Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,565 members, 7,820,038 topics. Date: Tuesday, 07 May 2024 at 08:52 AM

Chai!!! 'monkey' Fall From Palm Tree,break Spinal Cord Bicos Of N300 - Celebrities - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Celebrities / Chai!!! 'monkey' Fall From Palm Tree,break Spinal Cord Bicos Of N300 (1682 Views)

Dj Spinal Brags About His Nigerian Passport [PICS] / Yvonne Chai Saung-Wang And Oge Okoye Feature In Nollywood Film / See How Rita Dominic Showed People That Have Spinal Cord Injury Love(Pics (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Chai!!! 'monkey' Fall From Palm Tree,break Spinal Cord Bicos Of N300 by AKPOSbaba: 11:41am On Jul 21, 2015
For Mkpuma Agbaja in Izzi local government of Ebonyi State last weekend,
one bobo, Mr Egede Nwofe, wey he nickname na 'monkey'
fall from palm tree and break him spinal cord.
Akordin to Mr Nwamimi Okwuta, di man wey get di palm trees,
he say for di past five years naim he don dey hire Nwofe to
helpam harvest palm fruit and dat kain tin neva appun bifor.
Wen tori pipo carry waka enta dia village go hear from dem,
Mr Nwofe yarn say, di money wey him dey make from di palm tree climbing,naim he take dey feed im family.

He say na N500 him dey collect for tall palm tree and N300 for short one.
For dat day, Mr Nwofe don alreadi climb three trees.
He say as he dey climb di numba 4 tree,naim him bodi start to dey shake like shakespeare, Cold kon enta him.
Bifor he say Jesus! him don reach ground break him spinal cord.
Spinal cord wahala no be small pikin problem.
We wisham goodluck as he dey recover.

SOURCE.....http://ogakpatakpata..com/2015/07/monkey-fall-from-palm-treebreak-spinal.html

Re: Chai!!! 'monkey' Fall From Palm Tree,break Spinal Cord Bicos Of N300 by Swaggzkid: 11:48am On Jul 21, 2015
Ok abeg op helep me telliam solli .

Lwkm
Re: Chai!!! 'monkey' Fall From Palm Tree,break Spinal Cord Bicos Of N300 by kossyablaze(m): 12:00pm On Jul 21, 2015
Ok o

3 Likes 3 Shares

Re: Chai!!! 'monkey' Fall From Palm Tree,break Spinal Cord Bicos Of N300 by Eliza5050(f): 2:02pm On Jul 21, 2015
Lol Wahala dey

(1) (Reply)

PHOTOS: Patoranking Poses With His New G-wagon / 9 Of The Worlds Most Luxurious Houses / Photos Of Nollywood Actor Kenneth Okonkwo And His Sisters At Enugu High Court

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 8
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.