Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,839 members, 7,810,223 topics. Date: Saturday, 27 April 2024 at 12:43 AM

Startconfest17: Big Bang 7 Days Tech Event Happening In Uyo - Events - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Events / Startconfest17: Big Bang 7 Days Tech Event Happening In Uyo (490 Views)

Christmas Village Opens In Uyo, 21 Storey Building Light Adds To Allure. Pics / Omoaefe Ejere And Aniekeme Inyang's Traditional‎ Marriage In Uyo. Money Rains! / Top 5 Places To Host Your Tech Event (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Startconfest17: Big Bang 7 Days Tech Event Happening In Uyo by NewsinPidgin(f): 3:07pm On Sep 07, 2017
Base on say our last event been over make sense, Now na 3rd year, The Start Conference Festival #StartConFest don get full ground for national levels as e dey gather people wey get weight , wey be Oga for the industry wey dia heart dey pure for Start-Up Business eco-system for we country. Soak yourself for dis 7 days as you go catch fun, network, Learn and other confam things wey go help you do correct collabo.

We don arrange the program so e go fit ginger to Akwa Ibom reputation as capital of startup for Naija, base on say technology and entrepeneurship paroles dey increase wella , The festival don promise sey e go Provide gingers to Entrepreneurs,Enthusiasts,Students,Corporate Bodies and every body wey go come for the program. As the organizers and partners of #StartConFest don yarn , the festival go bring everything wey go put ginger inside entrepreneurial ecosystem for we country Naija, as e go show plenty talent wey full the state.

E go bring talk wey go ginger you from Oga for the industry, You go still sample your products, Music Performance , Film Screening , Theatre Performances, Spoken Words, Book readings, Daily Fashion shows, Funding Mentorship,Boot Camps, Pitches,Contests & Competitions, talent hunts, games, virtual reality experience , awesome networking platform, one on one yarn with people wey matter, As everything wey you go need go full ground yafu yafu.
Why You Suppose Attend

As the Festival dey go on, you got get opportunity to meet other StartUp from every side, you go learn new things, get certificate, know new things wey dey happen around the world, you go get access to plenty opportunity and follow join mouth sef to everything we go do.
Why You Suppose exhibit or sponsor

Join hand for this Ogbonge Marketing and sales Platofrm wey you go use reach people wey matter to your business, consumers, retailers, partners and people wey fit follow you carry your business go far.You go create brand awareness and get tight relationship with people, Every day. The Gbedu go start from 9am as we go do exhibitions for , Food and Beverage, Health & Lifestyle, Fashion , Education, Technology , Financial Services, Creative industry etc.

E go happen on

Date : Septermber 11th-17th 2017

Uyo, Akwa Ibom

Roothub Accelerator Systems

Roothub Akees Plaza

To attend, volunteer, exhibit or sponsor, visit www.startconfest.com
Tel: 08092427901, 08186420525
Email: info@theroothub.com
facebook,IG, Twitter – @theroothub

#STARTCONFEST17 # BACKTOTHEFUTURE#JOINFORCES# WEARETHEROOTHUB

Source : http://newsinpidgin.ng/startconfest-big-bang-tech-event-uyo/

1 Share

(1) (Reply)

Top Comic Actor, Okon Lagos Stormed Eket For ‘save The Youth’ Conference (pics) / My Birthday / Man Turns Instantly Mad@Stadium By Lying To The HolySpirit in Miracles inCalabar

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.