Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,653 members, 7,813,203 topics. Date: Tuesday, 30 April 2024 at 08:37 AM

Wetin Nepa Don Do Person For This Country Wey We Dey - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Wetin Nepa Don Do Person For This Country Wey We Dey (1343 Views)

#na The Matter We Dey Settle Since! / Serious Matter Wey We Dey Settle For My Compound Since Yesterday / Na The Matter We Dey Settle. (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Wetin Nepa Don Do Person For This Country Wey We Dey by OBAUX01(m): 2:13pm On Nov 15, 2016
I remember those days when we dey go our neighbour window make we for see television watch, that brother na Bachelor, he no dey allow us come inside so we go just dey sneak go im window, if I tell una wetin this Brother do people our street because of ordinary Black and white tv, una go say na lie so make i talk am today... Finally my papa come hustle, save buy one TV, he even buy that multiple colored glass wey dey make the pictures colored, una remember that glass? Okocha's head fit be green, his stomach yellow and his legs blue, that glass dey turn people to chameleon i swear.. As my father buy this Tv, chai we cook rice call party, we even carry am go church go dedicate, We come dey wait make Nepa bring light make we begin flex am, you know that kind anxiety nah, Few minutes Up Nepa!!!!!!!!!! My father was outside, the speed he take rush, Usain bolt no fit match am, As he plug the Tv, Nepa take light.. Devil is a Liar!! My father no gree comot again, all of us just stand there, Nepa must bring this light ooo, as God may have it they come bring am back, this time if you wan shout my father go soo eye you, make e no be the first shout make them take am, so we just dey shout the Up Nepa inside our mind!! As my Papa on am, una know say the thing they open like curtain, e never open finish, Nepa take light again... This happened like 5 more times, we no see light again, One day, 2 days, One week, two weeks Nobody see light, E come be say our transformer don blow, Chai if you see my papa that time you go pity am, Infact if you chew meat and my papa hear the sound, you go explain to am why the Transformer blow, he will whine your ear so much you will start shouting up Nepa, Na so we dey for two months no light... Na my Papa wey no been dey gree pay Nepa bill gather people we come dey go house by house dey collect money make we take repair the transforner... The Money don complete and na Like tommorrow them go repair the light, Na im armed robbers come for night come steal the TV....... My father never recover since that day!!! And Light dey dey steady now!!!

1 Like 1 Share

Re: Wetin Nepa Don Do Person For This Country Wey We Dey by Alexk2(m): 2:31pm On Nov 15, 2016
Op.....i can relate with all that but that your case critical O..chai, .i don laf tire here grin grin grin
Sorry o
Re: Wetin Nepa Don Do Person For This Country Wey We Dey by Nobody: 3:47pm On Nov 15, 2016
Dis tin dey happen o...i remember wen i buy my 1st nokia radio colour screen bodi dey sweet me.dem say make i charge'am 4hrs but nepa no gree bring light if light com 15mins dem don take am...it take me like 1week to charge de fone chai e pain me.if neva get face i for use cutlas cut am

(1) (Reply)

POLICE OFFICERS (mark Angel Comedy) (episode 108) Download / Davido Must See This.. Maybe You Too Want To See It. / My Experience Will Teach You A Lesson..

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.