Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,520 members, 7,954,974 topics. Date: Saturday, 21 September 2024 at 01:29 PM |
Nairaland Forum / Entertainment / Literature / A Touching Story In Pidgin English, Friday And Julie (773 Views)
My Story, My Life (A Touching Story) / We Are Able(a Touching Story) / Write Your Life Story In 6 Words (2) (3) (4)
A Touching Story In Pidgin English, Friday And Julie by Iceking1(m): 3:36pm On Sep 08, 2014 |
DIS NA BIG WAHALA O! I beg, I go try make this story nor long. I want make e short like Aki and Pawpaw and also make una nor vex 4 me say i use pidgin do dis write up, i use pidgin bcus i no go skul and i nor sabi speak english . Friday dey friend Julie for more than 3 years. The time when Friday cum ready to marry Julie, nai e mama and papa send for am from village say make e come. Say, their tradition for every first boy pikin na to marry woman wey come from their village becos na royal home dem for come. And the marriage of first born pikin to indigene na criteria for person to be king. For their village, na gate by gate dem dey rotate their kingship. As Friday quarrel reach, e papa and mama give am deaf ear becos na him be their senior pikin. Dem just tell am say dem dey wait make e talk say e wan marry. As soon as e talk am, dem go give am e wife wey dem don already choose for am from small pikin. Why dem nor tell am since? E nor get right to choose e wife? Dis kain thing still dey happen for this modern age? All those question nor concern anybody. Tradition na tradition. If you flaunt am, na only you go tell your story with tears. Friday nor know how e wan take tell Julie becos e know say Julie love am as winch love to suck small pikin blood. So that day, Friday don booze any how. E say e must go meet Julie make e burst the koko for her. Where e for dey kane e big jeans, nai Julie enter e bunk. After dem don chill for sometime, nai my guy clear her the koko. The cry wey Julie cry fit reach aboki take wash gbola. Meanwhile, Julie get one backup maga, Omasan. Where Julie for dey reason how she go take continue her life, nai Omasan begin show seriousness. Omasan dey work all this their 21 days on and 7 days off work for EGTL. Like play, Omasan cum tell Julie say e wan marry her. Dem cum do marriage like January. Like March, Julie belle don full. As e tell Omasan say she get Belle, nor be small sugar Dangote pack for e belle. God cum bless dem with a baby boy. That same year nai Friday go marry e wife wey e papa don arrange for am. One year pass, no pikin. Two years pass, no pikin. Friday cum suggest make dem go for medical check up. Na for St James nai Friday for jam julie with her first son. She don eat belle full again. E be like say na antenatal she cum for that day. As Friday see the small boy, e cum dey somehow shocked base on say the pikin resemble e own younger brother well well. Friday cum tell Julie say make she try cum see am for house say dem get matter to trash as per the pikin so. Julie cum wait make her hussy travel go work before she cum agree make Friday cum see her for house. Na there Friday for tell her say make she talk true, who really give her the belle wey she take born her first boy pikin? Truly sha, that month when Friday take tell her say e nor want again, na that month e take get belle. But she notice say her menses nor flow when Omasan take come for marriage. Base on say she dey fear abortion, nai she take code the belle put am for Omasan head. So, Julie know say na friday get the pikin, Omasan, feel say na him get the pikin. Friday dey feel say na him get the pikin. The situation nai be this, TO ALL WOMEN If na you be Julie, wetin you go do? TO ALL MEN If na you be FRIDAY, wetin you go do? If na you be OMASAN, wetin you go do, if you last last hear the matter? FACTS Many first pikin for many homes, nor be the papa nai give the mama the pikin belle. ADVICE Befor you start marriage plans with your woman, try go do pregnancy test. Many Churches dey doam. But court or registry nor dey doam. As a guy man, play your card well make you nor loose. In all, those families wey dey experience this kain situation, make unu nor let the matter scatter unu marriage. Just return the pikin to e papa make unu move on. Bury the past and let it stay buried. That na my own suggestion to the family wey bring this matter cum my studio. But I tell dem to wait, say I want make pipo wey get big brain box and Solomon sense for this forum, throw their words put for the matter. Oya, make all nairalanders talk put 4 dis matter. |
Re: A Touching Story In Pidgin English, Friday And Julie by Iceking1(m): 3:39pm On Sep 08, 2014 |
Oya make d comment start to dey rush like tap water |
Re: A Touching Story In Pidgin English, Friday And Julie by constance500: 3:45pm On Sep 08, 2014 |
Summary please |
Re: A Touching Story In Pidgin English, Friday And Julie by Iceking1(m): 5:42pm On Sep 08, 2014 |
constance500: Summary please wat summary again |
(1) (Reply)
Please Return The Modification Button. / Life And Writings / Write About Your Sweet Sorrow Experience.
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 21 |