Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,969 members, 7,825,031 topics. Date: Sunday, 12 May 2024 at 12:30 AM

Yobo Don Warn Osaze - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Yobo Don Warn Osaze (536 Views)

Woman Defrauds Osaze Of £70000 / Osaze Warns Keshi To Watch His Back / Osaze's Congratulatory Message To The Super Eagles (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Yobo Don Warn Osaze by Livermeka: 1:22pm On Dec 29, 2012
Yobo don warn Osaze
http://ng.supersport.mobi/football/nigeria-naija/news/121228/Yobo_don_warn_Osaze

Naija Supa Eagus skippo, Joseph Yobo, don tok say Wes Bron playa, Osaze Odemwingie, dey do like small pikin.
Since las Sunday, Osaze don dey cuss Eagus coachi, Stephen Keshi, NFF, Yobo, tori pipu (he neva cuss us for supersport.com sha) and even pipu wey dey look ball, on top twitter, sake of say Naija no gree carri am go Nations Cup.

Yobo bin dey follow Brila Fm (radio station) yarn, from hin base for Turkey, and he tok say even tho Osaze get case, “de way he dey do de tin na im no good”.

Yobo (na Fenerbahce he dey tap ball for) come follow tok say na de 2nd time wey Osaze go cuss am be dis.

He tok say no be onli Osaze be de ogbonge skills factory wey Keshi no carri go sef.

“We suppose dey hail Keshi for dis in list. He no fit carri everibodi na. Me sef follow bow say Kalu Uche no dey de team. Obafemi Martins sef no dey. Onli our coachi fit tell us wetin dey.”

“I sabi wetin dey make Osaze vex. E be like say no be jus becos of ball make coachi no gree carri am. But de guyman no jus get respet.”

“Na Osaze dey do hinsef. He don dey follow everibodi gbege and time don reach wen he go stop to do like small pikin. Dis na de 2nd time wey he go cuss me. He suppose look hinsef na. Na so he do for 2010. He come tok ‘sorry’. He suppose know wetin dey becos hin no be ‘Messi’ of Naija. Many men wey dey tap ball like winsh don dey bifor hin come. He fit dey tok true, but no be so dem dey do am”, na im Yobo tok.

Yobo (all man rememba am for Everton, abi?) come yarn say nes year Nations Cup go be hin las one.

He tok say nes year Nations Cup go tuff well, well becos “small pikin no dey ball again”, but he wan carri de cup as na hin las one be dis.

“Small pikin no dey ball again. Who bin tink say Zambia fit win de las Nations Cup? But dem win am. We know say all man go like waya Naija.”

“I wan win dis one bad, bad. Na my las Nations Cup be dis. Time don reach for me to waka so oda pipu fit get dia shine”, na im Yobo tok.

Yobo na de playa wey don come tap ball for Naija pass; he don play for Naija 87 tines, and he fit reach 90 sef, wen Nations Cup shele for January 19.


© supersport.com
http://ng.supersport.mobi/football/nigeria-naija/news/121228/Yobo_don_warn_Osaze

(1) (Reply)

Happy Life: / Nigeria, Ghana And Zambia All Face The Same Plight In Nations Cup Opening / Do You Think There Is A Plan To Eliminate Nigeria From Afcon 2013?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.