Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,454 members, 7,819,666 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 08:18 PM

Why Baba Polina No Dey Do Hunter Again - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Why Baba Polina No Dey Do Hunter Again (1464 Views)

Awaken: Divine Hunter / Why Baba Polina No Dey Do Hunta Again. / Mask Hunter (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Why Baba Polina No Dey Do Hunter Again by PapiWata: 9:11am On Dec 06, 2015
E been get one man when I know, wey hin name be Baba Polina, and before-before, dat man no get any work pass to dey carry shaka-gbula cap-gun and cutlass, and hunter-light enter bush, begin dey find meat dey go.

If na monkey o, Baba dey kill dem full two bag self. If na snake Baba meet for road, one-two, Baba don take cutlass kill am put for bag. Both grass-cutter, antelope, bush pig, together witii all that biggi-biggi bad-bad meat dem, when sabi fight well-well, no one when Baba Polina no dey hamma, unless him no see gun-powder and cap buy for him gun, or him no see carbide buy for the hunter-light wey him dey take see meat dem eye for night.

Sometime Baba Polina go enter bush from here, dey follow monkey gang, as dem dey wakka for up-up, on top big-big stick. As Baba sabi road reach for inside that bush, e get as he dey pass corner-corner for inside bush go for front, go doublecross the monkey dem for where dem nogo expect, come take eye find the one when big pass, to fire am. If Baba enter bush for one town, so-so wakka-wakka fit carry am sotaaaay, go bust out for another far village the second day, before he go come from there collect him meat and enter Okada luxurious charter motorcycle, when go carry am come back for him house.

Anyway, one day be one day wey Baba don take style go hide before daybreak under one big stick when pelenty monkey dem dey tanda sleep for night. Baba plan say when day break finish, wey de monkey dem go begin dey play, dey find chop for up, him go come get chance to look dem well-well, until him fiti take eye see the BIG monkey wey go be dem Area Fada, dem Oga Pata-Pata.

All hunter know say as monkey gang dey follow demself dey wakka plenty so, na only ONE monkey when biggi pass all of dem, na him dem go vote put for Director General of Monkey, for that area. Now, as Baba dey do softly dey study all de monkey dem for that daybreak, dey find that big man own when be dem Oga, na from there kata-kata come jam, lie no good.

You see the leg when Baba take climb one palm-tree wood when dey for ground like this, say make him stretch him neck, to get chance see the monkey dem well-well ? Na so that palm-tree wood just bust GBUAMM, because Baba no look the wood well before he take leg mach am, to take know say big hole don dey for inside that wood.

As the wood broke and carry Baba Polina fall down GBIII for inside potto-potto, na so honey-bee dem, PLENTY, justo wake up and bust out YAKATAAA for inside the hole when dey inside that palm-tree wood. Baba say make him quickly stand up and begin dey run 440, but as him start to run, the cutlass when him tight put for trouser come go hook one bush rope and carry Baba fall down again, GBRAGADAMMM. Na that time the honey-bee dem come face Baba Polina witi fight, begin dey take vex bite am for head, bite am for yansh, bite am for belle, sotaay Baba no even know the time when he throway him cap-gun and commot him trouser together with the cutlass, come wear only him tear-tear pant, take am dey run for inside swamp, dey halla say I beg o, I beg, I nogo do so again.

As fear don kuku scatter Baba Polina head reach that day, he no remember say the run wey him dey run go carry am jam one biiigi river for front, when deep well-well. The next thing, Baba take full speed go jump inside the river, JUUWAAAA, come begin dey drinki wata, dey shout say God I beg, today own don do, helep me God, if I commot this one, I nogo do hunter again. I beg ooooo helep me. I no sabi swim.

God so kind that day, because Baba Polina him second, when follow am go hunter bush that day, come begin dey hear how as Baba dey halla from faaaar away, and from there manage rush go near the river in time, to come see how as Baba dey fight GBUA-GBUA for inside water, dey cry like small pikin say him no wan die today o. From there Baba second come follow cut one heavy stick fall for inside water, before Baba hold the stick come see chance commot for the river.

And so, because of this ‘tory when I come nak here today, you self go know say if ya wakka-wakka carry you jam Baba Polina for this life, NO mistake go ask am why him no dey do hunter again o. Me I don talk my own. E get as e be.

1 Like

Re: Why Baba Polina No Dey Do Hunter Again by sugarcanelove: 9:48pm On Dec 06, 2015
PapiWata:

Re: Why Baba Polina No Dey Do Hunter Again by PapiWata: 12:26pm On Dec 12, 2015
IF una no hear broken reach to read all wettin I write for here, find ya way go for Warri main garage, ask for AWOOF MASTER, pay ya money, and from there den go teach you ALL broken language finish, wey be say you go come fit read all this my 'tory here, easy.
Re: Why Baba Polina No Dey Do Hunter Again by okwabayi(m): 12:46pm On Oct 13, 2018
Jakumo's second account?

(1) (Reply)

Join World Readers' Club / What I Want In A Woman / An Excurpt Of Chinua Achebe's "There Was A Country"

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 33
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.