Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,163,968 members, 7,855,915 topics. Date: Monday, 10 June 2024 at 11:23 AM

Rivers State University Don Start 2017/2018 Post-ume - Education - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Education / Rivers State University Don Start 2017/2018 Post-ume (841 Views)

Osun State University Announces 2017/2018 Post-UTME Screening / University Of Ibadan 2017/2018 Post-UTME Form Is Out. Cut-Off Remains 200 / Rivers State University Cut-Off Mark And Post-UTME Screening Exercise 2017-2018 (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Rivers State University Don Start 2017/2018 Post-ume by NewsinPidgin(f): 12:59pm On Aug 29, 2017
THIS INFORMATION DEY FOR EVERY BODY WEY DEY FIND WAY TO GET ADMISSION INSIDE RIVERS STATE UNIVERSITY FOR 2017/2018 ACADEMIC YEAR

As admission time don near so, Rivers State University don alert every body wey been select Rivers State University as school wey dem choose when dem been write 2017 Jamb, and dem don get alert from Jamb base on dia result and every informate , The school don announce say if you follow for those student make you take this information wey dem give you serious.





The aptitude test wey go take place , e dey for candidate wey take Rivers State University as dia first choice and dem don get alert from Jamb base on dat.
Na only people wey dia result reach 150 or pass 15o for jamb  na im go qualify for this aptitude test for every faculty wey dey inside the school.
 Everybody wey go write this aptitude test, suppose get atleast 5 O'Level credit as dat na standard pattern, base on wetin u suppose get before you enter University. E dey very important make you upload your 0/Level result and scan copy of your passport . Still on still people wey dia result never ready (awaiting result) make dem alert us as dem dey register.
Candidate go register for this aptitude test online , dem go visit the university website www.rsu.edu.ng , come use dia ATM make online payment , or dem fit still pay direct enter bank akant.  The complete money wey you go spend no go pass four thousand , five hundred naira (N4,500)
 Make every candidate sabi say na computer we go use write the aptitude test, e dey important make every body sabi use computer, make dem sabi use mouse and keyboard before dem go come for this screening . Base on dat one , Base on the computer matter, the university computer centre go do one week training so dem fit show candidate how the electronic aptitude test go be.
The registration don start dis monday wey just pass (28/08/2017) and e go end for Friday  8th September 2017.
The aptitude test go start from monday 11th september 2017, come reach friday 22nd september 2017, for inside the school Information Technology Centre (ITC).

Make every candidate sabi say the time, venue and the day  wey dem go write dia exam dey inside the printout wey dem go collect after dem don do online  registration finish.

We no go consider anybody wey no come that day , as the school expect make every body carry dia printout come for the test that day.

We no go allow anybody carry phone enter hall as the test dey go on, as we dey advise make every Mama, papa, sister or uncle no near where we go write the test that day.

Make everybody wey go write the test, showface for the venue 1hour before the time wey the person suppose write.

Any information wey go relate for this Screening , e go dey on our website www.rsu.edu.ng , make you know say every body wey pass dis test, we go publish their name for the same school website (www.rsu.edu.ng)

We dey wish every candidate success .

still on still

Sign

V.T.Jamabo (Mrs)

Ag. Registrar

Further details about the screening exercise can be obtained on-line at www.rsu.edu.ng.
It is important to note that the names of successful candidates for admission shall be
published on the same site (www.rsu.edu.ng.).
We wish all candidates a successful screening exercise.

(Sgd)
V. T. Jamabo (Mrs.)
Ag. Registrar

source: http://newsinpidgin.ng/rivers-state-university-don-dey-sell-aptitude-test-form/

Re: Rivers State University Don Start 2017/2018 Post-ume by sluvy4tune(m): 1:12pm On Aug 29, 2017
So who come be the ASUU people wey dey strike nah



Issokay!!!
Re: Rivers State University Don Start 2017/2018 Post-ume by NewsinPidgin(f): 1:58am On Sep 04, 2017
sluvy4tune:
So who come be the ASUU people wey dey strike nah



Issokay!!!



Federal Government bin don give dem go ahead to continue with d Post utme even as ASUU still dey strike.

(1) (Reply)

Which Of This Is Correct? / Congratulations To All Uniosun Aspirants / Just In : Jamb 2018 Admission Policy Meeting Updates

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 16
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.