Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,226 members, 7,818,770 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 01:39 AM

Mama Jennifer, A Very Touching Story In Pidgin English - Family - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Family / Mama Jennifer, A Very Touching Story In Pidgin English (1076 Views)

PHOTOS: Driver Knocked Out Two Teeth From His Baby Mama / A Quadruple Amputee & His Girlfriend's Love Story In Pictures / Is It Wise To Allow Our Kids To Speak Pidgin English? (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Mama Jennifer, A Very Touching Story In Pidgin English by Iceking1(m): 10:44pm On Oct 27, 2014
MAMA JENNIFER
Mama Jennifer born three children for her
sailor husband.


Dem dey stay top for one storey building
for Sapele.


Anytime the husband go sea, she go dey
doke their neighbour, Femi wey be
bachelor wey dey stay bottom of the
upstair.


One time when the husband come, one
other tenant cum tell am say e dey
suspect e wife with the guy.


This thing cause serious wahala for the
compound that week befor the husband
cum go back.


That first week, mama Jennifer couple.


The second week of her husband
travelling nai she cum start to dey go
doke this guy again.


Wetin don enter person blood, e dey hard
to comot am.


This fateful night, NEPA seize light.
She don baff and feed her children. She
cum do dem make dem sleep. Befor 8 O
clock, all of dem don dey sleep.


Mama
Jennifer go kitchen, serve food for cooler,
cum off the candle, lock the parlour door.


Na so she carry key inside her husband
shirt pocket cos na her hussy shirt she
wear that night. Na so she take climb
down go meet her guy who don dey
room dey wait her since.


As usual, she lock the guy sitting room
door for inside.
She cum carry the food wey she cook go
give am for room. Rechargeable light dey
on for the room even the parlour.


The guy end the gbagba akra and hot eba
finish nai show start.
She cum pull her skirts, naked, nai she
climb bed.


As dem dey commit dey go, nai be light
wey NEPA bring. Small time nai pipo begin
shout for the compound.


Fire o!
Fire o!!
Fire o!!!
When NEPA bring light, wire spark for
inside mama Jennifer house. Fire cum
start to burn.
Smoke don full everywhere.


The three
children nor dey see. The senior one
manage reach the door, but the door dey
locked.
Compound pipo dey shout.
The fire don dey spread enter the next
flat for top.


When dem dey shout fire fire, na so
mama Jennifer jump from the guy bed.
Everybody for the compound see her
when she dey come out from the guy
house.


Befor she finally open her house door,
the three children don roast like goat for
the fire.


Na so she take faint wey dem take carry
her go hospital.


This na marriage of 15 years o.
Dem don wire message to the husband
now say see wetin happen.
The husband dey ask now
Wetin unu advice am to do.


And my pipo, wetin unu advice the
woman to do befor her hussy come?
See, if you as a woman get any reason
why you must cheat on your husband or
straff another man, I advice make you
divorce your husband first befor you go
dey sleep with your man friend which is
even bad.


I dey cum Make I go sidon near papa Jennifer to
console am.
Re: Mama Jennifer, A Very Touching Story In Pidgin English by iceberylin(m): 10:50pm On Oct 27, 2014
[size=20pt]męђŋ,ŋā şųįçįdę [/size]

1 Like

Re: Mama Jennifer, A Very Touching Story In Pidgin English by Iceking1(m): 11:17am On Oct 28, 2014
iceberylin:
[size=20pt]męђŋ,ŋā şųįçįdę [/size]

lol
Re: Mama Jennifer, A Very Touching Story In Pidgin English by prettiest1(f): 11:54am On Oct 28, 2014
Na case this one be oo.
Re: Mama Jennifer, A Very Touching Story In Pidgin English by Peejayybold(f): 12:14pm On Oct 28, 2014
Hmmm
Re: Mama Jennifer, A Very Touching Story In Pidgin English by Mamaflex(f): 4:07pm On Oct 28, 2014
Mehn! It was difficult to read though.

The story is kinda related to the one I read sometime ago. It' was about a woman who claimed she went to pick up something from her nearby shop, only to come back and met her apartment aflame. She said there was a candle light on, while the children were asleep. lipsrsealed undecided

(1) (Reply)

Why Do Ladies Change Their Phone Numbers After Marriage? / Click to Learn How To Print Out Photos From Your Phone! / Revealed

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 15
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.