Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,898 members, 7,817,654 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 04:23 PM

Some Funny Slangs Used In Warri - Travel (5) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Travel / Some Funny Slangs Used In Warri (93195 Views)

14 Funny Lagos Traffic And Auto Slangs With Their Meanings / Slangs Used In Portharcourt / Top 10 Lagos Slangs You Must Know As A Resident (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (Reply) (Go Down)

Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 8:30pm On Oct 29, 2015
ALKARULEZZ:

Mukite - Fool (e.g. Freemanan na mukite abeg)

AREA!!
grin

1 Like 1 Share

Re: Some Funny Slangs Used In Warri by slimfresh(m): 8:30pm On Oct 29, 2015
Ok na dis one wey all of una dey spit waffi lingo........CAN SOME ONE TRANSLATE THIS CONVERATION

teacher: good morning stupid stubborn class
Class: good morning unco God bless not you very much sir
Teacher: what! In my class?
Oworitapko: wetin be what? Wetin be wetin uno? Wetin be what?
Teacher: oworitapko who made you head of this class?
Oworitapko: Oruwe! Area!
Class: hee!
Oworitapko: I sey area!
Class: hee!
Oworitapko: nor be dis small class wey you see unco? Lockup, I sey lockup.
In fact as you see me so I don spread class ur major activities for apian way
Teacher: apian what?
Oworitapko: shotopu urugbulue! yeye Tisha wey dey tish us nonsense.....after u don tish us to be beta beta students sey we future go be like treasure, you go pianti enta area go dey flenjo rag na measure for oshopo kona you nor dey feel me so? Wey u dey take choko, vegetable grass bah? Gbana, moinmoin and moroko...Tisha! I say lockup u dey fuckup.
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by acada111(f): 8:58pm On Oct 29, 2015
Henrypraise:
In warri slangs ar made everyday n most tyms a particular word is used for so many tins depending on d discussion @ hand. E.g Congo.

Congo (wit stress on d "go"wink means soldier. Oboy discharge Congo de area o. (telling ur guy to escape, soldiers ar in d environment)

Congo (wit stress on d "Con"wink means pusi.
I polish shege commot from Sandra Congo ytday. (I had rough sex wit sandra)

N to correct an impression, most of des warri slangs ar not used by thugs or touts or miscreants. It's used by all even in church pastors hu ar born n bred warri use dem. N de can be used codedly to pass out info's. For instance if I say: "Erema sawalele for d ground" only a few persons can decipher

Lol....it means fine chics plenty for the zone.

1 Like

Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 9:22pm On Oct 29, 2015
ALKARULEZZ:
AREA! Na blood e dey.. I dey feel ona, e nor easy..

Warri nor dey kari last, ona wan make me kari last for this thread o.. Well, at all at all na winch.. ma stil drop make e for nor loss

Cut Chain - Angry (e.g. Bob! My chenkel cut chain follow me wen she observe dat text o)

If at all - At least (e.g. Bros, if at all make H drop na)

Skull dey peel - Very hungry (e.g. Guy, ur pot get joy? My skull dey peel o)

Head burn - Broke (e.g. Efe, my head burn o..)

I dey observe my period - I'm broke (e.g. Ejiro, no levo for d now, I dey observe my period steady)

Old boy - Dad (e.g. Rukevwe, your old man dey coast?)

Sist - Sister (e.g. Sist, make dem bless me with green na)

Taban - Spoilt (e.g. Bob! Dis banga soup don taban)

Gbege - Chaos (e.g. Guy! nor dull o.. Na gbege before settlement win am o)

Coast - House (e.g. Oniovu, ma shuk head for my coast na)

Remove - Leave (e.g. Okoh! I lyk remove abeg)

Press - Chill (e.g. Goodboiyy, make dem forget sky for ur boy pocket make e take press na)

Mukite - Novice/Fool (e.g. Freemanan na mukite abeg)

Legbere - Weak (e.g. Free dat guy, na proper legbere)

Income - endowed (e.g. O bob! See as Onome back and front income anyhow)

Nack teeth - Argue (e.g. Onuwaje, nor too nack teeth with rapmoney eh.. D guy teeth to complete)

Your teeth complete - You are mouthed/relevant (e.g. Tonyebarcanista teeth complete unto political marras)

Show me love - Give me (e.g. fratermathy, make dem show me love with sky na..based on based)

Based - Acknowledgement (e.g. Bros, ma near u na.. Based on who u be)

Gbaga - to leave hurriedly (Guy, men gbaga anyhow when gbege surface Angle 90 na)

Day don old abeg.. Ma jur press am here, cos if dem free me ehn, I go use one hand clap based on who I be for Alaka..

Abeg make ona fire down.. na we way o! no falling of hand, na mind, nor be size if na lie ask dem 4 area

AREA!!

Guy you too much.. asin you murder me for the slangs sha.. u they represent.

1 Like 1 Share

Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Rapmoney(m): 9:53pm On Oct 29, 2015

Area, I hail you! Deh say if fish dor too tay for river, deh go call am juju!!! grin

1 Like 1 Share

Re: Some Funny Slangs Used In Warri by seagulsntrawler: 10:02pm On Oct 29, 2015
I spent some months in Delta state between 2002 and 2003 and it was indeed a memorable experience. I really found slangs used by drivers and conductors very funny and amusing. E.g
Conductor: Guy,when you reach Beeland make you anchor there.
Driver: ok
Conductor: Abeg flash me sky there.

Don't know how popular the slang below is:
Armed Robber: Guy, if you nor run, I go light you!!!
gringringrin

1 Like 1 Share

Re: Some Funny Slangs Used In Warri by raywise17(m): 10:44pm On Oct 29, 2015
Warri get slang pass any part of nija so tey if u dey gartherin wey ur friends no dey u no go understant 1 single tin....to have sex in warri mean quash or bourging or enjoymenr...while chele or dicharge me run.
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 11:18pm On Oct 29, 2015
Goodboiyy:

Am not comparing Warri with Lagos.. Every City has its own unique way of Life.. Comparing Lagos and warri is like Comparing Male/female ..

nor play with warri boys oo.. grin

Kpoko for you.your teeth complete,u noh get ebeke.This guy noh sey Warri noh dey carry last.
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 11:20pm On Oct 29, 2015
Rapmoney:
Area, I hail you! Deh say if fish dor too tay for river, deh go call am juju!!! grin

I dey feel ur marra dye

2 Likes

Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 11:31pm On Oct 29, 2015
Demigods:

I rep warri

Oh boy le,ur teeth complete o.u really enter class that year.u noh play skilolo when teacher dey teach.

For the marra,all the Orphorpise( wizo) when dey reason our marra their fuel go finish this nite as dem dey fly their groundnut kanda.Because Baba God pass them.

Make I go corky for my bed.
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Tcapello: 11:45pm On Oct 29, 2015
Haven stayed in lag, warri and now pH...I can confam DAT waffi slang mk brain pass
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Jennifer89(f): 4:48am On Oct 30, 2015
Anyhow ogoro must jump!
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 7:44am On Oct 30, 2015
DBriteLitehouse:

Oh boy le,ur teeth complete o.u really enter class that year.u noh play skilolo when teacher dey teach.

For the marra,all the Orphorpise( wizo) when dey reason our marra their fuel go finish this nite as dem dey fly their groundnut kanda.Because Baba God pass them.

Make I go corky for my bed.

Loooooooooolzzzzzzzzz confirm issue, I pray baba God continue they giv ur head more oil o, strs no easy.
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by rockafela(m): 8:04am On Oct 30, 2015
eterisan:
Area.. Mek una help me... As i de waka pass agbasa bridge ystdy nyt base on say i go block ma smally naim all dose bois wey de para wey nor get joy pina my ofor.. I wan go track them with ma guys o.. Bt base on say kpokpo de parol d ewo i jus say mek i pin. Noty spoil sha. Dem nr reach... Who fit write this story for english?

TRANSLATED:
I was passing thru agbasa bridge last nyt on. My way to see my girlfrnd, the angry area boys. Apprehended me and snatched my phone, on my way back with my friends to collect it I discovered there are policemen arooundd so I decided to wait but all Thesame no problm.
END

BTW I found out many pple on the thread were speaking urhobo and isoko sayin it's slangs abeg una make una nor change am for us.

2 Likes

Re: Some Funny Slangs Used In Warri by eterisan(m): 9:24am On Oct 30, 2015
rockafela:

TRANSLATED:
I was passing thru agbasa bridge last nyt on. My way to see my girlfrnd, the angry area boys. Apprehended me and snatched my phone, on my way back with my friends to collect it I discovered there are policemen arooundd so I decided to wait but all Thesame no problm.
END

BTW I found out many pple on the thread were speaking urhobo and isoko sayin it's slangs abeg una make una nor change am for us.
wink

guy u tyt pass kpeku shell wey close. Noty does u
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Lovechyld101(m): 11:32am On Oct 30, 2015
Warri slang no just sweet sounds like nursery rhyme !!!
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by marcondo13: 7:40pm On Oct 30, 2015
Area,kpafiondo for una! I dey feel una. Shuo, na Nairaland be this? Where una dey since sef? All of una just chuck in for one corner since!
I just wish say Errigga or Shaun Bebe dey Nairaland,make him come blow our heads with some lyrics wen dirty pass the pocket for jazz man skirt!
Abeg,make I save my battery cos no light for my cahbam!

1 Like

Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 9:26pm On Oct 30, 2015
Demigods:

Loooooooooolzzzzzzzzz confirm issue, I pray baba God continue they giv ur head more oil o, strs no easy.

Like this like this,this your prayer come at the right time.E be like sey u be Bishop of the world pastor o.This prayer just ginger my spirit o.
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 9:29pm On Oct 30, 2015
marcondo13:
Area,kpafiondo for una! I dey feel una. Shuo, na Nairaland be this? Where una dey since sef? All of una just chuck in for one corner since!
I just wish say Errigga or Shaun Bebe dey Nairaland,make him come blow our heads with some lyrics wen dirty pass the pocket for jazz man skirt!
Abeg,make I save my battery cos no light for my cahbam!

I dey feel you brotherly.BEDC marra tire person o.

Like this like this ehen,I dey enter Baba God cahbam to give am some kiromomo steps.you know every.make e for noh lost,this hosanna night marra dey take place for all Winners Chapel branches worldwide.

Area! kpoko for all of una for NL.all of una teeth complete,e noh get ebeke.
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 11:34pm On Oct 30, 2015
DBriteLitehouse:

Like this like this,this your prayer come at the right time.E be like sey u be Bishop of the world pastor o.This prayer just ginger my spirit o.

Carry on, nothing do you my guy.

1 Like

Re: Some Funny Slangs Used In Warri by fratermathy(m): 12:47am On Oct 31, 2015
daxlasaint:
Na from clap dem take dey enter dance... if you don't watch it you may go further than you planned

Fire down... You good to go

look a pass... over look

Catch... e.g. We go dey catch na ( we'll see again)
If if I catch you ehn...( if I see you or get ahold of you)

Oya teh me say waffi nor get confirm yarnings na grin grin grin

Waff boi till I die cool

Na so ose.

Follow me Waka, follow me Waka naim slave trade take start.
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by daxlasaint(m): 9:34am On Oct 31, 2015
fratermathy:

Na so ose.

Follow me Waka, follow me Waka naim slave trade take start.

This one good, this one good naso craze man take dey gather load grin

2 Likes

Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 9:44am On Oct 31, 2015
daxlasaint:

This one good, this one good naso craze man take dey gather load grin
Love ur neighbour as yourself nai make Papa Rukevwe get 20 wives today so

2 Likes 1 Share

Re: Some Funny Slangs Used In Warri by daxlasaint(m): 12:19pm On Oct 31, 2015
ALKARULEZZ:
Love ur neighbour as yourself nai make Papa Rukevwe get 20 wives today so

Nobody dey fear juju wen dem dey use water serve...

Before juju enter shrine back e must tear clothe... grin

1 Like

Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 1:02pm On Oct 31, 2015
daxlasaint:

Nobody dey fear juju wen dem dey use water serve...

Before juju enter shrine back e must tear clothe... grin
Them dey pursue fine animal enter bush, Pig say na because him dodge, naim make them nor catch am
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by fratermathy(m): 1:42pm On Oct 31, 2015
ALKARULEZZ:
Them dey pursue fine animal enter bush, Pig say na because him dodge, naim make them nor catch am

Temper hot, tempter hot; make dem use am boil rice.

Fly when de dodge flying bullet, who get house na broom e go use kill am.
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 2:14pm On Oct 31, 2015
fratermathy:

Temper hot, tempter hot; make dem use am boil rice.

Fly when de dodge flying bullet, who get house na broom e go use kill am.
them no de find virgin for maternity ward

1 Like

Re: Some Funny Slangs Used In Warri by daxlasaint(m): 2:52pm On Oct 31, 2015
ALKARULEZZ:
Them dey pursue fine animal enter bush, Pig say na because him dodge, naim make them nor catch am

For inside pot wen beef day kpomo dey count e sef as oga....
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 3:08pm On Oct 31, 2015
daxlasaint:

For inside pot wen beef day kpomo dey count e sef as oga....
to worwor nor be old age

Over-familiarity nai nor dey make man chop house-rat
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by fratermathy(m): 3:19pm On Oct 31, 2015
ALKARULEZZ:
to worwor nor be old age

Over-familiarity nai nor dey make man chop house-rat

Na pickin when nor know e mama boyfriend de call am uncle.

Na only ogbori go compare fish teeth and nama yansh
Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 3:43pm On Oct 31, 2015
fratermathy:

Na pickin when nor know e mama boyfriend de call am uncle.

Na only ogbori go compare fish teeth and nama yansh
Na Help when dem tell water make e help boil meat na im e take turn to soup

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (Reply)

Dead Bodies From The Helicopter Crash In Lagos (Photos) / US VISA LOTTERY,DV-2014 Program-online Registration! / The Kainji Dam In Pictures

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 54
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.