Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,235 members, 7,818,785 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 03:17 AM

Nigeria Vs Congo Live Commentary In Pidgin English - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Nigeria Vs Congo Live Commentary In Pidgin English (1524 Views)

Caf U23 Championship Qualifier :Nigeria 0 Vs Congo 0 (Live) / Olympic Qualifier: Nigeria Vs Congo (U23) 2-1 (Full Time) / Nigeria Vs Congo : AFCON 2015 Qualifiers (2 - 3) On Saturday September 6, 2014 (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Nigeria Vs Congo Live Commentary In Pidgin English by iamkay(m): 9:37am On Sep 06, 2014
De road to enta Morocco for de 2015 Nations
cup don open yesterday, and all countri for
Africa don dey run dey find de ticket wey go
make dem enta Morocco ness year for de
competition.
Naija go sabee dia level today for Calabar as de Supa Eagus
and de Red Devils of Congo go enta de same trouser for dia
fess match for de kwalifia for ness year Nations cup.
Na Naija be de countri wey win de lass Nations cup for South
Africa, and all man don sit down wan see how de Eagus go take
start dia waka today.
Since de day wey Naija don crash kommot for dis year World
Cup, na today go be de fess day wey de Eagus go tap ball
again for any level.
Walahi, na luck na hin Congo take enta dis Nations cup kwalifia
level, becos if no be Rwanda wey do wayo, Congo for no get de
chance.
Naija and Congo don jam diasef 7 times bifor bifor for
international level, and na 3 times na hin Naija take bilala dem.
Emmanuel Emenike and Ahmed Musa na hin plenty Naija fans
go dey look say make dem waya goal for dem today, and de
man talk say na muss make hin score.
“I know say de match wey we wan follow Congo play go tough
well well, but I don readi for dem becos na muss make I score
dem,” na wetin Emenike talk be dat.
Meanwilly, Naija go try make dem win dia game against Congo
today sake of say South Africa don waka go bilala Sudan 3
kondo for dia house lass nite.
Na 5pm Naija time na hin de match go start today for Calabar.
Re: Nigeria Vs Congo Live Commentary In Pidgin English by Omero(m): 2:11pm On Sep 06, 2014
na wich stetion go show d mach?
Re: Nigeria Vs Congo Live Commentary In Pidgin English by Haywhymido(m): 5:13pm On Sep 06, 2014
Dem dey show am 4 one local channel here.wish dem best of luck

(1) (Reply)

Betting: How To Win Your Bets +18 / Surebet247 Is Anonline Betting Websiteoperating From Nigeria. To Register Or Log / Done Deal: Chelsea Complete The Signing Of Coudrado

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.