Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,153,424 members, 7,819,534 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 05:41 PM |
Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Aproko Manager (comedy): Experiences Of Solarova a JJC In Lagos (1061 Views)
APROKO MANAGER (comedy): Solarova At UBN. / Aproko Manager (comedy); Solarova At United Bank Of Nevermind (ubn) Part One / Corper Solarova GUNSHOT (2) (3) (4)
(1) (Reply)
Aproko Manager (comedy): Experiences Of Solarova a JJC In Lagos by michesta(m): 7:11pm On Jul 18, 2015 |
Series of Aproko manager comedy can be read at www.michesta.com/category/jokes SOLAROVA DANFO EXPERIENCE IGNORANCE FINISH ME As I write u this night, I am in a state dey call semi-coma. With th situation of thing I no suppose write you but as the aproko manager one of michesta, I must brief you wetin happen and wetin my eye see.Wetin happen be say, I get an official assignment today and I already booked an appointment for 9:00am this morning. As day break, I put on my suit sorry coat after I don wear shirt wey I tuck in. I come crown am with shoe(na sandal i wan wear before Lols). I hit the bus-stop one time. E no suppose dey new to you say solarova na JJC for lagos. E no reach five minutes when a danfo came and the conductor shouting “sango, toll-gate, agbado-ijaye” na inn I whisper meiran, he said “oya wole, N70 “(enter N70) oh boy, see cheap danfo!!! I quickly jumped in and off we go. Zooooooooommmmm na so we reach where I go alight. Meanwhile, other people wey dey alight from thesame danfo wey I enter na on top motion dem dey drop. As e come reach my turn na inn I say make I do like others dey don dey do after all I don spend sometimes in lagos na. Unknown to me, I noticed all the people that alighted before me was running after the danfo like say dem forget something inside am little did I know that they were cooling the pressure of the speed they encountered while alighting. As the conductor shouted “meiran”(telling the passengers than people going to meiran to alight) me sef said “o wa” (say I dey alight o) as usual the danfo was on motion and me ghas alight. I jumped down and wanted to start walking forgetting I should cool the speed by running a bit before walking. My dear, I no open eye until now since around 8:45am. U dey asking me wetin happen I no know too o, but right now my uncle is eating pounded yam with chicken laps and na koko(pap) me dey drink. Wondering why My jaw has broken!!! 1 Share
|
Re: Aproko Manager (comedy): Experiences Of Solarova a JJC In Lagos by Behira(f): 9:16pm On Jul 24, 2015 |
Wowww i cant stop laffing....dis is super funny. 1 Like |
Re: Aproko Manager (comedy): Experiences Of Solarova a JJC In Lagos by dododawa1: 9:00am On Jul 25, 2015 |
It happen to me self 1 Like |
(1) (Reply)
Check Out This Wedding Pics(photo) / The Strangest Birthday Gift [comedy Skit] / There Are 2 Things Involved
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9 |