Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,194,837 members, 7,956,156 topics. Date: Monday, 23 September 2024 at 06:04 AM

**must Read****fulani MAN WICKED ? - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / **must Read****fulani MAN WICKED ? (674 Views)

Fulani Man Threatens Nigerians Wishing For Buhari's Death / "My Heritage Is My Pride" -Fulani Man Says As He Shares Photos Of His Cattle / Fulani Man Wicked - Buhari Must Go!!! (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

**must Read****fulani MAN WICKED ? by Ajagunhope: 7:36pm On Aug 02, 2015
FULANI MAN WICKED
BUHARI MUST GO!
Make una hear this tory wey i wan yarn
Fulani man is wicked. Buhari must go.
In fact, i regret voting for you Buhari.
In less than three months, your cup don full
And i will lead a campaign against you.
Now, who told you we are tired of blackout?
Without revival, NEPA don born again!
My fridge dey work, TV dey work,
As dem dey work all the time dem fit spoil!
My generators don retire, dey gather dusts.
I nor even know where my jerrycans dey sef
Filling station attendants no see person give dem
N20, N50 bribe again.
Buhari see yoursef? Who send you message?
Warri and Port Harcourt Refineries don dey work
Kaduna Refinery too go soon join.
So wetin go happen to our darling oil cabals
Wetin go sele to the subsidy regime?
If u get liver, try d cabals if we no go para!
Abi you no know say dem be saints?
Cockroach too dey enjoy Awilo music o,
Na fowl no allow am commot kon dance!
Our Otuoke brother say Stealing no be corruption.
Daura man say stealing na corruption.
Buhari, abi you chop winch?
PhD for Zoology dey talk
You common WAEC dey blow grammar
Ok, before you go far, show me your certificate
Show me where e dey for Koran say stealing is
corruption.
You see say this Fulani man no serious at all!
Walai Buhari, your fowl nor fit do nada
For corn wey dey inside bottle!
Also you no allow your wife chop Nigeria money.
How monkey head be wey gorilla own no be?
Every first lady chop Nigeria money.
Maryam Babangida chop. Maryam Abacha chop!
Stella Obasanjo wak. Turai sef lick!
And ...and Dia is Godu o even chop, shit for bodi!
Make your wife chop her own, you say no.
Fulani man wicked. You must go.
Bekos na only you waka come!
Who send you message go NNPC?
Now we dey hear how billions upon billions waka
This one wey you start
You go know say kerosene no dey sleep
Buhari nearly destroy our churches
Your elections kon show us say
Some prophets and pastors are liars
Some be original chop and quench!
Some be original chop and clean mouth!
Dem say God TOLD dem say Buhari go lose
How dia own god sabi blow lie i no sabi!
Buhari!
Buhari!
Buhari!
How many times i call you?
You go hear gburugudu gburugudu gburugudu
today!
No be how dem dey take chop corn
Dem dey take chop groundnut o!
You no get ministers, Nija still dey work
EFCC don wake, thieves dey enta admission!
Subuanalai, we don taya for you. Kon dey go.

This Fulani man till 2019
Re: **must Read****fulani MAN WICKED ? by Nobody: 7:38pm On Aug 02, 2015
Slave

Re: **must Read****fulani MAN WICKED ? by Nobody: 7:47pm On Aug 02, 2015
Very creative.
Re: **must Read****fulani MAN WICKED ? by ESHOIZA: 8:32am On Aug 03, 2015
ℓ̊ give U̶̲̥̅̊ hand jor

(1) (Reply)

Emperor of Country Of Western Nigeria Is The 4th Most Populated Africa Country / Troops Kill Eight, Arrest Boko Haram’s Fuel Supplier / BOOK: Nigeria Must Be Divided And Biafra Must Stand

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 23
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.