Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,807 members, 7,817,341 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 10:35 AM

My experience with some hoodlums - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / My experience with some hoodlums (634 Views)

My Experience With Busayo (true Life Story) / My Experience With an Upcoming Artist (Short Story ) (2) (3) (4)

(1) (Reply)

My experience with some hoodlums by Misolex(m): 10:42am On Apr 06, 2015
24 Dec,2012

Me: Ogbeni, do fast make we dey go abeg.
Padi me: na wa for you o. Chill na time stil dey.
Me: Where you see time? e be like dem take lateness swear for u. Remember say na trekking things o and na after 8 be dis.
Padi me: ogbeni, farabale. make 10 nak.
Me: if 9 or 9:30pm don reach i go dey shift comot from hear. If u like no do fast.

Earliar dat day, i been play go ma bros house around dat kain 6pm. As i dey comot na im ma bros sama{give} me 5naira{dats 5 thousand} 2 take flenjo xmas. Na so i put am inside ma MTN wallet begin match go ma padi side.

9:48pm
Padi me: miso, oya o. Movement things.
Me: oya oya.

My padi{i no one mention in name} and i don tey. We grew up together. We attended same primary,secondary n in same tertiary institution. Me i like to dey go places early but, ma padi na d opposit of me. Confam late comer.
Na so we begin catwalk de go church that night{xmas eve program}

Hoodlums: Eyin boys, ewa. Where to?
Me: Egbon, afe sare de shursh {4give me if i no write d yoruba wella}
Hoodlums: ehen? Oya, e fi nkan le fun awon boiz
Padi me: egbon, we no get anything, dat na y we de trek sef.
Hoodlum: ehen?
Me: Egbon, mo ni #200. How far?
Hoodlum: omo-to-sure. Muwa.

I handed the money over and we departed.

Service was great. Ofcuz any program wey food yapa gats dey great.

25 Dec,2012
at 4:30am, we begin go our house. We pass dat place wey we bin encounter our senior brosses dem.
After a long walk, we finally entered our domain{area}. We walked and got to a point where we had to path ways.

Padi me: misolex, help me chek dis phone abeg. Opera mini no gri open again.
Me: make i see. Make we sidon for that shop.
Padi me: no p. I forget i for don show you the phone since.

All of a sudden....
Two thugs aproached us.

Thug1: hey, wetin una dey do hear?
Me: egbon, we jst dey come from church. We say make we chil hear
Thug2: say hear resemble OSAS ni?

Osas na relaxation spot, bar, restuarant. But we dey call all that area not jst d building Osas.

Padi me: egbon, i just say make my padi help me do something before im pass go in side.
Thug2: ehen, so u no be omo adugbo?
Me: ah! Egbon, omo SURU ni mi o.
Thug1: i dey sure say una be gay....odamiloju. So una come hear come dey run things abi?
Me: ah! No o....Gay ke
thug2: shut up before i light your face.
Padi me: eyin egbon mi. Aki n se gay.
Thug1: e b like una dey mad abi?...baba{he called d second} search dis boys. I no trust dem rara especially dis one{pointing towards me}. Come, where your bunk dey?

At this point i could'nt think of any else other than the 5naira inside my MTN wallet.

Thug1: come, you dey craze? You no one talk abi?
Me: egbon, no o. Na adedoyin ma bunk dey.
Thug1: your padi nko?
Me: na john Ade in dey stay.
Thugs: Ehen, u no STUDENT.
Me: ah! Egbon, who no no student? Pesin wey no no student never pack come dis within.
Thug1: shut up over sabi....baba{calling his fellow thug} u don search dat one?
thug2: dis one dry jare.
Thug1: na your turn. Carry your hand up.

Oh chineke.....na so 5k one take go? I pondered. I thought of running. If i try am omo na die be that.

Thug1: o boy ye. See freshness. Baba, dis boy carry o.
Me: bros abeg, no be my own.
Thug1: i talk am. So u gbab the money from pesin, no be so?
Me: no o. Na... na...
Thug2: you won lie bah?
Thug1: see guys, make una dey go. Make we self hold dis one take celebrate xmas.
Oya...come dey go.

Na so we begin waka comot like mumu bt wetin we for fit do?

Padi me: wetin u go do nw, abi na so your 5k go go?
Me: o boy, i taya.
Padi me: make we go report to NATURE{oga awon agbero}.
Me: wetin we go tell nature, who we go tell nature say attack us?
Padi me: ah ah, u no sabi that guy wey search me?
Me: i no too see im face, who im be.
Padi me: dat na AWONBIOWO {one popular agbero for our area}
Me: ah.....na bros dey do dis kain thing? Na wa o. Na where we fit see nature dis early mo mo.
Padi me: im go dey OSAS area.

Na so we begin movement things go osas side hoping to find nature.

To be cont........

Am open to corrections.

(1) (Reply)

Stuffs / April 12 Of A Morning Trill / A Poem About Soldiers In Doubts:open To Criticism

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 20
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.