Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,770 members, 7,955,942 topics. Date: Sunday, 22 September 2024 at 07:14 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Travel / Some Funny Slangs Used In Warri (95555 Views)
14 Funny Lagos Traffic And Auto Slangs With Their Meanings / Slangs Used In Portharcourt / Top 10 Lagos Slangs You Must Know As A Resident (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (Reply) (Go Down)
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Etizz: 3:29pm On Oct 29, 2015 |
eterisan: Real old warri, I think say na English u won take tell me sef..... Correct. 1 Like |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by daxlasaint(m): 3:34pm On Oct 29, 2015 |
chrisbaba1:my life dey pain them |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by oshe11: 3:35pm On Oct 29, 2015 |
Goodboiyy:kpoko 4 U YOUR TEETH COMPLETE |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by LKO(m): 3:36pm On Oct 29, 2015 |
TellingItAsItIs: SADDIST. Which one ur people sabi? 1 Like 1 Share |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by daxlasaint(m): 3:43pm On Oct 29, 2015 |
All die na die... When a warri boy makes up his mind to do something dangerous no matter the consequences Na who die nai lose... When a brother gets himself killed cos he refused to listen to advice Fly, e.g. wer u fly comot here... rude way of saying get out! |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by fratermathy(m): 3:44pm On Oct 29, 2015 |
Goodboiyy: Confam matters! Twale for Ose! |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by ruffcoin99(m): 3:45pm On Oct 29, 2015 |
However una still be JJC for lagos anytime wey una enter. |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by daxlasaint(m): 3:45pm On Oct 29, 2015 |
TellingItAsItIs:jealousy is allowed... neck go pain you for hawe mata o... make u nor kpro for wer contain u |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by daxlasaint(m): 3:46pm On Oct 29, 2015 |
ruffcoin99: Wer u yarn well o, make we nor change am for you o |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 3:47pm On Oct 29, 2015 |
LKO:Things that actually benefit them. Use slang collect money for bank na,mtshew. |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Joe82834(m): 3:50pm On Oct 29, 2015 |
warriboy21: Correct. Brotherly no be say i de cast u o but based on tradition, make i chip in one or two matters. Chip in :- means to contribute Based on tradition :- what is expected or as it normally happens Cast:- can also be used to explain when something is exposed or sm1 is disgraced. e.g o boy that parols don cast. Guy as dem question that muchi he just cast d whole marra. Marra:- same as matter. 1 Like 1 Share |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by fratermathy(m): 3:54pm On Oct 29, 2015 |
warriboy21: Cast also means someone that is notorious or has made a place notorious. e.g Freemanan don cast everywhere for Nairaland. 1 Like 1 Share |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by daxlasaint(m): 3:58pm On Oct 29, 2015 |
Joe82834: Based on tradition for the deep waff lingo na 'based on based' |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by slimmyjimmy(m): 4:08pm On Oct 29, 2015 |
wtfCode: |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Okiemuteomos(m): 4:29pm On Oct 29, 2015 |
[color=#990000][/color]Na okpokpis my guy okpokpis |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by LKO(m): 4:31pm On Oct 29, 2015 |
TellingItAsItIs: Proudly tell us who ur people are and what they are known for? Go get a life. Mtcheeeeeeeeeeeew. Proudly a Warri boy. |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Kkmola(m): 4:50pm On Oct 29, 2015 |
Akpola!comot ur leg 4 wire!.who knw dis 1 na rili wafi niga 1 Like |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by benjamin007: 5:07pm On Oct 29, 2015 |
Park well,-take it easy DEY YOUR LANE;- mind your business YOU TOO DEY SHOWYOURSELF;-- too proud 1 Like 2 Shares |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 5:08pm On Oct 29, 2015 |
fratermathy:Hehehehe These boys! I dey fear una! |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by rockafela(m): 5:23pm On Oct 29, 2015 |
Old warri I hail! Green- 20 naira Blast- eat, slap Crash- sleep O'boy your mouth big, ur teeth complete- (Lagosians-OLENU)..meaning u re mouthed Gbege- problem No level -no wahala Oboy eh Don cast.-there's problem Sky-50 naira Gbaga, -run Kpoof -die Mara- mad ...let me stop here else I will continue till tomorrow. Warri I hail, Warri capital of the world. |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Cvesta(m): 6:16pm On Oct 29, 2015 |
Henrypraise: |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Roh50(f): 6:19pm On Oct 29, 2015 |
Area, I just dey laugh as I dey read this thread. Meeeeen, Wafi, correct no be small. Anyway sha, ogoro must jump. Wafi, I dey hail o. 1 Like |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by eterisan(m): 6:25pm On Oct 29, 2015 |
Area.. Mek una help me... As i de waka pass agbasa bridge ystdy nyt base on say i go block ma smally naim all dose bois wey de para wey nor get joy pina my ofor.. I wan go track them with ma guys o.. Bt base on say kpokpo de parol d ewo i jus say mek i pin. Noty spoil sha. Dem nr reach... Who fit write this story for english? 1 Like 1 Share |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by jey4all(m): 6:39pm On Oct 29, 2015 |
Henrypraise:. e clear say u be full wafarian. make dem gbes for u. |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by benchosky(m): 7:09pm On Oct 29, 2015 |
Hhahahhhah!!!! Dem full dae pour!! Dats d girls over plenty lordhugo: |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by hebenezher(m): 7:27pm On Oct 29, 2015 |
daxlasaint:geez! obonte dey crack, Alaye jew. na me you dey follow yarn o.t? H.S name "omoeleye" flying ibaka iya next still never collect am finish... e get as end be and e be as e get.... bros, come live for my area " bariga " there you know ruggedity and cap garri rice.. selense flat man |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Pabloairmar(m): 7:31pm On Oct 29, 2015 |
lemme add mine as per say worry boi
shine Congo=Bleep pussy
guy we get alignment=guy we get things to talk on
guy nor dea cari-talk oh=guy nor dea talk anyhow oh
how yr Mara b=how u dea
how yr skirt=how ur girlfriend
I don try abi? |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by JeffreyJamez(m): 7:34pm On Oct 29, 2015 |
SapeleWater: Una forget to add HeadBurn - I'm broke |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by efemena22(m): 7:43pm On Oct 29, 2015 |
Khd95:who be dis guy? Lagos slangs dey learn for Waff own dey nau. The Op nor try sef |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by daxlasaint(m): 7:55pm On Oct 29, 2015 |
hebenezher: Opportunity to spread your wings and rant o.t... use am well but nor come igbudu... na. Small pikin of like 15 or 16 yrs go run your mata... No case.... as for weda. I. Be jew or not....observation nor be carry talk for public forum 1 Like |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 8:25pm On Oct 29, 2015 |
AREA! Na blood e dey.. I dey feel ona, e nor easy.. Warri nor dey kari last, ona wan make me kari last for this thread o.. Well, at all at all na winch.. ma stil drop make e for nor loss Cut Chain - Angry (e.g. Bob! My chenkel cut chain follow me wen she observe dat text o) If at all - At least (e.g. Bros, if at all make H drop na) Skull dey peel - Very hungry (e.g. Guy, ur pot get joy? My skull dey peel o) Head burn - Broke (e.g. Efe, my head burn o..) I dey observe my period - I'm broke (e.g. Ejiro, no levo for d now, I dey observe my period steady) Old boy - Dad (e.g. Rukevwe, your old man dey coast?) Sist - Sister (e.g. Sist, make dem bless me with green na) Taban - Spoilt (e.g. Bob! Dis banga soup don taban) Gbege - Chaos (e.g. Guy! nor dull o.. Na gbege before settlement win am o) Coast - House (e.g. Oniovu, ma shuk head for my coast na) Remove - Leave (e.g. Okoh! I lyk remove abeg) Press - Chill (e.g. Goodboiyy, make dem forget sky for ur boy pocket make e take press na) Mukite - Novice/Fool (e.g. Freemanan na mukite abeg) Legbere - Weak (e.g. Free dat guy, na proper legbere) Income - endowed (e.g. O bob! See as Onome back and front income anyhow) Nack teeth - Argue (e.g. Onuwaje, nor too nack teeth with rapmoney eh.. D guy teeth to complete) Your teeth complete - You are mouthed/relevant (e.g. Tonyebarcanista teeth complete unto political marras) Show me love - Give me (e.g. fratermathy, make dem show me love with sky na..based on based) Based - Acknowledgement (e.g. Bros, ma near u na.. Based on who u be) Gbaga - to leave hurriedly (Guy, men gbaga anyhow when gbege surface Angle 90 na) Day don old abeg.. Ma jur press am here, cos if dem free me ehn, I go use one hand clap based on who I be for Alaka.. Abeg make ona fire down.. na we way o! no falling of hand, na mind, nor be size if na lie ask dem 4 area AREA!! 1 Like 1 Share |
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by oviejnr(m): 8:27pm On Oct 29, 2015 |
Area, Who no knw make he knw. Warrrrrri, der fada! |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (Reply)
Meet 22-Year-Old Lexie Alford Who Has Travelled To Every Country In The World / Is Life Abroad Worth The Stress And Hype? Memoirs Of A Naturalized Immigrant. / The Strid At Bolton Abbey In UK Is One Of The World Most Dangerous Places (Pix)
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 66 |