make d team solid wella, but e dey hard to find dat kain playa, market no good for dis kain time.

" Na so, e for like playa wey go show, tap beta ball, take improf we team, but e dey hard, Manchesta United buy Robin van Persie wit ogbonge 24 million pound and na 29 years im b.

" Dem get pipu wey dey look dey try find dem beta playa efriwhere for d world, dem scatta look, dem no find, dem come buy Van Persie, to find beta strika wey go dey improf Premier Lig team, score plenti plenti gol for dis kain time dey hard.

Paper pipu dem, dey do olofofo ,dey talk say Andrey Arshavin wan comot go, and e b like say Reading pipu wan carry am. Wenger sef no gbadu d gist.

" Na lie, dat one no dey road" im talk. Reading neva call me. .


© supersport.com

http://ng.supersport.mobi/football/nigeria-naija/news/121229/Wenger_ready_to_do_betta_shopping

(1) (Reply)

Chelsea's Mikel Receives Goal.comnigeria Player Of The Year Award / Leave A Word Of Apology To The SUPER EAGLES For Ever Doubting Them Vs Ivorycoast / Nigeria's Reply To Eboue....

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 13
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.